1 Coríntios 15
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF
1 My brodas and sistas, I wont make una remember di gospel wey I prish give una,
1 Também vos notifico, irmãos, o evangelho que já vos tenho anunciado; o qual também recebestes, e no qual também permaneceis.
2 di one wey una asept and dey stand on. Na dis gospel go save una if una whole di message wey I prish give una well-well, unless una faith nor strong.
2 Pelo qual também sois salvos se o retiverdes tal como vo-lo tenho anunciado; se não é que crestes em vão.
3 Bikos na wetin I receive, naim bi di first important tin wey I give una; sey Christ die for awa sins as dem rite for God word
3 Porque primeiramente vos entreguei o que também recebi: que Cristo morreu por nossos pecados, segundo as Escrituras,
4 and dem beri am, den God raiz am up afta three days as dem rite for God word.
4 E que foi sepultado, e que ressuscitou ao terceiro dia, segundo as Escrituras.
5 Christ appear to Pita, den to di twelf apostles.
5 E que foi visto por Cefas, e depois pelos doze.
6 Den e appear to more dan five hundred bilivers. Some of dem still dey alive, but some don die.
6 Depois foi visto, uma vez, por mais de quinhentos irmãos, dos quais vive ainda a maior parte, mas alguns já dormem também.
7 Den e appear to James, den to all di apostles.
7 Depois foi visto por Tiago, depois por todos os apóstolos.
8 Finally, e appear to mi; even doh I bi like pikin wey dem born before di time rish,
8 E por derradeiro de todos me apareceu também a mim, como a um abortivo.
9 bikos na mi small pass among all di apostles. But, I kause many wahala for God church, so dem nor suppose koll mi apostle.
9 Porque eu sou o menor dos apóstolos, que não sou digno de ser chamado apóstolo, pois que persegui a igreja de Deus.
10 But God kind! I bi wetin I bi and God mesi for mi, nor bi yeye tin. I dey work pass any oda apostle; aldo na God grace dey help mi.
10 Mas pela graça de Deus sou o que sou; e a sua graça para comigo não foi vã, antes trabalhei muito mais do que todos eles; todavia não eu, mas a graça de Deus, que está comigo.
11 But e nor mean anytin if I prish or dem prish, as long as all of una bilive di message wey wi dey prish.
11 Então, ou seja eu ou sejam eles, assim pregamos e assim haveis crido.
12 Naw, if wi dey prish sey God raiz Jesus from deat, wetin make some pipol among una dey sey resureshon nor dey?
12 Ora, se se prega que Cristo ressuscitou dentre os mortos, como dizem alguns dentre vós que não há ressurreição de mortos?
13 If resureshon nor dey, dat mean sey Christ nor raiz-up from grave.
13 E, se não há ressurreição de mortos, também Cristo não ressuscitou.
14 And if Christ nor raiz-up, den awa prishin and una faith nor mean anytin.
14 E, se Cristo não ressuscitou, logo é vã a nossa pregação, e também é vã a vossa fé.
15 So, if resureshon nor dey, dat mean sey, evritin wey wi don tok about God, na lie, bikos wi sey E raiz Jesus from deat wen E nor raiz am.
15 E assim somos também considerados como falsas testemunhas de Deus, pois testificamos de Deus, que ressuscitou a Cristo, ao qual, porém, não ressuscitou, se, na verdade, os mortos não ressuscitam.
16 If resureshon nor dey, na-im bi sey Christ nor raiz-up from deat.
16 Porque, se os mortos não ressuscitam, também Cristo não ressuscitou.
17 If God nor raiz Christ from deat, den una faith dey yuzles and una still dey inside una sin.
17 E, se Cristo não ressuscitou, é vã a vossa fé, e ainda permaneceis nos vossos pecados.
18 And doz wey bilive Christ before dem die, don lost bi dat.
18 E também os que dormiram em Cristo estão perdidos.
19 Bikos if na only for dis life wi get hope for Christ, den awa kase worse pass any oda pesin own for dis world.
19 Se esperamos em Cristo só nesta vida, somos os mais miseráveis de todos os homens.
20 But God don raiz Christ from deat! And E make us dey sure sey, oda pipol go raiz-up from deat too.
20 Mas de fato Cristo ressuscitou dentre os mortos, e foi feito as primícias dos que dormem.
21 Just as pipol go die bikos of Adam, na so too wi go raiz-up kom life, bikos of Christ.
21 Porque assim como a morte veio por um homem, também a ressurreição dos mortos veio por um homem.
22 Adam bring deat kom meet all of us, but Christ bring life kom.
22 Porque, assim como todos morrem em Adão, assim também todos serão vivificados em Cristo.
23 But all of us must wait for awa turn. Na Christ God first raiz kom life and Christ go raiz en pipol wen e kom back.
23 Mas cada um por sua ordem: Cristo as primícias, depois os que são de Cristo, na sua vinda.
24 Den afta Christ don distroy all pawas, di world go end and e go give di kingdom to God wey bi di Papa.
24 Depois virá o fim, quando tiver entregado o reino a Deus, ao Pai, e quando houver aniquilado todo o império, e toda a potestade e força.
25 Christ go rule until e don put all en enemies under en pawa
25 Porque convém que reine até que haja posto a todos os inimigos debaixo de seus pés.
26 and di last enemy wey e go distroy, na deat.
26 Ora, o último inimigo que há de ser aniquilado é a morte.
27 Wen God word sey, e go put evritin under en pawa, e nor mean sey, God dey among dem. Bikos na God put evritin under Jesus Christ pawa.
27 Porque todas as coisas sujeitou debaixo de seus pés. Mas, quando diz que todas as coisas lhe estão sujeitas, claro está que se excetua aquele que lhe sujeitou todas as coisas.
28 And wen evritin don dey under God pikin pawa, e go kon put ensef under God wey put evritin under en pikin pawa. Den God go kon bi evritin to evribody.
28 E, quando todas as coisas lhe estiverem sujeitas, então também o mesmo Filho se sujeitará àquele que todas as coisas lhe sujeitou, para que Deus seja tudo em todos.
29 If resureshon nor dey, wetin make dem dey baptize pipol for Christ?
29 Doutra maneira, que farão os que se batizam pelos mortos, se absolutamente os mortos não ressuscitam? Por que se batizam eles então pelos mortos?
30 And wetin make us dey risk awa life
30 Por que estamos nós também a toda a hora em perigo?
31 kon dey face deat evriday? Na di pride wey I get for una, bikos of awa Oga God Jesus Christ, naim make mi dey tok all dis tins.
31 Eu protesto que cada dia morro, gloriando-me em vós, irmãos, por Cristo Jesus nosso Senhor.
32 If resureshon nor dey, wetin kon bi my gain, afta I don fight wiked animal for Efesus? Na bikos of pride make mi do am? If na so, e go good make wi dey chop and drink bikos tumoro wi go die.
32 Se, como homem, combati em Éfeso contra as bestas, que me aproveita isso, se os mortos não ressuscitam? Comamos e bebamos, que amanhã morreremos.
33 Make una nor let anybody deceive una, “Bad friends dey spoil good karata.”
33 Não vos enganeis: as más conversações corrompem os bons costumes.
34 Make una get sense and stop to dey kommit sin. I still dey sopraiz sey some pipol among una nor know God.
34 Vigiai justamente e não pequeis; porque alguns ainda não têm o conhecimento de Deus; digo-o para vergonha vossa.
35 Some among una dey ask sey, “How pipol wey don die go take kom dis world back? Wish kind body dem go get?”
35 Mas alguém dirá: Como ressuscitarão os mortos? E com que corpo virão?
36 Una bi fool! Wetin pesin plant nor dey grow, unless di seed first die.
36 Insensato! o que tu semeias não é vivificado, se primeiro não morrer.
37 Wetin una plant, na ordinary seed, but na di full plant dey grow kom out.
37 E, quando semeias, não semeias o corpo que há de nascer, mas o simples grão, como de trigo, ou de outra qualquer semente.
38 Dis na bikos God dey give dem di kind body wey E wont make di plant get.
38 Mas Deus dá-lhe o corpo como quer, e a cada semente o seu próprio corpo.
39 Pipol, animals, birds and fish, na flesh God take make all of dem, but all of dem get difren flesh.
39 Nem toda a carne é uma mesma carne, mas uma é a carne dos homens, e outra a carne dos animais, e outra a dos peixes e outra a das aves.
40 As evritin for heaven get body, na so too evritin for dis eart get body. But one body difren from di oda ones.
40 E há corpos celestes e corpos terrestres, mas uma é a glória dos celestes e outra a dos terrestres.
41 Di sun nor bi like di moon; di moon nor bi like di star and di stars difren from each oda.
41 Uma é a glória do sol, e outra a glória da lua, e outra a glória das estrelas; porque uma estrela difere em glória de outra estrela.
42 Na so e go bi afta wi don raiz-up from deat. Dis body wey wi get naw, go die, but di body wey wi go take raiz from deat, go dey forever.
42 Assim também a ressurreição dentre os mortos. Semeia-se o corpo em corrupção; ressuscitará em incorrupção.
43 Wen dem beri dis body, e dey weak and go rotin, but wen God don raiz us up from deat, di body go kon dey fine and strong forever.
43 Semeia-se em ignomínia, ressuscitará em glória. Semeia-se em fraqueza, ressuscitará com vigor.
44 As Fisical body dey, na so too spiritual body dey. And awa Fisical body go shange to spiritual body.
44 Semeia-se corpo natural, ressuscitará corpo espiritual. Se há corpo natural, há também corpo espiritual.
45 Di first man na Adam and God word sey, “Dis Adam na pesin wey God kreate like us. But Jesus, wey bi di last Adam, na pesin wey dey give life to pipol.”
45 Assim está também escrito: O primeiro homem, Adão, foi feito em alma vivente; o último Adão em espírito vivificante.
46 Wi si sey di one wey get spiritual body nor first kom. E kom afta di one wey get Fisical body.
46 Mas não é primeiro o espiritual, senão o natural; depois o espiritual.
47 Na san God take make di first man, but di sekond man kom from heaven.
47 O primeiro homem, da terra, é terreno; o segundo homem, o Senhor, é do céu.
48 Evribody body for eart, bi like di first man and evribody body for heaven, bi like di sekond man own.
48 Qual o terreno, tais são também os terrestres; e, qual o celestial, tais também os celestiais.
49 Just as wi bi like di first man wey kom from eart, wi go bi like di sekond man wey kom from heaven.
49 E, assim como trouxemos a imagem do terreno, assim traremos também a imagem do celestial.
50 My friends, I wont make una know sey awa body wey get blood go rotin. Dat mean sey dis kind body, nor go fit enter God kingdom wey go dey forever.
50 E agora digo isto, irmãos: que a carne e o sangue não podem herdar o reino de Deus, nem a corrupção herdar a incorrupção.
51 I won tell una one big sekret: Nor bi all of us go die, but all of us go shange.
51 Eis aqui vos digo um mistério: Na verdade, nem todos dormiremos, mas todos seremos transformados;
52 Before wi klose awa eye open am, e go don happen. As dem dey blow di last trumpet, all doz wey don die go raiz. All of us go shange, so dat wi nor go die again.
52 Num momento, num abrir e fechar de olhos, ante a última trombeta; porque a trombeta soará, e os mortos ressuscitarão incorruptíveis, e nós seremos transformados.
53 Awa body wey don die and rotin go kon shange to body wey nor go ever die or rotin.
53 Porque convém que isto que é corruptível se revista da incorruptibilidade, e que isto que é mortal se revista da imortalidade.
54 Di body wey wi get naw, dey weak and e go die. But God go shange am to body wey go dey forever. So wetin dem rite for God word go kon happen sey: “Deat nor fit win di fight!”
54 E, quando isto que é corruptível se revestir da incorruptibilidade, e isto que é mortal se revestir da imortalidade, então cumprir-se-á a palavra que está escrita: Tragada foi a morte na vitória.
55 “Yu deat! Where yor pawa?
55 Onde está, ó morte, o teu aguilhão? Onde está, ó inferno, a tua vitória?
56 Na sin dey make deat win and na di law dey kause sin.
56 Ora, o aguilhão da morte é o pecado, e a força do pecado é a lei.
57 So, make wi tank God wey give us viktory thru awa Oga God Jesus Christ.
57 Mas graças a Deus que nos dá a vitória por nosso Senhor Jesus Cristo.
58 So my friends, make una dey strong and nor let anytin shake una. Make una always dey do God work, bikos una know sey, evritin wey una do for God, get gain.
58 Portanto, meus amados irmãos, sede firmes e constantes, sempre abundantes na obra do Senhor, sabendo que o vosso trabalho não é vão no Senhor.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Coríntios 15, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.