Gênesis 2

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT

Sair da comparação
NVT Nova Versão Transformadora
1 God kon kreate evritin wey dey di heaven and di eart finish.
1 Desse modo, completou-se a criação dos céus e da terra e de tudo que neles há.
2 For di sevent day, God finish di work wey E dey do and E kon rest.
2 No sétimo dia, Deus havia terminado sua obra de criação e descansou de todo o seu trabalho.
3 God bless di sevent day kon make am holy, bikos na dat day E stop all di work wey E dey do since.
3 Deus abençoou o sétimo dia e o declarou santo, pois foi o dia em que ele descansou de toda a sua obra de criação.
4 Dis na di story about di heaven and eart wey God kreate.
4 Esse é o relato da criação dos céus e da terra. Quando o S
5 For dis time, nor-tin don ever grow for di eart, bikos Oga God neva let rain fall and nobody dey wey go klear di groun or plant put.
5 nenhuma planta silvestre nem grãos haviam brotado na terra, pois o S enhor Deus ainda não tinha mandado chuva para regar a terra, e não havia quem a cultivasse.
6 But wota dey flow from di sea kon wet di groun.
6 Mas do solo brotava água, que regava toda a terra.
7 So Oga God take some san-san for groun take mold man kon breath life enter en nose, den di man kon dey breath.
7 Então o S enhor Deus formou o homem do pó da terra. Soprou o fôlego da vida em suas narinas, e o homem se tornou ser vivo.
8 God make Eden Gardin for di east kon put di man wey E kreate for der.
8 O S enhor Deus plantou um jardim no Éden, para os lados do leste, e ali colocou o homem que havia criado.
9 God kon make difren trees make dem grow for di soil and dem dey good for food. (Naw, di tree wey get life, wey dey make pesin know tins well-well; wey dey good and bad, dey for di gardin centre.)
9 O S enhor Deus fez brotar do solo árvores de todas as espécies, árvores lindas que produziam frutos deliciosos. No meio do jardim, colocou a árvore da vida e a árvore do conhecimento do bem e do mal.
10 So as wota dey flow from Eden go wota di gardin, e dey from der, divide into four river.
10 Da terra do Éden nascia um rio que regava o jardim e depois se dividia em quatro braços.
11 Di first river name na Pishon; e dey flow for Havilah land, di place where gold dey.
11 O primeiro braço, chamado Pisom, rodeava toda a terra de Havilá, onde existe ouro.
12 (Di gold wey dey di land, dey pure and difren-difren good iron still dey der too.)
12 O ouro dessa terra é de grande pureza; lá também há resina aromática e pedra de ônix.
13 Di sekond river name na Gihon; e dey flow pass Kush land.
13 O segundo braço, chamado Giom, rodeava toda a terra de Cuxe.
14 Di third river name na Tigris; e dey flow pass di east for Assyria. And di fourt one name, na Eufrates.
14 O terceiro braço, chamado Tigre, corria para o leste da terra da Assíria. O quarto braço era chamado de Eufrates.
15 God take man kon put am for Eden Gardin, so dat e go kare for evritin.
15 O S enhor Deus colocou o homem no jardim do Éden para cultivá-lo e tomar conta dele,
16 Den Oga God kommand di man sey, “Yu fit chop from evry tree wey dey di gardin,
16 mas o S enhor Deus lhe ordenou: “Coma à vontade dos frutos de todas as árvores do jardim,
17 but make yu nor chop from di tree wey get life; wey dey make pesin know tins; di tree wey dey good and bad, bikos wen ever yu chop from am, na dat day, yu go die.”
17 exceto da árvore do conhecimento do bem e do mal. Se você comer desse fruto, com certeza morrerá”.
18 Den God kon sey, “E nor good make only man dey. I go gi-am somebody wey go make belle sweet am.”
18 O S enhor Deus disse: “Não é bom que o homem esteja sozinho. Farei alguém que o ajude e o complete”.
19 God make evritin wey get life from di groun. E bring dem kom meet di man make e give dem name and any name wey di man koll any animal, na dat name go follow am.
19 O S enhor Deus formou da terra todos os animais selvagens e todas as aves do céu. Trouxe-os ao homem para ver como os chamaria, e o homem escolheu um nome para cada um deles.
20 So man name all di animals, birds for di sky and evritin wey get life for di eart, but Adam nor si anytin wey bi like am.
20 Deu nome a todos os animais domésticos, a todas as aves do céu e a todos os animais selvagens. O homem, porém, continuava sem alguém que o ajudasse e o completasse.
21 So Oga God kon make man sleep deep sleep and as e dey sleep, God take one from di man rib kon use flesh kover di place.
21 Então o S enhor Deus o fez cair num sono profundo. Enquanto o homem dormia, tirou dele uma das costelas e fechou o espaço que ela ocupava.
22 Den Oga God make anoda pesin from di rib wey E take from di man, den E bring am kom meet di man.
22 Dessa costela o S enhor Deus fez uma mulher e a trouxe ao homem.
23 Den di man sey,
23 “Finalmente!”, exclamou o homem. “Esta é osso dos meus ossos, e carne da minha carne! Será chamada ‘mulher’, porque foi tirada do ‘homem’”.
24 Dat na di rizin why man must live en papa and mama kon go stay with en wife and dem two go bikom one.
24 Por isso o homem deixa pai e mãe e se une à sua mulher, e os dois se tornam um só.
25 Di man and en wife nor wear anytin for body, but shame nor katch dem at-all.
25 O homem e a mulher estavam nus, mas não sentiam vergonha.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gênesis 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.