Mateus 26

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC

Sair da comparação
ARC Almeida Revista e Corrigida 2009
1 Wen Jesus tish finish, e kon tell en disciples,
1 E aconteceu que, quando Jesus concluiu todos esses discursos, disse aos seus discípulos:
2 “Make una know sey na two days remain before di Passova go start and dem go give Man Pikin to pipol wey go nail am for cross.”
2 Bem sabeis que, daqui a dois dias, é a Páscoa, e o Filho do Homem será entregue para ser crucificado.
3 Di priest oga dem and di eldas kon whole meetin with Kaiafas, di High Priest, for en palis.
3 Depois, os príncipes dos sacerdotes, e os escribas, e os anciãos do povo reuniram-se na sala do sumo sacerdote, o qual se chamava Caifás,
4 Dem kon plan for sekret to arrest Jesus make dem for kill-am.
4 e consultaram-se mutuamente para prenderem Jesus com dolo e o matarem.
5 But dem sey, “Make wi nor do am wen di Feast don start, so dat pipol nor go make trobol.”
5 Mas diziam: Não durante a festa, para que não haja alvoroço entre o povo.
6 Naw, as Jesus dey Betany for Simon, wey bi leper, house,
6 E, estando Jesus em Betânia, em casa de Simão, o leproso,
7 one woman bring kontaina wey get oil wey dear well-well kon pour di oil for Jesus head as e sidan for tabol dey chop.
7 aproximou-se dele uma mulher com um vaso de alabastro, com unguento de grande valor, e derramou-lho sobre a cabeça, quando ele estava assentado à mesa.
8 Wen di disciples si wetin happen, dem kon vex well-well, ask di woman, “Why yu dey waste dis oil?
8 E os seus discípulos, vendo isso, indignaram-se, dizendo: Por que este desperdício?
9 E for betta sey dem sell am kon give di money to poor pipol!”
9 Pois este unguento podia vender-se por grande preço e dar-se o dinheiro aos pobres.
10 Wen Jesus hear wetin dem tok, e kon sey, “Why una dey trobol dis woman? Na betta tin e do for mi o-o!
10 Jesus, porém, conhecendo isso, disse-lhes: Por que afligis esta mulher? Pois praticou
11 Poor pipol dey with una evritime, but mi, I nor go dey with una always!
11 Porquanto sempre tendes convosco os pobres, mas a mim não me haveis de ter sempre.
12 Wen di woman pour dis oil for my body, e dey prepare mi for my beri.
12 Ora, derramando ela este unguento sobre o meu corpo, fê-lo preparando-me para o meu sepultamento.
13 I tell una true word, anywhere wey dem go for prish dis gospel, dem go take dis tin wey di woman do so, take remember am for di whole world.”
13 Em verdade vos digo que, onde quer que este evangelho for pregado, em todo o mundo, também será referido o que ela fez para memória sua.
14 Den Judas Iskariot, wey dey among di twelf disciples go meet di priest oga dem,
14 Então, um dos doze, chamado Judas Iscariotes, foi ter com os príncipes dos sacerdotes
15 kon tell dem, “Wetin una go give mi, if I sell Jesus Christ give una?” So dem kon kount thirty silva koins gi-am.
15 e disse: Que me quereis dar, e eu vo-lo entregarei? E eles lhe pesaram trinta moedas de prata.
16 From dat time, Judas kon dey find how e go take sell Jesus Christ.
16 E, desde então, buscava oportunidade para o entregar.
17 For di day wen dem start di Feast for di Bread wey nor get yist, di disciples kom meet Jesus Christ tell am, “Tell us where yu for won chop di Passova Food, so dat wi go-go prepare di place.”
17 E, no primeiro dia da Festa dos Pães Asmos, chegaram os discípulos junto de Jesus, dizendo: Onde queres que preparemos a comida da Páscoa?
18 Jesus tell dem, “Make una go inside di town and una go meet one man. Make una tell am, ‘Di tisha sey, “My time don rish. I go chop di Passova Food with my disciples for yor house.” ’ ”
18 E ele disse: Ide à cidade a
19 So di disciples do as Jesus tell dem, den dem kon go prepare di Passova Food.
19 E os discípulos fizeram como Jesus lhes ordenara e prepararam a Páscoa.
20 Wen evening rish, Jesus sidan for di tabol with en twelf disciples.
20 E, chegada a tarde, assentou-se à mesa com os doze.
21 As dem dey chop, e kon sey, “I tell una true word, one of una go sell mi.”
21 E, enquanto eles comiam, disse: Em verdade vos digo que um de vós me há de trair.
22 Wetin e tok kon worry dem well-well, so dem kon bigin ask am, “Oga God, na mi?” Jesus and en disciple wen dem dey chop di last supper|alt="Jesus and His disxciples masking kwestions about his betrayal during the last supper" src="CN01778B.TIF" size="col" loc="MAT 26:14-22" copy="Cook" ref="26:22"
22 E eles, entristecendo-se muito, começaram um por um a dizer-lhe: Porventura, sou eu, Senhor?
23 Jesus ansa dem, “Di pesin wey go put hand inside plate with mi, na-im go sell mi.
23 E ele, respondendo, disse: O que mete comigo a mão no prato, esse me há de trair.
24 Man Pikin go die as dem rite about am, but curse dey di pesin head wey go sell am! E for betta sey dem nor born di pesin at-all.”
24 Em verdade o Filho do Homem vai, como acerca dele está escrito, mas ai daquele homem por quem o Filho do Homem é traído! Bom seria para esse homem se não houvera nascido.
25 Den Judas, di pesin wey go sell am, kon sey, “True-true, Oga God, na mi yu dey tok about?”
25 E, respondendo Judas, o que o traía, disse: Porventura, sou eu, Rabi? Ele disse: Tu o disseste.
26 As dem dey chop, Jesus take bread kon tank God, afta e divide am, e give en disciples, kon sey, “Make una chop, dis na my body.”
26 Enquanto comiam, Jesus tomou o pão, e, abençoando- o, o partiu, e o deu aos discípulos, e disse: Tomai, comei, isto é o meu corpo.
27 Afta, e take di cup kon tank God, den e give dem kon sey, “Make all of una drink from am,
27 E, tomando o cálice e dando graças, deu-lho, dizendo: Bebei dele todos.
28 bikos dis na my blood, wey bi di kovenant wey go make God forgive pipol dia sins.
28 Porque isto é o meu sangue, o Novo Testamento, que é derramado por muitos, para remissão dos pecados.
29 I tell una, from naw go, I nor go drink dis wine until di day wey I go drink di new wine with una for my Papa kingdom.”
29 E digo-vos que, desde agora, não beberei deste fruto da vide até àquele Dia em que o beba de novo convosco no Reino de meu Pai.
30 Afta dem sing one hymn, dem komot kon go Mount Olives.
30 E, tendo cantado um hino, saíram para o monte das Oliveiras.
31 Den Jesus kon tell dem, “Dis nite all of una go run leave mi, bikos God word sey,
31 Então, Jesus lhes disse: Todos vós esta noite vos escandalizareis em mim, porque está escrito: Ferirei o pastor, e as ovelhas do rebanho se dispersarão.
32 But afta God don raiz mi up from deat, I go-go Galilee, go wait for una.”
32 Mas, depois de eu ressuscitar, irei adiante de vós para a Galileia.
33 Pita kon ansa am, “If odas run leave yu, mi, I nor go ever leave yu!”
33 Mas Pedro, respondendo, disse-lhe: Ainda que todos se escandalizem em ti, eu nunca me escandalizarei.
34 Jesus kon tell am, “I tell yu di trut, for dis nite, before fawol go do ‘Kukuruku’, yu go deny mi three times.”
34 Disse-lhe Jesus: Em verdade te digo que, nesta mesma noite, antes que o galo cante, três vezes me negarás.
35 Pita still ansa, “Even if I go die, I nor go ever deny yu.” And all di disciples still tok di same tin.
35 Disse-lhe Pedro: Ainda que me seja necessário morrer contigo, não te negarei. E todos os discípulos disseram o mesmo.
36 Den Jesus go Getsemani with en disciples kon tell dem, “Make una sidan here bikos I wont cross go di oda side go pray.”
36 Então, chegou Jesus com eles a um lugar chamado Getsêmani e disse a seus discípulos: Assentai-vos aqui, enquanto vou além orar.
37 E take Pita, James and John, wey bi Zebedee two shidren, with am. But bikos of wetin won happen, belle nor sweet am.
37 E, levando consigo Pedro e os dois filhos de Zebedeu, começou a entristecer-se e a angustiar-se muito.
38 Den e tell dem, “My heart heavy and e bi like sey I won die. Make una stay here and make una nor sleep.”
38 Então, lhes disse: A minha alma está cheia de tristeza até à morte; ficai aqui e vigiai comigo.
39 E waka go front small kon liedan face groun, den e kon pray, “My Papa, if yu wont, yu go fit remove dis deat from mi! But nor bi as I wont, na as yu wont am.”
39 E, indo um pouco adiante, prostrou-se sobre o seu rosto, orando e dizendo: Meu Pai, se é possível, passa de mim este cálice; todavia, não seja como eu quero, mas como tu
40 Wen Jesus kom back, e kon si sey all en disciples dey sleep. Den e ask Pita, “So yu nor fit stay make yu nor sleep for one hour?
40 E, voltando para os seus discípulos, achou-os adormecidos; e disse a Pedro: Então, nem uma hora pudeste vigiar comigo?
41 Open yor eye make yu pray, so dat yu nor go fall inside temptashon. Yor spirit won do am, but yor flesh dey weak.”
41 Vigiai e orai, para que não entreis em tentação; na verdade, o espírito
42 Jesus kon go pray for di sekond time, “My Papa, if yu nor won take dis deat komot unless I die, den make wetin yu wont happen.”
42 E, indo segunda vez, orou, dizendo: Meu Pai, se este cálice não pode passar de mim sem eu o beber, faça-se a tua vontade.
43 E kom back kon si en disciples dey sleep again; dem nor fit open dia eyes.
43 E, voltando, achou-os outra vez adormecidos, porque os seus olhos estavam carregados.
44 So e leave dem, go pray di same way for di third time.
44 E, deixando-os de novo, foi orar pela terceira vez, dizendo as mesmas palavras.
45 Den e kon meet di disciples ask dem, “Una still dey sleep and rest? Si, di time don dey rish wen dem go sell Man Pikin give sinnas.
45 Então, chegou junto dos seus discípulos e disse-lhes: Dormi, agora, e repousai; eis que é chegada a hora, e o Filho do Homem será entregue nas mãos dos pecadores.
46 Make una stand up, make wi dey go. Si! Di pesin wey won sell mi, don dey kom!”
46 Levantai-vos, partamos; eis que é chegado o que me trai.
47 As Jesus still dey tok, Judas wey bi one of di disciples, kon kom. Plenty pipol wey di priest oga and eldas send, karry gun and big stik dey follow Judas for back.
47 E, estando ele ainda a falar, eis que chegou Judas, um dos doze, e com ele, grande multidão com espadas e porretes, vinda da parte dos príncipes dos sacerdotes e dos anciãos do povo.
48 (Naw, di pesin wey sell am, don give dem sign sey, “Di pesin wey I go kiss, naim bi di man. Make una arrest am!”)
48 E o traidor tinha-lhes dado um sinal, dizendo: O que eu beijar é esse; prendei-o.
49 At wons, Judas go meet Jesus, greet am kon sey, “Tisha”, den e kiss am.
49 E logo, aproximando-se de Jesus, disse: Eu te saúdo, Rabi. E beijou-o.
50 Jesus tell am, “My friend, do wetin make yu kom.”
50 Jesus, porém, lhe disse: Amigo, a que vieste? Então, aproximando-se eles, lançaram mão de Jesus e o prenderam.
51 But one of di disciples wey dey with Jesus draw en swod kom out, kon kut di High Priest slave ear komot.
51 E eis que um dos que estavam com Jesus, estendendo a mão, puxou da espada e, ferindo o servo do sumo sacerdote, cortou-lhe uma orelha.
52 Den Jesus tell am, “Put yor swod for where e dey before! Bikos anybody wey dey karry swod, na swod go kill-am.
52 Então, Jesus disse-lhe: Mete no seu lugar a tua espada, porque todos os que lançarem mão da espada à espada morrerão.
53 Yu tink sey, I nor fit koll my Papa sey make e send many angels kom help mi naw-naw?
53 Ou pensas tu que eu não poderia, agora, orar a meu Pai e que ele não me daria mais de doze legiões de anjos?
54 But if I do am, wetin dem rite for God word about dis matter, nor go happen.”
54 Como,
55 By dis time, Jesus tell di pipol wey follow Judas kom sey, “Una karry swod and stik kon arrest mi like sey I bi tif? I dey tish inside di temple evriday, but una nor arrest mi.”
55 Então, disse Jesus à multidão: Saístes, como para um salteador, com espadas e porretes, para me prender? Todos os dias me assentava junto de vós, ensinando no templo, e não me prendestes.
56 Dis one happen so dat wetin di profets rite for di book go bi true. Den all di disciples kon run leave am.
56 Mas tudo isso aconteceu para que se cumpram as Escrituras dos profetas. Então, todos os discípulos, deixando-o, fugiram.
57 Naw di pipol wey arrest Jesus take am go meet Kaiafas di High Priest, wey di law tishas and eldas don gada for en house.
57 E os que prenderam Jesus o conduziram à casa do sumo sacerdote Caifás, onde os escribas e os anciãos estavam reunidos.
58 But Pita follow dem go rish di High Priest yard. E kon sidan with di guards to si wetin go happen.
58 E Pedro o seguiu de longe até ao pátio do sumo sacerdote e, entrando, assentou-se entre os criados, para ver o fim.
59 Di priest oga dem and di Sanhedrin kon dey find wetin dem go take whole Jesus, make dem for fit kill-am.
59 Ora, os príncipes dos sacerdotes, e os anciãos, e todo o conselho buscavam falso testemunho contra Jesus, para poderem dar-lhe a morte,
60 But dem nor si anytin to take hold am, even doh many pipol kom lie against am.
60 e não o achavam, apesar de se apresentarem muitas testemunhas falsas, mas, por fim, chegaram duas
61 kon sey, “Dis man sey, ‘I go fit distroy God Temple and build am again for three days’.”
61 e disseram: Este disse: Eu posso derribar o templo de Deus e reedificá-lo em três dias.
62 So, di High Priest kon stand up ask Jesus, “Yu nor get any ansa? Wetin bi dis wey dem dey tok against yu so?”
62 E, levantando-se o sumo sacerdote, disse-lhe: Não respondes coisa alguma ao que estes depõem contra ti?
63 But Jesus kwayet.
63 E Jesus, porém, guardava silêncio. E, insistindo o sumo sacerdote, disse-lhe: Conjuro-te pelo Deus vivo que nos digas se tu és o Cristo, o Filho de Deus.
64 Jesus ansa am, “Yu don tok am. But I tell yu, from naw go, yu go si Man Pikin sidan for God rite hand dey kom down for kloud from heaven.”
64 Disse-lhes Jesus: Tu em breve o Filho do Homem assentado à direita do Todo-Poderoso e vindo sobre as nuvens do céu.
65 Den di High Priest tear en klot kon sey, “E don tok against God! Why wi still nid anoda witness? Una don hear as e tok against God!
65 Então, o sumo sacerdote rasgou as suas vestes, dizendo: Blasfemou; para que precisamos ainda de testemunhas? Eis que bem ouvistes, agora, a sua blasfêmia.
66 Wetin una tink?”
66 Que vos parece? E eles, respondendo, disseram: É réu de morte.
67 Dem kon spit for en face, beat am and some slap am,
67 Então, cuspiram-lhe no rosto e lhe davam murros, e outros o esbofeteavam,
68 dey sey, “Make yu tell us wetin go happen, yu wey bi Christ! Na who beat yu?”
68 dizendo: Profetiza-nos, Cristo, quem é o que te bateu?
69 As Pita sidan outside for di yard. One girl wey bi savant kon tell am, “Yorsef bin dey with Jesus Christ wey kom from Galilee.”
69 Ora, Pedro estava assentado fora, no pátio; e, aproximando-se dele uma criada, disse: Tu também estavas com Jesus, o galileu.
70 But Pita deny am for evribody front kon sey: “I nor know wetin yu dey tok about!”
70 Mas ele negou diante de todos, dizendo: Não sei o que dizes.
71 Wen e komot go outside, anoda girl wey bi savant si am kon tell di pipol wey dey der, “Dis man sef dey with Jesus wey kom from Nazaret.”
71 E, saindo para o vestíbulo, outra criada o viu e disse aos que ali estavam: Este também estava com Jesus, o Nazareno.
72 Pita kon swear deny again, “I nor know di man!”
72 E ele negou outra vez, com juramento: Não conheço tal homem.
73 Afta sometaim, pipol wey stand for der, kom meet Pita tell am, “Yu really bi one of dem, even di way yu dey tok show sey yu dey with am!”
73 E, logo depois, aproximando-se os que ali estavam, disseram a Pedro: Verdadeiramente, também tu és deles, pois a tua fala te denuncia.
74 As e hear dis one, Pita kon dey swear, “I nor know di man!”
74 Então, começou ele a praguejar e a jurar, dizendo: Não conheço esse homem. E imediatamente o galo cantou.
75 Den Pita kon remember wetin Jesus tell am, “Before fawol go make ‘Kukuruku’, yu go deny mi three times.” So Pita go outside bigin kry.
75 E lembrou-se Pedro das palavras de Jesus, que lhe dissera: Antes que o galo cante, três vezes me negarás. E, saindo dali, chorou amargamente.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 26, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.