Efésios 5
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 So, make una dey bihave like shidren wey God love well-well.
1 Portanto, sejam imitadores de Deus, como filhos amados,
2 Make wi love one anoda, just as Christ love and sakrifice ensef as ofrin wey get betta smell to God, bikos of us.
2 e vivam em amor, como também Cristo nos amou e se entregou por nós como oferta e sacrifício de aroma agradável a Deus.
3 To dey sleep with pesin wey yu nor marry; dey do tins wey nor dey pure and get long-trot, make una nor allow dis tins dey among una, bikos dem nor good for God pipol.
3 Entre vocês não deve haver nem sequer menção de imoralidade sexual nem de qualquer espécie de impureza nem de cobiça; pois estas coisas não são próprias para os santos.
4 Make una nor allow yeye and foolish word kom out from una mout. And make una nor dey tok anyhow or use bad word, bikos all dis tins nor good. Instead, make una dey tank God with una mout.
4 Não haja obscenidade nem conversas tolas nem gracejos imorais, que são inconvenientes, mas, ao invés disso, ação de graças.
5 One tin wey una must know bi sey, pesin wey dey sleep with who e nor marry; wey nor dey pure or wey get long-trot and dey serve juju, nor go enter Christ and God kingdom.
5 Porque vocês podem estar certos disto: nenhum imoral nem impuro nem ganancioso, que é idólatra, tem herança no Reino de Cristo e de Deus.
6 Make una nor let anybody deceive una with yeye word, na dis tins make God dey vex for doz wey nor dey obey am.
6 Ninguém os engane com palavras tolas, pois é por causa dessas coisas que a ira de Deus vem sobre os que vivem na desobediência.
7 So make una nor join dem.
7 Portanto, não participem com eles dessas coisas.
8 Before-before, una dey for darkness, but naw, una bi lite wey dey shine inside Christ. So make una dey do tins like shidren wey get lite,
8 Porque outrora vocês eram trevas, mas agora são luz no Senhor. Vivam como filhos da luz,
9 bikos di fruit wey lite get, dey bring goodness, raitiousness and trut.
9 pois o fruto da luz consiste em toda bondade, justiça e verdade;
10 So, make una always dey do tins wey go make God happy.
10 e aprendam a discernir o que é agradável ao Senhor.
11 Make una nor put hand for bad tins, instead, make una dey espose dem.
11 Não participem das obras infrutíferas das trevas; antes, exponham-nas à luz.
12 Shame nor go let wiked pipol tok about wetin dem dey do for sekret.
12 Porque aquilo que eles fazem em oculto, até mencionar é vergonhoso.
13 But evribody go si evritin wey kom out for lite.
13 Mas, tudo o que é exposto pela luz torna-se visível, pois a luz torna visíveis todas as coisas.
14 Bikos na lite dey make evritin shine kom out and na dis make dem rite sey:
14 Por isso é que foi dito: "Desperta, ó tu que dormes, levanta-te dentre os mortos e Cristo resplandecerá sobre ti".
15 Make una dey kareful as una dey live una life. Make una nor bi like pipol wey nor get sense.
15 Tenham cuidado com a maneira como vocês vivem; que não seja como insensatos, mas como sábios,
16 Make una use evry shance wey una get well, bikos dis time wey wi dey so, dey evil and wiked.
16 aproveitando ao máximo cada oportunidade, porque os dias são maus.
17 Bikos of dis, make una get sense to undastand wetin awa Oga God word tok and mean.
17 Portanto, não sejam insensatos, mas procurem compreender qual é a vontade do Senhor.
18 Make una nor dey drink strong drink, bikos e go distroy una. But make una allow God Spirit fill una mind.
18 Não se embriaguem com vinho, que leva à libertinagem, mas deixem-se encher pelo Espírito,
19 Make una dey tok to unasef with psalms, hymns and spiritual songs. For inside una heart, make una dey praiz God with hymns and psalms.
19 falando entre si com salmos, hinos e cânticos espirituais, cantando e louvando de coração ao Senhor,
20 With awa Oga God Jesus Christ name, make una dey tank God awa papa for each oda.
20 dando graças constantemente a Deus Pai por todas as coisas, em nome de nosso Senhor Jesus Cristo.
21 Bikos of di respet wey una get for Christ, make una dey respet one anoda.
21 Sujeitem-se uns aos outros, por temor a Cristo.
22 Una wey bi wife, make una dey respet una husband, just as una dey respet Christ,
22 Mulheres, sujeitem-se a seus maridos, como ao Senhor,
23 bikos na di husband bi di wife head, just as Christ bi head for di church and naim en save di body.
23 pois o marido é o cabeça da mulher, como também Cristo é o cabeça da igreja, que é o seu corpo, do qual ele é o Salvador.
24 As di church dey submit to Christ, na so too, wife suppose submit to dia husband for evritin.
24 Assim como a igreja está sujeita a Cristo, também as mulheres estejam em tudo sujeitas a seus maridos.
25 Husband, make una love una wife, just as Christ love di church kon sakrifice en life for am,
25 Maridos, amem suas mulheres, assim como Cristo amou a igreja e entregou-se a si mesmo por ela
26 so dat e go fit make am klean, thru baptizim and God word.
26 para santificá-la, tendo-a purificado pelo lavar da água mediante a palavra,
27 E do like dis, so dat di church go bi like wife wey fine well-well, wey nor get any stain, dey do anyhow or get any oda tin wey fit spoil am.
27 e apresentá-la a si mesmo como igreja gloriosa, sem mancha nem ruga ou coisa semelhante, mas santa e inculpável.
28 Na so too, husbands suppose love dia wife like dia own body. Man wey love en wife, love ensef.
28 Da mesma forma, os maridos devem amar as suas mulheres como a seus próprios corpos. Quem ama sua mulher, ama a si mesmo.
29 Nobody don ever hate e own body, but e dey feed and kare for am, just as Christ dey kare for di church,
29 Além do mais, ninguém jamais odiou o seu próprio corpo, antes o alimenta e dele cuida, como também Cristo faz com a igreja,
30 bikos wi bi part for en body.
30 pois somos membros do seu corpo.
31 Na bikos of dis, man go live en papa and mama go join en wife and di two of dem, go bi one flesh.
31 "Por essa razão, o homem deixará pai e mãe e se unirá à sua mulher, e os dois se tornarão uma só carne".
32 Dis sekret wey I dey tell una so big well-well, but na di tin wey dey between Christ and di church, I dey tok about.
32 Este é um mistério profundo; refiro-me, porém, a Cristo e à igreja.
33 So, each man suppose love en own wife, just as e love ensef and evry wife suppose respet en husband.
33 Portanto, cada um de vocês também ame a sua mulher como a si mesmo, e a mulher trate o marido com todo o respeito.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Efésios 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.