Lucas 2

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA

Sair da comparação
ARA Almeida Revista e Atualizada 1993
1 Dat time, Caesar Augustus kon give orda make evribody wey dey Rome go register dia name make dem for pay tax.
1 Naqueles dias, foi publicado um decreto de César Augusto, convocando toda a população do império para recensear-se.
2 Dis na di first time wey pipol go register, since di time wen Kwirinus bi govnor for Siria.
2 Este, o primeiro recenseamento, foi feito quando Quirino era governador da Síria.
3 Evribody kon go en home-town go register.
3 Todos iam alistar-se, cada um à sua própria cidade.
4 So Josef wey dey stay for Nazaret for Galilee kon travel go Betlehem, David Town for Judea, bikos na David family e from kom.
4 José também subiu da Galileia, da cidade de Nazaré, para a Judeia, à cidade de Davi, chamada Belém, por ser ele da casa e família de Davi,
5 Josef and Mary wey e won marry wey get belle, go register togeda.
5 a fim de alistar-se com Maria, sua esposa, que estava grávida.
6 As dem dey for Betlehem, time kon rish for marry to born.
6 Estando eles ali, aconteceu completarem-se-lhe os dias,
7 So e born en first son, wrap am kon put am for where dem dey keep animal, bikos know oda place dey for dem to stay.
7 e ela deu à luz o seu filho primogênito, enfaixou-o e o deitou numa manjedoura, porque não havia lugar para eles na hospedaria.
8 Some shepads dey for dat aria, dey kare for dia sheep for nite.
8 Havia, naquela mesma região, pastores que viviam nos campos e guardavam o seu rebanho durante as vigílias da noite.
9 God angel appear to dem and God glory kon dey shine for evriwhere, den fear katch dem.
9 E um anjo do Senhor desceu aonde eles estavam, e a glória do Senhor brilhou ao redor deles; e ficaram tomados de grande temor.
10 Di angel tell dem, “Make una nor fear! Make una listin well, bikos I kom tell una news wey go make pipol happy.
10 O anjo, porém, lhes disse: Não temais; eis aqui vos trago boa-nova de grande alegria, que o será para todo o povo:
11 Today, dem born una Savior for dis town wey David from kom, en name na Christ, wey bi di Oga God.
11 é que hoje vos nasceu, na cidade de Davi, o Salvador, que é Cristo, o Senhor.
12 Na dis go bi sign wey una go take know am: Una go si pikin wey dem use klot wrap inside where dem dey keep animal.”
12 E isto vos servirá de sinal: encontrareis uma criança envolta em faixas e deitada em manjedoura.
13 At wons, many angels appear for heaven kon stand with di first angel dey praiz God sey,
13 E, subitamente, apareceu com o anjo uma multidão da milícia celestial, louvando a Deus e dizendo:
14 “Na only God get Glory for heaven and eart,
14 Glória a Deus nas maiores alturas, e paz na terra entre os homens, a quem ele quer bem.
15 Wen di angels go back to heaven, di shepads kon tell each oda, “Make wi go Betlehem go si wetin happen, wey God don show us so.”
15 E, ausentando-se deles os anjos para o céu, diziam os pastores uns aos outros: Vamos até Belém e vejamos os acontecimentos que o Senhor nos deu a conhecer.
16 Dem kon go si Mary, Josef and di pikin for inside di animal house.
16 Foram apressadamente e acharam Maria e José e a criança deitada na manjedoura.
17 Wen dem si am, dem kon tok how di angel take tell dem about di pikin.
17 E, vendo-o, divulgaram o que lhes tinha sido dito a respeito deste menino.
18 Evribody wey hear wetin dem tok, sopraiz well-well.
18 Todos os que ouviram se admiraram das coisas referidas pelos pastores.
19 But Mary keep wetin e hear for en mind kon dey tink about am.
19 Maria, porém, guardava todas estas palavras, meditando-as no coração.
20 So di shepads go back, dey praiz God, bikos of all di tins wey dem hear and si. Evritin just bi as di angel tell dem sey e go bi.
20 Voltaram, então, os pastores glorificando e louvando a Deus por tudo o que tinham ouvido e visto, como lhes fora anunciado.
21 Wen di pikin rish eight days, dem sekonsaiz am kon koll am, “Jesus”, di name wey di angel tok before en mama even get belle.
21 Completados oito dias para ser circuncidado o menino, deram-lhe o nome de Jesus , como lhe chamara o anjo, antes de ser concebido.
22 Wen time rish for Mary to present ensef to God, as Moses Law tok, Josef and Mary kon karry Jesus go Jerusalem, go dedikate am give God,
22 Passados os dias da purificação deles segundo a Lei de Moisés, levaram-no a Jerusalém para o apresentarem ao Senhor,
23 (as dem rite am for God word, “Evry first-born wey bi boy, dem go gi-am to Mi”),
23 conforme o que está escrito na Lei do Senhor: Todo primogênito ao Senhor será consagrado;
24 and dem go offa sakrifice with two dove or pijin.
24 e para oferecer um sacrifício, segundo o que está escrito na referida Lei: Um par de rolas ou dois pombinhos.
25 One man dey Jerusalem wey en name bi Simeon and di Holy Spirit dey inside am. Di man dey fear God and dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God go free Israel.
25 Havia em Jerusalém um homem chamado Simeão; homem este justo e piedoso que esperava a consolação de Israel; e o Espírito Santo estava sobre ele.
26 Di Holy Spirit don show am sey e nor go die before e go si di Mezaya wey God promise.
26 Revelara-lhe o Espírito Santo que não passaria pela morte antes de ver o Cristo do Senhor.
27 So God Spirit karry Simeon enter di temple and wen Jesus papa and mama bring am to do wetin Moses Law tok,
27 Movido pelo Espírito, foi ao templo; e, quando os pais trouxeram o menino Jesus para fazerem com ele o que a Lei ordenava,
28 Simeon kon karry Jesus for en hand dey praiz God sey,
28 Simeão o tomou nos braços e louvou a Deus, dizendo:
29 “Naw, as yor word tok,
29 Agora, Senhor, podes despedir em paz o teu servo, segundo a tua palavra;
30 Bikos my eye don si di pesin wey yu won
30 porque os meus olhos já viram a tua salvação,
31 di One wey yu don prepare
31 a qual preparaste diante de todos os povos:
32 Na-im bi di lite
32 luz para revelação aos gentios, e para glória do teu povo de Israel.
33 So di pikin papa and mama sopraiz for wetin Simeon tok about am.
33 E estavam o pai e a mãe do menino admirados do que dele se dizia.
34 Den Simeon bless dem kon tell Mary, “Listin well-well: God don choose dis pikin to make some pipol for Israel fall and raiz odas up and e go bi sign wey many pipol nor go asept.
34 Simeão os abençoou e disse a Maria, mãe do menino: Eis que este menino está destinado tanto para ruína como para levantamento de muitos em Israel e para ser alvo de contradição
35 True-true, bikos of am, di sekret tins for many pipol mind go kom out and vexnashon like swod, go shuk dia heart!”
35 (também uma espada traspassará a tua própria alma), para que se manifestem os pensamentos de muitos corações.
36 One profetes dey, wey en name bi Anna, Fanuel dota, wey kom from Asher family. E don old well-well and e marry en husband for seven years, before di man die.
36 Havia uma profetisa, chamada Ana, filha de Fanuel, da tribo de Aser, avançada em dias, que vivera com seu marido sete anos desde que se casara
37 E don rish eighty-four years since en husband die. E nor dey komot for di temple, e dey serve God and dey fast and pray day and nite.
37 e que era viúva de oitenta e quatro anos. Esta não deixava o templo, mas adorava noite e dia em jejuns e orações.
38 For dat time, e kom meet Josef, Mary, di pikin and Simeon kon bigin tank God, dey tok about di pikin give evribody wey dey wait for di time wen God go free Jerusalem.
38 E, chegando naquela hora, dava graças a Deus e falava a respeito do menino a todos os que esperavam a redenção de Jerusalém.
39 So, wen Josef and Mary don do all di tins wey God law sey make dem do, dem kon go back to dia house for Nazaret for Galilee.
39 Cumpridas todas as ordenanças segundo a Lei do Senhor, voltaram para a Galileia, para a sua cidade de Nazaré.
40 Di pikin kon grow, dey strong, e get sense and God favor, dey with am.
40 Crescia o menino e se fortalecia, enchendo-se de sabedoria; e a graça de Deus estava sobre ele.
41 Evry year, Jesus papa and mama dey go Jerusalem for Passova Feast.
41 Ora, anualmente iam seus pais a Jerusalém, para a Festa da Páscoa.
42 Wen Jesus bi twelf years, dem kon go as dem dey do before
42 Quando ele atingiu os doze anos, subiram a Jerusalém, segundo o costume da festa.
43 and as dem dey go back to dia house, Jesus nor follow dem, but en papa and mama nor know;
43 Terminados os dias da festa, ao regressarem, permaneceu o menino Jesus em Jerusalém, sem que seus pais o soubessem.
44 bikos dem tink sey e dey among dem wey dey travel togeda. Wen dem don travel for one full day, dem kon dey find Jesus among dia rilashons and friends.
44 Pensando, porém, estar ele entre os companheiros de viagem, foram caminho de um dia e, então, passaram a procurá-lo entre os parentes e os conhecidos;
45 As dem nor si am, dem kon go back to Jerusalem go find am.
45 e, não o tendo encontrado, voltaram a Jerusalém à sua procura.
46 Afta three days, dem kon si am inside di temple, where e sidan with di tishas dey listin and dey ask dem many kweshon.
46 Três dias depois, o acharam no templo, assentado no meio dos doutores, ouvindo-os e interrogando-os.
47 Evribody wey hear wetin Jesus dey tok kon dey sopraiz for di way e undastand and di ansa wey e dey give.
47 E todos os que o ouviam muito se admiravam da sua inteligência e das suas respostas.
48 Wen en papa and mama si am, dem sopraiz well-well. Naim en mama sey, “My pikin, why yu do us like dis? Si, mi and yor papa dey find yu for evriwhere since.”
48 Logo que seus pais o viram, ficaram maravilhados; e sua mãe lhe disse: Filho, por que fizeste assim conosco? Teu pai e eu, aflitos, estamos à tua procura.
49 Jesus ansa dem, “Why una dey find mi? Una nor know sey I go dey my Papa house?”
49 Ele lhes respondeu: Por que me procuráveis? Não sabíeis que me cumpria estar na casa de meu Pai?
50 But en papa and mama nor undastand wetin Jesus mean.
50 Não compreenderam, porém, as palavras que lhes dissera.
51 Den Jesus follow dem go Nazaret kon dey do wetin dem tell am. But en mama keep all dis tins for mind.
51 E desceu com eles para Nazaré; e era-lhes submisso. Sua mãe, porém, guardava todas estas coisas no coração.
52 Jesus kon dey get sense more-more as e dey grow, so God and pipol like am well-well.
52 E crescia Jesus em sabedoria, estatura e graça, diante de Deus e dos homens.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.