Marcos 3

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC

Sair da comparação
ARC Almeida Revista e Corrigida 2009
1 Wen Jesus enter di sinagog again, one man wey en hand die, dey der.
1 E outra vez entrou na sinagoga, e estava ali um homem que tinha uma das mãos mirrada.
2 Di Farisee pipol kon dey look Jesus with korna eye weda e go heal di man for Sabat Day, so dat dem go si wetin dem go take akuiz am.
2 E estavam observando-o se curaria no sábado, para o acusarem.
3 So Jesus tell di man, “Make yu stand for centre make evribody si yu.”
3 E disse ao homem que tinha a mão mirrada: Levanta-te e vem para o meio.
4 Jesus kon ask, “E good make wi do good or bad tin for Sabat Day? Make wi save or distroy pesin?” But dem nor ansa.
4 E perguntou-lhes: É lícito no sábado fazer bem ou fazer mal? Salvar a vida ou matar? E eles calaram-se.
5 So Jesus vex kon look dem round, bikos dia heart strong well-well, den e tell di man, “Stresh yor hand.” So di man stresh en hand and di hand kon well again.
5 E, olhando para eles em redor com indignação, condoendo-se da dureza do seu coração, disse ao homem: Estende a mão. E ele a estendeu, e foi-lhe restituída a mão, sã como a outra.
6 Den di Farisee and Herod pipol kon kwik-kwik go outside go plan how dem go take kill Jesus.
6 E, tendo saído os fariseus, tomaram logo conselho com os herodianos contra ele, procurando ver como o matariam.
7 Den Jesus komot with en disciples go di wotaside and plenty pipol from Galilee follow am. Pipol from Judea,
7 E retirou-se Jesus com os seus discípulos para o mar, e seguia-o uma grande multidão da Galileia, e da Judeia,
8 Jerusalem, Idumea, some from across Jordan River and around Tyre and Sidon kom meet am wen dem hear about di tins wey e dey do.
8 e de Jerusalém, e da Idumeia, e dalém do Jordão, e de perto de Tiro, e de Sidom; uma grande multidão que, ouvindo quão grandes coisas fazia, vinha ter com ele.
9 Bikos of di pipol, Jesus kon tell en disciples make dem prepare one small boat for am, so dat pipol nor go push am anyhow.
9 E ele disse aos seus discípulos que lhe tivessem sempre pronto um barquinho junto dele, por causa da multidão, para que o não comprimisse,
10 Jesus heal many pipol, so all di pipol wey nor well kon dey push each oda, so dat dem go fit tosh am.
10 porque tinha curado a muitos, de tal maneira que todos quantos tinham algum mal se arrojavam sobre ele, para lhe tocarem.
11 And anytime evil spirit wey dey inside some pipol body si Jesus, dem go fall for en front dey shaut, “Yu bi God Pikin.”
11 E os espíritos imundos, vendo-o, prostravam-se diante dele e clamavam, dizendo: Tu és o Filho de Deus.
12 But Jesus warn dem well-well make dem nor let pipol know who e bi.
12 E ele os ameaçava muito, para que não o manifestassem.
13 Jesus klimb go on-top mountin kon koll di pipol wey e wont, make dem kom meet am for der.
13 E subiu ao monte e chamou para si os que ele quis; e vieram a ele.
14 E choose twelf pipol (wey e koll apostles), so dat dem go dey with am and e go fit send dem go prish.
14 E nomeou doze para que estivessem com ele e os mandasse a pregar
15 E kon give dem pawa to drive demons komot.
15 e para que tivessem o poder de curar as enfermidades e expulsar os demônios:
16 Na di twelf wey e choose bi dis: Simon wey e koll Pita,
16 Simão, a quem pôs o nome de Pedro;
17 James and en broda John, wey bi Zebedee shidren wey Jesus dey koll “Boanerges (wey mean ‘Tonda shidren’).”
17 Tiago, filho de Zebedeu, e João, irmão de Tiago, aos quais pôs o nome de Boanerges, que significa: Filhos do trovão;
18 Plus Andru, Filip, Bartolomew, Matiu, Tomas, James wey bi Afaeus pikin, Taddaeus, Simon wey dem dey koll Zealot (pesin wey dey fight for en kountry),
18 André, e Filipe, e Bartolomeu, e Mateus, e Tomé, e Tiago, filho de Alfeu, e Tadeu, e Simão, o Zelote,
19 and Judas Iskariot, wey sell Jesus give en enemies.
19 e Judas Iscariotes, o que o traiu.
20 Jesus go house and plenty pipol kon gada am sotey en and en disciples nor fit chop.
20 E foram para uma casa. E afluiu outra vez a multidão, de tal maneira que nem sequer podiam comer pão.
21 Wen Jesus family hear wetin dey happen, dem kon go hold am, bikos pipol dey sey, “E don dey kraze.”
21 E, quando os seus parentes ouviram isso, saíram para o prender, porque diziam: Está fora de si.
22 Di law tishas wey kom from Jerusalem sey, “Belzibub dey inside am” and “Na demon pawa e take dey drive demons komot from pipol body.”
22 E os escribas, que tinham descido de Jerusalém, diziam: Tem Belzebu e pelo príncipe dos demônios expulsa os demônios.
23 So Jesus kon tok to di pipol for parabol sey: “How Satan go fit take drive Satan komot?
23 E, chamando-os a si, disse-lhes por parábolas: Como pode Satanás expulsar Satanás?
24 Any kingdom where pipol dey fight each oda, nor go fit stand.
24 Se um reino se dividir contra si mesmo, tal reino não pode subsistir;
25 And any family wey dey fight demsef, go skata.
25 e se uma casa se dividir contra si mesma, tal casa não pode subsistir.
26 So, if Satan kingdom divide against ensef, e nor go fit stand and en end don rish.
26 Se Satanás se levantar contra si mesmo, e for dividido, não pode subsistir; antes, tem fim.
27 Nobody go fit enter strong man house tif en propaty, unless e first tie di strong man, before e go fit tif en tins.
27 Ninguém pode roubar os bens do valente, entrando-lhe em sua casa, se primeiro não manietar o valente; e, então, roubará a sua casa.
28 I tell una true word, God go forgive pipol di sins wey dem kommit and all di bad word wey dem tok.
28 Na verdade vos digo que todos os pecados serão perdoados aos filhos dos homens, e toda sorte de blasfêmias, com que blasfemarem.
29 But anybody wey tok bad word against di Holy Spirit, God nor go ever forgi-am, bikos e don kommit sin wey go last forever.”
29 Qualquer, porém, que blasfemar contra o Espírito Santo, nunca obterá perdão, mas será réu do eterno juízo.
30 Jesus tok so, bikos some pipol sey, “Evil spirit dey inside am.”
30 (Porque diziam: Tem espírito imundo.)
31 Jesus mama and en brodas kom meet am. Dem stand for outside kon send pesin go koll am.
31 Chegaram, então, seus irmãos e sua mãe; e, estando de fora, mandaram-no chamar.
32 Di pipol wey sidan near Jesus kon tell am, “Yor mama and yor brodas dey outside, dem won si yu.”
32 E a multidão estava assentada ao redor dele, e disseram-lhe: Eis que tua mãe e teus irmãos te procuram e estão lá fora.
33 But Jesus ansa dem, “Who bi my mama and my brodas?”
33 E ele lhes respondeu, dizendo: Quem é minha mãe e meus irmãos?
34 Den e look di pipol wey sidan round am kon tell dem, “Na my mama and my brodas bi dis pipol wey sidan here!
34 E, olhando em redor para os que estavam assentados junto dele disse: Eis aqui minha mãe e meus irmãos.
35 Bikos anybody wey do wetin God wont, na-im bi my broda, sista and mama.”
35 Porquanto qualquer que fizer a vontade de Deus, esse é meu irmão, e minha irmã, e minha mãe.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Marcos 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.