3 João 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Mi wey bi elder dey rite dis leta to Gaius, my broda wey I love well-well.
1 O presbítero ao amado Gaio, a quem eu amo na verdade.
2 My friend, I dey pray sey make evritin dey good for yu and make yor body well, just as yor soul well too.
2 Amado, peço a Deus que tudo corra bem com você e que esteja com boa saúde, assim como vai bem a sua alma.
3 I happy well-well wen awa brodas kom tok about how yu dey always live for di trut.
3 Pois fiquei muito alegre quando os irmãos vieram e deram testemunho de que você é fiel à verdade e vive de acordo com a verdade.
4 Wetin make mi happy well-well na wen I hear sey my shidren dey live akordin to di trut.
4 Não tenho maior alegria do que esta, a de ouvir que os meus filhos vivem de acordo com a verdade.
5 My friend, di tins wey yu dey do for awa brodas wey yu nor even know, good well-well.
5 Amado, você tem sido fiel no que faz pelos irmãos, mesmo quando são estrangeiros.
6 Dem don even tok about yor love for inside di church where God pipol gada. E go good sey wen dem kom yor side, make yu help dem, so dat belle go sweet God as dem dey kontinue dia journey.
6 Estes deram testemunho, diante da igreja, do amor que você tem. Você fará bem encaminhando-os em sua jornada de um modo que agrada a Deus.
7 Dem start dia journey bikos of “Christ name” and dem nor gri take anytin from pipol wey nor bi Christian.
7 Pois foi por causa do Nome que eles saíram, sem receber nada dos gentios.
8 So wi suppose to help doz pipol, so dat wi go bi dia ko-worker wey go make di trut stand.
8 Portanto, devemos acolher esses irmãos, para que nos tornemos cooperadores com eles na proclamação da verdade.
9 I bin rite leta to di church pipol, but Diotrefes, wey dey karry body up sey na-im bi dia leader, nor gri welkom us.
9 Escrevi algumas palavras à igreja, mas Diótrefes, que gosta de exercer a primazia entre eles, não nos dá acolhida.
10 So, wen I kom, I go tell evribody wetin e do; tins wey wi nor do and e sey wi do am. Even doh e dey tok bad about us, dat one nor do for am; nor bi only sey e nor dey welkom awa brodas, but e dey make odas nor welkom dem too and e dey drive dem komot from di church.
10 Por isso, quando eu for aí, farei com que se lembre das obras que ele pratica, proferindo contra nós palavras caluniosas. E, não satisfeito com isso, ele não recebe os irmãos, impede os que querem recebê-los e os expulsa da igreja.
11 My friend, make yu nor follow bad tin, but do wetin dey good. Di pesin wey dey do good, na God own and di pesin wey dey do wetin bad, neva know God.
11 Amado, não imite o que é mau, e sim o que é bom. Quem pratica o bem procede de Deus; quem pratica o mal jamais viu a Deus.
12 Pipol don tok about Demetrius, bikos e dey do good and even di trut wey e know, show sey e good. Wisef dey tok about how e good and yu know sey wetin wi dey tok, na true.
12 Quanto a Demétrio, todos dão bom testemunho dele, até a própria verdade. E nós também damos testemunho, e você sabe que o nosso testemunho é verdadeiro.
13 I get many tins wey I won tell yu, but I nor one rite dem with biro and paper.
13 Muitas coisas tinha para lhe escrever, mas não quis fazê-lo com tinta e pena,
14 I dey hope sey I go soon si yu and wi go tok face-to-face.
14 pois espero vê-lo em breve. Então conversaremos pessoalmente.
15 Make peace dey with yu. Awa friends for here dey salot yu too. Make yu greet all awa friends wey dey der.
15 A paz esteja com você. Os amigos mandam saudações. Dê saudações aos amigos, um por um.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 3 João 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.