Atos 10
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVT
1 One man wey en name bi Kornelius dey stay for Caesaria and e bi offisa for Italy soja.
1 Morava em Cesareia um oficial do exército romano chamado Cornélio, capitão do Regimento Italiano.
2 E dey holy and en and en family dey woship God. E dey help di pipol well-well and dey pray to God evritime.
2 Era um homem devoto e temente a Deus, como era também toda a sua família. Dava aos pobres esmolas generosas e sempre orava ao Senhor.
3 One day, around three oklok for aftanoon, e si vishon where God angel for koll am, “Kornelius.”
3 Certa tarde, por volta das três horas, teve uma visão na qual viu um anjo de Deus vir em sua direção e dizer: “Cornélio!”.
4 Fear katch am as e dey look di angel, so e ansa, “Oga God, Wetin yu wont?” Di angel tell am, “God don hear yor prayer and si all di good tins wey yu dey do for poor pipol.
4 Temeroso, Cornélio olhou fixamente para o anjo e perguntou: “Que é, senhor?”. E o anjo respondeu: “Suas orações e esmolas subiram até Deus, e ele as guarda na memória.
5 So, send some men go Joppa make dem go koll one man wey en name bi Simon Pita.
5 Agora, envie alguns homens a Jope e mande buscar Simão, também chamado Pedro.
6 Di man dey stay with Simon wey dey do leda work and di house dey near di sea.”
6 Ele está hospedado com Simão, um homem que trabalha com couro e mora à beira do mar”.
7 Wen di angel don go, Kornelius kon koll two of en house boys with one soja wey dey serve am
7 Assim que o anjo foi embora, Cornélio chamou dois servos de sua casa e um soldado devoto de seu grupo de auxiliares.
8 and wen e don tell dem evritin wey happen, e kon send dem go Joppa.Kornelius dey pray for roof top for Joppa|alt="Cornelius praying on di roof top in Joppa" src="WA03962b.tif" size="col" loc="ACTS 10:1-8" copy="Wade" ref="10:4"
8 Ele lhes contou o que havia acontecido e os enviou a Jope.
9 For aftanoon for di next day, as di men dey near di town, Pita kon go di housetop go pray,
9 No dia seguinte, quando os mensageiros de Cornélio se aproximavam da cidade, Pedro subiu ao terraço para orar. Era cerca de meio-dia,
10 afta sometaim, e kon dey hongry, but di food neva ready. As e dey wait, e kon si vishon.
10 e ele estava com fome. Enquanto a refeição era preparada, entrou num êxtase.
11 For di vishon, e si sey heaven open and sometin wey bi like tray, wey dem whole for en for korna kon dey kom down small-small.
11 Viu o céu aberto e algo semelhante a um grande lençol ser baixado por suas quatro pontas.
12 Difren-difren animals wey get four legs and di ones wey dey creep for groun and difren birds dey inside di tray.
12 No lençol havia toda espécie de animais, répteis e aves.
13 Den one vois tell am, “Pita, get up, kill make yu chop.”
13 Então uma voz lhe disse: “Levante-se, Pedro; mate e coma”.
14 But Pita ansa, “Oga God, I nor go fit, bikos yu know sey since dem born mi, I neva chop anytin wey get blood or wey nor klean.”
14 “De modo nenhum, Senhor!”, respondeu Pedro. “Jamais comi coisa alguma que fosse considerada impura e imprópria.”
15 But di vois tell am, “Wetin God don make klean, make yu nor forbid am.”
15 Mas a voz falou novamente: “Não chame de impuro o que Deus purificou”.
16 Dis tin happen three times and di tray kon go back to heaven.
16 A mesma visão se repetiu três vezes. Então, subitamente, o lençol foi recolhido ao céu.
17 As Pita still dey wonder wetin di vishon mean, di men wey Kornelius send kon rish Simon house.
17 Pedro ficou perplexo, pensando em qual seria o significado da visão. Nesse momento, os homens que Cornélio tinha enviado encontraram a casa de Simão. Eles se aproximaram do portão
18 Dem ask if anybody wey bi Simon Pita dey di house.
18 e perguntaram se estava hospedado ali Simão, também chamado Pedro.
19 As Pita still dey tink about di vishon, di Holy Spirit kon tell am, “Look! Three men dey find yu.
19 Enquanto Pedro ainda refletia sobre a visão, o Espírito lhe disse: “Três homens vieram procurá-lo.
20 Make yu get up go meet dem and make yu follow dem, bikos na Mi send dem kom.”
20 Levante-se, desça e vá encontrar-se com eles. Não hesite em acompanhá-los, pois eu os enviei”.
21 So Pita go down go meet di men kon sey, “Na mi bi di pesin wey una dey look for. Wetin bring una kom?”
21 Pedro desceu e disse aos homens: “Eu sou quem vocês procuram. Por que vieram?”.
22 Dem ansa, “Kornelius, di soja offisa, wey dey do good tins and dey woship God well-well, wey all Jew pipol dey respet, na-im send us kom. One angel kommand am sey make e invite yu kom prish gi-am.”
22 Eles responderam: “Cornélio, um oficial romano, nos enviou. Ele é um homem devoto e temente a Deus, respeitado por todos os judeus. Um santo anjo o instruiu a chamar o senhor à casa dele para que ele ouça sua mensagem”.
23 So Pita sey make dem enter house and e welkom dem well-well.
23 Então Pedro convidou os homens para se hospedarem ali aquela noite. No dia seguinte, foi com eles, acompanhado de alguns irmãos de Jope.
24 Afta dem don travel for one full day, dem kon rish Caesaria. Kornelius don gada all en family and friends dey wait for dem.
24 Chegaram a Cesareia no dia seguinte. Cornélio os esperava e havia reunido seus parentes e amigos íntimos.
25 So as Pita enter di kompond, Kornelius knee down for en front kon dey woship am.
25 Quando Pedro chegou à casa, Cornélio veio ao seu encontro e prostrou-se diante dele, adorando-o.
26 But Pita hold am kon sey, “Stand up, bikos I bi ordinary human being like yu.”
26 Mas Pedro o levantou e disse: “Fique de pé! Eu sou apenas um homem como você”.
27 As Pita still dey follow am dey tok wen e enter di house, e kon si sey many pipol gada dey wait am.
27 Os dois conversaram e depois entraram na casa, onde muitos outros estavam reunidos.
28 E tell dem, “Una know sey di law nor allow us, wey bi Jew pipol, to visit Gentile pipol or follow dem do anytin, but God don show mi sey make I nor sey anybody nor dey klean.
28 Pedro lhes disse: “Vocês sabem que nossas leis proíbem que um judeu entre num lar gentio como este ou se associe com os gentios. No entanto, Deus me mostrou que não devo mais considerar ninguém impuro ou impróprio.
29 Na dis make wen una send pipol kom koll mi, I nor sey ‘No’. So make una tell mi, ‘Why una koll mi?’ ”
29 Por isso, vim assim que fui chamado, sem levantar objeções. Agora digam por que vocês mandaram me buscar”.
30 Kornelius ansa, “For days ago, for dis kind time for aftanoon, as I dey pray for my house, one man wey en dress dey shine kon stand for my front.
30 Cornélio respondeu: “Quatro dias atrás, eu estava orando em casa por volta deste mesmo horário, às três da tarde. De repente, um homem vestido com roupas resplandecentes apareceu diante de mim.
31 E kon sey, ‘Kornelius, God don hear yor prayer and E don remember all di good tins wey yu dey do.
31 Ele me disse: ‘Cornélio, Deus ouviu sua oração e se lembrou de suas esmolas.
32 So make yu send pipol go Joppa go koll Simon, wey dem dey koll Pita. E dey stay as strenja with Simon wey dey do leda work, wey e house dey near di sea.’
32 Agora, envie mensageiros a Jope e mande buscar Simão, também chamado Pedro. Ele está hospedado na casa de Simão, um homem que trabalha com couro e mora à beira do mar’.
33 So, I kon send pipol go koll yu and yu do well as yu kom. Na wi bi dis for God present, wi ready to hear wetin E sey make yu tell us.”
33 Assim, mandei buscá-lo de imediato, e foi bom que tenha vindo. Agora estamos todos aqui, esperando diante de Deus para ouvir a mensagem que o Senhor mandou que você nos trouxesse”.
34 Den Pita tell dem, “Naw, I don undastand sey God nor dey opress anybody,
34 Então Pedro respondeu: “Vejo claramente que Deus não mostra nenhum favoritismo.
35 but for evry tribe, di pesin wey fear am and dey do wetin good, na dat pesin, E dey like.
35 Em todas as nações ele aceita aqueles que o temem e fazem o que é certo.
36 Una know di message wey E send to Israel pipol, wen E tok about di Good News wey dey give peace, thru Jesus Christ, di real Oga God.
36 Esta é a mensagem de boas-novas para o povo de Israel: Há paz com Deus por meio de Jesus Cristo, que é Senhor de todos.
37 Una know wetin happen from Galilee go rish Judea afta John prish sey,
37 Vocês sabem o que aconteceu em toda a Judeia, começando na Galileia, depois do batismo que João proclamou.
38 Jesus Christ wey kom from Nazaret, na-im God give di Holy Spirit and pawa. Una still know how e do good for evriwhere kon heal pipol wey devil dey opress, bikos God dey with am.
38 Sabem também que Deus ungiu Jesus de Nazaré com o Espírito Santo e com poder. Então Jesus foi por toda parte fazendo o bem e curando todos os oprimidos pelo diabo, porque Deus estava com ele.
39 All of us si di tins wey e do for Judea and Jerusalem, but dem hang am for three kon kill-am.
39 “E nós somos testemunhas de tudo que ele fez em toda a Judeia e em Jerusalém, onde o mataram. Penduraram-no numa cruz,
40 But God raiz am for di third day kon allow pipol si am.
40 mas Deus o ressuscitou no terceiro dia e permitiu que ele fosse visto,
41 Nor bi evribody si am, but na di ones wey God don choose, wey follow am chop and drink afta e don wake-up from deat.
41 não por todo o povo, mas por nós que fomos escolhidos por Deus de antemão para sermos suas testemunhas. Nós fomos os que comemos e bebemos com ele depois que ele ressuscitou dos mortos.
42 E kon kommand us make wi prish and warn pipol sey, na en ensef bi di Pesin wey God choose make e judge pipol wey dey alive and di ones wey don die.
42 E ele nos mandou anunciar sua mensagem em toda parte e testemunhar que Deus o designou juiz dos vivos e dos mortos.
43 All di profets tok about am sey, ‘Evribody wey bilive am, thru en name, God go forgive dem.’ ”
43 É a respeito dele que todos os profetas dão testemunho, dizendo que todo o que nele crer receberá o perdão de seus pecados por meio de seu nome”.
44 As Pita still dey tok, di Holy Spirit kon enter inside all di pipol wey dey hear di message.
44 Enquanto Pedro ainda falava, o Espírito Santo desceu sobre todos que ouviam a mensagem.
45 Di bilivers wey bi Jew wey follow Pita go Joppa kon sopraiz well-well sey Gentile pipol too, fit receive di Holy Spirit,
45 Os discípulos judeus que acompanhavam Pedro ficaram admirados de que o dom do Espírito Santo também fosse derramado sobre os gentios,
46 bikos dem dey hear wey dem dey use difren-difren language take dey praiz God. Den Pita sey,
46 pois os ouviram falar em outras línguas e louvar a Deus. Pedro perguntou:
47 “Anybody go fit sey make wi nor baptize all dis pipol wey don receive di Holy Spirit, just like us?”
47 “Pode alguém se opor a que eles sejam batizados agora que, como nós, também receberam o Espírito Santo?”.
48 So e sey make dem baptize dem for Jesus Christ name. Den di pipol sey make e stay with dem for some days.
48 Então ordenou que fossem batizados em nome de Jesus Cristo. Depois, pediram que Pedro ficasse com eles alguns dias.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Atos 10, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.