Gálatas 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Wetin I mean bi sey, di pesin wey inherit en papa propaty and e still bi small pikin, e nor dey difren from savant, even doh na en get evritin.
1 Explico-me: enquanto o herdeiro é menor, em nada difere do escravo, ainda que seja senhor de tudo,
2 But e go dey under who dey guide am, until di time wey en papa tok, go rish.
2 mas está sob tutores e administradores, até o tempo determinado por seu pai.
3 Na so e bi with us wen wi small; wi dey under di pawa wey dey kontrol dis world,
3 Assim também nós, quando menores, estávamos escravizados pelos rudimentos do mundo.
4 but wen di rite time rish, God kon send en pikin wey woman born under di law,
4 Mas quando veio a plenitude dos tempos, Deus enviou seu Filho, que nasceu de uma mulher e nasceu submetido a uma lei,
5 make e save pipol wey dey under di law, so dat God go make us en own shidren kon give us awa own propaty.
5 a fim de remir os que estavam sob a lei, para que recebêssemos a sua adoção.
6 Since wi bi God shidren, E put en Holy Spirit inside us and naim make us dey fit koll am, “Abba! Fada!”
6 A prova de que sois filhos é que Deus enviou aos vossos corações o Espírito de seu Filho, que clama: Aba, Pai!
7 So, una nor bi slave again, but una don bi God pikin and since una bi God shidren, una go get God propaty too.
7 Portanto já não és escravo, mas filho. E, se és filho, então também herdeiro por Deus.
8 Before-before, wen una nor know God, una dey do bad-bad tins.
8 Outrora, é certo, desconhecendo a Deus, servíeis aos que na realidade não são deuses.
9 But naw wey una don know am (or abi make I sey God don know una), why una still dey follow all dis weak and yeye pawas? Una won bi dia slave again?
9 Agora, porém, conhecendo a Deus, ou melhor, sendo conhecidos por Deus, como é que tornais aos rudimentos fracos e miseráveis, querendo de novo escravizar-vos a eles?
10 Dat time, una follow dia tradishon.
10 Observais dias, meses, estações e anos!
11 I dey fear sey make di work wey I do among una, nor waste.
11 Temo que os meus esforços entre vós tenham sido em vão. Voltemos à nossa confiança cordial
12 My brodas and sistas, Abeg, make una bi like mi, as I don bi like una, bikos una nor do mi any bad tin!
12 Irmãos, sede como eu, pois também eu me tornei como vós. Não tenho nenhum motivo de queixa contra vós.
13 But wen I first prish di gospel give una, una know sey I nor well,
13 Estais lembrados de como eu estava doente quando, pela primeira vez, vos preguei o Evangelho
14 even doh my sickness na problem to una, una nor laf or drive mi. Instead, una welkom mi like God angel; like sey na mi bi Jesus Christ!
14 e fui para vós uma provação por causa do meu corpo. Mas nem por isto me desprezastes nem rejeitastes, antes me acolhestes como um enviado de Deus, como Cristo Jesus.
15 Naw, na wetin don happen to una happiness? I know sey, if to sey e dey possibol, una for pul una eye give mi!
15 Onde está agora aquele vosso entusiasmo? Asseguro-vos que, se possível fora, teríeis arrancado os vossos olhos para mos dar!
16 So, I don bikom una enemy, bikos I dey tell una di trut?
16 Tornei-me, acaso, vosso inimigo, porque vos disse a verdade?
17 Di pipol wey won deceive una dey trit una well, but dem nor dey do am with betta mind; bikos dem wont make una leave mi kon follow dem.
17 Eles vos testemunham amizade com má intenção, e querem separar-vos de mim, para captar a vossa amizade.
18 But e good make una dey trit odas well, so-far una dey do am with betta mind and nor bi only wen I dey with una.
18 É maravilhoso receber demonstrações de boa amizade, mas que seja em todas as circunstâncias, e não somente quando estou convosco.
19 My shidren! Just like woman wey won born, I dey feel pain for una, until Christ pawa go dey inside una life!
19 Filhinhos meus, por quem de novo sinto dores de parto, até que Cristo seja formado em vós,
20 How I wish sey I dey with una naw, so dat I go know how to trit una, bikos I dey worry about una well-well.
20 quem me dera estar agora convosco, para descobrir o tom que convém à minha linguagem, visto que eu me encontro extremamente perplexo a vosso respeito.
21 Make una tell mi, wish of una won dey under di law? Una nor know wetin di law tok?
21 Dizei-me, vós que quereis estar sujeitos a uma lei: não ouvis a lei?
22 Dem rite am sey, Abraham get two boys, one wey di savant woman born and di oda pikin, na di really wife born am.
22 A Escritura diz que Abraão teve dois filhos, um da escrava e outro da livre.
23 Di one wey savant born, na ordinary pikin e bi, but na thru God promise di really wife take born.
23 O da escrava, filho da natureza; e o da livre, filho da promessa.
24 Betta sense dey for dis story, bikos dis two wimen bi like two kovenant. One na from Mount Sinai wey bi like di shidren wey Hagar, di slave woman, born.
24 Nestes fatos há uma alegoria, visto que aquelas mulheres representam as duas alianças: uma, a do monte Sinai, que gera para a escravidão, é Agar.
25 Hagar bi like Mount Sinai for Arabia kountry and na di same with Jerusalem wey dey naw, bikos e dey inside der as slave with en pikin.
25 {O monte Sinai está na Arábia.} Corresponde à Jerusalém atual, que é escrava com seus filhos.
26 But di Jerusalem wey kom from heaven, dey free and na-im bi awa mama.
26 Mas a Jerusalém lá do alto é livre e esta é a nossa mãe,
27 Bikos dem rite am sey:
27 porque está escrito: Alegra-te, ó estéril, que não davas à luz; rejubila e canta, tu que não tinhas dores de parto, pois são mais numerosos os filhos da abandonada do que daquela que tem marido {Is 54,1}.
28 But my brodas and sistas, una bi shidren wey get promise, just as Isaak bi.
28 Como Isaac, irmãos, vós sois filhos da promessa.
29 For dat time, di one wey dem born for normal way, trobol di one wey dem born with di Spirit and na so e bi with una naw.
29 Como naquele tempo o filho da natureza perseguia o filho da promessa, o mesmo se dá hoje.
30 But wetin dem rite for God word? “Make yu drive di savant woman and en pikin komot, bikos di savant pikin nor go share with di pikin wey di really wife born.”
30 Que diz, porém, a Escritura? Lança fora a escrava e seu filho, porque o filho da escrava não será herdeiro com o filho da livre {Gn 21,10}.
31 So my brodas and sistas, wi nor bi savant shidren. Na di really woman shidren, wi bi.
31 Pelo que, irmãos, não somos filhos da escrava, mas sim da que é livre.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gálatas 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.