Filemom 1
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 Na Paul wey bi prisona bikos of Jesus Christ and awa broda Timoti rite dis leta to Filemon, awa dear broda and ko-worker.
1 Paulo, prisioneiro de Cristo Jesus, e o irmão Timóteo, ao amado Filemom, também nosso colaborador,
2 And to Afia awa sista, Arkippus awa fellow soja and di church pipol wey dey meet for en house.
2 e à irmã Áfia, e a Arquipo, nosso companheiro de lutas, e à igreja que está em tua casa,
3 Make God and awa Oga God Jesus Christ give una grace and peace.
3 graça e paz a vós outros, da parte de Deus, nosso Pai, e do Senhor Jesus Cristo.
4 Evritime wey I remember yu for my prayers, I dey tank my God,
4 Dou graças ao meu Deus, lembrando-me, sempre, de ti nas minhas orações,
5 bikos I don hear about di faith and love wey yu get for awa Oga God Jesus Christ and all God pipol,
5 estando ciente do teu amor e da fé que tens para com o Senhor Jesus e todos os santos,
6 so I dey pray sey di faith wey yu get go make yu undastand all di blessings wey bi yor own inside Christ.
6 para que a comunhão da tua fé se torne eficiente no pleno conhecimento de todo bem que há em nós, para com Cristo.
7 I get joy and my heart dey strong bikos of yor love and thru yu, all God pipol heart don strong too.Paul dey tok with Onesimus|alt="Paul talking eith Onesimus" src="CN02090B.TIF" size="col" loc="PHM" copy="Cook" ref="1:7"
7 Pois, irmão, tive grande alegria e conforto no teu amor, porquanto o coração dos santos tem sido reanimado por teu intermédio.
8 Since I get strong bilive for Christ sey, I fit tell yu make yu do wetin dey rite,
8 Pois bem, ainda que eu sinta plena liberdade em Cristo para te ordenar o que convém,
9 mi Paul, wey bi old man and prisona bikos of Christ, won advise yu with love.
9 prefiro, todavia, solicitar em nome do amor, sendo o que sou, Paulo, o velho e, agora, até prisioneiro de Cristo Jesus;
10 Abeg, make yu dey kind to Onesimus, wey bi my pikin for God work and e dey prison with mi.
10 sim, solicito-te em favor de meu filho Onésimo, que gerei entre algemas.
11 Before, e nor dey yuzful to yu, but naw, e dey yuzful to mi and yu.
11 Ele, antes, te foi inútil; atualmente, porém, é útil, a ti e a mim.
12 I dey send am kom back kom meet yu (even doh I love am well-well).
12 Eu to envio de volta em pessoa, quero dizer, o meu próprio coração.
13 If to sey yu dey here, I for wont make e help mi as I still dey prison bikos of di gospel work.
13 Eu queria conservá-lo comigo mesmo para, em teu lugar, me servir nas algemas que carrego por causa do evangelho;
14 But I nor won do anytin wey yu nor go like, so dat di good wey yu do, nor go bi by force, but e go kom from yor mind.
14 nada, porém, quis fazer sem o teu consentimento, para que a tua bondade não venha a ser como que por obrigação, mas de livre vontade.
15 May bi na bikos of dis make am nor dey with yu since, but naw, e go dey with yu forever.
15 Pois acredito que ele veio a ser afastado de ti temporariamente, a fim de que o recebas para sempre,
16 Nor bi as slave, but as broda wey wi love, bikos e don big pass slave. E don bikom awa broda naw, bikos God don shange am.
16 não como escravo; antes, muito acima de escravo, como irmão caríssimo, especialmente de mim e, com maior razão, de ti, quer na carne, quer no Senhor.
17 So, if yu si mi as yor broda and patina, make yu asept am as yu go take asept mi.
17 Se, portanto, me consideras companheiro, recebe-o, como se fosse a mim mesmo.
18 If e tif or whole yu anytin before, make yu tell mi and I go pay.
18 E, se algum dano te fez ou se te deve alguma coisa, lança tudo em minha conta.
19 Na mi Paul take my hand rite dis leta sey, I go pay back, but I fit still sey, yu yorsef dey whole mi.
19 Eu, Paulo, de próprio punho, o escrevo: Eu pagarei — para não te alegar que também tu me deves até a ti mesmo.
20 So my broda, make yu do dis tin for mi bikos of Christ, so dat belle go sweet mi.
20 Sim, irmão, que eu receba de ti, no Senhor, este benefício. Reanima-me o coração em Cristo.
21 I dey sure sey yu go do wetin I ask yu, so I dey rite give yu, bikos I know sey yu go do pass wetin I ask.
21 Certo, como estou, da tua obediência, eu te escrevo, sabendo que farás mais do que estou pedindo.
22 So, make yu prepare where I go stay, bikos I know sey yor prayers go make dem free mi kom meet yu soon.
22 E, ao mesmo tempo, prepara-me também pousada, pois espero que, por vossas orações, vos serei restituído.
23 Epafras, wey dey prison with mi, bikos of Jesus Christ, dey greet yu.
23 Saúdam-te Epafras, prisioneiro comigo, em Cristo Jesus,
24 Mark, Aristakus, Demas and Luke, wey bi my ko-workers, dey greet yu too.
24 Marcos, Aristarco, Demas e Lucas, meus cooperadores.
25 Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with yor spirit.
25 A graça do Senhor Jesus Cristo seja com o vosso espírito.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Filemom 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.