Mateus 22

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Jesus kon tok to dem again for parabol sey:
1 De novo, entrou Jesus a falar por parábolas, dizendo-lhes:
2 “God Kingdom bi like wen one king do marriage for en son.
2 O reino dos céus é semelhante a um rei que celebrou as bodas de seu filho.
3 E send en savant go koll di pipol wey dem invite kom di party, but dem nor gri kom.
3 Então, enviou os seus servos a chamar os convidados para as bodas; mas estes não quiseram vir.
4 “Den e send oda savants sey, ‘Make una go tell di pipol wey wi invite sey, “Si! Di party go soon start. I don kill big melu and oda animals and evritin don ready, so make una kom for di marriage.” ’
4 Enviou ainda outros servos, com esta ordem: Dizei aos convidados: Eis que já preparei o meu banquete; os meus bois e cevados já foram abatidos, e tudo está pronto; vinde para as bodas.
5 “But di pipol nor gri listin to wetin di savants tok, instead one go en farm and di oda kon go do en business.
5 Eles, porém, não se importaram e se foram, um para o seu campo, outro para o seu negócio;
6 Di oda one seize di savants, beat dem anyhow and kill some.
6 e os outros, agarrando os servos, os maltrataram e mataram.
7 Di king vex well-well kon send en sojas make dem go kill di pipol wey kill en savants and make dem burn evritin for dia town.
7 O rei ficou irado e, enviando as suas tropas, exterminou aqueles assassinos e lhes incendiou a cidade.
8 “Den e kon tell en savants. ‘Di marriage don start,’ di pipol wey I invite before, nor bi di pipol wey suppose kom.
8 Então, disse aos seus servos: Está pronta a festa, mas os convidados não eram dignos.
9 So make una go di strits and invite evribody wey una si kom di party.
9 Ide, pois, para as encruzilhadas dos caminhos e convidai para as bodas a quantos encontrardes.
10 So di savants go di strits kon gada all di pipol wey dem si, both bad and good, kom di marriage and di hall kon full.
10 E, saindo aqueles servos pelas estradas, reuniram todos os que encontraram, maus e bons; e a sala do banquete ficou repleta de convidados.
11 “Wen di king si di pipol wey kom di party, e kon si one man wey nor wear marriage klot.
11 Entrando, porém, o rei para ver os que estavam à mesa, notou ali um homem que não trazia veste nupcial
12 So di king ask am, ‘My friend, how yu take enter here wen yu nor wear marriage klot?’ But di man nor fit ansa am.
12 e perguntou-lhe: Amigo, como entraste aqui sem veste nupcial? E ele emudeceu.
13 “Den di king tell en savants, ‘Make una tie en hand and leg trow am outside for darkness, where e go kry and grind en tit.’
13 Então, ordenou o rei aos serventes: Amarrai-o de pés e mãos e lançai-o para fora, nas trevas; ali haverá choro e ranger de dentes.
14 “Na only few pipol God choose from di many wey e koll.”
14 Porque muitos são chamados, mas poucos, escolhidos.
15 Den di Farisee pipol komot go plan how dem go take katch Jesus with wetin e go tok.
15 Então, retirando-se os fariseus, consultaram entre si como o surpreenderiam em alguma palavra.
16 So dem kon send dia disciples, with some pipol wey dey support Herod, go meet Jesus sey, “Tisha, wi know sey yu dey tok trut well-well and yu dey tish wetin God wont. Yu nor dey favor anybody, bikos yu nor dey play wayo.
16 E enviaram-lhe discípulos, juntamente com os herodianos, para dizer-lhe: Mestre, sabemos que és verdadeiro e que ensinas o caminho de Deus, de acordo com a verdade, sem te importares com quem quer que seja, porque não olhas a aparência dos homens.
17 Wetin yu tink? E good make wi pay tax give Caesar?”
17 Dize-nos, pois: que te parece? É lícito pagar tributo a César ou não?
18 But Jesus know dia wiked plan, so e kon tell dem, “Una wey dey pritend! Why una one set trap for mi?
18 Jesus, porém, conhecendo-lhes a malícia, respondeu: Por que me experimentais, hipócritas?
19 Make una show mi di money wey una dey take pay tax.” So dem bring di money kom.
19 Mostrai-me a moeda do tributo. Trouxeram-lhe um denário.
20 Jesus ask dem, “Wish pesin face and name dem stamp put for di money?”
20 E ele lhes perguntou: De quem é esta efígie e inscrição?
21 Dem ansa, “Na Caesar own.”
21 Responderam: De César. Então, lhes disse: Dai, pois, a César o que é de César e a Deus o que é de Deus.
22 So wen dem hear wetin e tok, dem kon waka leave am.
22 Ouvindo isto, se admiraram e, deixando-o, foram-se.
23 For di same day, di Sadusi pipol (wey bilive sey resureshon nor dey), kom meet and ask Jesus,
23 Naquele dia, aproximaram-se dele alguns saduceus, que dizem não haver ressurreição, e lhe perguntaram:
24 “Tisha, Moses tok sey, ‘If man wey nor get pikin die, en broda must marry en wife, so dat e go fit born pikin for en broda wey don die.’
24 Mestre, Moisés disse: Se alguém morrer, não tendo filhos, seu irmão casará com a viúva e suscitará descendência ao falecido.
25 Yu si, e get seven brodas wey dey stay here with us. Di first one marry, leta e kon die, since e nor get pikin, en broda kon marry en wife.
25 Ora, havia entre nós sete irmãos. O primeiro, tendo casado, morreu e, não tendo descendência, deixou sua mulher a seu irmão;
26 Di same tin happen to di sekond broda and di third one, go rish di nomba seven.
26 o mesmo sucedeu com o segundo, com o terceiro, até ao sétimo;
27 At last, di woman kon die too.
27 depois de todos eles, morreu também a mulher.
28 Wen pipol wey don die go kom back to life, wish pesin wife di woman go bi out of di seven brodas wey marry am?”
28 Portanto, na ressurreição, de qual dos sete será ela esposa? Porque todos a desposaram.
29 Jesus ansa dem, “Una dey make mistake, bikos una nor know God word and en pawa.
29 Respondeu-lhes Jesus: Errais, não conhecendo as Escrituras nem o poder de Deus.
30 For resureshon day, pipol nor dey marry or give woman out for marriage, bikos dem go bi like angel for heaven.
30 Porque, na ressurreição, nem casam, nem se dão em casamento; são, porém, como os anjos no céu.
31 Koncerning weda pesin wey don die go kom back to life, una neva read wetin God tell una?
31 E, quanto à ressurreição dos mortos, não tendes lido o que Deus vos declarou:
32 God sey, ‘I bi Abraham, Isaak and Jakob God. I nor bi God for pipol wey don die, but I bi God for pipol wey dey alive!’ ”
32 Eu sou o Deus de Abraão, o Deus de Isaque e o Deus de Jacó?
33 Wen di pipol hear as Jesus dey tok, dem sopraiz for wetin e dey tish.
33 Ouvindo isto, as multidões se maravilhavam da sua doutrina.
34 Wen di Farisee pipol hear sey Jesus don make di Sadusi pipol kwayet, dem kon gada.
34 Entretanto, os fariseus, sabendo que ele fizera calar os saduceus, reuniram-se em conselho.
35 One of dem wey bi law tish kon ask Jesus one kweshon to take try am.
35 E um deles, intérprete da Lei, experimentando-o, lhe perguntou:
36 “Tisha, wish kommandment big pass?”
36 Mestre, qual é o grande mandamento na Lei?
37 Jesus ansa, “Make pesin love God with all en heart, with all en soul and with all en mind.
37 Respondeu-lhe Jesus:
38 Na dis bi di first kommandment and naim big pass.
38 Este é o grande e primeiro mandamento.
39 Di sekond one bi like di first one: ‘Make pesin love en neighbour as e love ensef.’
39 O segundo, semelhante a este, é:
40 Na dis two kommandments, Moses Law and wetin di profets tish, dey follow.”
40 Destes dois mandamentos dependem toda a Lei e os Profetas.
41 As di Farisee pipol gada, Jesus kon ask dem one kweshon.
41 Reunidos os fariseus, interrogou-os Jesus:
42 “Wetin una tink about Christ, wey bi di Mezaya? Wish pesin pikin e bi?”
42 Que pensais vós do Cristo? De quem é filho? Responderam-lhe eles: De Davi.
43 Jesus ask dem again, “Den, how kom David koll am, ‘Oga God’, thru God Spirit, wen e sey,
43 Replicou-lhes Jesus: Como, pois, Davi, pelo Espírito, chama-lhe Senhor, dizendo:
44 “Di OGA tell my Oga God sey,
44 Disse o Senhor ao meu Senhor: Assenta-te à minha direita, até que eu ponha os teus inimigos debaixo dos teus pés?
45 If David koll am, ‘Oga God,’ den, how e kom take bi David pikin?”
45 Se Davi, pois, lhe chama Senhor, como é ele seu filho?
46 So nobody fit ansa Jesus and from dat day go, nobody try to ask am kweshon again.
46 E ninguém lhe podia responder palavra, nem ousou alguém, a partir daquele dia, fazer-lhe perguntas.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 22, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.