Lucas 20
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 One day wen Jesus dey tish pipol for di temple, di priest oga dem and di law tishas kon meet am,
1 Num daqueles dias, Jesus ensinava no templo e anunciava ao povo a boa nova. Chegaram os príncipes dos sacerdotes e os escribas com os anciãos,
2 dey sey, “Make yu tell us, na wish pawa yu take dey do dis tins? Na who give yu di pawa sef?”
2 e falaram-lhe: Dize-nos: com que direito fazes essas coisas, ou quem é que te deu essa autoridade?
3 Jesus ansa dem, “Make I still ask una one kweshon and make una ansa mi.
3 Jesus respondeu: Também eu vos farei uma pergunta.
4 John baptizim kom from heaven, abi na from pipol?”
4 Respondei-me: o batismo de João era do céu ou dos homens?
5 Dem kon dey tok with each oda sey, “If wi sey na from heaven, e go sey, ‘Den why una nor bilive am?’
5 Eles começaram a raciocinar entre si, dizendo: Se dissermos: Do céu, ele dirá: Por que razão, pois, não crestes nele?
6 But if wi sey, ‘Na from pipol’, dis pipol go stone us, bikos dem bilive sey, John na profet.”
6 Se, porém, dissermos: Dos homens, todo o povo nos apedrejará, porque está convencido de que João era profeta.
7 So dem kon tell Jesus sey dem nor know where di baptizim from kom.
7 Responderam por fim que não sabiam de onde era.
8 Den Jesus tell dem, “Mi too nor go tell una who give mi di pawa to do all dis tins.”
8 Replicou-lhes também Jesus: Nem eu vos direi com que direito faço estas coisas.
9 Jesus kon tell di pipol one parabol: “One man rent en grape farm give tenants, den e travel.
9 Então Jesus propôs-lhes esta parábola: Um homem plantou uma vinha, arrendou-a a vinhateiros e ausentou-se por muito tempo para uma terra estranha.
10 Wen harvest time rish, e kon send one savant go meet di tenants make dem gi-am en share from di harvest. But di tenants beat di savant kon send am go back with empty hand.
10 No tempo da colheita, enviou um servo aos vinhateiros para que lhe dessem do produto da vinha. Estes o feriram e o reenviaram de mãos vazias.
11 So e send anoda savant and dem still beat and do am anyhow, den dem kon send am back with empty hand.
11 Tornou a enviar outro servo; eles feriram também a este, ultrajaram-no e despediram-no sem coisa alguma.
12 Di man kon send di third savant go, but di tenants wound am kon trow am outside too.
12 Tornou a enviar um terceiro; feriram também este e expulsaram-no.
13 “So di grape farm owner kon sey, ‘Wetin I go do naw? I go send di only pikin wey I get, may bi dem go respet am.’
13 Disse então o senhor da vinha: Que farei? Mandarei meu filho amado; talvez o respeitem.
14 “But wen di tenant si di pikin, dem kon sey, ‘Na di owner pikin dey kom so, make wi kill-am, so dat all di propaty go bi awa own!’
14 Vendo-o, porém, os vinhateiros discorriam entre si e diziam: Este é o herdeiro; matemo-lo, para que se torne nossa a herança.
15 Dem karry di pikin go outside, kon kill-am. So, wetin una tink sey di owner go do di tenants?
15 E lançaram-no fora da vinha e mataram-no. Que lhes fará, pois, o dono da vinha?
16 E go kom distroy all dis tenant, den give di grape farm to new tenants.”
16 Virá e exterminará estes vinhateiros e dará a vinha a outros. A estas palavras, disseram: Que Deus não o permita!
17 But Jesus look dem for face kon ask, “Wetin God word mean wen e sey:
17 Mas Jesus, fixando o olhar neles, disse-lhes: Que quer dizer então o que está escrito: A pedra que os edificadores rejeitaram tornou-se a pedra angular {Sl 117,22}?
18 Anybody wey fall for dis stone, go break into pieces and di pesin wey di stone fall press, go die.”
18 Todo o que cair sobre esta pedra ficará despedaçado; e sobre quem ela cair, este será esmagado!
19 Den di Farisee pipol and di law tishas won kon arrest Jesus for dat place, bikos dem know sey Jesus dey tok against dem. But dem dey fear di pipol.
19 Naquela mesma hora os príncipes dos sacerdotes e os escribas procuraram prendê-lo, mas temeram o povo. Tinham compreendido que se referia a eles ao propor essa parábola.
20 Den di Farisee pipol and di law tishas kon dey wosh Jesus well-well. Dem send some pipol go pritend like sey dem dey follow Jesus, so dat dem go fit use en word against am, kon ripot am to di Roman Govnor.
20 Puseram-se então a observá-lo e mandaram espiões que se disfarçassem em homens de bem, para armar-lhe ciladas e surpreendê-lo no que dizia, a fim de o entregarem à autoridade e ao poder do governador.
21 So dem ask am, “Tisha, wi know sey wetin yu dey tok korrect and yu nor dey do wayo, bikos yu dey tish di trut about God.
21 Perguntaram-lhe eles: Mestre, sabemos que falas e ensinas com retidão e que, sem fazer acepção de pessoa alguma, ensinas o caminho de Deus segundo a verdade.
22 Make yu tell us, ‘E good make wi pay tax give Caesar?’ ”
22 É-nos permitido pagar o imposto ao imperador ou não?
23 But Jesus know sey na trap, so e kon tell dem,
23 Jesus percebeu a astúcia e respondeu-lhes:
24 “Make una show mi di money. Wish pesin face and name dey?” Dem ansa, “Na Caesar own.”
24 Mostrai-me um denário. De quem leva a imagem e a inscrição? Responderam: De César.
25 So Jesus tell dem, “Den make una give Caesar wetin bi Caesar own and make una give God wetin bi God own.”
25 Então lhes disse: Dai, pois, a César o que é de César e a Deus o que é de Deus.
26 So dem nor fit get am with en word for di pipol present. Dem sopraiz for di ansa wey e give and dem nor fit tok again.
26 Assim não puderam surpreendê-lo em nenhuma de suas palavras diante do povo. Pelo contrário, admirados da sua resposta, tiveram que calar-se.
27 Den some Sadusi pipol (wey nor bilive sey pipol go wake-up from deat) kom meet Jesus,
27 Alguns saduceus - que negam a ressurreição - aproximaram-se de Jesus e perguntaram-lhe:
28 dey sey, “Tisha, Moses Law sey, ‘If pesin die leave en wife and di woman nor born for am, en broda must marry di woman wey en husband don die, so dat e go born shidren for di broda wey don die.’
28 Mestre, Moisés prescreveu-nos: Se alguém morrer e deixar mulher, mas não deixar filhos, case-se com ela o irmão dele, e dê descendência a seu irmão.
29 E get one family wey get seven brodas. Di first one marry, but dem nor born before di man die.
29 Ora, havia sete irmãos, o primeiro dos quais tomou uma mulher, mas morreu sem filhos.
30 Den di sekond one kon marry di woman,
30 Casou-se com ela o segundo, mas também ele morreu sem filhos.
31 den di third one, until nomba seven die too, but di woman nor still born for any of dem.
31 Casou-se depois com ela o terceiro. E assim sucessivamente todos os sete, que morreram sem deixar filhos.
32 At last, di woman kon die too.
32 Por fim, morreu também a mulher.
33 For di day wey pipol go wake-up from deat, wish pesin wife di woman go bi, since all di seven brodas marry am?”
33 Na ressurreição, de qual deles será a mulher? Porque os sete a tiveram por mulher.
34 So Jesus ansa dem, “Pipol for di word naw dey marry.
34 Jesus respondeu: Os filhos deste mundo casam-se e dão-se em casamento,
35 But di pipol wey God go wake-up from deat karry go heaven, nor go marry.
35 mas os que serão julgados dignos do século futuro e da ressurreição dos mortos não terão mulher nem marido.
36 Dem go bi like angels and dem nor go die again. Dem go bi God shidren, bikos dem don wake-up from deat.
36 Eles jamais poderão morrer, porque são iguais aos anjos e são filhos de Deus, porque são ressuscitados.
37 But even Moses tok sey pipol wey don die go wake-up. Moses tok like dis wen e rite about how e koll God, ‘Abraham, Isaak and Jakob God’, wen e dey di bush wey dey burn.
37 Por outra parte, que os mortos hão de ressuscitar é o que Moisés revelou na passagem da sarça ardente {Ex 3,6}, chamando ao Senhor: Deus de Abraão, Deus de Isaac, Deus de Jacó .
38 Awa God nor bi God for dead pipol, but na God wey dey alive, bikos for God eye, evribody dey alive.”
38 Ora, Deus não é Deus dos mortos, mas dos vivos; porque todos vivem para ele.
39 Den some law tishas ansa, “Tisha, yu don tok well!”
39 Alguns dos escribas disseram, então: Mestre, falaste bem.
40 So dem nor dare ask Jesus kweshon again.
40 E já não se atreviam a fazer-lhe pergunta alguma.
41 Jesus kon tell dem, “Wetin make dem sey Mezaya na David pikin?
41 Jesus perguntou-lhes: Como se pode dizer que Cristo é filho de Davi?
42 Bikos David ensef tok for Psalms Book sey,
42 Pois o próprio Davi, no livro dos Salmos, diz: Disse o Senhor a meu Senhor: Senta-te à minha direita,
43 until I go put yor enemies
43 até que eu ponha os teus inimigos por escabelo dos teus pés {Sl 109,1}.
44 If David koll am ‘Oga God,’ how e kon take bi David pikin?”
44 Portanto, Davi o chama de Senhor! Como, pois, é ele seu filho?
45 As all di pipol dey listin, Jesus kon tell en disciples,
45 Enquanto todo o povo o ouvia, disse a seus discípulos:
46 “Make una guide unasef from di law tishas. Dem like to dey waka with long klot make pipol dey shaut dia name for market and chairs wey betta pass for sinagog, na der dem dey like to sidan.
46 Guardai-vos dos escribas, que querem andar de roupas compridas e gostam das saudações nas praças públicas, das primeiras cadeiras nas sinagogas e dos primeiros lugares dos banquetes;
47 Dem dey sofa wimen wey dia husband don die and kollect dia tins kon dey pray long prayer make pipol for si dem. So na dia ponishment go big pass.”
47 que devoram as casas das viúvas, fingindo fazer longas orações. Eles receberão castigo mais rigoroso.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 20, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.