Deuteronômio 14
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 Since una bi Oga God shidren, make una nor ever kut unasef or shave una hair sey una dey kry for who don die.
1 Filhos sois do Senhor vosso Deus; não vos cortareis a vós mesmos, nem abrireis calva entre vossos olhos por causa de algum morto.
2 Bikos una dey holy to di Oga una God, na-im make am choose una as en pipol wey E love pass among evry oda tin for dis world.
2 Porque és povo santo ao Senhor teu Deus, e o Senhor te escolheu para lhe seres o seu próprio povo, acima de todos os povos que há sobre a face da terra.
3 Make una nor chop anytin wey dem dey forbid.
3 Nenhuma coisa abominável comereis.
4 Dis na di animals wey una fit chop: melu, sheep, goat,
4 Estes são os animais que comereis: o boi, a ovelha, a cabra,
5 gazelle, deer, wiked goat, antelope, wiked oryx and di sheep for mountin.
5 o veado, a gazela, o cabrito montês, a cabra montesa, o antílope, o órix e a ovelha montesa.
6 Una fit chop animals wey dia leg divide into two and dey shew grass,
6 Dentre os animais, todo o que tem a unha fendida, dividida em duas, e que rumina, esse podereis comer.
7 but if di animal nor get am, make una nor chop am. So make una nor chop kamel, hare or hyrax. Dem dey really shew grass, but dia leg nor divide, so dem nor dey klean to chop.
7 Porém, dos que ruminam, ou que têm a unha fendida, não podereis comer os seguintes: o camelo, a lebre e o querogrilo, porque ruminam, mas não têm a unha fendida; imundos vos serão;
8 Make una nor chop pig. E get strong leg wey divide, but e nor dey shew, so e nor dey klean. Make una nor chop dis animals or even tosh dia dead body.
8 nem o porco, porque tem unha fendida, mas não rumina; imundo vos será. Não comereis da carne destes, e não tocareis nos seus cadáveres.
9 For all di animals wey dey for river, una fit chop anytin wey get both fins and skales.
9 Isto podereis comer de tudo o que há nas águas: tudo o que tem barbatanas e escamas podereis comer;
10 But make una nor chop any animal for wota wey nor get fins and skales, bikos dem nor dey klean.
10 mas tudo o que não tem barbatanas nem escamas não comereis; imundo vos será.
11 Una fit chop any bird wey dey klean.
11 De todas as aves limpas podereis comer.
12 Di birds wey una nor go chop na: eagle, vulture, black vulture,
12 Mas estas são as de que não comereis: a águia, o quebrantosso, o xofrango,
13 kite, falkon, any buzzard,
13 o açor, o falcão, o milhafre segundo a sua espécie,
14 any kind raven,
14 todo corvo segundo a sua espécie,
15 ostrich, owl, seagul, any kind hawk,
15 o avestruz, o mocho, a gaivota, o gavião segundo a sua espécie,
16 small owl, big owl or barn owl,
16 o bufo, a coruja, o porfirião,
17 owl for wildaness, Egypt vulture, kormorant,
17 o pelicano, o abutre, o corvo marinho,
18 stork, any kind herons, hoopoe and bat.
18 a cegonha, a garça segundo a sua espécie, a poupa e o morcego.
19 Any insect wey dey waka for groun with feada nor dey klean for una and make una nor chop dem.
19 Também todos os insetos alados vos serão imundos; não se comerão.
20 But una fit chop any bird and insect wey dey fly, bikos dem dey klean.
20 De todas as aves limpas podereis comer.
21 Make una nor chop anytin wey die on en own. Una fit gi-am to strenja wey dey stay una town or una fit sell am give strenjas. But make una nor chop am at-all, bikos una bi di Oga una God pipol. Make una nor kill or chop small goat wey still dey suck breast.
21 Não comerás nenhum animal que tenha morrido por si; ao peregrino que está dentro das tuas portas o darás a comer, ou o venderás ao estrangeiro; porquanto és povo santo ao Senhor teu Deus. Não cozerás o cabrito no leite de sua mãe.
22 Una must make sure sey una dey give God one from evry ten tin wey una get or harvest dat year.
22 Certamente darás os dízimos de todo o produto da tua semente que cada ano se recolher do campo.
23 Una go bring am kom di Oga una God present, so dat en go chop from una plant, new wine, olive oil and evry first-born for una animal. Una go bring am kom meet am for di place wey E choose sey una go for honor en name, so dat una go learn to always woship di Oga una God.
23 E, perante o Senhor teu Deus, no lugar que escolher para ali fazer habitar o seu nome, comerás os dízimos do teu grão, do teu mosto e do teu azeite, e os primogênitos das tuas vacas e das tuas ovelhas; para que aprendas a temer ao Senhor teu Deus por todos os dias.
24 Wen E bless una, if di place where E choose sey una go for honor en name dey far,
24 Mas se o caminho te for tão comprido que não possas levar os dízimos, por estar longe de ti o lugar que Senhor teu Deus escolher para ali por o seu nome, quando o Senhor teu Deus te tiver abençoado;
25 una fit sell all doz tins kon travel with di money wey una sell am go di place wey di Oga una God don choose by ensef.
25 então vende-os, ata o dinheiro na tua mão e vai ao lugar que o Senhor teu Deus escolher.
26 Wen una rish der, una fit use di money take buy any food wey una wont, plus kattle, sheep, goats, wine or beer and anytin wey una like. Den make una do party for di Oga una God present kon celebrate with una family.
26 E aquele dinheiro darás por tudo o que desejares, por bois, por ovelhas, por vinho, por bebida forte, e por tudo o que te pedir a tua alma; comerás ali perante o Senhor teu Deus, e te regozijarás, tu e a tua casa.
27 Make una nor forget Levi pipol wey dey una town, bikos dem nor get land or propaty among una.
27 Mas não desampararás o levita que está dentro das tuas portas, pois não tem parte nem herança contigo.
28 For di end of evry three years, una go bring all di tithe for dat year harvest kom, den keep am for di town wey dey near where God choose.
28 Ao fim de cada terceiro ano levarás todos os dízimos da tua colheita do mesmo ano, e os depositarás dentro das tuas portas.
29 Make una gi-am to Levi pipol, bikos dem nor get land or propaty among una. Make una still give to di strenjas wey dey stay with una; shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die, so dat dem go chop beleful. Den di Oga una God go bless una for evritin wey una dey do.
29 Então virá o levita {pois nem parte nem herança tem contigo}, o peregrino, o órfão, e a viúva, que estão dentro das tuas portas, e comerão, e fartar-se-ão; para que o Senhor teu Deus te abençoe em toda obra que as tuas mãos fizerem.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Deuteronômio 14, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.