Mateus 15

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Some Farisee pipol and law tishas kom meet Jesus for Jerusalem ask am,
1 Então alguns fariseus e escribas vieram de Jerusalém até Jesus e perguntaram:
2 “Why yor disciples nor dey obey awa eldas tradishon? Dem nor dey wosh dia hand before dem chop.”
2 — Por que os seus discípulos transgridem a tradição dos anciãos? Pois não lavam as mãos, quando comem.
3 Jesus ansa dem, “Why una nor dey obey God kommandment, na bikos una won keep una tradishon?
3 Jesus, porém, lhes respondeu:
4 God sey, ‘Respet yor papa and mama, anybody wey curse en papa or mama, dem must kill-am.’
4 Porque Deus disse: “Honre o seu pai e a sua mãe.” E: “Quem maldisser o seu pai ou a sua mãe seja punido de morte.”
5 But una sey, ‘If anybody tell en papa or mama, “Wetin I won give yu before, I don gi-am to God”,
5 Vocês, porém, dizem que, se alguém disser ao seu pai ou à sua mãe: “A ajuda que você poderia receber de mim é oferta ao Senhor”,
6 den e nor nid to respet en papa again.’ Bikos of una tradishon, una don make God word yeye.
6 esse não precisará mais honrar os seus pais. E, assim, vocês invalidam a palavra de Deus, por causa da tradição de vocês.
7 Una wey dey pritend! True-true, na una Profet Isaya tok about wen e sey,
7 Hipócritas! Bem profetizou Isaías a respeito de vocês, dizendo:
8 “ ‘Dis pipol dey praiz mi with dia mout,
8 “Este povo me honra
9 and di woship wey dem dey give mi,
9 E em vão me adoram,
10 Den Jesus gada di pipol kon dey tish dem, “Make una listin so dat una go undastand.
10 E, convocando a multidão, Jesus disse:
11 Nor bi wetin pesin chop dey make am dirty, but na wetin e tok from en mout.”
11 o que contamina a pessoa não é o que entra pela boca, mas o que sai da boca; isto, sim, contamina a pessoa.
12 Den di disciples kon meet am sey, “Yu know sey Farisee pipol dey vex, bikos of wetin yu tok?”
12 Então, aproximando-se dele os discípulos, disseram: — Sabia que os fariseus, ouvindo o que o senhor disse, ficaram escandalizados?
13 Jesus ansa, “Any plant wey my Papa for heaven nor plant, dem go rut am trowey.
13 Mas ele respondeu:
14 Make una leave dem! Dem bi blind pipol wey dey show blind pipol road. If pesin wey blind dey show anoda blind pesin road, two of dem go fall inside gutta.”
14 Esqueçam os fariseus; são cegos, guias de cegos. Ora, se um cego guiar outro cego, ambos cairão num buraco.
15 But Pita tell Jesus, “Tell us wetin yu mean.”
15 Então Pedro disse a Jesus: — Explique-nos esta parábola.
16 Jesus ansa, “Afta evritin wey I don tok so, una nor still undastand?
16 Jesus, porém, disse:
17 Una nor know sey anytin wey pesin chop enter belle, e go shit am kom out?
17 Não compreendem que tudo o que entra pela boca desce para o estômago e depois é eliminado?
18 But di tins wey dey kom out from pesin mout, dey kom from en heart and na dis tins dey make di pesin dirty.
18 Mas o que sai da boca vem do coração, e é isso que contamina a pessoa.
19 Na from pesin heart bad-bad tins dey kom out and na dis tins dey make dem kill; sleep with who dem nor marry; tif; lie and judge pesin for en back.
19 Porque do coração procedem maus pensamentos, homicídios, adultérios, imoralidade sexual, furtos, falsos testemunhos, blasfêmias.
20 Na all dis tins dey make pesin dirty, nor bi bikos pesin chop with en hand wey e nor wosh.”
20 São estas as coisas que contaminam a pessoa; mas o comer sem lavar as mãos não a contamina.
21 Jesus komot der kon go Tyre and Sidon aria.
21 Saindo dali, Jesus foi para a região de Tiro e Sidom.
22 For der, one Kanaan woman kry kom meet am sey, “Oga God, David Pikin, make yu sorry for mi! My dota nor well, bikos demon dey trobol am!”
22 E eis que uma mulher cananeia, que tinha vindo daqueles lados, clamava: — Senhor, Filho de Davi, tenha compaixão de mim! Minha filha está horrivelmente endemoniada.
23 But Jesus nor tok. So en disciples kon beg am, “Drive dis woman komot for here, bikos e dey disturb us.”
23 Jesus, porém, não lhe respondeu palavra. Então os seus discípulos, aproximando-se, disseram: — Mande-a embora, pois vem gritando atrás de nós.
24 Jesus kon tell di woman, “Na di sheep wey lost among Israel pipol, naim God send mi kom find.”
24 Mas Jesus respondeu:
25 Di woman knee down for en front kon dey beg am sey, “Oga God, make yu help mi!”
25 Ela, porém, veio e o adorou, dizendo: — Senhor, me ajude!
26 Jesus tell am, “E nor good to give dog di bread wey shidren suppose to chop.”
26 Jesus respondeu:
27 Den di woman ansa, “Yes Oga God. But di dog demsef dey chop di small-small bread wey dey fall from dia oga tabol.”
27 A mulher disse: — É verdade, Senhor, pois os cachorrinhos comem das migalhas que caem da mesa dos seus donos.
28 So Jesus tell am, “Madam, yor faith big well-well! Make wetin yu dey find rish yor hand.” Dat same time, di pikin kon well.
28 Então Jesus exclamou: E, desde aquele momento, a filha dela ficou curada.
29 Jesus komot from der go Galilee wotaside. Den e klimb one mountin go sidan.
29 Saindo dali, Jesus foi para junto do mar da Galileia; e, subindo ao monte, assentou-se ali.
30 Many pipol karry pipol wey nor fit waka, blind, paralaiz, dumb and odas wey get difren sickness kom en front and e heal all of dem.
30 E vieram a ele muitas multidões trazendo consigo coxos, cegos, aleijados, mudos e muitos outros e os deixaram junto aos pés de Jesus; e ele os curou.
31 Di pipol kon sopraiz well-well wen dem si who nor fit tok, dey tok, who nor fit waka, dey waka, who blind before, dey si naw and all of dem kon praiz Israel pipol God.
31 O povo ficou maravilhado ao ver que os mudos falavam, os aleijados recuperavam a saúde, os coxos andavam e os cegos viam. E glorificavam o Deus de Israel.
32 Jesus koll en disciples kon tell dem, “I dey sorry for dis pipol bikos dem don dey here with mi for three days and dem nor get anytin to chop. I nor wont make dem go back with honga, so dat dem nor go faint for road.”
32 Então Jesus chamou os seus discípulos e disse:
33 Di disciples ansa, “As dis pipol plenty so, where wi go fit get food wey go rish dem chop for dis wildaness?”
33 Mas os discípulos lhe disseram: — Onde haverá neste deserto pão suficiente para saciar tão grande multidão?
34 Jesus ask dem, “How many bread una get?”
34 Jesus perguntou: Eles responderam: — Sete pães e alguns peixinhos.
35 So, Jesus tell di pipol make dem sidan for groun,
35 Então, tendo mandado o povo assentar-se no chão,
36 kon take di seven bread and di fish. Afta e don tank God, e divide di bread and fish give en disciples make dem share am for di pipol.
36 pegou os sete pães e os peixes e, tendo dado graças, os partiu e deu aos discípulos, e estes distribuíram ao povo.
37 Di pipol chop beleful and di food wey remain, full seven basket.
37 Todos comeram e se fartaram; e, dos pedaços que sobraram, recolheram sete cestos cheios.
38 Di men wey chop na 4,000, even doh dem nor kount wimen and shidren join dem.
38 Ora, os que comeram eram quatro mil homens, além de mulheres e crianças.
39 Afta Jesus don send di pipol go dia house, e kon enter boat go Magadan aria.
39 E, tendo despedido as multidões, Jesus entrou no barco e foi para o território de Magadã.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 15, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.