Romanos 12
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA
1 My brodas and sistas, God dey good. So Abeg, as una dey alive, make una dey offa una body gi-am as sakrifice. Make una dey do wetin E tok and wetin go make belle sweet am. Na dis bi di best way to serve God.
1 Portanto, irmãos, pelas misericórdias de Deus, peço que ofereçam o seu corpo como sacrifício vivo, santo e agradável a Deus. Este é o culto racional de vocês.
2 Make una nor bi like pipol for di world, but make una allow God shange una mind, den una go know how to serve God and do tins wey dey make belle sweet am.
2 E não vivam conforme os padrões deste mundo, mas deixem que Deus os transforme pela renovação da mente, para que possam experimentar qual é a boa, agradável e perfeita vontade de Deus.
3 By di grace wey God give mi, I dey tell all of una, make una nor tink sey una too dey important. Instead, make una use good sense tink and undastand di faith wey God give una.
3 Porque, pela graça que me foi dada, digo a cada um de vocês que não pense de si mesmo além do que convém. Pelo contrário, pense com moderação, segundo a medida da fé que Deus repartiu a cada um.
4 Pesin body get difren parts and all di parts get dia own work.
4 Porque assim como num só corpo temos muitos membros, mas nem todos os membros têm a mesma função,
5 Na so e bi with us. Wi many, but wi bi difren parts for Christ body and wi bilong to each oda.
5 assim também nós, embora sejamos muitos, somos um só corpo em Cristo e membros uns dos outros.
6 True God grace, E don give us difren-difren gift to use. If wi dey profesai, make wi do am akordin to di faith wey wi get.
6 Temos, porém, diferentes dons segundo a graça que nos foi dada: se é profecia, seja segundo a proporção da fé;
7 If wi dey serve odas, make wi serve dem well. If wi dey tish, make wi tish well.
7 se é ministério, dediquemo-nos ao ministério; o que ensina dedique-se ao ensino;
8 If wi dey prish, make wi prish well. If wi dey give, make wi do am with betta mind. If wi dey lead odas, make wi do awa best. If wi dey do good to odas, make wi do am with happiness.
8 o que exorta faça-o com dedicação; o que contribui, com generosidade; o que preside, com zelo; quem exerce misericórdia, com alegria.
9 Make wi love each oda well-well. Make una hate anytin wey dey bad, but una must love anytin wey get trut.
9 O amor seja sem hipocrisia. Odeiem o mal e apeguem-se ao bem.
10 Make una love each oda like brodas and sistas and make una respet oda pipol pass unasef.
10 Amem uns aos outros com amor fraternal. Quanto à honra, deem sempre preferência aos outros.
11 Make una nor taya, but with di Holy Spirit help, make una serve God with betta mind.
11 Quanto ao zelo, não sejam preguiçosos. Sejam fervorosos de espírito, servindo o Senhor.
12 Make una let una hope give una happiness. Make una dey patient wen trobol kom and nor stop to pray.
12 Alegrem-se na esperança, sejam pacientes na tribulação e perseverem na oração.
13 Make una give food to God pipol wey dey hongry and make una dey welkom dem for una house.
13 Ajudem a suprir as necessidades dos santos. Pratiquem a hospitalidade.
14 Make una nor curse pipol wey dey opress una, but make una pray make God bless dem.
14 Abençoem aqueles que perseguem vocês; abençoem e não amaldiçoem.
15 Wen pipol dey happy, make una follow dem happy and wen dem dey kry, make una follow dem kry too.
15 Alegrem-se com os que se alegram e chorem com os que choram.
16 Make una try to bi friend with evribody. Make una nor karry body up kon feel sey una wise pass evribody, instead, make una dey make friend with doz wey nor dey important.
16 Tenham o mesmo modo de pensar de uns para com os outros. Em vez de serem orgulhosos, sejam solidários com os humildes. Não sejam sábios aos seus próprios olhos.
17 Make una nor pay evil for evil, but make sure sey wetin una dey do, good for God and pipol eye
17 Não paguem a ninguém mal por mal; procurem fazer o bem diante de todos.
18 and make una try to live for peace with evribody.
18 Se possível, no que depender de vocês, vivam em paz com todas as pessoas.
19 Make una nor try to pay anybody for di bad tin wey dem do una, but make una leave am for God, bikos God word sey, “Na mi go revensh for una. I go pay dem back.”
19 Meus amados, não façam justiça com as próprias mãos, mas deem lugar à ira de Deus, pois está escrito: “A mim pertence a vingança; eu é que retribuirei, diz o Senhor.”
20 God word still sey, “If yor enemy dey hongry, make yu gi-am food chop, if en troat dry, make yu gi-am wota drink, bikos as una dey do so, na wahala una dey karry put for en head.”
20 Façam o contrário: “Se o seu inimigo tiver fome, dê-lhe de comer; se tiver sede, dê-lhe de beber; porque, fazendo isto, você amontoará brasas vivas sobre a cabeça dele.”
21 So, make una nor let bad tins kontrol una, but make una let di good tins wey una dey do, plenty pass wikedness.
21 Não se deixe vencer pelo mal, mas vença o mal com o bem.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Romanos 12, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.