Mateus 27
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 For early morning, di priest oga dem and di eldas kon dey plan as dem go take kill Jesus.
1 Chegando a manhã, todos os príncipes dos sacerdotes e os anciãos do povo reuniram-se em conselho para entregar Jesus à morte.
2 Dem tie am kon take am go meet Pilate, wey bi di govnor.
2 Ligaram-no e o levaram ao governador Pilatos.
3 Wen Judas wey sell Jesus si sey dem kondemn am, en mind kon dey judge am for wetin e do, so e riton di thirty silva koins give di priest oga dem and eldas,
3 Judas, o traidor, vendo-o então condenado, tomado de remorsos, foi devolver aos príncipes dos sacerdotes e aos anciãos as trinta moedas de prata,
4 kon sey, “I don sin as I sell dis innocent man make dem kill-am!”
4 dizendo-lhes: Pequei, entregando o sangue de um justo. Responderam-lhe: Que nos importa? Isto é lá contigo!
5 So Judas kon trow di silva koins inside di temple, den e komot go hang ensef.
5 Ele jogou então no templo as moedas de prata, saiu e foi enforcar-se.
6 Di priest oga dem take di money kon sey, “Moses Law sey make dem nor put blood money for di temple pus.”
6 Os príncipes dos sacerdotes tomaram o dinheiro e disseram: Não é permitido lançá-lo no tesouro sagrado, porque se trata de preço de sangue.
7 Afta dem don tok di matter, dem kon take di money buy one land wey di name bi “Potta Field” and na strenjas dem dey beri for der.
7 Depois de haverem deliberado, compraram com aquela soma o campo do Oleiro, para que ali se fizesse um cemitério de estrangeiros.
8 Na bikos of dis make dem dey koll di land “Blood Field” kon rish today.
8 Esta é a razão por que aquele terreno é chamado, ainda hoje, Campo de Sangue.
9 So wetin profet Jeremaya tok kon happen: “Dem take thirty silva koins, di money wey Israel pipol don gri to take sell Jesus,
9 Assim se cumpriu a profecia do profeta Jeremias: Eles receberam trinta moedas de prata, preço daquele cujo valor foi estimado pelos filhos de Israel;
10 den dem use di money take buy, ‘Di Potta Field’, just as God tell mi.”
10 e deram-no pelo campo do Oleiro, como o Senhor me havia prescrito.
11 As Jesus stand for di govnor front, di govnor kon ask am, “Na yu bi di Jew pipol king?”
11 Jesus compareceu diante do governador, que o interrogou: És o rei dos judeus? Sim, respondeu-lhe Jesus.
12 Wen di priest oga dem and di eldas dey akuiz Jesus, e nor ansa dem.
12 Ele, porém, nada respondia às acusações dos príncipes dos sacerdotes e dos anciãos.
13 Den Pilate tell Jesus, “Yu nor hear all di tins wey dem dey tok sey yu do?”
13 Perguntou-lhe Pilatos: Não ouves todos os testemunhos que levantam contra ti?
14 But Jesus nor ansa and di govnor kon sopraiz well-well.
14 Mas, para grande admiração do governador, não quis responder a nenhuma acusação.
15 For Passova Feast, di govnor dey always release one prisona give di pipol.
15 Era costume que o governador soltasse um preso a pedido do povo em cada festa de Páscoa.
16 Dat time, e get one wiked prisona and en name na (Jesus) Barabas.
16 Ora, havia naquela ocasião um prisioneiro famoso, chamado Barrabás.
17 So, wen dem don gada, Pilate ask dem, “Who una wont make I release give una? (Jesus) Barabas or Jesus Christ?”
17 Pilatos dirigiu-se ao povo reunido: Qual quereis que eu vos solte: Barrabás ou Jesus, que se chama Cristo?
18 (Bikos Pilate know sey na jealousy make dem bring Jesus Christ kom meet am.)
18 {Ele sabia que tinham entregue Jesus por inveja.}
19 As Pilate sidan for di judgement seat, en wife send message go meet am sey, “Nor put hand for dat innocent man matter, bikos last nite, I dream bad dream about am.”
19 Enquanto estava sentado no tribunal, sua mulher lhe mandou dizer: Nada faças a esse justo. Fui hoje atormentada por um sonho que lhe diz respeito.
20 But di priest oga dem and di eldas sey make di pipol ask for Barabas, so dat dem go fit kill Jesus Christ.
20 Mas os príncipes dos sacerdotes e os anciãos persuadiram o povo que pedisse a libertação de Barrabás e fizesse morrer Jesus.
21 Di govnor kon ask dem again, “Wish one for dis two pipol una wont make I release give una?”
21 O governador tomou então a palavra: Qual dos dois quereis que eu vos solte? Responderam: Barrabás!
22 So, Pilate kon still ask dem, “Den wetin I go do with Jesus wey dem dey koll Christ?”
22 Pilatos perguntou: Que farei então de Jesus, que é chamado o Cristo? Todos responderam: Seja crucificado!
23 Pilate kon ask, “Why? Wish bad tin e do?”
23 O governador tornou a perguntar: Mas que mal fez ele? E gritavam ainda mais forte: Seja crucificado!
24 Wen Pilate si sey di pipol nor gri and trobol won start, e kon take wota wosh en hand for di pipol front dey sey, “Dis man blood nor dey my head. Make only una go kill-am!”
24 Pilatos viu que nada adiantava, mas que, ao contrário, o tumulto crescia. Fez com que lhe trouxessem água, lavou as mãos diante do povo e disse: Sou inocente do sangue deste homem. Isto é lá convosco!
25 Di pipol ansa, “Make en blood dey awa head and awa shidren own!”
25 E todo o povo respondeu: Caia sobre nós o seu sangue e sobre nossos filhos!
26 Den Pilate release Barabas give dem. Afta dem flog Jesus Christ, Pilate kon gi-am to dem make dem nail am for cross.
26 — ausente —
27 Di sojas take Jesus Christ enter di govnor house and all of dem kon gada am.
27 Os soldados do governador conduziram Jesus para o pretório e rodearam-no com todo o pelotão.
28 Dem remove en klot kon wear am klot wey make am bi like king.
28 Arrancaram-lhe as vestes e colocaram-lhe um manto escarlate.
29 Dem take shuku-shuku make crown wear am for en head, put walkin stik for en hand, den knee down for en front kon dey laf am dey sey: “Make una hail Jew pipol king o-o!”
29 Depois, trançaram uma coroa de espinhos, meteram-lha na cabeça e puseram-lhe na mão uma vara. Dobrando os joelhos diante dele, diziam com escárnio: Salve, rei dos judeus!
30 Dem spit for en body kon take walkin stik nak en head many times.
30 Cuspiam-lhe no rosto e, tomando da vara, davam-lhe golpes na cabeça.
31 Wen dem laf am finish, dem remove di king klot wey dem wear am kon wear am en own klot. Den dem take am go nail for cross.
31 Depois de escarnecerem dele, tiraram-lhe o manto e entregaram-lhe as vestes. Em seguida, levaram-no para o crucificar.
32 As dem dey go outside, dem si one man from Sirene wey en name na Simon and dem kon force am make e karry Jesus Christ cross.
32 Saindo, encontraram um homem de Cirene, chamado Simão, a quem obrigaram a levar a cruz de Jesus.
33 Wen dem rish one place wey dem dey koll Golgota (wey mean “Skull Place”),
33 Chegaram ao lugar chamado Gólgota, isto é, lugar do crânio.
34 dem kon give Jesus Christ betta wine make e drink. But wen e taste am, e nor gri drink am.
34 Deram-lhe de beber vinho misturado com fel. Ele provou, mas se recusou a beber.
35 Wen dem don nail am for cross, dem kon gambol take divide en klot.
35 Depois de o haverem crucificado, dividiram suas vestes entre si, tirando a sorte. Cumpriu-se assim a profecia do profeta: Repartiram entre si minhas vestes e sobre meu manto lançaram a sorte {Sl 21,19}.
36 Dem sidan der dey look make anybody nor tosh am.
36 Sentaram-se e montaram guarda.
37 On-top of en head for di cross, dem rite wetin dem take akuiz am: “Dis na Jesus Christ, Jew pipol king.”
37 Por cima de sua cabeça penduraram um escrito trazendo o motivo de sua crucificação: Este é Jesus, o rei dos judeus.
38 Dem still nail two tif near Jesus Christ for cross, one for en rite and di oda for en left hand.
38 Ao mesmo tempo foram crucificados com ele dois ladrões, um à sua direita e outro à sua esquerda.
39 So di pipol wey dey pass where Jesus Christ dey kon dey laf am and dey shake dia head
39 Os que passavam o injuriavam, sacudiam a cabeça e diziam:
40 dey sey, “Yu wey sey yu go distroy di temple kon build am back for three days, make yu save yorsef! If yu really bi God Pikin, make yu kom down from di cross!”
40 Tu, que destróis o templo e o reconstróis em três dias, salva-te a ti mesmo! Se és o Filho de Deus, desce da cruz!
41 Na like dis too, di priest oga dem, di law tishas and di eldas dey laf am sey,
41 Os príncipes dos sacerdotes, os escribas e os anciãos também zombavam dele:
42 “E save oda pipol, but e nor fit save ensef! If e kom down naw from di cross, wi go bilive sey, na-im bi Israel King!
42 Ele salvou a outros e não pode salvar-se a si mesmo! Se é rei de Israel, desça agora da cruz e nós creremos nele!
43 Since e trust God, make God kon save am naw, bikos e sey, ‘I bi God Pikin!’ ”
43 Confiou em Deus, Deus o livre agora, se o ama, porque ele disse: Eu sou o Filho de Deus!
44 Di tifs wey dem nail for cross near Jesus Christ, still dey curse am too.
44 E os ladrões, crucificados com ele, também o ultrajavam.
45 E kon happen sey, from twelf go rish three oklok for aftanoon, darkness kon kover di whole land.
45 Desde a hora sexta até a nona, cobriu-se toda a terra de trevas.
46 Wen three oklok won rish, Jesus Christ kon shaut, “Eli, Eli, lema Sabaktani?” wey mean, “My God, My God, wetin make yu abandon mi?”
46 Próximo da hora nona, Jesus exclamou em voz forte: Eli, Eli, lammá sabactáni? - o que quer dizer: Meu Deus, meu Deus, por que me abandonaste?
47 Some of di pipol wey hear di word kon sey, “Dis Man dey koll Elijah make e kom help am.”
47 A estas palavras, alguns dos que lá estavam diziam: Ele chama por Elias.
48 At wons, one of dem run go bring sponge kon soak am for wine wey don sawa, put am for stik, den kon give Jesus make e drink.
48 Imediatamente um deles tomou uma esponja, embebeu-a em vinagre e apresentou-lha na ponta de uma vara para que bebesse.
49 But di remainin pipol sey, “Leave am! Make wi si weda Elijah go kom save am.”
49 Os outros diziam: Deixa! Vejamos se Elias virá socorrê-lo.
50 So Jesus Christ kry again, den e kon die.
50 Jesus de novo lançou um grande brado, e entregou a alma.
51 At wons, di temple kotton tear from up go rish bottom. Di groun bigin shake and rocks kon skata for evriwhere.
51 E eis que o véu do templo se rasgou em duas partes de alto a baixo, a terra tremeu, fenderam-se as rochas.
52 Graves open and God pipol wey don die kom wake-up.
52 Os sepulcros se abriram e os corpos de muitos justos ressuscitaram.
53 Afta Jesus raiz from grave, God pipol wey don die follow am raiz, den dem kon enter di holy Town with am and many pipol si dem.
53 Saindo de suas sepulturas, entraram na Cidade Santa depois da ressurreição de Jesus e apareceram a muitas pessoas.
54 Wen di sojas oga and di pipol wey dey guide Jesus Christ si di eartkweke and wetin happen, dem fear well-well kon sey, “True-true dis man na God Pikin.”
54 O centurião e seus homens que montavam guarda a Jesus, diante do estremecimento da terra e de tudo o que se passava, disseram entre si, possuídos de grande temor: Verdadeiramente, este homem era Filho de Deus!
55 Many wimen wey follow Jesus Christ from Galilee and wey dey help am, dey der too. Dem dey look wetin dey happen for der.
55 Havia ali também algumas mulheres que de longe olhavam; tinham seguido Jesus desde a Galiléia para o servir.
56 Mary Magdalin, Mary, wey bi James and Josef mama and Zebedee shidren mama, dey der too.
56 Entre elas se achavam Maria Madalena e Maria, mãe de Tiago e de José, e a mãe dos filhos de Zebedeu.
57 Wen evening rish, Josef, one rish man from Arimatea, wey bi Jesus Christ disciple
57 À tardinha, um homem rico de Arimatéia, chamado José, que era também discípulo de Jesus,
58 go meet Pilate kon ask am for Jesus Christ body. So Pilate kon sey make dem gi-am di body.
58 foi procurar Pilatos e pediu-lhe o corpo de Jesus. Pilatos cedeu-o.
59 So Josef karry di body kon wrap am with klean white klot.
59 José tomou o corpo, envolveu-o num lençol branco
60 E put am inside en own new grave wey e dig inside rock. Den e roll one big stone kover di grave mout.
60 e o depositou num sepulcro novo, que tinha mandado talhar para si na rocha. Depois rolou uma grande pedra à entrada do sepulcro e foi-se embora.
61 (Mary Magdalin and di oda Mary sidan for di oda side wey face di grave).
61 Maria Madalena e a outra Maria ficaram lá, sentadas defronte do túmulo.
62 Di next day (wey bi Sabat Day) di priest oga dem and di Farisee pipol kon gada for Pilate front
62 No dia seguinte - isto é, o dia seguinte ao da Preparação -, os príncipes dos sacerdotes e os fariseus dirigiram-se todos juntos à casa de Pilatos.
63 dey sey, “Oga God, wi remember sey wen dat wayo man still dey for dis world, e tok sey, ‘Afta three days, e go wake-up.’
63 E disseram-lhe: Senhor, nós nos lembramos de que aquele impostor disse, enquanto vivia: Depois de três dias ressuscitarei.
64 So make yu give orda make dem guide di grave until di three days go rish. If not, en disciples go-go tif en body kon tell pipol sey, ‘E don wake-up from deat’ and dis go make di last wayo worse pass di first one.”
64 Ordena, pois, que seu sepulcro seja guardado até o terceiro dia. Os seus discípulos poderiam vir roubar o corpo e dizer ao povo: Ressuscitou dos mortos. E esta última impostura seria pior que a primeira.
65 So Pilate tell dem, “Make una take plenty sojas go guide di place as una wont.”
65 Respondeu Pilatos: Tendes uma guarda. Ide e guardai-o como o entendeis.
66 So dem karry sojas go guide di grave and dem kon block di grave mout, so dat Jesus Christ nor go fit kom out.
66 Foram, pois, e asseguraram o sepulcro, selando a pedra e colocando guardas.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 27, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.