2 Tessalonicenses 3

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH

Sair da comparação
NTLH Nova Tradução na Linguagem de Hoje 2000
1 Finally, my brodas and sistas, make una pray for us, so dat Christ message go kontinue to spread kon get glory just as e really get among una.
1 Finalmente, irmãos, orem por nós para que a mensagem do Senhor continue a se espalhar rapidamente e seja bem-aceita, como aconteceu entre vocês.
2 Make God diliver us from wiked and evil pipol, bikos nor bi evribody get faith.
2 Orem também para que Deus nos livre das pessoas más e perversas, pois nem todos creem na mensagem.
3 But Christ dey keep en promise and E go make una strong.
3 Mas o Senhor Jesus é fiel. Ele lhes dará forças e os livrará do Maligno .
4 Wi get mind sey Christ go help una and una go do all di tins wey wi tell una.
4 E o Senhor faz com que confiemos em vocês; temos a certeza de que estão fazendo e continuarão a fazer o que lhes recomendamos.
5 I pray make God guide una heart to undastand en love more-more, so dat una go get Christ patient.
5 Que o Senhor os faça compreender melhor o amor de Deus por vocês e a firmeza que ele, Cristo, dá!
6 My brodas and sistas, wi dey kommand una with awa Oga God Jesus Christ name sey, make una nor follow bilivers wey dey do anyhow and nor dey do as wi tell dem.
6 Irmãos, em nome do nosso Senhor Jesus Cristo, ordenamos a vocês que se afastem de todos os irmãos que vivem sem trabalhar e que não seguem os ensinamentos que demos a eles.
7 Una know sey una suppose to dey imitate us, bikos wi nor bihave anyhow wen wi dey with una.
7 Vocês sabem muito bem que devem seguir o nosso exemplo, pois não temos vivido entre vocês sem trabalhar.
8 Wi nor chop anybody food wey wi nor pay for. Instead, wi dey struggol and work hard for day and nite, so dat wi nor go bi wahala to una.
8 Não temos recebido nada de ninguém, sem pagar; na verdade trabalhamos e nos cansamos. Trabalhamos sem parar, dia e noite, a fim de não sermos um peso para nenhum de vocês.
9 Nor bi sey wi nor get rite to ask una, but wi won use awasef as ezample for una,
9 É claro que temos o direito de receber sustento; mas não temos pedido nada a fim de que vocês seguissem o nosso exemplo.
10 bikos even wen wi dey with una, wi tell una sey, “Pesin wey nor ready to work, make e nor chop.”
10 Porque, quando estávamos aí, demos esta regra: “Quem não quer trabalhar que não coma.”
11 Wi hear sey some pipol among una dey leave anyhow and dem nor dey mind dia business, instead dem dey put eye for anoda pesin tin.
11 Estamos afirmando isso porque ouvimos dizer que há entre vocês algumas pessoas que vivem como os preguiçosos: não fazem nada e se metem na vida dos outros.
12 Wi dey kommand and enkourage dis kind pipol with awa Oga God Jesus Christ name sey, make dem do dia work well, so dat dem go fit feed demsef.
12 Em nome do Senhor Jesus Cristo, ordenamos com insistência a essas pessoas que vivam de um modo correto e trabalhem para se sustentar.
13 My brodas and sistas, make e nor taya una to do good.
13 Mas vocês, irmãos, não se cansem de fazer o bem.
14 But if anybody nor obey awa message thru dis leta, make una look dat kind pesin well-well and make nobody follow am waka or do anytin togeda, so dat shame go katch am.
14 Se alguém não quiser obedecer ao que estamos mandando nesta carta, vejam bem quem está fazendo isso e se afastem dele para que fique envergonhado.
15 Make una nor si am as enemy, but make una korrect am as una broda.
15 No entanto não o tratem como inimigo, mas o aconselhem como se aconselha um irmão.
16 Naw, make Christ wey dey give peace, give una en peace evritime and make di peace dey with una always.
16 Que o Senhor da paz dê a vocês a paz, sempre e de todas as maneiras! E que o Senhor esteja com todos vocês!
17 Na mi Paul dey rite and greet una with my own hand, just as I dey do for evry leta wey I don send kom meet una.
17 Com a minha própria mão escrevo isto: Saudações de Paulo. É assim que assino todas as minhas cartas; é assim que escrevo.
18 Make awa Oga God Jesus Christ grace dey with all of una.
18 Que a graça do nosso Senhor Jesus Cristo esteja com todos vocês!

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 2 Tessalonicenses 3, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.