Lucas 21
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA
1 For inside di temple, Jesus kon si rish pipol dey put dia money for ofrin box.
1 Jesus estava observando e viu os ricos que lançavam seu dinheiro na caixa de ofertas.
2 E still si one poor woman wey en husband don die dey put two koins inside di box.
2 Viu também certa viúva pobre lançar ali duas pequenas moedas.
3 Jesus kon sey, “I tell una true word, di money wey dis poor widow put so, big pass all di oda pipol own;
3 Então Jesus disse:
4 bikos di rish pipol give dia ofrin from di plenty money wey dem get, but as dis woman poor rish, e put evritin wey e get.”
4 Porque todos esses deram como oferta daquilo que lhes sobrava; esta, porém, da sua pobreza deu tudo o que possuía, todo o seu sustento.
5 As some pipol dey tok about how di temple fine rish, bikos of di stones wey dem take build am and di ofrin wey pipol dey give, Jesus kon sey,
5 Alguns falavam a respeito do templo, como estava ornado de belas pedras e de dádivas.
6 “Di day dey kom wen all di stones wey una dey si so, go skata and one nor go dey on-top anoda again.”
6 Então Jesus disse:
7 So, dem kon ask am, “Tisha, wen dis tins go happen? And wetin go bi di sign sey di time for dis tins to happen don rish?”
7 Perguntaram a Jesus: — Mestre, quando será isto? E que sinal haverá quando estas coisas estiverem para acontecer?
8 Jesus ansa, “Make una shine una eye, so dat nobody go deceive una. Bikos many pipol go kom prish with my name sey, ‘Na mi bi Jesus’ or ‘Di time don near.’ Make una nor follow dem!
8 Jesus respondeu:
9 And wen una hear rumor about war and wahala, make una nor fear. Bikos all dis tins go first happen, but dat nor mean sey di end don rish.”
9 Quando vocês ouvirem falar de guerras e revoluções, não fiquem assustados; pois é necessário que primeiro aconteçam estas coisas, mas o fim não será logo.
10 Den Jesus tell dem, “Kountry go fight kountry, kingdom go fight kingdom.
10 Então Jesus lhes disse:
11 Strong eartkweke, honga and sickness go dey evriwhere; difren-difren tins and bad signs go dey happen and fear go katch evribody.
11 Haverá grandes terremotos, epidemias e fome em vários lugares, coisas espantosas e também grandes sinais vindos do céu.
12 “But before dem go happen, dem go arrest and ponish una for wetin una nor do, den go karry una go judge for inside sinagog, den dem go trow una inside prison. Dem go karry una go meet kings and govnors, bikos of my name.
12 Antes, porém, de todas estas coisas, vocês serão presos e perseguidos. Vocês serão entregues às sinagogas e lançados nas prisões; serão levados à presença de reis e de governadores, por causa do meu nome.
13 Dis na di time for una to spread di Good News.
13 Isto acontecerá para que vocês deem testemunho.
14 So make una ready una mind before di time rish. Make una nor tink how una go take defend unasef,
14 Tomem, pois, a decisão de não se preocupar com o que irão responder,
15 bikos I go give una di word wey una go tok and wisdom wey una enemy nor go fit oppoz.
15 porque eu lhes darei palavras e sabedoria a que não poderão resistir nem contradizer todos os que se opuserem a vocês.
16 Una papa, mama, brodas, rilashons and friends go sey dem nor know una and dem go even kill some of una.
16 E vocês serão entregues até por seus próprios pais, irmãos, parentes e amigos; e eles matarão alguns de vocês.
17 Evribody go hate una bikos of my name.
17 Todos odiarão vocês por causa do meu nome.
18 But God eye go always dey wosh una.
18 Mas não se perderá um só fio de cabelo da cabeça de vocês.
19 So, if una stand rish di end, God go save una.”
19 É pela perseverança que vocês ganharão a sua alma.
20 “But wen una si sey sojas don surround Jerusalem, make una know sey di time wey dem go distroy Jerusalem, don near.
20 — Quando, porém, vocês virem Jerusalém sitiada de exércitos, saibam que está próxima a sua devastação.
21 So, make di pipol wey dey Judea run go mountin and doz wey dey inside town must komot der. Make doz wey dey outside, nor enter di town again,
21 Então os que estiverem na Judeia fujam para os montes; os que se encontrarem dentro da cidade saiam dela; e os que estiverem nos campos não entrem na cidade.
22 bikos na dat time God go judge di world, since evritin wey dem rite for God word, must happen.
22 Porque esses dias são de vingança, para se cumprir tudo o que está escrito.
23 Dat time, e go bad well-well for wimen wey get belle or get small pikin for hand! Strong wahala go kom for dis land and God ponishment go fall for pipol head.
23 Ai das que estiverem grávidas e das que amamentarem naqueles dias! Porque haverá grande aflição na terra e ira contra este povo.
24 Dem go use swod kill some, karry some as prisona go anoda kountry and di Gentile pipol go distroy Jerusalem, until di time wey God sey Israel must sofa, go end.
24 Cairão a fio de espada e serão levados cativos para todas as nações; e, até que os tempos dos gentios se completem, Jerusalém será pisada por eles.
25 “Difren-difren signs go show for sun, moon and star. For inside dis world, pipol for difren kountries go dey worry and fear, bikos of di way rivers go dey move and wota go dey rush from sea enter land.
25 — Haverá sinais no sol, na lua e nas estrelas; sobre a terra, angústia entre as nações em perplexidade por causa do bramido do mar e das ondas.
26 Pipol go dey faint and fear go dey katch some, bikos of wetin dey happen for di world and difren pawas inside di sky, go shake komot for where dem dey.
26 Haverá pessoas que desmaiarão de terror e pela expectativa das coisas que sobrevirão ao mundo, pois os poderes dos céus serão abalados.
27 Den, dem go si Man Pikin dey kom inside kloud with pawa and glory.
27 Então verão o Filho do Homem vindo numa nuvem, com poder e grande glória.
28 So, wen dis tins dey happen, make una stand and dey ready, bikos una salvashon don near.”
28 Ora, quando estas coisas começarem a acontecer, levantem-se e fiquem de cabeça erguida, porque a redenção de vocês se aproxima.
29 Den, Jesus kon tell dem dis parabol: “Make una tink about di fig tree and all di oda trees.
29 Jesus ainda lhes contou uma parábola, dizendo:
30 Wen dia leaf start to fall komot, make una know sey dry sizin don near.
30 Quando veem que começam a brotar, vocês mesmos sabem que o verão está próximo.
31 Na so una go still know too, wen una si all dis tins dey happen, una go know sey God Kingdom don near.
31 Assim também, quando virem acontecer essas coisas, saibam que está próximo o Reino de Deus.
32 “I tell una true word, di pipol for dis world naw nor go die finish before all dis tins go happen.
32 Em verdade lhes digo que não passará esta geração sem que tudo isto aconteça.
33 Heaven and eart go vanish komot, but my word go dey forever.
33 Passará o céu e a terra, porém as minhas palavras não passarão.
34 “So, make una shine una eye! Nor let party and wahala for dis life full una mind, if not, dat Day go kom wen una nor espect,
34 — Tenham cuidado para não acontecer que o coração de vocês fique sobrecarregado com as consequências da orgia, da embriaguez e das preocupações deste mundo, e para que aquele dia não venha sobre vocês repentinamente,
35 bikos dat Day go sopraiz evribody wey dey for dis world.
35 como uma armadilha. Pois sobrevirá a todos os que vivem sobre a face de toda a terra.
36 But make una dey shine una eye evritime, dey pray make God give una pawa take pass all dis test wey go happen, so dat una go fit stand for Man Pikin front.”
36 Portanto, vigiem o tempo todo, orando, para que vocês possam escapar de todas essas coisas que têm de acontecer e para que possam estar em pé na presença do Filho do Homem.
37 So, Jesus kon dey tish for di temple evriday, but wen nite rish, e go-go Mount Olives.
37 Jesus ensinava todos os dias no templo, mas à noite saía e ficava no monte chamado das Oliveiras.
38 And for early morning, all di pipol dey go listin to am inside di temple.
38 E todo o povo madrugava para ir ao encontro dele no templo, a fim de ouvi-lo.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 21, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.