Gênesis 7
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 So Oga God tell Noah, “Make una enter di boat, yu and yor family, bikos I si sey yu nor get fault among evribody for dis yor generashon.
1 Então o Senhor disse a Noé: "Entre na arca, você e toda a sua família, porque você é o único justo que encontrei nesta geração.
2 Yu must karry seven man and seven woman for evry klean animal follow body, but for evry animal wey nor dey klean, yu go take only one man and one woman.
2 Leve com você sete casais de cada espécie de animal puro, macho e fêmea, e um casal de cada espécie de animal impuro, macho e fêmea,
3 Den yu go still take seven man and seven woman from evry kind bird wey dey fly for sky, so dat dem go born many shidren leta.
3 e leve também sete casais de aves de cada espécie, macho e fêmea, a fim de preservá-las em toda a terra.
4 Bikos seven days from naw, I go send rain kom di eart for forty days and forty nite kon kill evritin wey get life wey I kreate.”
4 Daqui a sete dias farei chover sobre a terra quarenta dias e quarenta noites, e farei desaparecer da face da terra todos os seres vivos que fiz".
5 So Noah do as God kommand am.
5 E Noé fez tudo como o Senhor lhe tinha ordenado.
6 Noah don rish six hundred years wen wota kover di eart.
6 Noé tinha seiscentos anos de idade quando as águas do Dilúvio vieram sobre a terra.
7 Noah enter di boat with en sons, en wife and en shidren wife dem wen di rain won fall.
7 Noé, seus filhos, sua mulher e as mulheres de seus filhos entraram na arca, por causa das águas do Dilúvio.
8 Two-two from evry klean animal; animals wey nor klean; birds and evritin wey dey creep for groun,
8 Casais de animais grandes, puros e impuros, de aves e de todos os animais pequenos que se movem rente ao chão
9 both man and woman, all enter di boat kom meet Noah, just as God kommand am.
9 vieram a Noé e entraram na arca, como Deus tinha ordenado a Noé.
10 And afta seven days, di rain kon start to fall. Noah Ark|alt="Noah's Ark" src="CO00630B.TIF" size="col" loc="GEN 7:1ff" copy="Cook" ref="7:10"
10 E depois dos sete dias, as águas do Dilúvio vieram sobre a terra.
11 Wen Noah don old rish six hundred and two monts, for di seventint day for di mont, all di wota for sky bigin rush anyhow and di heaven kon open,
11 No dia em que Noé completou seiscentos anos, um mês e dezessete dias, nesse mesmo dia todas as fontes das grandes profundezas jorraram, e as comportas do céu se abriram.
12 den rain from heaven kon start to fall for di eart for forty days and forty nites.
12 E a chuva caiu sobre a terra quarenta dias e quarenta noites.
13 For dat very day, Noah enter di boat with en sons Shem, Ham and Jafet, plus en wife and en shidren wife.
13 Naquele mesmo dia, Noé e seus filhos, Sem, Cam e Jafé, com sua mulher e com as mulheres de seus três filhos, entraram na arca.
14 Dem enter with evry kind tin wey get life; difren animal; evritin wey dey creep for groun akordin to how dem bi and evry bird akordin to how dem bi, plus evritin wey get feada.
14 Com eles entraram todos os animais de acordo com as suas espécies: todos os animais selvagens, todos os rebanhos domésticos, todos os demais seres vivos que se movem rente ao chão e todas as criaturas que têm asas: todas as aves e todos os outros animais que voam.
15 Two-two from evritin wey get life kom meet Noah inside di boat.
15 Casais de todas as criaturas que tinham fôlego de vida vieram a Noé e entraram na arca.
16 Doz wey enter na man and woman, just as God kommand am. Den Oga God klose di boat door.
16 Os animais que entraram foram um macho e uma fêmea de cada ser vivo, conforme Deus ordenara a Noé. Então o Senhor fechou a porta.
17 Di wota fall for di eart for forty days. As di wota dey many, di boat dey go up.
17 Quarenta dias durou o Dilúvio sobre a terra, e as águas aumentaram e elevaram a arca acima da terra.
18 Di wota kover di eart and di boat kon dey float on-top di wota.
18 As águas prevaleceram, aumentando muito sobre a terra, e a arca flutuava na superfície das águas.
19 Di wota kon kover di eart sotey e even kover di mountins wey high pass for di eart.
19 As águas dominavam cada vez mais a terra, e foram cobertas todas as altas montanhas debaixo do céu.
20 Di wota kon high rish twenty fit afta e don kover di mountins wey high pass.
20 As águas subiram até quase sete metros acima das montanhas.
21 And evritin wey get life for di eart kon die: di bird for sky, animals, both di ones for house and wiked ones; evritin wey dey di eart and all human being.
21 Todos os seres vivos que se movem sobre a terra pereceram: aves, rebanhos domésticos, animais selvagens, todas as pequenas criaturas que povoam a terra e toda a humanidade.
22 Evritin for land wey dey breath thru dia nose kon die.
22 Tudo o que havia em terra seca e tinha nas narinas o fôlego de vida morreu.
23 So Oga God distroy evritin wey get life for di eart: pipol, animals, di ones wey dey creep for groun and birds for di sky. All of dem die komot di eart. Only Noah and doz wey dey with am for di boat, naim save.
23 Todos os seres vivos foram exterminados da face da terra; tanto os homens, como os animais grandes, os animais pequenos que se movem rente ao chão e as aves do céu foram exterminados da terra. Só restaram Noé e aqueles que com ele estavam na arca.
24 Di wota kover di eart for one hundred and fifty days.
24 E as águas prevaleceram sobre a terra cento e cinqüenta dias.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 7, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.