Lucas 17

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Jesus tell en disciples, “Tins wey go make pipol kommit sin must happen, but e go bad well-well for di pesin wey go make dem happen!
1 Jesus disse também a seus discípulos: É impossível que não haja escândalos, mas ai daquele por quem eles vêm!
2 E betta make dem tie big stone for di pesin neck, trow am for river, dan sey e make any of dis small-small wons kommit sin.
2 Melhor lhe seria que se lhe atasse em volta do pescoço uma pedra de moinho e que fosse lançado ao mar, do que levar para o mal a um só destes pequeninos. Tomai cuidado de vós mesmos.
3 Make yu shine yor eye!
3 Se teu irmão pecar, repreende-o; se se arrepender, perdoa-lhe.
4 Even if e sin against yu seven times for one day and e kon tell yu seven times sey, ‘I don shange’, yu must forgi-am.”
4 Se pecar sete vezes no dia contra ti e sete vezes no dia vier procurar-te, dizendo: Estou arrependido, perdoar-lhe-ás.
5 Di disciples kon tell Jesus, “Wi beg! Make yu make awa faith strong.”
5 Os apóstolos disseram ao Senhor: Aumenta-nos a fé!
6 Jesus ansa, “Even if una faith small like mustard seed, una go fit tell dis big tree sey, ‘Make yu komot from here go enter river’ and e go obey una.
6 Disse o Senhor: Se tiverdes fé como um grão de mostarda, direis a esta amoreira: Arranca-te e transplanta-te no mar, e ela vos obedecerá.
7 “Wish of una go tell en savant wen e kom from farm afta e don feed di sheep and melu finish sey, ‘Kom sidan, make yu follow mi chop’?
7 Qual de vós, tendo um servo ocupado em lavrar ou em guardar o gado, quando voltar do campo lhe dirá: Vem depressa sentar-te à mesa?
8 No! Instead una go tell am, ‘Prepare my evening food and serve mi, make I chop and drink. Wen I don finish, yu fit go chop yor own.’
8 E não lhe dirá ao contrário: Prepara-me a ceia, cinge-te e serve-me, enquanto como e bebo, e depois disto comerás e beberás tu?
9 Di oga nor go tank di savant sey e do wetin e send am, abi e go do so?
9 E se o servo tiver feito tudo o que lhe ordenara, porventura fica-lhe o senhor devendo alguma obrigação?
10 Na so too e go bi with una. Wen una don do all wetin dem send una, make una sey, ‘Na savant wi bi, wi nor rish make dem praiz us, bikos wi just do wetin wi suppose to do.’ ”
10 Assim também vós, depois de terdes feito tudo o que vos foi ordenado, dizei: Somos servos como quaisquer outros; fizemos o que devíamos fazer.
11 As Jesus dey go Jerusalem, e kon pass di place wey divide Samaria and Galilee.
11 Sempre em caminho para Jerusalém, Jesus passava pelos confins da Samaria e da Galiléia.
12 As e dey enter one village, ten men wey get leprosy meet am for road. Dem stand for far,
12 Ao entrar numa aldeia, vieram-lhe ao encontro dez leprosos, que pararam ao longe e elevaram a voz, clamando:
13 kon dey shaut, “Oga God Jesus! Wi beg, make yu sorry for us.”
13 Jesus, Mestre, tem compaixão de nós!
14 Wen Jesus si dem e kon sey, “Make una go show unasef to di priests.” And as dem dey go for road, dia body kon well.
14 Jesus viu-os e disse-lhes: Ide, mostrai-vos ao sacerdote. E quando eles iam andando, ficaram curados.
15 Wen one of dem si sey e don well, e kon turn back dey shaut dey praiz God.
15 Um deles, vendo-se curado, voltou, glorificando a Deus em alta voz.
16 E fall face groun for Jesus front kon dey tank am. (Di man na from Samaria.)
16 Prostrou-se aos pés de Jesus e lhe agradecia. E era um samaritano.
17 Den Jesus ask, “Nor bi ten pipol I heal? Where di oda Nine?
17 Jesus lhe disse: Não ficaram curados todos os dez? Onde estão os outros nove?
18 Na only dis man wey bi strenja fit kom back kon praiz God?”
18 Não se achou senão este estrangeiro que voltasse para agradecer a Deus?!
19 Den Jesus tell di man, “Get up make yu dey go. Yor faith don make yu well.”
19 E acrescentou: Levanta-te e vai, tua fé te salvou.
20 One day, di Farisee pipol kon ask Jesus wen God Kingdom go kom. Jesus ansa, “God Kingdom nor go kom with sign wen pipol go si
20 Os fariseus perguntaram um dia a Jesus quando viria o Reino de Deus. Respondeu-lhes: O Reino de Deus não virá de um modo ostensivo.
21 and nobody go fit sey, ‘Si am for here!’ Or ‘Si am for der!’ Bikos true-true, God Kingdom don already dey with una.”
21 Nem se dirá: Ei-lo aqui; ou: Ei-lo ali. Pois o Reino de Deus já está no meio de vós.
22 Den Jesus tell en disciples, “Di time dey kom wen una go won si Man Pikin, but una nor go si am.
22 Mais tarde ele explicou aos discípulos: Virão dias em que desejareis ver um só dia o Filho do Homem, e não o vereis.
23 Dat time, pipol go tell una, ‘Si am for der!’ or ‘Si am for here!’ Make una nor follow dem.
23 Então vos dirão: Ei-lo aqui; e: Ei-lo ali. Não deveis sair nem os seguir.
24 Bikos as tonda lite dey flash from one side go anoda for sky, na so Man Pikin go kom for en time.
24 Pois como o relâmpago, reluzindo numa extremidade do céu, brilha até a outra, assim será com o Filho do Homem no seu dia.
25 But e must first sofa many tins and di pipol for dis generashon go rijet am.
25 É necessário, porém, que primeiro ele sofra muito e seja rejeitado por esta geração.
26 “As e bi for Noah time, na so e go still bi for Man Pikin time.
26 Como ocorreu nos dias de Noé, acontecerá do mesmo modo nos dias do Filho do Homem.
27 Dat time, pipol dey chop and drink, even for di day wen Noah enter di ark, men and wimen still dey marry, until wota kon distroy all of dem.
27 Comiam e bebiam, casavam-se e davam-se em casamento, até o dia em que Noé entrou na arca. Veio o dilúvio e matou a todos.
28 “Na so e still bi for Lot time, pipol dey chop and drink, dey buy and sell, dey plant and build house;
28 Também do mesmo modo como aconteceu nos dias de Lot. Os homens festejavam, compravam e vendiam, plantavam e edificavam.
29 but di day wen Lot komot from Sodom, fire and sulfur fall like rain from heaven kon kill all of dem.
29 No dia em que Lot saiu de Sodoma, choveu fogo e enxofre do céu, que exterminou todos eles.
30 “Na so e go bi for di day wen Man Pikin go show ensef.
30 Assim será no dia em que se manifestar o Filho do Homem.
31 Dat day, anybody wey dey on-top rut for en house, make e nor go inside house go karry anytin and anybody wey dey farm, make e nor go back to en house.
31 Naquele dia, quem estiver no terraço e tiver os seus bens em casa não desça para os tirar; da mesma forma, quem estiver no campo não torne atrás.
32 Make una remember wetin happen to Lot wife!
32 Lembrai-vos da mulher de Lot.
33 Anybody wey won keep en life, go luz am and anybody wey luz en life, go save am.
33 Todo o que procurar salvar a sua vida, perdê-la-á; mas todo o que a perder, encontrá-la-á.
34 I tell una true word, dat nite, two pipol go dey one bed, God go take one kon leave di oda one.
34 Digo-vos que naquela noite dois estarão numa cama: um será tomado e o outro será deixado;
35 Two wimen go dey grind pepper togeda; God go take one kon leave di oda one.
35 duas mulheres estarão moendo juntas: uma será tomada e a outra será deixada.
36 Two pipol go dey farm dey work; God go take one kon leave di oda one.”
36 Dois homens estarão no campo: um será tomado e o outro será deixado.
37 Den di disciples ask Jesus, “Oga God, for where dis tins go for happen?”
37 Perguntaram-lhe os discípulos: Onde será isto, Senhor? Respondeu-lhes: Onde estiver o cadáver, ali se reunirão também as águias.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 17, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.