João 1
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 Since wen di time start naim di Word dey and di Word dey with God and na God ensef bi di Word.
1 No princípio era o Verbo, e o Verbo estava junto de Deus e o Verbo era Deus.
2 Di Word dey with God from wen time bigin.
2 Ele estava no princípio junto de Deus.
3 Na God make evritin and if to sey E nor make dem, dem nor for dey dis world at-all.
3 Tudo foi feito por ele, e sem ele nada foi feito.
4 Na inside am life dey and na dat life bi di lite wey pipol get.
4 Nele havia a vida, e a vida era a luz dos homens.
5 Di lite dey shine inside darkness, but darkness nor gri with am.
5 A luz resplandece nas trevas, e as trevas não a compreenderam.
6 E get one man wey en name bi John, wey God send kom dis world.
6 Houve um homem, enviado por Deus, que se chamava João.
7 E kom bear witness for di lite, make evribody for fit get di shance to bilive wetin God tok thru en word.
7 Este veio como testemunha, para dar testemunho da luz, a fim de que todos cressem por meio dele.
8 Nor bi John ensef bi di lite, but e kom tell pipol about Jesus wey bi di lite.
8 Não era ele a luz, mas veio para dar testemunho da luz.
9 Na Jesus bi di true lite wey go shine for evribody for dis world.
9 {O Verbo} era a verdadeira luz que, vindo ao mundo, ilumina todo homem.
10 E kom inside di world wey e make my ensef, but di pipol nor know am.
10 Estava no mundo e o mundo foi feito por ele, e o mundo não o reconheceu.
11 E kom meet en own pipol, but dem nor wont am.
11 Veio para o que era seu, mas os seus não o receberam.
12 But evribody wey receive and bilive en name, e go give dem di rite to bi God pikin.
12 Mas a todos aqueles que o receberam, aos que crêem no seu nome, deu-lhes o poder de se tornarem filhos de Deus,
13 Dem go bi God shidren, nor bi as dia papa and mama take born dem from belle, or bikos somebody make dem so, but bikos God ensef make dem en own shidren.
13 os quais não nasceram do sangue, nem da vontade da carne, nem da vontade do homem, mas sim de Deus.
14 Den di Word kon shange to pesin and e stay with us for dis world. Wi si en glory wey show sey, naim bi di only pikin wey get korrect favor and trut, wey God send kom meet us.
14 E o Verbo se fez carne e habitou entre nós, e vimos sua glória, a glória que o Filho único recebe do seu Pai, cheio de graça e de verdade.
15 John kon bigin shaut sey, “Dis na di pesin wey I tell una about sey, ‘Di pesin wey go kom afta mi, big pass mi, bikos e dey before mi.’ ”
15 João dá testemunho dele, e exclama: Eis aquele de quem eu disse: O que vem depois de mim é maior do que eu, porque existia antes de mim.
16 Evribody for dis world don receive plenty good tins from am.
16 Todos nós recebemos da sua plenitude graça sobre graça.
17 Na thru Moses God give us di law, but God give us favor and trut, thru Jesus Christ.
17 Pois a lei foi dada por Moisés, a graça e a verdade vieram por Jesus Cristo.
18 Nobody don fit si God face before. But Jesus, wey bi God ensef, wey en and en Papa bi tait friend, na-im kom show us how God bi.
18 Ninguém jamais viu Deus. O Filho único, que está no seio do Pai, foi quem o revelou.
19 Di Jew oga dem send priests and Levi pipol make dem go ask John sey, “Who yu bi sef?”
19 Este foi o testemunho de João, quando os judeus lhe enviaram de Jerusalém sacerdotes e levitas para perguntar-lhe: Quem és tu?
20 E ansa dem, “I nor dey lie, bikos nor bi mi bi di Christ.”
20 Ele fez esta declaração que confirmou sem hesitar: Eu não sou o Cristo.
21 Den dem ask am, “So, na who yu bi? Abi yu bi Elijah?”
21 Pois, então, quem és?, perguntaram-lhe eles. És tu Elias? Disse ele: Não o sou. És tu o profeta? Ele respondeu: Não.
22 Again, dem ask am, “Who yu bi sef? Make yu tell us, so dat wi go know wetin to tell di pipol wey send us. Who yu sey yu bi?”
22 Perguntaram-lhe de novo: Dize-nos, afinal, quem és, para que possamos dar uma resposta aos que nos enviaram. Que dizes de ti mesmo?
23 John kon sey, “Na mi bi dat vois wey dey shaut inside wildaness sey, ‘Make una make di road wey pipol go pass go meet God strait well-well’, as Profet Isaya tok before.”
23 Ele respondeu: Eu sou a voz que clama no deserto: Endireitai o caminho do Senhor, como o disse o profeta Isaías {40,3}.
24 (Na di Farisee pipol send dis pipol go meet John).
24 Alguns dos emissários eram fariseus.
25 Dem kon ask John sey, “Why yu dey baptize pipol, if yu nor bi di Christ or Elijah or di Profet?”
25 Continuaram a perguntar-lhe: Como, pois, batizas, se tu não és o Cristo, nem Elias, nem o profeta?
26 John ansa dem, “I dey baptize pipol with wota, but among una, one pesin dey wey una nor know.
26 João respondeu: Eu batizo com água, mas no meio de vós está quem vós não conheceis.
27 E go kom afta mi. I nor rish to luz di rope wey dey en shoe.”
27 Esse é quem vem depois de mim; e eu não sou digno de lhe desatar a correia do calçado.
28 All dis tins happen for Betany where pipol dey cross Jordan River kom meet John, make e baptize dem.
28 Este diálogo se passou em Betânia, além do Jordão, onde João estava batizando.
29 Wen day break, John si Jesus dey waka kom meet am, den John sey, “Make una look! Dis na di Sheep wey God send kom die, so dat God go forgive us awa sins.”
29 No dia seguinte, João viu Jesus que vinha a ele e disse: Eis o Cordeiro de Deus, que tira o pecado do mundo.
30 Na dis pesin I tell una sey, “Afta mi, one man wey big pass mi go kom, bikos e dey before mi.
30 É este de quem eu disse: Depois de mim virá um homem, que me é superior, porque existe antes de mim.
31 Misef nor know am before, but I dey baptize pipol with wota, so dat God go show Israel pipol who Jesus bi.”
31 Eu não o conhecia, mas, se vim batizar em água, é para que ele se torne conhecido em Israel.
32 Den John bear witness sey, “I si God Spirit wey kom down like dove from heaven kon stay for Jesus head.
32 {João havia declarado: Vi o Espírito descer do céu em forma de uma pomba e repousar sobre ele.}
33 I nor know am before, but di pesin wey send mi kom baptize with wota tell mi sey, ‘Di pesin wey yu go si God Spirit kom stay on-top en head, na-im go baptize pipol with Holy Spirit.’
33 Eu não o conhecia, mas aquele que me mandou batizar em água disse-me: Sobre quem vires descer e repousar o Espírito, este é quem batiza no Espírito Santo.
34 I don si am and I bear witness sey, ‘Dis man na di pesin wey God choose.’ ”
34 Eu o vi e dou testemunho de que ele é o Filho de Deus.
35 Wen day break, John with en two disciple stand for outside.
35 No dia seguinte, estava lá João outra vez com dois dos seus discípulos.
36 Dem kon dey look Jesus wen e dey waka pass, den John kon sey, “Make una look! Na dat pesin bi God Sheep.”
36 E, avistando Jesus que ia passando, disse: Eis o Cordeiro de Deus.
37 Wen John two disciples hear wetin e tok, dem kon follow Jesus.
37 Os dois discípulos ouviram-no falar e seguiram Jesus.
38 Jesus look back kon si di disciples dey follow am. Den e ask dem, “Wetin una wont?”
38 Voltando-se Jesus e vendo que o seguiam, perguntou-lhes: Que procurais? Disseram-lhe: Rabi {que quer dizer Mestre}, onde moras?
39 Jesus ansa dem, “Make una kom si am.”
39 Vinde e vede, respondeu-lhes ele. Foram aonde ele morava e ficaram com ele aquele dia. Era cerca da hora décima.
40 Andru, Simon Pita broda, na one for di disciples wey hear wetin John tok kon follow Jesus.
40 André, irmão de Simão Pedro, era um dos dois que tinham ouvido João e que o tinham seguido.
41 E first go find en broda Simon kon tell am, “Wi don si di Mezaya”, (wey mean Christ).
41 Foi ele então logo à procura de seu irmão e disse-lhe: Achamos o Messias {que quer dizer o Cristo}.
42 Andru kon bring Simon kom meet Jesus.
42 Levou-o a Jesus, e Jesus, fixando nele o olhar, disse: Tu és Simão, filho de João; serás chamado Cefas {que quer dizer pedra}.
43 Wen day break, Jesus kon plan to go Galilee. Wen e si Filip, e tell am, “Make yu follow mi.”
43 No dia seguinte, tinha Jesus a intenção de dirigir-se à Galiléia. Encontra Filipe e diz-lhe: Segue-me.
44 Filip na from Betsaida, wey bi Andru and Pita home-town.
44 {Filipe era natural de Betsaida, cidade de André e Pedro.}
45 Wen Filip si Netanel, e tell am, “Wi don si di pesin wey Moses and di profets rite about for dia book sey, ‘En name na Jesus, wey en home-town bi Nazaret and na Josef pikin e bi.’ ”
45 Filipe encontra Natanael e diz-lhe: Achamos aquele de quem Moisés escreveu na lei e que os profetas anunciaram: é Jesus de Nazaré, filho de José.
46 Netanel kon sey, “Betta tin go fit kom out from Nazaret?”
46 Respondeu-lhe Natanael: Pode, porventura, vir coisa boa de Nazaré? Filipe retrucou: Vem e vê.
47 Wen Jesus si Netanel dey waka kom meet am, e kon sey, “Make una look! Dis na betta pesin wey kom from Israel, wayo nor dey en belle.”
47 Jesus vê Natanael, que lhe vem ao encontro, e diz: Eis um verdadeiro israelita, no qual não há falsidade.
48 Netanel ask am, “How yu take know mi.”
48 Natanael pergunta-lhe: Donde me conheces? Respondeu Jesus: Antes que Filipe te chamasse, eu te vi quando estavas debaixo da figueira.
49 Netanel sey, “Tisha, true-true, yu bi God Pikin and na yu bi Israel king.”
49 Falou-lhe Natanael: Mestre, tu és o Filho de Deus, tu és o rei de Israel.
50 Jesus tell am, “Bikos I tell yu sey I si yu under di fig tree, yu bilive wetin I tok? Bikos yu bilive, yu go si wetin big pass dis one.”
50 Jesus replicou-lhe: Porque eu te disse que te vi debaixo da figueira, crês! Verás coisas maiores do que esta.
51 Den e kon sey, “Wetin I dey tell una na true word, una go si heaven open and God angels go dey waka up-and-down on-top God Pikin.”
51 E ajuntou: Em verdade, em verdade vos digo: vereis o céu aberto e os anjos de Deus subindo e descendo sobre o Filho do Homem.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.