Romanos 6
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF
1 So wetin wi go tok? Make wi kontinue to dey sin so dat God grace go dey with us?
1 Que diremos pois? Permaneceremos no pecado, para que a graça abunde?
2 No! Why wi wey don turn from sin go still dey live inside am?
2 De modo nenhum. Nós, que estamos mortos para o pecado, como viveremos ainda nele?
3 Abi una nor know sey all di pipol wey dem baptize inside Christ don die with am?
3 Ou não sabeis que todos quantos fomos batizados em Jesus Cristo fomos batizados na sua morte?
4 Dem beri us with am wen wi baptize, so as God raiz Christ from deat thru en pawa with glory, na so wi too go get life wey nor dey end.
4 De sorte que fomos sepultados com ele pelo batismo na morte; para que, como Cristo foi ressuscitado dentre os mortos, pela glória do Pai, assim andemos nós também em novidade de vida.
5 Bikos if wi don die with Jesus Christ thru baptizim, God go raiz us up with am.
5 Porque, se fomos plantados juntamente com ele na semelhança da sua morte, também o seremos na da sua ressurreição;
6 Wi know sey di pesin wey wi bi before, dem don nail am for cross with Jesus. So awa body nor bi sin savant again.
6 Sabendo isto, que o nosso homem velho foi com ele crucificado, para que o corpo do pecado seja desfeito, para que não sirvamos mais ao pecado.
7 Bikos pesin wey don die, don free from sin.
7 Porque aquele que está morto está justificado do pecado.
8 As wi die with Christ, wi bilive sey wi go live with am.
8 Ora, se já morremos com Cristo, cremos que também com ele viveremos;
9 Wi know sey since God don raiz Christ up, e nor go die and deat nor get pawa for en body again.
9 Sabendo que, tendo sido Cristo ressuscitado dentre os mortos, já não morre; a morte não mais tem domínio sobre ele.
10 Bikos as e die, e don ovakom sin forever, so di life wey e dey live naw, e dey live am for God.
10 Pois, quanto a ter morrido, de uma vez morreu para o pecado; mas, quanto a viver, vive para Deus.
11 So make una know sey, una don ovakom sin too and una get life thru Jesus Christ.
11 Assim também vós considerai-vos certamente mortos para o pecado, mas vivos para Deus em Cristo Jesus nosso Senhor.
12 Derfor, make una nor allow sin kontrol una body again, so dat una nor go dey do bad tins.
12 Não reine, portanto, o pecado em vosso corpo mortal, para lhe obedecerdes em suas concupiscências;
13 Make una nor let Satan use una body take do bad tins, but make una karry unasef give God as pipol wey don wake-up from deat, so dat una go dey do good tins.
13 Nem tampouco apresenteis os vossos membros ao pecado por instrumentos de iniqüidade; mas apresentai-vos a Deus, como vivos dentre mortos, e os vossos membros a Deus, como instrumentos de justiça.
14 Sin nor go fit kontrol una, bikos una nor dey under di law again, but na God grace dey kontrol una naw.
14 Porque o pecado não terá domínio sobre vós, pois não estais debaixo da lei, mas debaixo da graça.
15 So na wetin wi go tok? Make wi still dey sin, bikos wi get God grace and wi nor dey under di law again? God forbid!
15 Pois que? Pecaremos porque não estamos debaixo da lei, mas debaixo da graça? De modo nenhum.
16 Yu nor know sey wetin yu give yor body to, na-im go kontrol yu? If na sin, e go kause deat, but if na God, E go make yu dey live raitious life.
16 Não sabeis vós que a quem vos apresentardes por servos para lhe obedecer, sois servos daquele a quem obedeceis, ou do pecado para a morte, ou da obediência para a justiça?
17 But wi tank God sey, even doh una bi slave to sin before, una don use una heart dey obey all di tins wey wi dey tish una.
17 Mas graças a Deus que, tendo sido servos do pecado, obedecestes de coração à forma de doutrina a que fostes entregues.
18 And as e bi sey una don free from sin, una don bikom slave to good tins.
18 E, libertados do pecado, fostes feitos servos da justiça.
19 (I dey tok with human being sense, bikos I know sey una dey weak.) Before, una dey give una body like slave to bad tins, but naw, una must use una full body take serve God, so dat una go dey do only wetin God wont.
19 Falo como homem, pela fraqueza da vossa carne; pois que, assim como apresentastes os vossos membros para servirem à imundícia, e à maldade para maldade, assim apresentai agora os vossos membros para servirem à justiça para santificação.
20 Bikos wen una bi sin savant, una nor nid to dey raitious.
20 Porque, quando éreis servos do pecado, estáveis livres da justiça.
21 So wetin una gain from all doz bad tins wey una do? Na shame and deat doz tins dey bring.
21 E que fruto tínheis então das coisas de que agora vos envergonhais? Porque o fim delas é a morte.
22 But naw, una don dey free from sin kon bi God savant. Dis go make una dey holy and God go give una life wey nor dey end.
22 Mas agora, libertados do pecado, e feitos servos de Deus, tendes o vosso fruto para santificação, e por fim a vida eterna.
23 Bikos, di reward for sin, na deat, but God gift wey Jesus Christ dey give us, na life wey nor dey end.
23 Porque o salário do pecado é a morte, mas o dom gratuito de Deus é a vida eterna, por Cristo Jesus nosso Senhor.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Romanos 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.