Tiago 2
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 My brodas and sistas, since una get faith for awa Oga God Jesus Christ, make una nor dey do parsha.
1 Meus irmãos, não tenhais a fé de nosso Senhor Jesus Cristo, Senhor da glória, em acepção de pessoas.
2 If pesin wear gold ring and fine klot enter una church and poor pesin with dirty klot enter too
2 Porque, se no vosso ajuntamento entrar algum homem com anel de ouro no dedo, com vestes preciosas, e entrar também algum pobre com sórdida vestimenta,
3 and una respet di one wey wear fine klot, kon tell am, “Sidan for betta place,” but una tell di poor pesin, “Stand der,” or “Sidan for groun.”
3 e atentardes para o que traz a veste preciosa e lhe disserdes: Assenta-te tu aqui, num lugar de honra, e disserdes ao pobre: Tu, fica aí em pé ou assenta-te abaixo do meu estrado,
4 Dat mean sey una dey do parsha and kondemn pipol from una mind.
4 porventura não fizestes distinção dentro de vós mesmos e não vos fizestes juízes de maus pensamentos?
5 My brodas and sistas, make una listin! God nor choose poor pipol for dis world sey, make dem rish for faith and inherit di kingdom wey E promise sey E go give doz wey love am?
5 Ouvi, meus amados irmãos. Porventura, não escolheu Deus aos pobres deste mundo para serem ricos na fé e herdeiros do Reino que prometeu aos que o amam?
6 But una nor dey respet poor pipol! Nor bi rish pipol dey opress and drag una go kourt?
6 Mas vós desonrastes o pobre. Porventura, não vos oprimem os ricos e não vos arrastam aos tribunais?
7 Or dem nor dey tok bad about Jesus name wey una bilive?
7 Porventura, não blasfemam eles o bom nome que sobre vós foi invocado?
8 But if una do wetin dem rite for God word, “Make yu love yor neighbour as yu love yorsef,” una don do good bi dat.
8 Todavia, se cumprirdes, conforme a Escritura, a lei real: Amarás a teu próximo como a ti mesmo, bem fazeis.
9 If una do parsha, una dey kommit sin and di law don kondemn una as pipol wey nor dey do wetin dey di law.
9 Mas, se fazeis acepção de pessoas, cometeis pecado e sois redarguidos pela lei como transgressores.
10 Di pesin wey dey do evritin wey dey di law and e break one, don break all of dem bi dat.
10 Porque qualquer que guardar toda a lei e tropeçar em um só ponto tornou-se culpado de todos.
11 Bikos di same God wey sey, “Nor sleep with who yu nor marry,” naim still sey, “Nor kill anybody.” If yu nor sleep with who yu nor marry, but yu kill pesin, yu don break di law bi dat.
11 Porque aquele que disse: Não cometerás adultério, também disse: Não matarás. Se tu, pois, não cometeres adultério, mas matares, estás feito transgressor da lei.
12 Make una tok and do like pipol wey dem go judge with di law wey go free pipol.
12 Assim falai e assim procedei, como devendo ser julgados pela lei da liberdade.
13 Judgement nor get mesi for anybody wey nor dey mesi for odas, bikos mesi betta pass judgement.
13 Porque o juízo será sem misericórdia sobre aquele que não fez misericórdia; e a misericórdia triunfa sobre o juízo.
14 My brodas and sistas, wetin dey good if pesin sey e get faith, but e nor dey do anytin? Dat kind faith go fit save am?
14 Meus irmãos, que aproveita se alguém disser que tem fé e não tiver as obras? Porventura, a fé pode salvá-lo?
15 If one broda or sista nor get klot to wear or food to chop
15 E, se o irmão ou a irmã estiverem nus e tiverem falta de mantimento cotidiano,
16 and one pesin among una tell am, “Make peace dey with yu; make kold nor katch yu and make yu go chop beleful, but yu nor gi-am wetin di body wont, na wish kind good bi dat?”
16 e algum de vós lhes disser: Ide em paz, aquentai-vos e fartai-vos; e lhes não derdes as coisas necessárias para o corpo, que proveito virá daí?
17 Na so faith bi too, if yor faith nor dey produce betta result, e go die and dey yuzles.
17 Assim também a fé, se não tiver as obras, é morta em si mesma.
18 If anybody sey, “I get faith and yu get work.” I go sey, “Make yu show mi yor faith wey nor get work and I go show yu my faith thru my work.”
18 Mas dirá alguém: Tu tens a fé, e eu tenho as obras; mostra-me a tua fé sem as tuas obras, e eu te mostrarei a minha fé pelas minhas obras.
19 Yu bilive sey na only one good God dey. Demons bilive so too and fear dey katch dem well-well.
19 Tu crês que há um só Deus? Fazes bem; também os demônios o creem e estremecem.
20 Foolish man! Yu wont make I show yu sey faith wey nor get work dey yuzles?
20 Mas, ó homem vão, queres tu saber que a fé sem as obras é morta?
21 Wen awa papa Abraham put en pikin Isaak for di altar, wetin e do dey good for God eye?
21 Porventura Abraão, o nosso pai, não foi justificado pelas obras, quando ofereceu sobre o altar o seu filho Isaque?
22 Yu nor si sey en faith and work dey togeda and na en work make en faith pafet?
22 Bem vês que a fé cooperou com as suas obras e que, pelas obras, a fé foi aperfeiçoada,
23 And wetin dem rite for God word kon happen, “Abraham bilive wetin God tok and na dat one make am good for God eye, so God kon koll am, en friend.”
23 e cumpriu-se a Escritura, que diz: E creu Abraão em Deus, e foi-lhe isso imputado como justiça, e foi chamado o amigo de Deus.
24 So, pesin work dey make am good too, nor bi only en faith.
24 Vedes, então, que o homem é justificado pelas obras e não somente pela fé.
25 Nor bi so e bi for Rahab, wey bi ashawo, wen e welkom di messenjas kon show dem anoda road wey dem go pass run?
25 E de igual modo Raabe, a meretriz, não foi também justificada pelas obras, quando recolheu os emissários e os despediu por outro caminho?
26 Body wey nor get spirit don die, na so too, faith wey nor get work, don die.
26 Porque, assim como o corpo sem o espírito está morto, assim também a fé sem obras é morta.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Tiago 2, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.