Mateus 13
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARA
1 Dat same day, Jesus komot from di house go sidan for Galilee wotaside.
1 Naquele mesmo dia, saindo Jesus de casa, assentou-se à beira-mar;
2 Many pipol gada round am, so e enter one boat and all di pipol sidan for groun near di wota.
2 e grandes multidões se reuniram perto dele, de modo que entrou num barco e se assentou; e toda a multidão estava em pé na praia.
3 E kon use parabol tish dem many tins: “Si! E get one farmer wey go plant seed for en farm.
3 E de muitas coisas lhes falou por parábolas e dizia: Eis que o semeador saiu a semear.
4 As e dey plant, some seed fall for road and bird kon chop dem.
4 E, ao semear, uma parte caiu à beira do caminho, e, vindo as aves, a comeram.
5 Some fall for san wey get big-big stone. Di one wey fall for san, kwik grow bikos di san nor deep.
5 Outra parte caiu em solo rochoso, onde a terra era pouca, e logo nasceu, visto não ser profunda a terra.
6 So wen sun kom out, e burn dem and bikos dia rut nor deep well, dem kon die.
6 Saindo, porém, o sol, a queimou; e, porque não tinha raiz, secou-se.
7 Some seed fall for shuku-shuku. Dem grow kom out, but di shuku-shuku, shuk dem die.
7 Outra caiu entre os espinhos, e os espinhos cresceram e a sufocaram.
8 But some seed fall for betta groun. Dem grow well kon bear oda seeds, some bear rish hundred, some sixty and some thirty.
8 Outra, enfim, caiu em boa terra e deu fruto: a cem, a sessenta e a trinta por um.
9 Anybody wey get ear, make e hear!”
9 Quem tem ouvidos [para ouvir], ouça.
10 Den di disciples kom meet Jesus ask am, “Why yu dey tok to dis pipol with parabol?”
10 Então, se aproximaram os discípulos e lhe perguntaram: Por que lhes falas por parábolas?
11 Jesus ansa dem, “God don make una know all di sekret tins about en kingdom, but dis pipol nor know.
11 Ao que respondeu: Porque a vós outros é dado conhecer os mistérios do reino dos céus, mas àqueles não lhes é isso concedido.
12 Pesin wey get sometin, dem go gi-am more and wetin e get go kon plenty. But pesin wey nor get anytin, even di small one wey e get, dem go take am from am.
12 Pois ao que tem se lhe dará, e terá em abundância; mas, ao que não tem, até o que tem lhe será tirado.
13 Naim make I dey tok with parabol sey:
13 Por isso, lhes falo por parábolas; porque, vendo, não veem; e, ouvindo, não ouvem, nem entendem.
14 Na dis tin make wetin Profet Isaya tok happen,
14 De sorte que neles se cumpre a profecia de Isaías:
15 Dis pipol nor go fit undastand; dem nor won hear anytin,
15 Porque o coração deste povo está endurecido, de mau grado ouviram com os ouvidos e fecharam os olhos; para não suceder que vejam com os olhos, ouçam com os ouvidos, entendam com o coração, se convertam e sejam por mim curados.
16 But God go bless una eye, bikos dem dey si well and una ear, bikos dem dey hear word.
16 Bem-aventurados, porém, os vossos olhos, porque veem; e os vossos ouvidos, porque ouvem.
17 I tell una true word, many profets and good-good pipol don wait taya make dem for hear and si wetin una dey si, but dem nor si or hear am.
17 Pois em verdade vos digo que muitos profetas e justos desejaram ver o que vedes e não viram; e ouvir o que ouvis e não ouviram.
18 “So, make una undastand wetin di farmer parabol mean:
18 Atendei vós, pois, à parábola do semeador.
19 ‘Wen pesin hear God word and e nor undastand am, di devil go kom tif di word wey dem plant for en heart, dis na di seed wey fall for road.
19 A todos os que ouvem a palavra do reino e não a compreendem, vem o maligno e arrebata o que lhes foi semeado no coração. Este é o que foi semeado à beira do caminho.
20 Di seed wey fall for san wey get big-big stone, na pesin wey hear God word kon receive am with joy,
20 O que foi semeado em solo rochoso, esse é o que ouve a palavra e a recebe logo, com alegria;
21 but di seed nor get rut, bikos di word wey e hear, nor strong for en heart, so wen trobol kom, e nor go fit bear-am.
21 mas não tem raiz em si mesmo, sendo, antes, de pouca duração; em lhe chegando a angústia ou a perseguição por causa da palavra, logo se escandaliza.
22 Di seed wey fall for shuku-shuku, na pesin wey hear God word, but wahala, long-trot and to kwik get money for dis world kon shuk di word die for en heart and e nor kon bear fruit.
22 O que foi semeado entre os espinhos é o que ouve a palavra, porém os cuidados do mundo e a fascinação das riquezas sufocam a palavra, e fica infrutífera.
23 But di seed wey fall for betta groun, na pesin wey hear and undastand God word. E kom bear fruit wey rish hundred, sixty and thirty.’ ”
23 Mas o que foi semeado em boa terra é o que ouve a palavra e a compreende; este frutifica e produz a cem, a sessenta e a trinta por um.
24 Jesus kon tell en disciples anoda parabol, “God Kingdom bi like wen pesin plant good seed for en land.
24 Outra parábola lhes propôs, dizendo: O reino dos céus é semelhante a um homem que semeou boa semente no seu campo;
25 But for nite wen evribody dey sleep, di enemy kon go plant grass join dem.
25 mas, enquanto os homens dormiam, veio o inimigo dele, semeou o joio no meio do trigo e retirou-se.
26 Wen di seeds grow kon dey bear fruit, di grass grow too.
26 E, quando a erva cresceu e produziu fruto, apareceu também o joio.
27 “So di savants tell dia oga sey, ‘Nor bi good seed wi plant for yor farm? Na where di grass from kom?’
27 Então, vindo os servos do dono da casa, lhe disseram: Senhor, não semeaste boa semente no teu campo? Donde vem, pois, o joio?
28 “Di oga ansa, ‘Na enemy plant dem.’
28 Ele, porém, lhes respondeu: Um inimigo fez isso. Mas os servos lhe perguntaram: Queres que vamos e arranquemos o joio?
29 “But di oga tell dem, ‘No, if una go rut di grass komot, una fit make mistake rut some for di good seeds too.
29 Não! Replicou ele, para que, ao separar o joio, não arranqueis também com ele o trigo.
30 Make di good seeds and di grass grow togeda until harvest. Dat time, I go tell di pipol wey dey harvest sey, “Make una first rut all di grass, tie and burn dem, den gada di good seeds put inside my store.” ’ ”
30 Deixai-os crescer juntos até à colheita, e, no tempo da colheita, direi aos ceifeiros: ajuntai primeiro o joio, atai-o em feixes para ser queimado; mas o trigo, recolhei-o no meu celeiro.
31 Jesus kon tell dem anoda parabol: “God Kingdom bi like mustard seed wey one man plant for en farm.
31 Outra parábola lhes propôs, dizendo: O reino dos céus é semelhante a um grão de mostarda, que um homem tomou e plantou no seu campo;
32 Na di seed small pass but wen e grow, na di plant big pass oda plants for di farm and difren-difren birds kon build dia house for en branches.”
32 o qual é, na verdade, a menor de todas as sementes, e, crescida, é maior do que as hortaliças, e se faz árvore, de modo que as aves do céu vêm aninhar-se nos seus ramos.
33 Jesus still tell dem anoda parabol: “God Kingdom bi like yist wey one woman take bake bread. E mix am with plenty flower and di small yist kon make di bread raiz well-well.”
33 Disse-lhes outra parábola: O reino dos céus é semelhante ao fermento que uma mulher tomou e escondeu em três medidas de farinha, até ficar tudo levedado.
34 Jesus tok all dis tins for parabol to di pipol. Evritin wey e tell dem, na parabol e use.
34 Todas estas coisas disse Jesus às multidões por parábolas e sem parábolas nada lhes dizia;
35 E do am so dat wetin di profet tok, go happen:
35 para que se cumprisse o que foi dito por intermédio do profeta: Abrirei em parábolas a minha boca; publicarei coisas ocultas desde a criação [do mundo].
36 Den Jesus kon leave di pipol enter inside house. En disciples kon tell am, “Tell us wetin di grass parabol for farm mean.”
36 Então, despedindo as multidões, foi Jesus para casa. E, chegando-se a ele os seus discípulos, disseram: Explica-nos a parábola do joio do campo.
37 Jesus ansa dem, “Pesin wey plant good seed na God Pikin;
37 E ele respondeu: O que semeia a boa semente é o Filho do Homem;
38 di farm na di world and di good seed na di kingdom pipol. Di grass na devil shidren
38 o campo é o mundo; a boa semente são os filhos do reino; o joio são os filhos do maligno;
39 and di enemy wey plant dem, na di devil. Di harvest na di last days and di harvest workers, na di angels for heaven.
39 o inimigo que o semeou é o diabo; a ceifa é a consumação do século, e os ceifeiros são os anjos.
40 “Just as dem gada di grass burn dem for fire, na so e go bi for di last day.
40 Pois, assim como o joio é colhido e lançado ao fogo, assim será na consumação do século.
41 God Pikin go send en angels make dem go remove evritin inside en Kingdom wey dey make pipol sin and break God law.
41 Mandará o Filho do Homem os seus anjos, que ajuntarão do seu reino todos os escândalos e os que praticam a iniquidade
42 Dem go trow dem inside fire wey nor dey kwensh, where dem go kry and grind dia tit.
42 e os lançarão na fornalha acesa; ali haverá choro e ranger de dentes.
43 Den, God pipol go shine like sun inside dia Papa Kingdom. Anybody wey get ear, make e hear!
43 Então, os justos resplandecerão como o sol, no reino de seu Pai. Quem tem ouvidos [para ouvir], ouça.
44 “God Kingdom bi like gold wey dem beri for field. One pesin wey si am, kon hide am. With happiness, e go sell evritin wey e get buy di land.
44 O reino dos céus é semelhante a um tesouro oculto no campo, o qual certo homem, tendo-o achado, escondeu. E, transbordante de alegria, vai, vende tudo o que tem e compra aquele campo.
45 “Again, God Kingdom bi like trada wey dey look for betta gold to buy.
45 O reino dos céus é também semelhante a um que negocia e procura boas pérolas;
46 Wen e si one gold wey dear well-well, e kon go sell evritin wey e get buy am.
46 e, tendo achado uma pérola de grande valor, vende tudo o que possui e a compra.
47 Again, God Kingdom bi like net for sea wey katch difren-difren fish.
47 O reino dos céus é ainda semelhante a uma rede que, lançada ao mar, recolhe peixes de toda espécie.
48 Wen di net full, dem drag am komot from di wota kon sidan bigin put di good fish inside difren kontaina and trowey all di bad one.
48 E, quando já está cheia, os pescadores arrastam-na para a praia e, assentados, escolhem os bons para os cestos e os ruins deitam fora.
49 Na so e go bi for di day wen di world go end. Angels go kom separate evil pipol from di good ones
49 Assim será na consumação do século: sairão os anjos, e separarão os maus dentre os justos,
50 and dem go trow evil pipol inside hell-fire, where dem go kry and grind dia tit.”
50 e os lançarão na fornalha acesa; ali haverá choro e ranger de dentes.
51 Jesus ask dem, “Una undastand all dis tins?”
51 Entendestes todas estas coisas? Responderam-lhe: Sim!
52 Den Jesus kom tell dem, “Anybody wey dey tisha di law and e bi disciple for God Kingdom, go bi like pesin wey get house kon bring new and old tins kom out from inside di house.”
52 Então, lhes disse: Por isso, todo escriba versado no reino dos céus é semelhante a um pai de família que tira do seu depósito coisas novas e coisas velhas.
53 Wen Jesus tok di parabol finish, e kon komot for der.
53 Tendo Jesus proferido estas parábolas, retirou-se dali.
54 Den e rish en village kon bigin tish di pipol for dia sinagog. Dem sopraiz well-well kon sey, “Where dis man from get dis kind sense and pawa wey e take dey do mirakle sef?”
54 E, chegando à sua terra, ensinava-os na sinagoga, de tal sorte que se maravilhavam e diziam: Donde lhe vêm esta sabedoria e estes poderes miraculosos?
55 “Nor bi di karpenter pikin bi dis? Nor bi Mary bi en mama? James, Josef, Simon and Judas, nor bi dia broda e bi?
55 Não é este o filho do carpinteiro? Não se chama sua mãe Maria, e seus irmãos, Tiago, José, Simão e Judas?
56 Nor bi all en sistas dey stay here with us so? Na from where e for get all dis pawa?”
56 Não vivem entre nós todas as suas irmãs? Donde lhe vem, pois, tudo isto?
57 So dem kon dey vex for am.
57 E escandalizavam-se nele. Jesus, porém, lhes disse: Não há profeta sem honra, senão na sua terra e na sua casa.
58 So Jesus nor do many mirakle for der, bikos dem nor bilive am.
58 E não fez ali muitos milagres, por causa da incredulidade deles.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 13, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.