Mateus 14

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Dat time, Herod wey dey rule hear about Jesus,
1 Por aquele tempo, o tetrarca Herodes soube da fama de Jesus
2 so e kon tell en savants, “Dis na John di Baptist wey wake-up from deat! Naim make am get pawa to do all dis mirakle.”
2 e disse aos que o serviam: — Este é João Batista. Ele ressuscitou dos mortos, e, por isso, forças miraculosas operam nele.
3 Before dis time, Herod don arrest John put for prison, bikos John dey akuiz am sey,
3 Porque Herodes, havendo prendido João, o amarrou e pôs na prisão, por causa de Herodias, mulher do seu irmão Filipe.
4 “E marry Herodias wey bi en broda Filip wife.”
4 Pois João lhe dizia: “Você não tem o direito de viver com ela.”
5 Herod kon get mind to kill John, but e dey fear di pipol, bikos dem bilive sey, John na profet.
5 Embora Herodes quisesse matá-lo, tinha medo do povo, porque consideravam João como profeta.
6 So, for Herod birtday, Herodias dota dance well-well kon make Herod happy.
6 Mas, quando chegou o dia do aniversário de Herodes, a filha de Herodias dançou diante de todos e agradou a Herodes.
7 Sotey Herod promise sey e go gi-am anytin wey e ask for.
7 Este prometeu, com juramento, dar-lhe o que ela pedisse.
8 Just as en mama tell am, di girl kon sey, “Make yu give mi John di Baptist head for tray.”
8 Então ela, instigada por sua mãe, disse: — Dê-me, aqui, num prato, a cabeça de João Batista.
9 Di tin pain di king well-well, but as e don promise and bikos of di pipol wey kom di party, e kon kommand make dem go kill John.
9 O rei ficou triste, mas, por causa do juramento e dos que estavam com ele à mesa, ordenou que o pedido fosse atendido.
10 So e send en sojas go kut John head for inside prison.
10 Assim, deu ordens para que João fosse decapitado na prisão.
11 Dem bring di head for tray kon give di girl and e karry am go give en mama.
11 A cabeça foi trazida num prato e dada à jovem, que a levou à sua mãe.
12 Den, John disciples kon karry en body go beri and dem kon go tell Jesus wetin happen.
12 Então vieram os discípulos de João, levaram o corpo e o sepultaram; depois, foram e anunciaram isso a Jesus.
13 Wen Jesus hear wetin happen, e komot der enter boat kon go where pipol nor dey. But wen pipol from difren-difren town hear where e go, dem kon follow am.
13 Jesus, ouvindo isto, retirou-se dali num barco para um lugar deserto, à parte. Ao saberem disso, as multidões vieram das cidades seguindo-o por terra.
14 As e kom down from di boat, e si plenty pipol, so e sorry for dem kon heal all di pipol wey nor well among dem.
14 Ao desembarcar, Jesus viu uma grande multidão, compadeceu-se dela e curou os seus enfermos.
15 Wen evening rish, en disciples kom meet am sey, “Dis place na wildaness and day don dey dark. Make yu send dis pipol go find food buy for demsef inside di village.”
15 Ao cair da tarde, os discípulos se aproximaram de Jesus e disseram: — Este lugar é deserto, e já é tarde. Mande as multidões embora, para que, indo pelas aldeias, comprem para si o que comer.
16 Jesus ansa, “Dem nor nid to go, make una find sometin give dem chop.”
16 Jesus, porém, lhes disse:
17 Dem kon tell am, “Na only five bread and two fish wi get for here.”
17 Mas eles responderam: — Não temos aqui senão cinco pães e dois peixes.
18 Jesus ansa dem again, “Make una bring di bread and fish kom.”
18 Então Jesus disse:
19 Den e tell di pipol make dem sidan for di grass. E take di five bread and two fish face heaven kon tank God. Afta e don tank God, e share di bread give en disciples make dem give di pipol.
19 E, tendo mandado que a multidão se assentasse sobre a relva, pegando os cinco pães e os dois peixes, erguendo os olhos para o céu, os abençoou. Depois, tendo partido os pães, deu-os aos discípulos, e estes deram às multidões.
20 All of dem chop beleful and wen dem gada di food wey remain, e rish twelf basket.
20 Todos comeram e se fartaram, e ainda recolheram doze cestos cheios dos pedaços que sobraram.
21 Di pipol wey chop na about 5,000 men, even doh dem nor kount wimen and shidren join.
21 E os que comeram eram cerca de cinco mil homens, além de mulheres e crianças.
22 Afta Jesus don send di pipol go dia house, e kon tell en disciples make dem enter boat cross go di oda side.
22 Logo a seguir, Jesus fez com que os discípulos entrassem no barco e fossem adiante dele para o outro lado, enquanto ele despedia as multidões.
23 Afta di pipol don go, Jesus kon klimb go mountin go pray. E stay der go rish evening.
23 E, tendo despedido as multidões, ele subiu ao monte, a fim de orar sozinho. Ao cair da tarde, lá estava ele, só.
24 By dis time, di boat don go far from land. Strong wave kom dey karry di boat up-and-down bikos heavy breeze dey blow.
24 Entretanto, o barco já estava longe, a uma boa distância da terra, açoitado pelas ondas; porque o vento era contrário.
25 For early morning, Jesus kon dey waka go meet en disciples on-top di wota.
25 De madrugada, Jesus foi até onde eles estavam, andando sobre o mar.
26 Wen di disciples si am dey waka on-top wota, fear katch dem. Dem kon dey shake dey shaut, “Na ghost o-o!”
26 Os discípulos, porém, vendo-o andar sobre o mar, ficaram apavorados e disseram: — É um fantasma! E, tomados de medo, gritaram.
27 But Jesus tell dem, “Make una heart strong! Na mi, make una nor fear.”
27 Mas Jesus imediatamente lhes disse:
28 Naim Pita ansa, “Oga God, if na yu true-true, koll mi make I kom meet yu for di wota.”
28 Então Pedro disse: — Se é o Senhor mesmo, mande que eu vá até aí, andando sobre as águas.
29 So, Jesus tell am, “Make yu kom!”
29 Jesus disse: E Pedro, descendo do barco, andou sobre as águas e foi até Jesus.
30 But wen e si as di breeze strong rish, fear katch am and e kon bigin sink. So e shaut, “Oga God, save mi o-o!”
30 Reparando, porém, na força do vento, teve medo; e, começando a afundar, gritou: — Salve-me, Senhor!
31 At wons, Jesus stresh en hand katch am kon tell am, “Yor faith too small. Why yu dey doubt mi?”
31 E, prontamente, Jesus, estendendo a mão, o segurou e disse:
32 Wen di two of dem don enter di boat, di breeze kon stop.
32 Subindo ambos para o barco, o vento cessou.
33 Den di oda disciples for di boat kon bow down for Jesus front woship am sey, “True-true, yu bi God Pikin.”
33 E os que estavam no barco o adoraram, dizendo: — Verdadeiramente o senhor é o Filho de Deus!
34 Wen dem don cross di river go di oda side, dem kon land for Gennesaret.
34 Estando já no outro lado, chegaram à terra de Genesaré.
35 Wen di pipol for der know sey na Jesus, dem send message go all dia village, den dem kon bring all di pipol wey nor well kom meet am,
35 Quando as pessoas daquela terra o reconheceram, mandaram avisar em todos aqueles arredores e lhe trouxeram todos os enfermos.
36 dey beg am sey, “Make di pipol wey nor well tosh yor dress” and all of dem wey tosh am, kon well.
36 E pediam-lhe que ao menos pudessem tocar na borda da sua roupa. E todos os que tocavam nela ficaram curados.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 14, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.