Lucas 18
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB
1 Den Jesus tell dem one parabol to show sey, e good make pipol dey always pray.
1 Contou-lhes também uma parábola sobre o dever de orar sempre, e nunca desfalecer.
2 E sey, “One judge dey for one town wey nor dey fear God and e nor dey respet anybody.
2 dizendo: Havia em certa cidade um juiz que não temia a Deus, nem respeitava os homens.
3 For dat town, e get one woman wey en husband don die. E kon go meet di judge kon beg am, ‘Make yu help mi, bikos some pipol dey shit mi.’
3 Havia também naquela mesma cidade uma viúva que ia ter com ele, dizendo: Faze-me justiça contra o meu adversário.
4 “Di judge nor first listin to am, but afta, e tok for en mind sey, ‘Aldo I nor dey fear God and respet anybody,
4 E por algum tempo não quis atendê-la; mas depois disse consigo: Ainda que não temo a Deus, nem respeito os homens,
5 but bikos dis woman dey disturb mi, I go make sure sey e get wetin e suppose get, oda-wise e nor go let mi rest with dis en beggy-beggy wey nor dey finish.’ ”
5 todavia, como esta viúva me incomoda, hei de fazer-lhe justiça, para que ela não continue a vir molestar-me.
6 Jesus sey, “If di wiked judge tok like dis,
6 Prosseguiu o Senhor: Ouvi o que diz esse juiz injusto.
7 una nor tink sey God go help en pipol wey dey kry to am both day and nite? Abi, God go wait tey before E help dem?
7 E não fará Deus justiça aos seus escolhidos, que dia e noite clamam a ele, já que é longânimo para com eles?
8 I tell una true word, God go help dem kwik-kwik. But wen Man Pikin kom back, e go si pipol wey get faith?”
8 Digo-vos que depressa lhes fará justiça. Contudo quando vier o Filho do homem, porventura achará fé na terra?
9 Jesus kon tell dis parabol to some pipol wey bilive and feel sey, na dem holy pass and nobody good rish dem.
9 Propôs também esta parábola a uns que confiavam em si mesmos, crendo que eram justos, e desprezavam os outros:
10 “Two men go inside Temple go pray. One na Farisee and di oda one na tax kollector.
10 Dois homens subiram ao templo para orar; um fariseu, e o outro publicano.
11 Di Farisee kon stand dey pray about ensef sey: ‘God, I tank yu sey I nor bi like oda pipol wey dey play wayo, dey sin, pipol wey dey kommit adultery or even like dis tax kollector.
11 O fariseu, de pé, assim orava consigo mesmo: ó Deus, graças te dou que não sou como os demais homens, roubadores, injustos, adúlteros, nem ainda com este publicano.
12 I dey fast two times a week and I dey pay one out of evry ten tins wey I get, give yu.’
12 Jejuo duas vezes na semana, e dou o dízimo de tudo quanto ganho.
13 “But di tax kollector stand for far place and e nor even look heaven, but kon nak en chest dey sey, ‘God, make yu sorry for mi, bikos I bi sina!’
13 Mas o publicano, estando em pé de longe, nem ainda queria levantar os olhos ao céu, mas batia no peito, dizendo: ó Deus, sê propício a mim, o pecador!
14 “I tell una true word, na di tax kollector God go forgive, nor bi di Farisee. Bikos anybody wey karry ensef go up, God go bring am down, but di pesin wey put ensef down, God go karry am up.”
14 Digo-vos que este desceu justificado para sua casa, e não aquele; porque todo o que a si mesmo se exaltar será humilhado; mas o que a si mesmo se humilhar será exaltado.
15 Some pipol kon bring dia pikin make Jesus tosh dem. But wen di disciples si dem, dem kon bigin shaut for di pipol wey bring di shidren.
15 Traziam-lhe também as crianças, para que as tocasse; mas os discípulos, vendo isso, os repreendiam.
16 But Jesus koll di shidren kon sey, “Make una allow di small-small shidren kom meet mi, nor stop dem, bikos na pipol like dem get God Kingdom.
16 Jesus, porém, chamando-as para si, disse: Deixai vir a mim as crianças, e não as impeçais, porque de tais é o reino de Deus.
17 I tell una true word, anybody wey nor receive God Kingdom like small pikin, nor go enter inside.”
17 Em verdade vos digo que, qualquer que não receber o reino de Deus como criança, de modo algum entrará nele.
18 One day, one Jew oga ask Jesus, “Good tisha, wetin I go do to get life wey nor dey end?”
18 E perguntou-lhe um dos principais: Bom Mestre, que hei de fazer para herdar a vida eterna?
19 Jesus kon tell am, “Why yu dey koll mi good? Nobody good escept God.
19 Respondeu-lhe Jesus: Por que me chamas bom? Ninguém é bom, senão um, que é Deus.
20 Yu know di kommandment dem wey sey, ‘Make yu nor sleep with pesin wey nor bi yor husband or wife, nor kill pesin, nor tif, respet yor papa and mama.’ ”
20 Sabes os mandamentos: Não adulterarás; não matarás; não furtarás; não dirás falso testemunho; honra a teu pai e a tua mãe.
21 Di man ansa Jesus, “I dey obey all dis law with all my heart since I bi small boy.”
21 Replicou o homem: Tudo isso tenho guardado desde a minha juventude.
22 Wen Jesus hear wetin di man tok, e kon tell am, “E still get one tin wey yu neva do, make yu sell evritin wey yu get, give di money to poor pipol, den yu go get betta propaty for heaven. Afta dat, make yu kom follow mi.”
22 Quando Jesus ouviu isso, disse-lhe: Ainda te falta uma coisa; vende tudo quanto tens e reparte-o pelos pobres, e terás um tesouro no céu; e vem, segue-me.
23 Wen di man hear dis one, e kon dey vex, bikos e rish well-well.
23 Mas, ouvindo ele isso, encheu-se de tristeza; porque era muito rico.
24 Wen Jesus know sey di man dey vex, e kon tell di pipol wey dey with am, “E go hard well-well for pesin wey rish well-well to enter God Kingdom!
24 E Jesus, vendo-o assim, disse: Quão dificilmente entrarão no reino de Deus os que têm riquezas!
25 E dey eazy for kamel to pass nidol whole dan for pesin wey rish well-well to enter God Kingdom.”
25 Pois é mais fácil um camelo passar pelo fundo duma agulha, do que entrar um rico no reino de Deus.
26 Pipol wey hear dis word kon sey, “Den who God go save?”
26 Então os que ouviram isso disseram: Quem pode, então, ser salvo?
27 Jesus ansa, “Wetin nor possibol for human being, dey possibol with God.”
27 Respondeu-lhes: As coisas que são impossíveis aos homens são possíveis a Deus.
28 Den Pita sey, “Oga God, wi don leave evritin wey wi get kon follow yu!”
28 Disse-lhe Pedro: Eis que nós deixamos tudo, e te seguimos.
29 Jesus kon tell dem, “I tell una di trut, anybody wey leave en house, wife, brodas, papa, mama or pikin bikos of God Kingdom,
29 Respondeu-lhes Jesus: Em verdade vos digo que ninguém há que tenha deixado casa, ou mulher, ou irmãos, ou pais, ou filhos, por amor do reino de Deus,
30 God go bless am with wetin pass all di tins wey e leave, both for dis world and for di life wey dey kom.”
30 que não haja de receber no presente muito mais, e no mundo vindouro a vida eterna.
31 Jesus koll di twelf disciples go korna kon tell dem, “Si, wi dey go Jerusalem and evritin wey di profets rite about Man Pikin go happen for der.
31 Tomando Jesus consigo os doze, disse-lhes: Eis que subimos a Jerusalém e se cumprirá no filho do homem tudo o que pelos profetas foi escrito;
32 Bikos dem go gi-am to Gentile pipol and dem go laf, curse and spit for en body.
32 pois será entregue aos gentios, e escarnecido, injuriado e cuspido;
33 Dem go flog am well-well and dem go kon kill-am. But for di third day, e go wake-up.”
33 e depois de o açoitarem, o matarão; e ao terceiro dia ressurgirá.
34 But di twelf disciples nor undastand wetin Jesus tok, bikos God hide wetin e mean from dem.
34 Mas eles não entenderam nada disso; essas palavras lhes eram obscuras, e não percebiam o que lhes dizia.
35 As Jesus near Jeriko, one man wey blind sidan for di road korna dey beg.
35 Ora, quando ele ia chegando a Jericó, estava um cego sentado junto do caminho, mendigando.
36 Wen e hear plenty pipol dey pass, e kon ask wetin dey happen.
36 Este, pois, ouvindo passar a multidão, perguntou que era aquilo.
37 Dem kon tell am sey Jesus wey kom from Nazaret dey pass.
37 Disseram-lhe que Jesus, o nazareno, ia passando.
38 So di man kon dey shaut, “Jesus, David pikin, make yu sorry for mi o-o!”
38 Então ele se pôs a clamar, dizendo: Jesus, Filho de Davi, tem compaixão de mim!
39 So di pipol wey dey en front kon dey shaut for am make e kwayet, but e kon dey shaut more-more, “David pikin, make yu sorry for mi o-o!”
39 E os que iam à frente repreendiam-no, para que se calasse; ele, porém, clamava ainda mais: Filho de Davi, tem compaixão de mim!
40 So Jesus stop kon sey make dem bring di beggar kom meet am. Wen di man kom, Jesus ask am,
40 Parou, pois, Jesus, e mandou que lho trouxessem. Tendo ele chegado, perguntou-lhe:
41 “Wetin yu wont make I do for yu?”
41 Que queres que te faça? Respondeu ele: Senhor, que eu veja.
42 Jesus kon tell am, “Make yu si naw, yor faith don heal yu.”
42 Disse-lhe Jesus: Vê; a tua fé te salvou.
43 At wons, di man bigin si and e kon follow Jesus, dey praiz God. Wen di pipol si wetin happen, dem kon bigin praiz God.
43 Imediatamente recuperou a vista, e o foi seguindo, gloficando a Deus. E todo o povo, vendo isso, dava louvores a Deus.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 18, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.