João 6

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Wen Jesus don tok finish, e kon cross go Tiberias wey dey di oda side for Galilee wotaside.
1 Depois dessas coisas, Jesus atravessou o mar da Galileia, que é o de Tiberíades.
2 Plenty pipol follow am, bikos dem si wen e heal pipol wey nor well.
2 Uma grande multidão o seguia, porque tinham visto os sinais que ele fazia na cura dos enfermos.
3 Jesus komot for der go di mountin side kon sidan der with en disciples.
3 Então Jesus subiu ao monte e sentou-se ali com os seus discípulos.
4 (Dat time, Passova Feast don rish.)
4 Ora, a Páscoa, festa dos judeus, estava próxima.
5 Wen Jesus look up, e si plenty pipol dey kom meet am. Den e ask Filip, “Na where wi go fit si bread buy wey all dis pipol go chop?”
5 Então Jesus, erguendo os olhos e vendo que uma grande multidão se aproximava, disse a Filipe:
6 Jesus tok dis one make e for si wetin Filip go do, bikos en ensef know wetin e won do.
6 Mas Jesus dizia isto para testá-lo, porque sabia o que estava para fazer.
7 Filip ansa, “Even if wi buy bread wey rish two hundred silva koins and if dem share am small-small, e nor go rish evribody chop.”
7 Filipe respondeu: — Nem mesmo duzentos denários de pão seriam suficientes para que cada um recebesse um pedaço.
8 Anoda disciple wey en name bi Andru, wey bi Simon Pita broda kon tell Jesus sey,
8 Um dos discípulos, chamado André, irmão de Simão Pedro, disse a Jesus:
9 “One boy dey here wey get five bread and two fish, but dis one nor go rish dis plenty pipol chop at-all!”
9 — Aqui está um menino que tem cinco pães de cevada e dois peixinhos. Mas o que é isto para tanta gente?
10 Jesus ansa, “Tell all di pipol make dem sidan” (as plenty grass dey di place wey dem go fit sidan put). Di men wey sidan, rish 5,000.
10 Jesus disse: Havia muita relva naquele lugar. Assim, os homens se assentaram, e eram quase cinco mil.
11 Jesus take di bread kon tank God. Den e divide am give di pipol wey sidan. E do di same tin with di fish. All of dem chop as dem wont kon beleful well-well. Bread and fish wey Jesus use take feed many pipol|alt="Loaves and fish Jesus prayed over to feed many people" src="44_John6.9-13_BarleyLoaves.tif" size="col" loc="JHN 9:6-13" copy="Gordon" ref="6:6-13"
11 Então Jesus pegou os pães e, tendo dado graças, distribuiu-os entre eles; e também igualmente os peixes, tanto quanto queriam.
12 Wen evribody don beleful, Jesus kon tell en disciples, “Make una gada wetin remain, make anytin nor waste.”
12 E, quando já estavam satisfeitos, Jesus disse aos seus discípulos:
13 Wen dem gada wetin dem chop remain for di five bread, e full twelf basket.
13 Assim, pois, o fizeram e encheram doze cestos de pedaços dos cinco pães de cevada, que sobraram depois que todos tinham comido.
14 So wen di pipol si di mirakle wey Jesus do, dem kon dey tok among demsef sey, “True-true, dis man na di profet wey God send kom dis world.”
14 Quando as pessoas viram o sinal que Jesus havia feito, disseram: — Este é verdadeiramente o profeta que devia vir ao mundo.
15 Since Jesus know sey dem go won take am by force go make am dia king, only en kon komot go on-top di mountin alone.
15 Jesus ficou sabendo que estavam para vir com a intenção de fazê-lo rei à força. Então ele se retirou outra vez, sozinho, para o monte.
16 Wen evening rish, en disciples kon go wotaside go wait am,
16 Ao final do dia, os discípulos de Jesus desceram para o mar.
17 dem enter one kenu, cross go Kapanaum (by dis time, evriwhere don dey dark and Jesus neva kom meet dem.)
17 E, entrando num barco, passaram para o outro lado, rumo a Cafarnaum. Já estava escuro, e Jesus ainda não tinha ido até onde eles estavam.
18 Den strong breeze bigin blow and di river kon dey rof well-well.
18 E o mar começava a ficar agitado, porque soprava um vento forte.
19 Wen dem don padol di kenu go rish about three or for mile, dem si Jesus dey waka on-top di wota dey kom near dem. Fear kon katch dem well-well.
19 Os discípulos já tinham navegado uns cinco ou seis quilômetros, quando viram Jesus andando sobre o mar, aproximando-se do barco; e ficaram com medo.
20 Jesus tell dem, “Na mi, make una nor fear.”
20 Mas Jesus lhes disse:
21 As dem dey try make e enter inside di kenu, dem kon si sey di kenu don rish where dem dey go.
21 Então eles o receberam com alegria, e logo o barco chegou ao seu destino.
22 Wen day don break, di pipol wey dey di oda side for di river know sey na only one small kenu dey der. Dem still know sey Jesus enter di kenu with dem.
22 No dia seguinte, a multidão que tinha ficado do outro lado do mar notou que ali havia apenas um pequeno barco e que Jesus não tinha entrado nele com os seus discípulos, tendo estes partido sozinhos.
23 So some kenu wey kom from Tiberias kon rish di wotaside near di place wey dem for chop bread, afta Jesus don pray.
23 Entretanto, outros barquinhos de Tiberíades se aproximaram do lugar onde a multidão havia comido o pão depois que o Senhor deu graças.
24 So wen di pipol si sey Jesus and en disciples nor dey der, dem enter di kenu kon go look for Jesus for anoda town wey dem dey koll Kapanaum.
24 Quando aquela multidão viu que Jesus não estava ali nem os seus discípulos, entraram nos barcos e partiram para Cafarnaum à procura de Jesus.
25 Wen dem si Jesus for di oda side for di river, dem ask am, “Tisha, wish time yu kom here?”
25 E, tendo-o encontrado no outro lado do mar, lhe perguntaram: — Mestre, quando o senhor chegou aqui?
26 Jesus ansa dem, “Make I tell una true word, na bikos of di bread wey una chop naim make una dey find mi, nor bi bikos of di mirakles wey una si.
26 Jesus respondeu:
27 Make una nor work for food wey nor dey last, but for food wey go give una life wey nor dey end and dat kind food, na only Man Pikin go fit give una, bikos na-im God send kom.”
27 Trabalhem, não pela comida que se estraga, mas pela que permanece para a vida eterna, a qual o Filho do Homem dará a vocês; porque Deus, o Pai, o confirmou com o seu selo.
28 Dem kon ask am, “Wetin wi go do to make God happy with us?”
28 Então lhe perguntaram: — Que faremos para realizar as obras de Deus?
29 Jesus ansa, “God wont sey make una bilive di pesin wey E send.”
29 Jesus respondeu:
30 Dem still ask Jesus, “Wish kind mirakle yu go do make wi si, make wi for bilive yu?
30 Então eles disseram: — Que sinal o senhor fará para que vejamos e creiamos no senhor? O que o senhor pode fazer?
31 Awa grand-grand papa dem chop manna for wildaness as dem rite for God word sey, ‘God give dem bread from heaven to chop.’ ”
31 Nossos pais comeram o maná no deserto, como está escrito: “Deu-lhes a comer pão do céu.”
32 Den Jesus tell dem, “Make I tell una true word, nor bi Moses give una bread from heaven, but God, wey bi my Papa, na-im give una di true bread from heaven.
32 Jesus lhes disse:
33 God bread na di pesin wey kom down from heaven kon give betta life to di pipol wey dey dis world.”
33 Porque o pão de Deus é o que desce do céu e dá vida ao mundo.
34 So dem tell am, “Oga God, from naw go, make yu give us dis bread.”
34 Então lhe disseram: — Senhor, dê-nos sempre desse pão.
35 Jesus kon tell dem, “Na mi bi di bread wey dey give life. Pesin wey kom meet mi nor go hongry lie-lie and di pesin wey bilive mi, nor go hongry for wota again.
35 Jesus respondeu:
36 As I don tell una, una dey si mi, but una nor bilive.
36 Porém eu já disse que vocês não creem, embora estejam me vendo.
37 Anybody wey my Papa give mi, go kom meet mi and wen e kom, I nor go ever drive am.
37 Todo aquele que o Pai me dá, esse virá a mim; e o que vem a mim, de modo nenhum o lançarei fora.
38 Nor bi to do wetin I wont make mi kom down from heaven, but na to do wetin my Papa wont.
38 Porque eu desci do céu, não para fazer a minha própria vontade, mas a vontade daquele que me enviou.
39 Wetin my Papa wey send mi wont, na make I nor luz anybody wey e give mi, but make I for take dem go up for di last day.
39 E a vontade de quem me enviou é esta: que eu não perca nenhum de todos os que ele me deu; pelo contrário, eu o ressuscitarei no último dia.
40 Wetin my Papa wont bi sey, anybody wey bilive en pikin, go get life wey nor dey end and I go wake am up for di last day.”
40 De fato, a vontade de meu Pai é que todo aquele que vir o Filho e nele crer tenha a vida eterna; e eu o ressuscitarei no último dia.
41 Den di Jew pipol bigin vex and komplain about Jesus, bikos e tok sey, “Na mi bi di bread wey kom down from heaven.”
41 Então os judeus começaram a murmurar contra ele, porque tinha dito: “Eu sou o pão que desceu do céu.”
42 Den dem sey, “Dis Jesus sef nor bi Josef pikin, wey wi know en papa and mama? Na how e kon dey tok sey, ‘I kom down from heaven?’ ”
42 E diziam: — Este não é Jesus, o filho de José? Por acaso não conhecemos o pai e a mãe dele? Como é que ele agora diz: “Desci do céu”?
43 Jesus ansa, “Make una nor komplain about mi give each oda.
43 Jesus respondeu:
44 Nobody go fit kom meet mi with en own pawa, unless my Papa wey send mi draw am kom meet mi and I go take am go up for di last day.
44 Ninguém pode vir a mim se o Pai, que me enviou, não o trouxer; e eu o ressuscitarei no último dia.
45 Na so di profets rite sey, ‘God go tish evribody.’ Anybody wey hear wetin my Papa tok, go kom meet mi.
45 Está escrito nos Profetas: “E todos serão ensinados por Deus.” Portanto, todo aquele que ouviu e aprendeu do Pai, esse vem a mim.
46 (Nor bi sey anybody don si di Papa before, escept mi wey kom from heaven).
46 Não que alguém tenha visto o Pai, a não ser aquele que vem de Deus; este já viu o Pai.
47 I dey tell una true word, anybody wey bilive mi, don get life wey nor dey end.
47 — Em verdade, em verdade lhes digo: quem crê em mim tem a vida eterna.
48 Na mi bi di bread wey dey give pesin life.
48 Eu sou o pão da vida.
49 Una grand-grand papa dem chop manna for wildaness, but dem still die.
49 Os pais de vocês comeram o maná no deserto e morreram.
50 Dis na di bread wey kom from heaven, so dat anybody wey chop am, go get life wey nor dey end.
50 Este é o pão que desce do céu, para que todo o que dele comer não pereça.
51 Na mi bi di bread wey kom down from heaven. Anybody wey chop dis bread go live forever. Na my flesh bi di bread wey I go give di pipol wey dey for dis world.”
51 Eu sou o pão vivo que desceu do céu; se alguém comer deste pão, viverá eternamente. E o pão que eu darei pela vida do mundo é a minha carne.
52 Den di Jew pipol wey dey vex with Jesus kon bigin dey argue with one anoda dey sey, “How dis man go give us en flesh make wi chop?”
52 Então os judeus começaram a discutir entre si, dizendo: — Como é que este pode nos dar a sua própria carne para comer?
53 Jesus tell dem, “I dey tell una true word, unless una chop Man Pikin flesh and drink en blood, una nor go get life for inside una.
53 Jesus respondeu:
54 Di pesin wey go chop my flesh and drink my blood, don get life wey nor dey end and I go take am up for di last day.
54 Quem come a minha carne e bebe o meu sangue tem a vida eterna, e eu o ressuscitarei no último dia.
55 My flesh na di real food and my blood na di korrect drink.
55 Pois a minha carne é verdadeira comida, e o meu sangue é verdadeira bebida.
56 Di pesin wey chop my flesh and drink my blood, go stay inside mi and I go dey inside am too.
56 Quem come a minha carne e bebe o meu sangue permanece em mim, e eu permaneço nele.
57 Na my Papa wey dey for heaven send mi and as I dey for dis life bikos of am, na so di pesin wey chop my flesh go get life, bikos of mi.
57 Assim como o Pai, que vive, me enviou, e igualmente eu vivo por causa do Pai, também quem de mim se alimenta viverá por mim.
58 Dis na di bread wey kom down from heaven, e nor bi like di bread wey una grand-grand papa dem chop and afta, dem still die. Di pesin wey go chop dis bread nor go ever die, but e go live forever.”
58 Este é o pão que desceu do céu, em nada semelhante àquele que os pais de vocês comeram e, mesmo assim, morreram; quem comer este pão viverá eternamente.
59 Jesus tok dis tins wen e dey tish dem for inside di temple for Kapanaum.
59 Jesus disse essas coisas quando ensinava na sinagoga de Cafarnaum.
60 Wen Jesus many disciples hear wetin e tok, dem kon sey, “Dis tin wey Jesus dey tok so hard well-well o-o! Na who go fit undastand dem?”
60 Muitos dos seus discípulos, tendo ouvido tais palavras, disseram: — Duro é este discurso; quem pode suportá-lo?
61 Wen Jesus know sey en disciples dey komplain about wetin e tok, e kon ask dem, “Wetin I tok so dey make una vex too?
61 Mas Jesus, sabendo por si mesmo que os seus discípulos murmuravam a respeito do que ele havia falado, disse-lhes:
62 Wetin go happen if una si Man Pikin go back to heaven where e dey before?
62 Que acontecerá, então, se virem o Filho do Homem subir para o lugar onde primeiro estava?
63 Na di Spirit go fit give pesin life; human being pawa nor fit do am. All dis word wey I dey tell una so, dem bi Spirit and dem dey give pesin life.
63 O Espírito é o que vivifica; a carne para nada aproveita. As palavras que eu lhes tenho falado são espírito e são vida.
64 But some of una nor bilive.” (From biginnin, Jesus don know di pipol wey nor go bilive and di pesin wey go sell am give en enemy.)
64 Mas há descrentes entre vocês. Ora, Jesus sabia, desde o princípio, quais eram os que não criam e quem iria traí-lo.
65 So Jesus kon sey, “Na bikos of dis I tell una sey, nobody go fit kom meet mi with en own pawa, unless my Papa let am kom.”
65 E prosseguiu:
66 Afta dis, Jesus many disciples kon stop to follow am.
66 Diante disso, muitos dos seus discípulos o abandonaram e já não andavam com ele.
67 Den Jesus ask en twelf disciples, “Una won go too?”
67 Então Jesus perguntou aos doze:
68 Den Simon Pita ansa am, “Oga God, na who wi go kon go meet? Na yu get di word wey dey give pipol di life wey nor dey end.
68 Simão Pedro respondeu: — Senhor, para quem iremos? O senhor tem as palavras da vida eterna,
69 Wi don bilive and know sey, ‘Na yu bi di Holy One wey God send kom meet us.’ ”
69 e nós temos crido e conhecido que o senhor é o Santo de Deus.
70 Jesus ansa, “Nor bi twelf of una I choose? But one pesin among una na devil pikin.”
70 Então Jesus lhes disse:
71 (E tok dis one about Judas, wey bi Simon Iskariot pikin, bikos na dis Judas, wey bi one among en twelf disciples, naim go sell am give en enemy.)
71 Ele se referia a Judas, filho de Simão Iscariotes, porque este, sendo um dos doze, era quem o haveria de trair.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar João 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.