Hebreus 10
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 Moses Law bi like shadow wey dey show good tins wey dey kom. Di shadow nor bi di tins, bikos di sakrifice wey dem dey offa evry year nor fit forgive pipol dia sins.
1 A Lei traz apenas uma sombra dos benefícios que hão de vir, e não a realidade dos mesmos. Por isso ela nunca consegue, mediante os mesmos sacrifícios repetidos ano após ano, aperfeiçoar os que se aproximam para adorar.
2 If pipol wey dey woship God don free from dia sins, dem nor for dey offa sakrifice again.
2 Se pudesse fazê-lo, não deixariam de ser oferecidos? Pois os adoradores, tendo sido purificados uma vez por todas, não mais se sentiriam culpados de seus pecados.
3 Doz sakrifice dey remind pipol of dia sins evry year,
3 Contudo, esses sacrifícios são uma recordação anual dos pecados,
4 since melu and goat blood nor fit really klean pesin from all en sins.
4 pois é impossível que o sangue de touros e bodes tire pecados.
5 So wen Christ one kom dis world, e tell God:
5 Por isso, quando Cristo veio ao mundo, disse: "Sacrifício e oferta não quiseste, mas um corpo me preparaste;
6 since yu nor like animal blood
6 de holocaustos e ofertas pelo pecado não te agradaste".
7 Den I sey, ‘Na mi bi dis,
7 Então eu disse: Aqui estou, no livro está escrito a meu respeito; vim para fazer a tua vontade, ó Deus.
8 Christ first sey, “Yu nor wont animal or sin ofrin, (even wen dem dey offa am akordin to di law).”
8 Primeiro ele disse: "Sacrifícios, ofertas, holocaustos e ofertas pelo pecado não quiseste, nem deles te agradaste" ( os quais eram feitos conforme a Lei ).
9 Den e tok again sey, “Na mi bi dis, God na wetin yu wont I kom do.” So God remove di first sakrifice, so dat E go fit bring di new one, wey bi Christ.
9 Então acrescentou: "Aqui estou; vim para fazer a tua vontade". Ele cancela o primeiro para estabelecer o segundo.
10 Bikos Jesus do wetin God wont, all of us don dey holy thru di sakrifice wey e use en body make for us.
10 Pelo cumprimento dessa vontade fomos santificados, por meio do sacrifício do corpo de Jesus Cristo, oferecido uma vez por todas.
11 Before-before, di priest dey serve evriday and dey offa di same sakrifice wey nor fit remove sin.
11 Dia após dia, todo sacerdote apresenta-se e exerce os seus deveres religiosos; repetidamente oferece os mesmos sacrifícios, que nunca podem remover os pecados.
12 But naw, Christ offa only one sakrifice for sin wons and for all, den e kon go sidan for God rite hand,
12 Mas quando este sacerdote acabou de oferecer, para sempre, um único sacrifício pelos pecados, assentou-se à direita de Deus.
13 where e dey wait until God go put en enemies under en leg.
13 Daí em diante, ele está esperando até que os seus inimigos sejam colocados como estrado dos seus pés;
14 Na with one sakrifice e take klean pipol from dia sins and dem don dey klean forever.
14 porque, por meio de um único sacrifício, ele aperfeiçoou para sempre os que estão sendo santificados.
15 Di Holy Spirit dey bear witness about dis tins sey,
15 O Espírito Santo também nos testifica a este respeito. Primeiro ele diz:
16 “Dis na di kovenant wey I go make with una and afta dat time,
16 "Esta é a aliança que farei com eles, depois daqueles dias, diz o Senhor. Porei as minhas leis em seus corações e as escreverei em suas mentes";
17 e kon sey, ‘I nor go remember dia sins and sturbones again.’ ”
17 e acrescenta: "Dos seus pecados e iniqüidades não me lembrarei mais".
18 Wen God don forgive sins, e get any nid to offa sakrifice again?
18 Onde essas coisas foram perdoadas, não há mais necessidade de sacrifício pelo pecado.
19 So my brodas and sistas, wi bilive sey wi go enter God Holy Temple thru Jesus Christ blood,
19 Portanto, irmãos, temos plena confiança para entrar no Santo dos Santos pelo sangue de Jesus,
20 bikos e give us dis new life and e go take us pass di curtain wey bi en body.
20 por um novo e vivo caminho que ele nos abriu por meio do véu, isto é, do seu corpo.
21 And wi get one High Priest wey dey kare for God Temple.
21 Temos, pois, um grande sacerdote sobre a casa de Deus.
22 So make wi draw near God with betta heart and strong faith, bikos God don wosh awa heart and body with klean wota.
22 Sendo assim, aproximemo-nos de Deus com um coração sincero e com plena convicção de fé, tendo os corações aspergidos para nos purificar de uma consciência culpada e tendo os nossos corpos lavados com água pura.
23 So make wi whole di hope wey wi get strong well-well, bikos God wey promise us dey always keep en promise.
23 Apeguemo-nos com firmeza à esperança que professamos, pois aquele que prometeu é fiel.
24 Make wi always dey tink of how wi go enkourage, love and do good for one anoda.
24 E consideremo-nos uns aos outros para incentivar-nos ao amor e às boas obras.
25 Make wi nor stop to dey meet and fellowship togeda, as some pipol dey do, but make wi enkourage one anoda more-more, since wi know sey, “Di Day wen Christ go kom,” don near.
25 Não deixemos de reunir-nos como igreja, segundo o costume de alguns, mas encorajemo-nos uns aos outros, ainda mais quando vocês vêem que se aproxima o Dia.
26 If wi kontinue to sin afta God don show us di trut, e nor get any oda sakrifice wey go fit forgive us awa sins again.
26 Se continuarmos a pecar deliberadamente depois que recebemos o conhecimento da verdade, já não resta sacrifício pelos pecados,
27 But wetin wi go dey fear for na di Judgement Day wey dey kom and hell-fire wey go distroy doz wey bi God enemies.
27 mas tão-somente uma terrível expectativa de juízo e de fogo intenso que consumirá os inimigos de Deus.
28 Wen two or three pipol bi witness sey somebody rijet Moses Law, dem go kill-am without sey dem sorry for am.
28 Quem rejeitava a lei de Moisés morria sem misericórdia pelo depoimento de duas ou três testemunhas.
29 If pipol wey nor dey obey Man Pikin; dey take di kovenant blood make yeye and dey curse di Spirit wey bring grace, na how dia own ponishment go big rish?
29 Quão mais severo castigo, julgam vocês, merece aquele que pisou aos pés o Filho de Deus, que profanou o sangue da aliança pelo qual ele foi santificado, e insultou o Espírito da graça?
30 Bikos God sey, “I go revensh, I go pay dem back” and en word still sey, “God go judge en pipol.”
30 Pois conhecemos aquele que disse: "A mim pertence a vingança; eu retribuirei"; e outra vez: "O Senhor julgará o seu povo".
31 Na big wahala if pesin fall enter God ponishment!
31 Terrível coisa é cair nas mãos do Deus vivo!
32 But make una remember how tins bi with una before, how una dey sofa afta una don receive God lite, yet una nor allow di sofa shange una mind.
32 Lembrem-se dos primeiros dias, depois que vocês foram iluminados, quando suportaram muita luta e muito sofrimento.
33 Dat time, some pipol curse and sofa una and for oda times, una dey help odas wey dey sofa like una too.
33 Algumas vezes vocês foram expostos a insultos e tribulações; em outras ocasiões fizeram-se solidários com os que assim foram tratados.
34 True-true, una sofa like oda prisonas and una dey happy wen dem seize all una propaty, bikos una know sey una get betta tin wey go last forever.
34 Vocês se compadeceram dos que estavam na prisão e aceitaram alegremente o confisco dos próprios bens, pois sabiam que possuíam bens superiores e permanentes.
35 So make una always dey strong, bikos una go get betta reward.
35 Por isso, não abram mão da confiança que vocês têm; ela será ricamente recompensada.
36 Una nid to dey patient, so dat una go fit do wetin God wont and den, una go receive en promise.
36 Vocês precisam perseverar, de modo que, quando tiverem feito a vontade de Deus, recebam o que ele prometeu;
37 Bikos God word sey: “E nor go tey again before di Pesin wey dey plan to kom, go kom.
37 pois em breve, muito em breve "Aquele que vem virá, e não demorará.
38 My raitious pipol go live and bilive, but if anybody turn back, I nor go dey happy with am.”
38 Mas o meu justo viverá pela fé. E, se retroceder, não me agradarei dele".
39 Wi nor dey among pipol wey go turn back kon perish, but wi get faith wey go save us forever.
39 Nós, porém, não somos dos que retrocedem e são destruídos, mas dos que crêem e são salvos.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Hebreus 10, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.