Gálatas 5

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC

Sair da comparação
ARC Almeida Revista e Corrigida 2009
1 Make una nor dey karry load for head like slave again, but make una stand strong for groun, bikos Christ don make us free.
1 Estai, pois, firmes na liberdade com que Cristo nos libertou e não torneis a meter-vos debaixo do jugo da servidão.
2 Una dey hear so! Mi wey bi Paul dey tell una sey, if dem sekonsaiz una, den Christ nor mean anytin to una again.
2 Eis que eu, Paulo, vos digo que, se vos deixardes circuncidar, Cristo de nada vos aproveitará.
3 And I dey warn evribody; anybody wey gri make dem sekonsaiz am, must obey evry oda tin wey di law tok.
3 E, de novo, protesto a todo homem que se deixa circuncidar que está obrigado a guardar toda a lei.
4 Pipol wey wont make pipol know sey dem dey good, bikos dem dey keep di law, dem don already fall komot from God grace.
4 Separados estais de Cristo, vós os que vos justificais pela lei; da graça tendes caído.
5 Bikos na thru faith for God Spirit, naim wi hope sey, God go make us dey good for en eye.
5 Porque nós, pelo espírito da fé, aguardamos a esperança da justiça.
6 For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.
6 Porque, em Jesus Cristo, nem a circuncisão nem a incircuncisão têm virtude alguma, mas, sim, a fé que opera por amor.
7 Before, una dey do well; but naw, who sey make una nor obey di trut?
7 Corríeis bem; quem vos impediu, para que não obedeçais à verdade?
8 Nor bi God wey koll una sey make una dey do like dis!
8 Esta persuasão não vem daquele que vos chamou.
9 Na small yist dey make bread raiz!
9 Um pouco de fermento leveda toda a massa.
10 I get mind sey, God nor go let una listin to anoda pesin. But di pesin wey dey konfuse una, go face judgement, no matter who e bi.
10 Confio de vós, no Senhor, que nenhuma outra coisa sentireis; mas aquele que vos inquieta, seja ele quem for, sofrerá a condenação.
11 Naw, my brodas and sistas, if I still dey prish about how dem go take sekonsaiz una, why pipol dey trobol mi? If na so, my tishing about Christ cross nor suppose kause any trobol.
11 Eu, porém, irmãos, se prego ainda a circuncisão, por que sou, pois, perseguido? Logo, o escândalo da cruz está aniquilado.
12 I wish sey doz wey dey disturb una go-go sekonsaiz demsef!
12 Eu quereria que fossem cortados aqueles que vos andam inquietando.
13 My brodas and sistas, God don koll una make una dey free; but make una nor use di freedom wey God give una anyhow, instead make una love each oda.
13 Porque vós, irmãos, fostes chamados à liberdade. Não useis, então, da liberdade para dar ocasião à carne, mas servi-vos uns aos outros pelo amor.
14 Bikos if dem add di whole law togeda, dem go kon bi one kommandment wey sey, “Make yu love yor neighbour as yu love yorsef.”
14 Porque toda a lei se cumpre numa só palavra, nesta: Amarás o teu próximo como a ti mesmo.
15 But if una kontinue to kworel among unasef; una go fit wound or kill each oda by mistake.
15 Se vós, porém, vos mordeis e devorais uns aos outros, vede não vos consumais também uns aos outros.
16 I tell una, make una let di Spirit direct una life and una nor go do wetin di flesh wont.
16 Digo, porém: Andai em Espírito e não cumprireis a concupiscência da carne.
17 Bikos di tins wey di body like, difren from wetin di Spirit like and wetin di Spirit wont, nor dey gri with wetin di flesh wont.
17 Porque a carne cobiça contra o Espírito, e o Espírito, contra a carne; e estes opõem-se um ao outro; para que não façais o que quereis.
18 But if una allow di Spirit kontrol una, den una nor dey under di law again.
18 Mas, se sois guiados pelo Espírito, não estais debaixo da lei.
19 Na di tins wey di flesh dey do bi dis: To sleep with pesin wey yu nor marry; to get bad mind; to opress pipol;
19 Porque as obras da carne são manifestas, as quais são: prostituição, impureza, lascívia,
20 to dey serve juju; dey do majik; kworel-kworel life; fighty-fighty; jealousy; anyhow vexnashon; long-trot; tins wey dey skata pipol;
20 idolatria, feitiçarias, inimizades, porfias, emulações, iras, pelejas, dissensões, heresias,
21 bad belle; killi-killi; to dey drink anyhow and dey do oda tins like all dis ones. I dey warn una naw as I don warn una before sey, pipol wey dey do dis kind tins, nor go enter God kingdom!
21 invejas, homicídios, bebedices, glutonarias e coisas semelhantes a estas, acerca das quais vos declaro, como já antes vos disse, que os que cometem tais coisas não herdarão o Reino de Deus.
22 But di fruit wey di Holy Spirit dey bear inside us; na love, joy, peace, patient, kindness, goodness, faithfulnes,
22 Mas o fruto do Espírito é: amor, gozo, paz, longanimidade, benignidade, bondade, fé, mansidão, temperança.
23 gentolness and to kontrol awasef. Di law nor dey against all dis tins.
23 Contra essas coisas não há lei.
24 Pipol wey dey inside Christ don kill dia flesh with all di bad tins wey di flesh dey like to do.
24 E os que são de Cristo crucificaram a carne com as suas paixões e concupiscências.
25 If di Holy Spirit dey inside us, den make wi dey live awa life as di Holy Spirit wont.
25 Se vivemos no Espírito, andemos também no Espírito.
26 Make wi nor dey karry body up and dey do wetin go vex pipol or dey jealous one anoda.
26 Não sejamos cobiçosos de vanglórias, irritando-nos uns aos outros, invejando-nos uns aos outros.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Gálatas 5, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.