Marcos 13
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC
1 As Jesus dey komot from di temple varanda, one of en disciple kon sey. “Tisha, si di fine-fine stone wey dem take build dis house!”
1 Saindo Jesus do templo, disse-lhe um dos seus discípulos:Mestre, olha que pedras e que construções!
2 Jesus ansa, “Una dey si all dis big house? Dem nor go even leave one stone on-top anoda. All of dem go skata!”
2 Jesus replicou-lhe: Vês este grande edifício? Não se deixará pedra sobre pedra que não seja demolida.
3 As Jesus sidan for Mount Olives wey face di temple, Pita, James, John and Andru kom meet am wen odas nor dey and dem kon sey,
3 E estando sentado no monte das Oliveiras, defronte do templo, perguntaram-lhe à parte Pedro, Tiago, João e André:
4 “Make yu tell us wish time dis tins go happen and wetin go bi di sign to show sey di time for dis tins to happen, don rish?”
4 Dize-nos, quando hão de suceder essas coisas? E por que sinal se saberá que tudo isso se vai realizar?
5 Jesus ansa dem, “Make una take kare, so dat nobody go deceive una.
5 Jesus pôs-se então a dizer-lhes: Cuidai que ninguém vos engane.
6 Many pipol go kom with my name sey, ‘Na mi bi Christ’ and dem go deceive many pipol.
6 Muitos virão em meu nome, dizendo: Sou eu. E seduzirão a muitos.
7 Wen una hear about war wey dey happen and rumor sey war won happen, make una nor fear. All dis tins must happen, but time neva rish wen di world go end.
7 Quando ouvirdes falar de guerras e de rumores de guerra, não temais; porque é necessário que estas coisas aconteçam, mas não será ainda o fim.
8 Difren kountries and kingdoms go fight each oda. Eartkweke and honga go dey for many place. But wen di wahala won start, e go bi like wen woman won born.
8 Levantar-se-ão nação contra nação e reino contra reino; e haverá terremotos em diversos lugares, e fome. Isto será o princípio das dores.
9 “Make una shine una eye. Dem go take una go kourt and dem go beat una for sinagog. Bikos of mi, una go stand for govnors and kings front, so dat una go fit tell dem about mi.
9 Cuidai de vós mesmos; sereis arrastados diante dos tribunais e açoitados nas sinagogas, e comparecereis diante dos governadores e reis por minha causa, para dar testemunho de mim diante deles.
10 Before di world go end, pipol must first prish di gospel for evry kountry for dis world.
10 Mas primeiro é necessário que o Evangelho seja pregado a todas as nações.
11 Wen dem arrest una karry go kourt, make una nor worry about wetin una go tok. God go give una wetin to tok for dat time, bikos nor bi una go tok, but na di Holy Spirit go tok thru una.
11 Quando vos levarem para vos entregar, não premediteis no que haveis de dizer, mas dizei o que vos for inspirado naquela hora; porque não sois vós que falais, mas sim o Espírito Santo.
12 “Broda go betray en broda make dem kill-am and papa go sell en pikin. Shidren go betray dia papa and mama and dem go kill dem.
12 O irmão entregará à morte o irmão, e o pai, o filho; e os filhos insurgir-se-ão contra os pais e dar-lhes-ão a morte.
13 Evribody go hate una bikos of my name. But di pesin wey go fit bear rish end, go dey save.”
13 E sereis odiados de todos por causa de meu nome. Mas o que perseverar até o fim será salvo.
14 “Wen una si wetin nor suppose happen dey happen for di Holy Place (make di pesin wey dey read, know wetin dis word mean), den doz wey dey Judea, must run go mountin.
14 Quando virdes a abominação da desolação no lugar onde não deve estar o leitor entenda , então os que estiverem na Judéia fujam para os montes;
15 Make di pesin wey dey on-top house nor kom down or go inside en house go kollect anytin.
15 o que estiver sobre o terraço não desça nem entre em casa para dela levar alguma coisa;
16 Make di pesin wey dey farm nor go back to en house go kollect klot.
16 e o que se achar no campo não volte a buscar o seu manto.
17 For dat time, e go bad well-well for wimen wey get belle and doz with pikin wey still dey suck breast!
17 Ai das mulheres que naqueles dias estiverem grávidas e amamentando!
18 Make una pray sey dis tins nor go happen for di time wen kold dey well-well.
18 Rogai para que isto não aconteça no inverno!
19 Bikos wen dis tins go dey happen, di kind sofa wey go dey, neva dey since wen God kreate dis world and dat kind sofa, nor go dey again.
19 Porque naqueles dias haverá tribulações tais, como não as houve desde o princípio do mundo que Deus criou até agora, nem haverá jamais.
20 If God nor kut doz days short, nobody go save. But bikos of di pipol wey God don choose, E don make doz days short.
20 Se o Senhor não abreviasse aqueles dias, ninguém se salvaria; mas ele os abreviou em atenção aos eleitos que escolheu.
21 Dat time, if anybody tell una, ‘Look! Make una si Jesus for here!’ or ‘Si am for der!’ make una nor bilive dem.
21 E se então alguém vos disser: Eis, aqui está o Cristo; ou: Ei-lo acolá, não creiais.
22 Bikos fake christs and profets go kom and dem go do signs and mirakles wey bi like majik to deceive pipol. If to sey e possibol, dem go deceive di pipol wey God don choose.
22 Porque se levantarão falsos cristos e falsos profetas, que farão sinais e portentos para seduzir, se possível for, até os escolhidos.
23 Make una take kare! I don tell una evritin before di time go rish.”
23 Ficai de sobreaviso. Eis que vos preveni de tudo.
24 “But for dat time, afta di sofa,
24 Naqueles dias, depois dessa tribulação, o sol se escurecerá, a lua não dará o seu resplendor;
25 Di stars go fall from heaven
25 cairão os astros do céu e as forças que estão no céu serão abaladas.
26 “Den evribody go si Man Pikin dey kom from inside kloud with strong pawa and glory.
26 Então verão o Filho do homem voltar sobre as nuvens com grande poder e glória.
27 Den, God go send en angels go gada di pipol wey E don choose from di for korna for di world go rish heaven.”
27 Ele enviará os anjos, e reunirá os seus escolhidos dos quatro ventos, desde a extremidade da terra até a extremidade do céu.
28 “Make una learn wetin dis fig tree parabol mean: Wen en branches don dey soft and en leaf dey fall komot, make una know sey dry sizin don near.
28 Compreendei por uma comparação tirada da figueira. Quando os seus ramos vão ficando tenros e brotam as folhas, sabeis que está perto o verão.
29 So wen unasef si dis tins dey happen, make una know sey di time wey Man Pikin go kom, don near.
29 Assim também quando virdes acontecer estas coisas, sabei que o Filho do homem está próximo, às portas.
30 I tell una true word, di pipol for dis time nor go die finish before all dis tins go happen.
30 Em verdade vos digo: não passará esta geração sem que tudo isto aconteça.
31 Heaven and eart go vanish, but my word go dey forever.”
31 Passarão o céu e a terra, mas as minhas palavras não passarão.
32 “Di day or di time wen dis tins go happen, nobody know am, even angels for heaven nor know and God Pikin sef nor know too. Na only di Papa, for heaven know am.
32 A respeito, porém, daquele dia ou daquela hora, ninguém o sabe, nem os anjos do céu nem mesmo o Filho, mas somente o Pai.
33 Make una dey wosh and shine una eye, bikos una nor know wen di time go rish.
33 Ficai de sobreaviso, vigiai; porque não sabeis quando será o tempo.
34 E go bi like wen man dey travel go far. E leave en house make en savant look am, give dem work do kon tell di gateman make e wosh en house.
34 Será como um homem que, partindo em viagem, deixa a sua casa e delega sua autoridade aos seus servos, indicando o trabalho de cada um, e manda ao porteiro que vigie.
35 “So make una shine una eye, bikos una nor know wen di house owner go kom back, weda na for evening, nite, morning or wen day don break.
35 Vigiai, pois, visto que não sabeis quando o senhor da casa voltará, se à tarde, se à meia-noite, se ao cantar do galo, se pela manhã,
36 If not, e go fit kom back wen una nor espect and e go meet una dey sleep.
36 para que, vindo de repente, não vos encontre dormindo.
37 Wetin I dey tell una so, I dey tell evribody. So make una shine una eye!”
37 O que vos digo, digo a todos: vigiai!
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Marcos 13, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.