Lucas 24

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 For early morning for di first day for di week, di wimen karry di perfume wey dem prepare go di grave where dem beri Jesus put.
1 Mas, no primeiro dia da semana, alta madrugada, as mulheres foram ao túmulo, levando os óleos aromáticos que haviam preparado.
2 Dem kon si sey dem don roll di stone komot from di grave mout,
2 Encontraram a pedra removida do túmulo,
3 but wen dem enter inside, dem nor si Jesus body for der.
3 mas, ao entrar, não acharam o corpo do Senhor Jesus.
4 As dem dey konfuse bikos of dis tin, dem kon si two men wey dia klot dey shine like lite and dem stand for korna.
4 Aconteceu que, perplexas a esse respeito, apareceram-lhes dois homens com roupas resplandecentes.
5 Fear katch di wimen and dem kon face groun. But di men tell dem, “Why una dey find pesin wey dey alive for where dead body dey?
5 Estando elas com muito medo e baixando os olhos para o chão, eles disseram: — Por que vocês estão procurando entre os mortos aquele que vive?
6 E nor dey here again, God don wake am! Una remember wetin e tell una wen e dey Galilee sey,
6 Ele não está aqui, mas ressuscitou. Lembrem-se do que ele falou para vocês, estando ainda na Galileia:
7 ‘Dem must sell Man Pikin give wiked pipol and dem go kill-am trowey and for di third day, e go wake-up.’ ” Angel tok to di wimen wey go Jesus grave|alt="Angels dey greet di wimen wey go visit Jesus grave" src="WA03931b.tif" size="col" loc="LOOK 24:4-7" copy="Wade" ref="24:7"
7 “É necessário que o Filho do Homem seja entregue nas mãos de pecadores, seja crucificado e ressuscite no terceiro dia.”
8 Den di wimen kon remember wetin Jesus tell dem,
8 Então elas se lembraram das palavras de Jesus.
9 so dem komot from di grave kon go tell di eleven apostles and di rest pipol wetin happen.
9 E, voltando do túmulo, anunciaram todas estas coisas aos onze e a todos os outros que estavam com eles.
10 Na Mary Magdalin, Joanna, Mary wey bi James mama and di oda wimen wey dey with dem, na dem tell di apostles all dis tins.
10 Essas mulheres eram Maria Madalena, Joana e Maria, mãe de Tiago; também as demais que estavam com elas confirmaram estas coisas aos apóstolos.
11 But dia word nor mean anytin to di apostles, so dem nor bilive di wimen.
11 Mas para eles tais palavras pareciam um delírio; eles não acreditaram no que as mulheres diziam.
12 But Pita kon get up, run go di grave. E ben-down look inside and e si only di klot, den e kon go house dey wonder wetin happen.
12 Pedro, porém, levantando-se, correu ao túmulo. E, abaixando-se, viu somente os lençóis de linho e nada mais; e retirou-se para casa, admirado com o que tinha acontecido.
13 Dat day, two men among Jesus disciples dey waka go one village wey dem dey koll Emmaus, wey nor too far from Jerusalem.
13 Naquele mesmo dia, dois discípulos estavam indo para uma aldeia chamada Emaús, que ficava a uns dez quilômetros de Jerusalém.
14 Dem dey tok to each oda about di tins wey happen.
14 E iam conversando a respeito de tudo o que tinha acontecido.
15 As dem dey tok, Jesus kon bigin waka with dem,
15 Enquanto conversavam e discutiam, o próprio Jesus se aproximou e ia com eles.
16 (but Jesus nor let dem know who e bi.)
16 Porém os olhos deles estavam como que impedidos de o reconhecer.
17 Den Jesus kon ask dem, “Na wetin make una dey tok like dis for road?”
17 Então ele lhes perguntou: E eles pararam entristecidos.
18 Den one among dem, wey en name bi Kleopas, kon tell am, “Na only yu bi strenja for Jerusalem wey nor know di tins wey dey happen since?”
18 Um, porém, chamado Cleopas, respondeu: — Será que você é o único que esteve em Jerusalém e não sabe o que aconteceu lá, nestes últimos dias?
19 Jesus ask dem, “Wish tins?”
19 Ele lhes perguntou: Eles explicaram: — Aquilo que aconteceu com Jesus, o Nazareno, que era profeta, poderoso em obras e palavras, diante de Deus e de todo o povo,
20 and how awa priest oga dem and di pipol wey dey rule us kill-am trowey.
20 e como os principais sacerdotes e as nossas autoridades o entregaram para ser condenado à morte e o crucificaram.
21 But wi bin hope sey naim go free Israel and dis tins don happen for three days naw.
21 Nós esperávamos que fosse ele quem havia de redimir Israel. Mas, depois de tudo isto, já estamos no terceiro dia desde que essas coisas aconteceram.
22 Some wimen wey dey with us kon even sopraiz us. Dem go where dem beri am put dis morning
22 É verdade também que algumas mulheres do nosso grupo nos surpreenderam. Indo de madrugada ao túmulo
23 and dem nor si en body for der. Dem kom back dey tok sey dem si angels wey tell dem sey Jesus dey alive.
23 e não achando o corpo de Jesus, voltaram dizendo que tinham tido uma visão de anjos, os quais afirmam que ele vive.
24 Den some pipol wey dey with us kon go di grave and dem si evritin as di wimen tok, but dem nor si Jesus.”
24 De fato, alguns dos nossos foram ao túmulo e verificaram a exatidão do que as mulheres disseram; mas não o viram.
25 So Jesus tell dem, “Una nor get sense and una nor dey kwik bilive wetin all di profets tok.
25 Então ele lhes disse:
26 Dem nor tok sey di Mezaya go must sofa all dis tins and den e go enter en glory?”
26 Não é verdade que o Cristo tinha de sofrer e entrar na sua glória?
27 Den e kon use wetin Moses and all di profets rite take tell dem wetin God tok about am for en word.
27 E, começando por Moisés e todos os Profetas, explicou-lhes o que constava a respeito dele em todas as Escrituras.
28 As dem near di village wey dem dey go, Jesus do like sey e won waka go front,
28 Quando se aproximavam da aldeia para onde iam, ele fez menção de passar adiante.
29 but dem tell am, “Make yu stay with us, bikos evening don nearly rish and day go soon dark.” So Jesus enter di village kon follow dem stay.
29 Mas eles o convenceram a ficar, dizendo: — Fique conosco, porque é tarde, e o dia já está chegando ao fim. E entrou para ficar com eles.
30 E sidan for where dem dey chop; e take bread, bless am kon divide am give dem.
30 E aconteceu que, quando estavam à mesa, ele pegou o pão e o abençoou; depois, partiu o pão e o deu a eles.
31 At wons dia eye open and dem kon know am. Den e vanish from dia front.
31 Então os olhos deles se abriram, e eles reconheceram Jesus; mas ele desapareceu da presença deles.
32 Dem kon tell each oda, “No wonder e bi like sey fire dey burn inside awa heart wen e dey tok with us for road about God!”
32 E disseram um ao outro: — Não é verdade que o coração nos ardia no peito, quando ele nos falava pelo caminho, quando nos explicava as Escrituras?
33 So dem get up at wons go back to Jerusalem. Dem si di eleven apostles and di oda pipol wey dey with dem
33 E, na mesma hora, levantando-se, voltaram para Jerusalém, onde acharam reunidos os onze e outros com eles,
34 kon tell dem, “Jesus don really wake-up and e don appear to Simon!”
34 os quais diziam: — De fato, o Senhor ressuscitou e já apareceu a Simão!
35 Den dem tok wetin happen for road and how dem take know Jesus wen e divide di bread.
35 Então os dois contaram o que lhes tinha acontecido no caminho e como tinham reconhecido o Senhor no partir do pão.
36 As dem still dey tok, Jesus kon stand with dem, tell dem, “Make peace dey with una.”
36 Falavam eles ainda estas coisas quando Jesus apareceu no meio deles e lhes disse:
37 But dem shok kon bigin fear, bikos dem tink sey na spirit dem dey si.
37 Eles, porém, ficaram assustados e com medo, pensando que estavam vendo um espírito.
38 Den Jesus kon sey, “Why una dey fear and nor bilive?
38 Mas ele lhes disse:
39 Make una look my hand and leg and make una tosh mi: spirit nor get flesh and bone as una si sey I get.”
39 Vejam as minhas mãos e os meus pés, que sou eu mesmo. Toquem em mim e vejam que é verdade, porque um espírito não tem carne nem ossos, como vocês estão vendo que eu tenho.
40 Wen Jesus don tok dis one, e kon show dem en hand and leg.
40 Dizendo isto, mostrou-lhes as mãos e os pés.
41 And as dem neva still bilive (bikos of dia happiness) and still dey sopraiz, Jesus ask dem, “Una get anytin to chop for here?”
41 E, por não acreditarem eles ainda, por causa da alegria, e como estavam admirados, Jesus lhes disse:
42 So dem kon gi-am fish wey dem don kook,
42 Então lhe apresentaram um pedaço de peixe assado,
43 e kon take am chop for dia front.
43 e ele comeu na presença deles.
44 Den Jesus tell dem, “Na di word wey I tell una wen I still dey with una bi dis, evritin wey dem rite about mi for Moses Law, di profets book and Psalms, must happen.”
44 A seguir, Jesus lhes disse:
45 Den e open dia mind so dat dem go fit undastand God word
45 Então lhes abriu o entendimento para compreenderem as Escrituras.
46 kon tell dem, “Na wetin dem rite bi dis, ‘Di Mezaya go sofa and e go wake-up from deat for di third day
46 E disse-lhes:
47 and dem go use en name prish give pipol make dem for turn from dia sin kom meet God and di prishin go start from Jerusalem.’
47 e que em seu nome se pregasse arrependimento para remissão de pecados a todas as nações, começando em Jerusalém.
48 Una bi witness for dis tins.
48 Vocês são testemunhas destas coisas.
49 I dey send wetin my Papa promise kom meet una. So make una stay for dis town until pawa go kom from heaven kon kover una.”
49 Eis que envio sobre vocês a promessa de meu Pai; permaneçam, pois, na cidade, até que vocês sejam revestidos do poder que vem do alto.
50 Den Jesus take dem go Betany kon lift en hand and bless dem.
50 Então Jesus os levou para fora, até Betânia. E, erguendo as mãos, os abençoou.
51 As e dey bless dem, God kon karry am go heaven.
51 Aconteceu que, enquanto os abençoava, ia-se retirando deles, sendo elevado para o céu.
52 So, dem woship am kon go back to Jerusalem dey happy well-well
52 Então eles, adorando-o, voltaram para Jerusalém cheios de alegria.
53 and dem dey go di temple evritime, dey praiz God.
53 E estavam sempre no templo, louvando a Deus.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 24, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.