Mateus 24

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 As Jesus dey komot from di temple, en disciples kon show am how di temple building bi.
1 Tendo Jesus saído do templo, ia-se retirando, quando se aproximaram dele os seus discípulos para lhe mostrar as construções do templo.
2 Jesus kon tell dem, “Una dey si all dis tins? I tell una true word, wen di time rish, one block nor go dey on-top anoda one, bikos di building go skata finish!”
2 Ele, porém, lhes disse: Não vedes tudo isto? Em verdade vos digo que não ficará aqui pedra sobre pedra que não seja derribada.
3 As Jesus sidan for Mount Olives, en disciples kom meet am for korna ask am, “Make yu tell us wen dis tins go happen? How wi go take know sey di time wen yu go kom, don rish?”
3 No monte das Oliveiras, achava-se Jesus assentado, quando se aproximaram dele os discípulos, em particular, e lhe pediram: Dize-nos quando sucederão estas coisas e que sinal haverá da tua vinda e da consumação do século.
4 Jesus ansa dem, “Make una shine una eye, so dat nobody go fit deceive una.
4 E ele lhes respondeu: Vede que ninguém vos engane.
5 Many pipol go kom with my name dey sey, ‘I bi Christ wey bi di Mezaya’ and dem go deceive many pipol.
5 Porque virão muitos em meu nome, dizendo: Eu sou o Cristo, e enganarão a muitos.
6 Una go dey hear rumor sey war dey happen for difren place. Make una nor fear, bikos e must happen, but di time wey I go kom, neva rish.
6 E, certamente, ouvireis falar de guerras e rumores de guerras; vede, não vos assusteis, porque é necessário assim acontecer, mas ainda não é o fim.
7 One kountry go fight with anoda kountry and one kingdom go fight with anoda kingdom. Honga go dey evriwhere and eartkweke go happen for difren place.
7 Porquanto se levantará nação contra nação, reino contra reino, e haverá fomes e terremotos em vários lugares;
8 Wen dis tins go dey happen, e go bi like wen belle dey pain woman wey won born.”
8 porém tudo isto é o princípio das dores.
9 “Dem go karry una wey bi my disciples give pipol wey go sofa and kill una. Bikos of mi, pipol for difren town wey nor know God, go hate una.
9 Então, sereis atribulados, e vos matarão. Sereis odiados de todas as nações, por causa do meu nome.
10 Many pipol nor go gri follow mi again and dem go dey lie and hate each oda.
10 Nesse tempo, muitos hão de se escandalizar, trair e odiar uns aos outros;
11 Many wayo profets go kom and dem go deceive many pipol.
11 levantar-se-ão muitos falsos profetas e enganarão a muitos.
12 Bikos pipol nor go obey God law, di love wey many pipol get for God, nor go strong again.
12 E, por se multiplicar a iniquidade, o amor se esfriará de quase todos.
13 But God go save di pesin wey go bear go rish end.
13 Aquele, porém, que perseverar até o fim, esse será salvo.
14 Before di world go end, my pipol go prish about God Kingdom go rish evriwhere.”
14 E será pregado este evangelho do reino por todo o mundo, para testemunho a todas as nações. Então, virá o fim.
15 “As Profet Daniel tok, ‘Bad tins go happen for di Holy Place, inside di temple’ (Anybody wey hear dis word, make e undastand wetin e mean).
15 Quando, pois, virdes o abominável da desolação de que falou o profeta Daniel, no lugar santo (quem lê entenda),
16 Pipol for Judea go run go on-top mountin.
16 então, os que estiverem na Judeia fujam para os montes;
17 Pesin wey dey on-top roof, make e nor kom down kon take anytin from en house
17 quem estiver sobre o eirado não desça a tirar de casa alguma coisa;
18 and pesin wey dey farm, make e nor go back to en house go take en klot.
18 e quem estiver no campo não volte atrás para buscar a sua capa.
19 For dis time, e go hard well-well for wimen wey get belle and doz wey get small pikin for hand.
19 Ai das que estiverem grávidas e das que amamentarem naqueles dias!
20 Make una pray sey, e nor go bi for Sabat Day or Rainin Sizin naim all dis tins go happen,
20 Orai para que a vossa fuga não se dê no inverno, nem no sábado;
21 bikos for dat time, di sofa wey go dey, go strong pass any sofa wey don happen since wen God kreate di world kom rish naw and dis kind sofa, nor go dey again.
21 porque nesse tempo haverá grande tribulação, como desde o princípio do mundo até agora não tem havido e nem haverá jamais.
22 And if God nor reduce di days wen dis tins go happen, evribody go die finish. But bikos of di pipol wey God choose, e go reduce di days.
22 Não tivessem aqueles dias sido abreviados, ninguém seria salvo; mas, por causa dos escolhidos, tais dias serão abreviados.
23 So if anybody kon tell una sey, ‘Look o-o, Christ dey here or e dey der!’ Make una nor bilive am.
23 Então, se alguém vos disser: Eis aqui o Cristo! Ou: Ei-lo ali! Não acrediteis;
24 Lie-lie messiahs and profets go kom do big-big mirakles take deceive pipol. If e possibol sef, dem go deceive pipol wey God choose.
24 porque surgirão falsos cristos e falsos profetas operando grandes sinais e prodígios para enganar, se possível, os próprios eleitos.
25 Make una remember wetin I dey tell una so, before dem go happen.
25 Vede que vo-lo tenho predito.
26 “So if anybody tell una sey, ‘Look, Christ dey inside bush,’ make una nor go, or ‘Look, e dey inside house,’ make una nor bilive.
26 Portanto, se vos disserem: Eis que ele está no deserto!, não saiais. Ou: Ei-lo no interior da casa!, não acrediteis.
27 Just as tonda lite dey kom from east go west, na so e go bi wen Man Pikin go kom.
27 Porque, assim como o relâmpago sai do oriente e se mostra até no ocidente, assim há de ser a vinda do Filho do Homem.
28 Bikos na where dead body dey, na der vultures dey gada put.”
28 Onde estiver o cadáver, aí se ajuntarão os abutres.
29 “Afta di wahala wey go happen for dat time,
29 Logo em seguida à tribulação daqueles dias, o sol escurecerá, a lua não dará a sua claridade, as estrelas cairão do firmamento, e os poderes dos céus serão abalados.
30 “Den Man Pikin sign go appear for heaven and all di tribes for dis world, go kry. Dem go si God Pikin dey kom from inside di kloud for heaven with pawa and betta glory.
30 Então, aparecerá no céu o sinal do Filho do Homem; todos os povos da terra se lamentarão e verão o Filho do Homem vindo sobre as nuvens do céu, com poder e muita glória.
31 God go send en angels go blow loud trumpet and dem go gada di pipol wey E choose from evriwhere for di world.”
31 E ele enviará os seus anjos, com grande clangor de trombeta, os quais reunirão os seus escolhidos, dos quatro ventos, de uma a outra extremidade dos céus.
32 “Make una hear di fig tree parabol: Anytime en branches dey bring leaf kom out, pipol go know sey dry sizin don near.
32 Aprendei, pois, a parábola da figueira: quando já os seus ramos se renovam e as folhas brotam, sabeis que está próximo o verão.
33 So wen una si all dis tins dey happen, make una know sey di time don rish and e dey near una door-mot.
33 Assim também vós: quando virdes todas estas coisas, sabei que está próximo, às portas.
34 I tell una true word, di pipol wey dey di world for dis time, nor go die finish before all dis tins go happen.
34 Em verdade vos digo que não passará esta geração sem que tudo isto aconteça.
35 Heaven and eart go vanish, but my word go still dey.
35 Passará o céu e a terra, porém as minhas palavras não passarão.
36 “Nobody know dat day or di time, even di angels for heaven nor know am, escept my Papa.
36 Mas a respeito daquele dia e hora ninguém sabe, nem os anjos dos céus, nem o Filho, senão o Pai.
37 Just like e happen for Noah time, na so Man Pikin go take kom.
37 Pois assim como foi nos dias de Noé, também será a vinda do Filho do Homem.
38 For Noah time, before di flood kom, pipol dey chop and drink, dey marry and dey give dia pikin out for marriage, until di day wen Noah enter di ark.
38 Porquanto, assim como nos dias anteriores ao dilúvio comiam e bebiam, casavam e davam-se em casamento, até ao dia em que Noé entrou na arca,
39 Dem nor know wetin dey happen until wota kom karry dem go. Na like dat e go bi wen Man Pikin go kom.
39 e não o perceberam, senão quando veio o dilúvio e os levou a todos, assim será também a vinda do Filho do Homem.
40 Dat time, two men go dey for farm; one go vanish leave di oda one.
40 Então, dois estarão no campo, um será tomado, e deixado o outro;
41 Two wimen go dey grind korn for engine, one go vanish leave di oda one.
41 duas estarão trabalhando num moinho, uma será tomada, e deixada a outra.
42 “So, make una shine una eye, bikos una nor know di day wen Christ go kom.
42 Portanto, vigiai, porque não sabeis em que dia vem o vosso Senhor.
43 But make una remember sey: If pesin wey get house know di time wen tif go kom for nite, e go ready ensef make di tif nor for enter en house.
43 Mas considerai isto: se o pai de família soubesse a que hora viria o ladrão, vigiaria e não deixaria que fosse arrombada a sua casa.
44 So, make una dey ready, bikos Man Pikin go kom for di time wen una nor tink sey e go kom.
44 Por isso, ficai também vós apercebidos; porque, à hora em que não cuidais, o Filho do Homem virá.
45 “Who bi di savant wey wise and good? Na di pesin wey en oga make leader among di oda savants, so dat e go give dem food for di korrect time.
45 Quem é, pois, o servo fiel e prudente, a quem o senhor confiou os seus conservos para dar-lhes o sustento a seu tempo?
46 E go good for dat savant wen en oga go kom back kon si am dey work.
46 Bem-aventurado aquele servo a quem seu senhor, quando vier, achar fazendo assim.
47 I tell una true word, di oga go sey, ‘Make yu kare for di whole house.’
47 Em verdade vos digo que lhe confiará todos os seus bens.
48 But if na wiked savant, e go tell ensef, ‘My oga nor go kwik kom back’,
48 Mas, se aquele servo, sendo mau, disser consigo mesmo: Meu senhor demora-se,
49 so e go bigin beat di oda savants and e go dey chop and drink with drunkards.
49 e passar a espancar os seus companheiros e a comer e beber com ébrios,
50 Wen di oga go kom back for di day wen di savant nor espect and di time wen e nor know,
50 virá o senhor daquele servo em dia em que não o espera e em hora que não sabe
51 e go kut di savant to pieces kon trow am put for where pritendas dey, where e go dey kry and grind en tit.”
51 e castigá-lo-á, lançando-lhe a sorte com os hipócritas; ali haverá choro e ranger de dentes.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 24, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.