Mateus 5
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA
1 Wen Jesus si di pipol, e klimb go di mountin and en disciples follow am. Afta e don sidan,
1 Ao ver as multidões, Jesus subiu ao monte. Ele se assentou e os seus discípulos se aproximaram dele.
2 e kon bigin tish dem sey;
2 Então ele passou a ensiná-los. Jesus disse:
3 “God go bless una wey dey poor for spirit,
3 — Bem-aventurados
4 God go bless una wey dey mourn,
4 — Bem-aventurados
5 God go bless una wey nor dey karry body up,
5 — Bem-aventurados os mansos,
6 God go bless una wey dey like to do good tins,
6 — Bem-aventurados
7 God go bless una wey dey sorry for pipol,
7 — Bem-aventurados
8 God go bless una wey get pure heart,
8 — Bem-aventurados
9 God go bless una wey dey make peace,
9 — Bem-aventurados
10 God go bless una wey dey sofa bikos una dey do wetin dey rite,
10 — Bem-aventurados
11 “God go bless una wey pipol dey curse, dey sofa and lie for una head, bikos of mi,
11 — Bem-aventurados são vocês quando, por minha causa, os insultarem e os perseguirem, e, mentindo, disserem todo mal contra vocês.
12 make una happy and make belle sweet una, bikos na big tin dey wait una for heaven. Make una remember sey, na so di profets wey kom before una, sofa too.”
12 Alegrem-se e exultem, porque é grande a sua recompensa nos céus; pois assim perseguiram os profetas que viveram antes de vocês.
13 “Na una bi salt for dis eart. But if salt nor get taste; how e go bi for pipol mout? E betta make dem trowey am and make pipol mash am.
13 — Vocês são o sal da terra; ora, se o sal vier a ser insípido, como lhe restaurar o sabor? Para nada mais presta senão para, lançado fora, ser pisado pelos homens.
14 “Na una bi lite for dis world and town wey dey on-top mountin, nor dey hide.
14 — Vocês são a luz do mundo. Não se pode esconder uma cidade situada no alto de um monte.
15 Pesin nor dey lite lamp kon kover am with basin, instead e go put am for where evribody wey dey inside di house go si am.
15 Nem se acende uma lamparina para colocá-la debaixo de um cesto, mas num lugar adequado onde ilumina bem todos os que estão na casa.
16 Like dat too, make yor lite shine well-well for where pipol dey, so dat dem go si di good tins wey yu dey do, wey go make dem praiz yor Papa wey dey heaven.”
16 Assim brilhe também a luz de vocês diante dos outros, para que vejam as boas obras que vocês fazem e glorifiquem o Pai de vocês, que está nos céus.
17 “Make una nor tink sey I kom spoil Moses Law and di tins wey di profets tish. Nor bi so, misef kom obey dem.
17 — Não pensem que vim revogar a Lei ou os Profetas; não vim para revogar, mas para cumprir.
18 I tell una true word, before dis world go end, evritin wey dey inside di Law, even di small-small ones, go happen.
18 Porque em verdade lhes digo: até que o céu e a terra passem, nem um i ou um til jamais passará da Lei, até que tudo se cumpra.
19 So anybody wey nor do wetin God kommand and dey tish odas to do as e dey do, naim go small pass for God Kingdom. But pesin wey obey God and tish odas to do wetin di Law tok, na big pesin e go bi for God Kingdom.
19 Aquele, pois, que desrespeitar um destes mandamentos, ainda que dos menores, e ensinar os outros a fazer o mesmo, será considerado mínimo no Reino dos Céus; aquele, porém, que os observar e ensinar, esse será considerado grande no Reino dos Céus.
20 I tell yu di trut, if di good wey yu do, nor betta pass wetin di Farisee and di pipol wey dey tish di Law do, yu nor go fit enter God Kingdom.”
20 Porque eu afirmo que, se a justiça de vocês não exceder em muito a dos escribas e fariseus, jamais entrarão no Reino dos Céus.
21 “Yu hear as God tell awa papa dem before-before sey, ‘Nor kill and anybody wey kill, God go judge am.’
21 — Vocês ouviram o que foi dito aos antigos: “Não mate.” E ainda: “Quem matar estará sujeito a julgamento.”
22 But I tell una, anybody wey vex for en broda, God go judge am too. Anybody wey curse en broda, go face di kansol and anybody wey koll pesin, ‘Mumu’, go-go hell-fire.
22 Eu, porém, lhes digo que todo aquele que se irar contra o seu irmão estará sujeito a julgamento; e quem insultar o seu irmão estará sujeito a julgamento do tribunal; e quem o chamar de tolo estará sujeito ao inferno de fogo.
23 “If yu take gift go altar and yu kon remember sey yor broda get bad belle for yu,
23 Portanto, se você estiver trazendo a sua oferta ao altar e lá se lembrar que o seu irmão tem alguma coisa contra você,
24 make yu leave di gift for di altar, first go setol with yor broda, den yu go fit kom back kon give yor gift.
24 deixe diante do altar a sua oferta e vá primeiro reconciliar-se com o seu irmão; e então volte e faça a sua oferta.
25 “Kwik setol with who dey akuiz yu before una rish kourt, if not, e go give yu to di judge and di warda go trow yu inside prison.
25 — Entre em acordo sem demora com o seu adversário, enquanto você está com ele a caminho, para que o adversário não entregue você ao juiz, o juiz entregue você ao oficial de justiça, e você seja jogado na prisão.
26 I tell una di trut, yu nor go komot from dat trobol until yu pay all di money!”
26 Em verdade lhe digo que você não sairá dali enquanto não pagar o último centavo.
27 “Yu hear wey pipol sey, ‘Make yu nor sleep with who yu nor marry.’
27 — Vocês ouviram o que foi dito: “Não cometa adultério.”
28 But I dey tell una naw sey, ‘Anybody wey look woman kon get di mind to sleep with am, don already kommit sin for en heart.’
28 Eu, porém, lhes digo: todo o que olhar para uma mulher com intenção impura, já cometeu adultério com ela no seu coração.
29 If yor rite eye go make yu sin, make yu plok am komot. E betta sey one part for yor body nor dey, dan sey all yor body enter hell-fire.
29 — Se o seu olho direito leva você a tropeçar, arranque-o e jogue-o fora. Pois é preferível você perder uma parte do seu corpo do que ter o corpo inteiro lançado no inferno.
30 If yor rite hand go make yu do bad tin, make yu kut am trowey! E betta sey one part for yor body nor dey, dan sey all yor body enter hell-fire.”
30 E, se a sua mão direita leva você a tropeçar, corte-a e jogue-a fora. Pois é preferível você perder uma parte do seu corpo do que o corpo inteiro ir para o inferno.
31 “Pipol dey sey, ‘Anybody wey drive en wife, must gi-am paper sey e nor won marry am again.’
31 — Também foi dito: “Aquele que repudiar a sua mulher deve dar-lhe uma carta de divórcio.”
32 But I dey tell una naw sey, anybody wey drive en wife komot from marriage, wey nor bi sey di woman sleep with anoda man, don make di woman kommit adultery and any man wey marry di woman, don kommit adultery too.”
32 Eu, porém, lhes digo: quem repudiar a sua mulher, exceto em caso de relações sexuais ilícitas, a expõe a se tornar adúltera; e aquele que casar com a repudiada comete adultério.
33 “Again, yu don hear sey dem tell pipol before-before sey, ‘Make yu nor break yor promise, but do wetin yu promise God.’
33 — Vocês também ouviram o que foi dito aos antigos: “Não faça juramento falso, mas cumpra rigorosamente para com o Senhor o que você jurou.”
34 But I dey tell una naw sey, make una nor ever use heaven swear at-all, bikos na God throne e bi,
34 Eu, porém, lhes digo: não jurem de modo nenhum; nem pelo céu, por ser o trono de Deus;
35 or with eart, bikos naim God dey put en leg, or use Jerusalem, bikos na di big king town
35 nem pela terra, por ser estrado de seus pés; nem por Jerusalém, por ser a cidade do grande Rei.
36 Nor even take yor head swear, bikos yu nor fit make one singol hair white or black.
36 Não jure pela sua cabeça, porque você não pode fazer com que um só cabelo fique branco ou preto.
37 Wen yu sey, ‘Yes,’ make yu mean am and wen yu sey ‘No,’ make yu mean am too. Any oda tin wey yu tok pass dis, na devil e from kom.”
37 Que a palavra de vocês seja: Sim, sim; não, não. O que passar disto vem do Maligno.
38 “Una hear sey, ‘Anytin anybody do una, make una do am back.’
38 — Vocês ouviram o que foi dito: “Olho por olho, dente por dente.”
39 But I tell una, make una nor fight, if anybody slap yor face, turn di oda side gi-am too.
39 Eu, porém, lhes digo: Não resistam ao perverso. Se alguém lhe der um tapa na face direita, ofereça-lhe também a face esquerda.
40 If anybody drag yor shirt with yu, make yu gi-am yor koat join.
40 Se alguém quer processar você e tirar-lhe a túnica, deixe que leve também a capa.
41 And if anybody force yu waka one mile, make yu follow am waka two mile.
41 Se alguém obrigar você a andar uma milha, vá com ele duas.
42 Give pipol anytin wey dem ask from yu and nor drive anybody wey kom borrow sometin from yu.”
42 Dê a quem lhe pede e não volte as costas ao que quer lhe pedir emprestado.
43 “Una hear sey, ‘Make una love una neighbour and hate una enemy.’
43 — Vocês ouviram o que foi dito: “Ame o seu próximo e odeie o seu inimigo.”
44 But I tell una naw sey, ‘Make una love una enemies and pray for pipol wey dey sofa una’,
44 Eu, porém, lhes digo: amem os seus inimigos e orem pelos que perseguem vocês,
45 so dat una go bi like una Papa for heaven wey dey allow sun to shine and rain to fall on-top bad and good pipol.
45 para demonstrarem que são filhos do Pai de vocês, que está nos céus. Porque ele faz o seu sol nascer sobre maus e bons e vir chuvas sobre justos e injustos.
46 If una love only di pipol wey love una, wetin una go gain? Na so bad pipol dey do too, abi nor bi so?
46 Porque, se vocês amam aqueles que os amam, que recompensa terão? Os publicanos também não fazem o mesmo?
47 If una dey greet only una brodas, una nor betta pass odas, bikos pipol wey nor know God still dey do like dat, abi nor bi so?
47 E, se saudarem somente os seus irmãos, o que é que estão fazendo de mais? Os gentios também não fazem o mesmo?
48 So make una dey pafet as una Papa wey dey for heaven, pafet.”
48 Portanto, sejam perfeitos como é perfeito o Pai de vocês, que está no céu.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.