Marcos 15

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 For early morning afta dem don plan wetin dem go do Jesus, di priest oga dem with di law tishas and di Sanhedrin, tie am kon take am go meet Pilate.
1 Logo pela manhã se reuniram os sumos sacerdotes com os anciãos, os escribas e com todo o conselho. E tendo amarrado Jesus, levaram-no e entregaram-no a Pilatos.
2 So Pilate ask Jesus, “Na yu bi di Jew pipol king?”
2 Este lhe perguntou: És tu o rei dos judeus? Ele lhe respondeu: Sim.
3 Den di priest oga dem still dey akuiz am,
3 Os sumos sacerdotes acusavam-no de muitas coisas.
4 so Pilate ask Jesus again, “Yu nor get anytin to tok? Yu dey hear all dis tins wey dem sey yu do?”
4 Pilatos perguntou-lhe outra vez: Nada respondes? Vê de quantos delitos te acusam!
5 But Jesus nor tok anytin and dis tin kon sopraiz Pilate well-well.
5 Mas Jesus nada mais respondeu, de modo que Pilatos ficou admirado.
6 Anytime wen dem dey do di Passova Feast, Pilate always dey free one prisona wey di pipol ask for.
6 Ora, costumava ele soltar-lhes em cada festa qualquer dos presos que pedissem.
7 Barabas, one man wey kill pesin for di time wey dem dey rayot, dey prison with pipol wey nor dey obey govment law.
7 Havia na prisão um, chamado Barrabás, que fora preso com seus cúmplices, o qual na sedição perpetrara um homicídio.
8 Den di pipol kom meet Pilate kon ask am sey, make e free one prisona for dem, as e dey do before.
8 O povo que tinha subido começou a pedir-lhe aquilo que sempre lhes costumava conceder.
9 So Pilate ask dem, “Una wont make I free Jew pipol king for una?”
9 Pilatos respondeu-lhes: Quereis que vos solte o rei dos judeus?
10 (Pilate know sey di priest oga dem bring Jesus to am, bikos dem dey jealous).
10 {Porque sabia que os sumos sacerdotes o haviam entregue por inveja.}
11 But di priest oga dem tell di pipol make dem ask Pilate make e free Barabas.
11 Mas os pontífices instigaram o povo para que pedissem de preferência que lhes soltasse Barrabás.
12 So Pilate ask dem again, “Den wetin una wont make I do to dis man wey una koll Jew pipol king?”
12 Pilatos falou-lhes outra vez: E que quereis que eu faça daquele a quem chamais o rei dos judeus?
13 Dem kon shaut, “Kill-am trowey!”
13 Eles tornaram a gritar: Crucifica-o!
14 Pilate ask dem, “Why? Wish bad tin e do?”
14 Pilatos replicou: Mas que mal fez ele? Eles clamavam mais ainda: Crucifica-o!
15 Bikos Pilate one do wetin di pipol wont, e kon free Barabas for dem, den afta e tell en sojas make dem flog Jesus, e kon give Jesus to di pipol make dem go kill-am.
15 Querendo Pilatos satisfazer o povo, soltou-lhes Barrabás e entregou Jesus, depois de açoitado, para que fosse crucificado.
16 So di sojas push Jesus enter di varanda for di govnor palis kon koll evribody gada.
16 Os soldados conduziram-no ao interior do pátio, isto é, ao pretório, onde convocaram toda a coorte.
17 Dem wear am purpol klot kon take shuku-shuku make crown wear for en head.
17 Vestiram Jesus de púrpura, teceram uma coroa de espinhos e a colocaram na sua cabeça.
18 Dem kon dey salot am, “Wi hail yu o-o, Jew pipol king!”
18 E começaram a saudá-lo: Salve, rei dos judeus!
19 Dem take stik nak am for head kon spit for en body. Dem knee down for en front dey bow for am.
19 Davam-lhe na cabeça com uma vara, cuspiam nele e punham-se de joelhos como para homenageá-lo.
20 Wen dem don laf am finish, dem pul di purpol klot komot from en body kon wear am en own klot. Den, dem kon go kill-am.
20 Depois de terem escarnecido dele, tiraram-lhe a púrpura, deram-lhe de novo as vestes e conduziram-no fora para o crucificar.
21 Di sojas kon force Simon, one man from Sirene, wey just dey enter di town, make e karry Jesus cross. (Di man na Alexanda and Rufus papa.)
21 Passava por ali certo homem de Cirene, chamado Simão, que vinha do campo, pai de Alexandre e de Rufo, e obrigaram-no a que lhe levasse a cruz.
22 Dem take Jesus go di place wey dem dey koll Golgota (wey mean, “Skull Place”).
22 Conduziram Jesus ao lugar chamado Gólgota, que quer dizer lugar do crânio.
23 Dem gi-am wine wey dem mix with myrrh, but Jesus nor gri drink am.
23 Deram-lhe de beber vinho misturado com mirra, mas ele não o aceitou.
24 Dem nail am for cross kon divide en klot, dey trow dice make dem for know wetin go rish each pesin.
24 Depois de o terem crucificado, repartiram as suas vestes, tirando a sorte sobre elas, para ver o que tocaria a cada um.
25 Na nine oklok for morning dem take nail Jesus for cross.
25 Era a hora terceira quando o crucificaram.
26 Dem kon rite sey, “Dis na Jew pipol king.”
26 A inscrição que motivava a sua condenação dizia: O rei dos judeus.
27 Dem nail two tif with am for cross, one for en left and di oda for en rite side.
27 Crucificaram com ele dois bandidos: um à sua direita e outro à esquerda.
28 Wetin dem rite for God word kon happen sey, “Dem kount Jesus join bad pipol.”
28 {Cumpriu-se assim a passagem da Escritura que diz: Ele foi contado entre os malfeitores {Is 53,12}.}
29 Pipol wey dey waka pass kon dey shake dia head and dey tok bad about am sey, “Eehen! Yu wey sey, yu go fit distroy di temple kon build am again for three days.
29 Os que iam passando injuriavam-no e abanavam a cabeça, dizendo: Olá! Tu que destróis o templo e o reedificas em três dias,
30 Oya! Save yorsef make yu kom down from di cross!”
30 salva-te a ti mesmo! Desce da cruz!
31 Even di priest oga dem and di law tishas dey laf Jesus for where dem sidan, dey sey, “E save oda pipol, but e nor fit save ensef!
31 Desta maneira, escarneciam dele também os sumos sacerdotes e os escribas, dizendo uns para os outros: Salvou a outros e a si mesmo não pode salvar!
32 Christ, wey sey e bi Israel king, make e kom down from di cross naw make wi si am, so dat wi go bilive!” Doz wey dem nail for cross with am kon dey curse am too.
32 Que o Cristo, rei de Israel, desça agora da cruz, para que vejamos e creiamos! Também os que haviam sido crucificados com ele o insultavam.
33 Wen twelf oklok for aftanoon rish, darkness kon kover di kountry until three oklok for aftanoon.
33 Desde a hora sexta até a hora nona, houve trevas por toda a terra.
34 Around three oklok, Jesus kon shaut sey, “Eloi! Eloi! Lama Sabaktani?” Wey mean, “My God! My God! Wetin make yu abandon mi?”
34 E à hora nona Jesus bradou em alta voz: Elói, Elói, lammá sabactáni?, que quer dizer: Meu Deus, meu Deus, por que me abandonaste?
35 Wen some pipol wey stand near der hear wetin e tok, dem kon sey, “Listin. E dey koll Elijah!”
35 Ouvindo isto, alguns dos circunstantes diziam: Ele chama por Elias!
36 Den one pesin run kom with foam kon soak am inside betta wine, den e put am for stik give Jesus make e drink, den e kon sey, “Make una leave am! Make wi si weda Elijah go kom save am.”
36 Um deles correu e ensopou uma esponja em vinagre e, pondo-a na ponta de uma vara, deu-lho para beber, dizendo: Deixai, vejamos se Elias vem tirá-lo.
37 But Jesus shaut again, den e kon die.
37 Jesus deu um grande brado e expirou.
38 So di curtain for di temple tear into two from top go rish bottom.
38 O véu do templo rasgou-se então de alto a baixo em duas partes.
39 Wen di soja wey stand for Jesus front si how e take die, e kon sey, “True-true dis man na God Pikin!”
39 O centurião que estava diante de Jesus, ao ver que ele tinha expirado assim, disse: Este homem era realmente o Filho de Deus.
40 Some wimen dey der dey look from far. Dem bi Mary Magdalin, Mary wey bi Josef, James and Salome mama.
40 Achavam-se ali também umas mulheres, observando de longe, entre as quais Maria Madalena, Maria, mãe de Tiago, o Menor, e de José, e Salomé,
41 For di time wen Jesus dey Galilee, dis wimen dey follow and help am. Many oda wimen wey follow am kom from Jerusalem, dey der too.
41 que o tinham seguido e o haviam assistido, quando ele estava na Galiléia; e muitas outras que haviam subido juntamente com ele a Jerusalém.
42 Wen evening don rish for di day before di Sabat Day,
42 Quando já era tarde - era a Preparação, isto é‚ é a véspera do sábado -,
43 Josef wey kom from Arimatea, wey bi Jew kansol memba, wey dey wait for God Kingdom and pipol dey respet am well-well, go meet Pilate kon ask for Jesus body.
43 veio José de Arimatéia, ilustre membro do conselho, que também esperava o Reino de Deus; ele foi resoluto à presença de Pilatos e pediu o corpo de Jesus.
44 Pilate sopraiz sey Jesus don die. So e koll di soja kon ask am weda e don tey wen Jesus die.
44 Pilatos admirou-se de que ele tivesse morrido tão depressa. E, chamando o centurião, perguntou se já havia muito tempo que Jesus tinha morrido.
45 Wen Pilate hear wetin di soja tok, e kon sey make Josef go karry di body.
45 Obtida a resposta afirmativa do centurião, mandou dar-lhe o corpo.
46 Josef buy linen klot, bring Jesus body kom down from di cross kon take di klot wrap am, den e put am for grave wey dem dig inside rock. Den e roll big stone kover di grave mout.
46 Depois de ter comprado um pano de linho, José tirou-o da cruz, envolveu-o no pano e depositou-o num sepulcro escavado na rocha, rolando uma pedra para fechar a entrada.
47 Mary Magdalin and Mary wey bi Josef mama dey look and dem si where dem beri Jesus put.
47 Maria Madalena e Maria, mãe de José, observavam onde o depositavam.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Marcos 15, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.