Êxodo 21
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARC
1 “Naw, dis na di laws wey yu go tell Israel pipol:
1 Estes são os estatutos que lhes proporás:
2 “If una buy any Hibru slave, e go serve una for six years, but e go dey free for di sevent year and e nor go pay anytin.
2 Se comprares um servo hebreu, seis anos servirá; mas, ao sétimo, sairá forro, de graça.
3 If di slave neva marry before e kom, na only en go komot, but if e don marry before e kom, di slave go komot with en wife.
3 Se entrou só com o seu corpo, só com o seu corpo sairá; se ele era homem casado, sairá sua mulher com ele.
4 “If na en oga gi-am wife and en wife born shidren, den na en oga go get di wife and di shidren, so na only di slave go-go.
4 Se seu senhor lhe houver dado uma mulher, e ela lhe houver dado filhos ou filhas, a mulher e seus filhos serão de seu senhor, e ele sairá só com seu corpo.
5 But if di slave sey, ‘I love my oga, my wife and shidren; I nor go-go,’
5 Mas, se aquele servo expressamente disser: Eu amo a meu senhor, e a minha mulher, e a meus filhos, não quero sair forro,
6 den di oga go take am go meet doz wey dey judge. Dem go bring am kom di town gate kon put hole for di slave ear and di slave go serve en oga forever.
6 então, seu senhor o levará aos juízes, e o fará chegar à porta, ou ao postigo, e seu senhor lhe furará a orelha com uma sovela; e o servirá para sempre.
7 “If anybody sell en dota as slave, di girl nor go-go like man slave.
7 E, se algum vender sua filha por serva, não sairá como saem os servos.
8 If di girl nor make belle sweet en oga wey buy am, den di oga go let am go. E nor get rite to sell am give strenjas, bikos na di oga break di kontract with am.
8 Se desagradar aos olhos de seu senhor, e não se desposar com ela, fará que se resgate; não poderá vendê-la a um povo estranho, usando deslealmente com ela.
9 If e give di slave to en son as wife, e go trit di slave like en own dota.
9 Mas, se a desposar com seu filho, fará com ela conforme o direito das filhas.
10 If di man kon marry anoda wife, e must kontinue to give en first wife food, klot and evritin wey e nid as wife.
10 Se lhe tomar outra, não diminuirá o mantimento desta, nem a sua veste, nem a sua obrigação marital.
11 And if e nor fit give di girl dis three tins, e must free am and di girl nor go pay anytin.”
11 E, se lhe não fizer estas três coisas, sairá de graça, sem dar dinheiro.
12 “Anybody wey nak and kill anoda pesin, dat pesin must die too.
12 Quem ferir alguém, que morra, ele também certamente morrerá;
13 But if na by mistake, den e go eskape go di place where I go choose and e go dey save for der.
13 porém, se lhe não armou ciladas, mas Deus o fez encontrar nas suas mãos, ordenar-te-ei um lugar para onde ele fugirá.
14 Like dis too, if anybody use wayo take kill en neighbour, den una go take am komot from my altar go kill.
14 Mas, se alguém se ensoberbecer contra o seu próximo, matando-o com engano, tirá-lo-ás do meu altar para que morra.
15 “Anybody wey beat en papa or mama, dem must surely kill-am.
15 O que ferir a seu pai ou a sua mãe certamente morrerá.
16 “Anybody wey kidnap and sell pesin or dem katch di pesin for en hand, dem must kill-am.
16 E quem furtar algum homem e o vender, ou for achado na sua mão, certamente morrerá.
17 “Anybody wey do or trit en papa or mama anyhow, dem must kill-am.
17 E quem amaldiçoar a seu pai ou a sua mãe certamente morrerá.
18 “If two pipol fight and one among dem nak en sekond with stone or with en hand and e nor die, but e sick
18 E, se alguns homens pelejarem, ferindo um ao outro com pedra ou com o punho, e este não morrer, mas cair na cama;
19 and leta e kon stand up waka by ensef, den di pesin wey nak am, don dey innocent, but e go pay di pesin wey e wound all di time wey e don waste kon make sure sey en body strong.
19 se ele tornar a levantar-se e andar fora sobre o seu bordão, então, aquele que o feriu será absolvido; somente lhe pagará o tempo que perdera e o fará curar totalmente.
20 “Anybody wey nak en savant, weda na man or woman savant with stik and e die, dem must ponish dat pesin.
20 Se alguém ferir a seu servo ou a sua serva com vara, e morrerem debaixo da sua mão, certamente será castigado;
21 But if di savant wey wound nor die afta one or two days, dem nor go ponish en owner, bikos e nor luz anytin.
21 porém, se ficarem vivos por um ou dois dias, não será castigado, porque é seu dinheiro.
22 “If two man dey fight and one mistakingly nak woman wey get belle and e kon born di pikin before nine monts, but e nor too wound, dem go ponish am akordin to wetin di woman husband ask for and e go pay anytin wey kourt sey make e pay.
22 Se alguns homens pelejarem, e ferirem uma mulher grávida, e forem causa de que aborte, porém se não houver morte, certamente aquele que feriu será multado conforme o que lhe impuser o marido da mulher e pagará diante dos juízes.
23 But if di wound sirious and di woman kon die, den dem must kill who kill di woman and
23 Mas, se houver morte, então, darás vida por vida,
24 na dat one bi eye-for-eye, tit-for-tit, hand-for-hand and leg-for-leg.
24 olho por olho, dente por dente, mão por mão, pé por pé,
25 Who burn pesin, dem go burn am too. Who wound pesin, dem go wound am too and who beat pesin, dem go beat am too.
25 queimadura por queimadura, ferida por ferida, golpe por golpe.
26 “If anybody blind en savant eye, di man must free di savant, bikos of di eye wey e blind.
26 E, quando alguém ferir o olho do seu servo ou o olho da sua serva e o danificar, o deixará ir forro pelo seu olho.
27 And if di man nak en savant tit komot, e must let am go free, bikos of di tit wey komot.”
27 E, se tirar o dente do seu servo ou o dente da sua serva, o deixará ir forro pelo seu dente.
28 “If pesin melu kill pesin, den dem go stone di melu die; nobody go chop di meat and dem nor go ponish di owner.
28 E, se algum boi escornar homem ou mulher, que morra, o boi será apedrejado certamente, e a sua carne se não comerá; mas o dono do boi será absolvido.
29 But if di melu dey always take en horn wound pipol and dem don warn di owner before and e nor do anytin koncerning di matter, before di melu kon kill pesin, dem must stone di melu die kon kill di owner too.
29 Mas, se o boi dantes era escornador, e o seu dono foi conhecedor disso e não o guardou, matando homem ou mulher, o boi será apedrejado, e também o seu dono morrerá.
30 But if dem put prize for di owner head to save en life, den e go pay di full amount.
30 Se lhe for imposto resgate, então, dará como resgate da sua vida tudo quanto lhe for imposto,
31 “If di melu take en horn wound pesin pikin, dem go judge am like di oda ones.
31 quer tenha escornado um filho, quer tenha escornado uma filha; conforme a este estatuto lhe será feito.
32 If di melu take en horn wound pesin savant, di owner must pay three shekel for silva and pipol go stone di melu die.
32 Se o boi escornar um servo, ou uma serva, dar-se-ão trinta siclos de prata ao seu senhor, e o boi será apedrejado.
33 “If anybody dig pit for groun and e nor kover am and one melu or donkey fall enter,
33 Se alguém abrir uma cova ou se alguém cavar uma cova e não a cobrir, e nela cair um boi ou jumento,
34 di pesin wey get di pit must pay for di animal. E must pay to di owner, den di animal wey don die, go bi en own.
34 o dono da cova o pagará, ao seu dono o dinheiro restituirá; mas o morto será seu.
35 “If one man melu wound en neighbour melu and e die, den di two pipol go sell di melu wey dey alive kon share di money and dem go still share di melu wey die too.
35 Se o boi de alguém ferir de morte o boi do seu próximo, então, se venderá o boi vivo, e o dinheiro dele se repartirá igualmente, e também o morto se repartirá igualmente.
36 Or if pipol know sey di melu dey always attack odas and dem tell di owner and e nor do anytin koncerning di matter, e must use di melu take pay, den di one wey don die, go bi en own.”
36 Mas, se foi notório que aquele boi dantes era escornador, e seu dono não o guardou, certamente pagará boi por boi; porém o morto será seu.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Êxodo 21, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.