1 Tessalonicenses 5

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Brodas and sistas, koncerning di time and sizin wen dis tins go happen, wi nor nid to rite anytin give una.
1 A respeito da época e do momento, não há necessidade, irmãos, de que vos escrevamos.
2 Bikos una really know sey, di day wen Christ go kom, e go bi like wen tif dey kom for nite.
2 Pois vós mesmos sabeis muito bem que o dia do Senhor virá como um ladrão de noite.
3 Wen pipol dey sey, “Evritin dey okay and peaceful,” na dat time wahala wey go skata evriwhere go kom and e go bi like di pain wey woman dey face wen e won born and nobody go eskape from am.
3 Quando os homens disserem: Paz e segurança!, então repentinamente lhes sobrevirá a destruição, como as dores à mulher grávida. E não escaparão.
4 But una wey bi awa brodas and sistas, make una komot from darkness, so dat, dat day nor go kom meet una as tif dey kom wen nobody dey espect,
4 Mas vós, irmãos, não estais em trevas, de modo que esse dia vos surpreenda como um ladrão.
5 bikos all of una na lite shidren. Wi nor bi nite or darkness shidren,
5 Porque todos vós sois filhos da luz e filhos do dia. Não somos da noite nem das trevas.
6 so make wi nor dey sleep as odas dey do, but make wi shine awa eye well-well.
6 Não durmamos, pois, como os demais. Mas vigiemos e sejamos sóbrios.
7 Na for nite pipol dey sleep and dey drink anyhow.
7 Porque os que dormem, dormem de noite; e os que se embriagam, embriagam-se de noite.
8 But since wi bilong to lite, make wi dey kwayet, use faith and love take protet awa chest, den wear di hope wey wi get like priest kap for head.
8 Nós, ao contrário, que somos do dia, sejamos sóbrios. Tomemos por couraça a fé e a caridade, e por capacete a esperança da salvação.
9 Bikos God nor choose us to sofa en vexnashon, but to get salvashon thru awa Oga God Jesus Christ
9 Porquanto não nos destinou Deus para a ira, mas para alcançar a salvação por nosso Senhor Jesus Cristo.
10 wey die for us, so dat weda wi dey alive or wi don die wen e kom, wi go stay togeda with am for heaven.
10 Ele morreu por nós, a fim de que nós, quer em estado de vigília, quer de sono, vivamos em união com ele.
11 So make una dey enkourage and help each oda, just as una dey do naw.
11 Assim, pois, consolai-vos mutuamente e edificai-vos uns aos outros, como já o fazeis.
12 Naw wi dey beg una, awa brodas and sistas, make una dey respet doz wey dey work, guide and tell una wetin to do about dis matter wey koncern Christ.
12 Suplicamo-vos, irmãos, que reconheçais aqueles que arduamente trabalham entre vós para dirigir-vos no Senhor e vos admoestar.
13 Bikos of di work wey dem dey do, make una love and respet dem well-well.
13 Tende para com eles singular amor, em vista do cargo que exercem. Conservai a paz entre vós.
14 Wi dey beg una, awa brodas and sistas, make una tell pipol wey dey bihave anyhow sey, wetin dem dey do nor good, den make una help doz wey dey weak, but make una dey patient with evribody.
14 Pedimo-vos, porém, irmãos, corrigi os desordeiros, encorajai os tímidos, amparai os fracos e tende paciência para com todos.
15 Make una dey sure sey nobody pay bad for bad, but for evritime, make una always dey do good for each oda and for evribody.
15 Vede que ninguém pague a outro mal por mal. Antes, procurai sempre praticar o bem entre vós e para com todos.
16 Make una dey happy evritime.
16 Vivei sempre contentes.
17 Make una dey pray evritime.
17 Orai sem cessar.
18 Make una dey tank God for evritin, bikos na so God wont sey make una wey dey inside Christ dey do.
18 Em todas as circunstâncias, dai graças, porque esta é a vosso respeito a vontade de Deus em Jesus Cristo.
19 Make una nor drive God Spirit komot for una life.
19 Não extingais o Espírito.
20 Make una nor take God word wey pesin tok as yeye tin.
20 Não desprezeis as profecias.
21 Make una test evritin kon dey do wetin good.
21 Examinai tudo: abraçai o que é bom.
22 Make una nor put hand for wiked and evil tins.
22 Guardai-vos de toda a espécie de mal.
23 Make God wey dey give peace, help una to dey holy go rish di end, so dat for di day wen Christ go kom, una spirit, soul and mind go dey without fault.
23 O Deus da paz vos conceda santidade perfeita. Que todo o vosso ser, espírito, alma e corpo, seja conservado irrepreensível para a vinda de nosso Senhor Jesus Cristo!
24 Di Pesin wey koll una to do en work dey faithful.
24 Fiel é aquele que vos chama, e o cumprirá.
25 My brodas and sistas, make una pray for us.
25 Irmãos, orai também por nós.
26 Make una greet all di brodas and sistas as God wont am.
26 Saudai a todos os irmãos com o ósculo santo.
27 I kommand una with Jesus name sey, make una read dis leta give all di brodas and sistas wey bilive.
27 Peço-vos encarecidamente, no Senhor, que esta carta seja lida a todos os irmãos.
28 Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with una.
28 A graça de nosso Senhor Jesus Cristo esteja convosco!

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Tessalonicenses 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.