1 Coríntios 11

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs BKJ

Sair da comparação
1 Make una follow mi as I dey follow Christ.
1 Sede meus seguidores, como também eu o sou de Cristo.
2 I dey praiz una, bikos una always dey do di tins wey I tell una,
2 Ora, louvo-vos, irmãos, porque vos lembrais de mim em todas as coisas, e guardais as ordenanças, como eu as entreguei a vós.
3 but I wont make una undastand sey as Christ bi evribody head, na so too husband bi head for en house and na God bi Christ head.
3 Mas eu quero que saibais que a cabeça de todo homem é Cristo, e a cabeça da mulher é o homem; e a cabeça de Cristo é Deus.
4 So any man wey dey pray or prish God message kon kover en head dey woship God, dey disgrace Christ.
4 Todo homem que ora ou profetiza, tendo sua cabeça coberta, desonra a sua cabeça.
5 And any woman wey dey pray or prish God message and e nor kover en head, dey disgrace en head, wey bi en husband; e for betta sey di woman shave en head.
5 Mas toda mulher que ora ou profetiza com sua cabeça descoberta desonra a sua cabeça, porque seria como se fosse rapada.
6 If di woman nor one kover en hair, den make e go shave am.
6 Pois, se a mulher não se cobre, tosquie-se também. Mas, se para a mulher é vergonha tosquiar-se ou rapar-se, que ela se cubra.
7 Man nor nid to kover en head, bikos e dey show as God glory bi. But woman dey show as man glory bi;
7 Pois, o homem certamente não deve cobrir sua cabeça, porque ele é a imagem e glória de Deus, mas a mulher é a glória do homem.
8 bikos God nor kreate di man from woman, but E kreate di woman from man.
8 Porque o homem não é da mulher, mas a mulher é do homem.
9 God nor kreate man bikos of woman, but E kreate woman, bikos of man.
9 Nem foi o homem criado por causa da mulher, mas a mulher por causa do homem.
10 Bikos of di angels, di woman must kover en head to show sey na en husband dey protet am.
10 Por esta causa a mulher deve ter poder sobre sua cabeça, por causa dos anjos.
11 As wi dey serve Christ, di woman and di man, dey togeda for Christ body.
11 Todavia, nem o homem é sem a mulher, nem a mulher é sem o homem no Senhor.
12 Aldo God make woman from man, but na woman dey born evribody, even doh na God kreate evribody.
12 Porque, como a mulher é do homem, assim também é o homem da mulher, mas todas as coisas de Deus.
13 Make una judge by unasef weda e dey good for woman to dey prish God word wen e nor kover en head.
13 Julgai em vós mesmos: É decente que uma mulher ore a Deus descoberta?
14 Wetin make pipol for di world dey sey, na disgrace for man to karry long hair?
14 Ou não vos ensina a mesma natureza que é vergonhoso para um homem ter cabelo comprido?
15 But long hair dey make woman fine well-well. God give di woman di long hair, so dat di hair go kover di woman head.
15 Mas se uma mulher tem cabelo comprido, isso é glória para ela, pois seu cabelo lhe foi dado para se cobrir.
16 Dis na how dem dey do tins for God church, so nobody go fit follow mi kworel for wetin I dey tok.
16 Mas, se algum homem quiser ser contencioso, nós não temos tal costume, nem as igrejas de Deus.
17 Di way una dey woship God, dey kause wahala pass di good wey E dey do for una. Bikos of dis, I nor go fit praiz una.
17 Ora, nisto eu declaro a vós, não vos louvo, porque não vos congregais para o melhor, mas para pior.
18 Bikos I hear sey wen una gada dey woship God for church, na so-so kworel una dey kworel and I bilive sey some for wetin I hear, na true.
18 Porque, primeiro de tudo, quando vos ajuntais na igreja, ouço que há divisões entre vós, e em parte eu acredito.
19 Bikos if una nor kworel, wi nor go know di good ones among una.
19 Porque também é necessário haver heresias entre vós, para que os que são aprovados se manifestem entre vós.
20 Wen una dey togeda, nor bi di Oga God Supper una dey chop?
20 Portanto, quando vos ajuntais em um lugar, isto não é para comer a ceia do Senhor.
21 But before evribody go rish di meetin, some pipol among una don start to chop and drink, wen odas dey hongry.
21 Porque ao comer, cada um toma antes do outro a sua própria ceia; e um tem fome, e outro está embriagado.
22 Una nor get house wey una go for chop and drink? Abi una hate God church? Una won disgrace pipol wey nor get anytin to chop? Wetin I go fit tell una naw? I nor go fit praiz una at-all.
22 Não tendes, porventura, casas para comer e para beber? Ou desprezais a igreja de Deus e envergonhais aos que não têm? O que vos direi? Devo louvar-vos? Eu não vos louvo.
23 I don already tell una wetin awa Oga God Jesus do for di nite wen dem sell am. And na Christ tok am by ensef. E take some bread for en hand
23 Porque eu recebi do Senhor o que também vos entreguei: Que o Senhor Jesus, na mesma noite em que ele foi traído, tomou pão;
24 and afta e don tank God, e divide am kon sey, “Dis na my body wey I dey give una. Make una always dey chop am to remember mi.”
24 e tendo dado graças, ele o partiu, e disse: Tomai, comei; isto é o meu corpo que é partido por vós; fazei isto em memória de mim.
25 Afta dem chop finish, Jesus take di cup kon sey, “Dis na my blood wey God take make new kovenant with una. Make una always dey drink am to remember mi.”
25 Depois, da mesma maneira também, ele tomou o cálice, depois de cear, dizendo: Este cálice é o novo testamento no meu sangue; fazei isto, todas as vezes que o beberdes, em memória de mim.
26 Jesus mean sey, wen una chop di bread kon drink from di cup, una dey tell odas about Christ deat until e go kom back.
26 Porque todas as vezes que comerdes este pão, e beberdes este cálice, proclamais a morte do Senhor, até que ele venha.
27 Bikos of dis, anybody wey chop di bread or drink di wine anyhow wey e like, dat pesin don sin against Christ body and en blood.
27 Portanto, qualquer que comer este pão e beber este cálice do Senhor indignamente, será culpado do corpo e do sangue do Senhor.
28 So make evribody shek ensef, before e chop di bread and drink from di cup.
28 Mas, examine-se o homem a si mesmo, e assim coma deste pão, e beba deste cálice.
29 But if una nor undastand sey na una bi Christ body, una don already kondemn unasef with di way wey una dey chop and drink from di cup.
29 Porque aquele que come e bebe indignamente, come e bebe condenação para si mesmo, não discernindo o corpo do Senhor.
30 Na dis make many of una wey nor well, weak and some among una don even die.
30 Por causa disso, muitos estão fracos e enfermos entre vós, e muitos dormem.
31 But if wi judge awasef, God nor go ponish us.
31 Porque, se julgássemos a nós mesmos, não seríamos julgados.
32 But wen God judge and ponish us, E dey do am, so dat E nor go kondemn us with dis world.
32 Mas, quando somos julgados, somos disciplinados pelo Senhor, para não sermos condenados com o mundo.
33 My brodas and sistas, make una dey wait for evribody, before una go start to chop di Oga God Supper.
33 Portanto, meus irmãos, quando vos ajuntais para comer, esperai uns pelos outros.
34 But if anybody really dey hongry, make e chop kom from en house. Den wen una dey togeda, una nor go kondemn unasef. So wen I kom, I go tell una oda tins wey una suppose know.
34 Mas, se algum homem tiver fome, coma em casa, para que não vos ajunteis para condenação. Quanto ao restante, colocarei em ordem quando eu chegar.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Coríntios 11, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.