1 Samuel 8
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI
1 Wen Samuel don old, e kon sey make en sons dey judge Israel pipol.
1 Quando envelheceu, Samuel nomeou seus filhos como líderes de Israel.
2 En first boy name na Joel and di sekond one na Abijah. Dem dey judge Israel pipol for Beersheba.
2 Seu filho mais velho chamava-se Joel, o segundo, Abias. Eles eram líderes em Berseba.
3 But en boys nor follow wetin e tish dem, instead dem dey take bribe and nor dey judge well.
3 Mas os filhos dele não andaram em seus caminhos. Eles se tornaram gananciosos, aceitaram suborno e perverteram a justiça.
4 So all di leaders for Israel gada go meet Samuel for Rama
4 Por isso, todas as autoridades de Israel reuniram-se e foram falar com Samuel, em Ramá.
5 kon tell am, “Si, yu don old and yor shidren nor dey do as yu dey do. So make yu choose king wey go lead us, just as all di oda nashons get.”
5 E disseram-lhe: "Tu já estás idoso, e teus filhos não andam em teus caminhos; escolhe agora um rei para que nos lidere, à semelhança das outras nações".
6 But Samuel nor like wetin dem ask for, bikos dem sey, “Give us king wey go lead us.” So Samuel kon pray to God.
6 Quando, porém, disseram: "Dá-nos um rei para que nos lidere", isto desagradou a Samuel; então ele orou ao Senhor.
7 God tell Samuel, “Make yu do evritin wey di pipol ask yu, bikos nor bi yu dem rijet, but na mi dem rijet as dia king.
7 E o Senhor lhe respondeu: "Atenda a tudo o que o povo está lhe pedindo; não foi a você que rejeitaram; foi a mim que rejeitaram como rei.
8 Since I take dem komot Egypt kon rish today, na so dem dey rijet mi. Dem rijet mi kon dey serve difren gods. Na di same tin dem dey do to yu naw.
8 Assim como fizeram comigo desde o dia em que os tirei do Egito, até hoje, abandonando-me e prestando culto a outros deuses, também estão fazendo com você.
9 So naw, make yu do as I tok. But make yu warn dem well-well kon make dem know evritin about how di king go rule dem.”
9 Agora atenda-os; mas advirta-os solenemente e diga-lhes que direitos reivindicará o rei que os governará".
10 So Samuel tell di pipol wey dey ask for king evritin wey God don tok.
10 Samuel transmitiu todas as palavras do Senhor ao povo, que estava lhe pedindo um rei,
11 E sey, “E get di way di king go take rule una; e go turn una shidren to sojas; some of dem go bi savant for en shariot and odas go dey run follow di horse.
11 dizendo: "Isto é o que o rei que reinará sobre vocês reivindicará como seu direito: ele tomará os filhos de vocês para servi-lo em seus carros de guerra e em sua cavalaria, e para correr à frente dos seus carros de guerra.
12 “Na only en go choose leaders wey go dey look ova tazon and doz wey go dey look ova fifty, plus doz wey go dey klear en field kon harvest wetin e plant and dem go dey make en war materials for am.
12 Colocará alguns como comandantes de mil e outros como comandantes de cinqüenta. Ele os fará arar as terras dele, fazer a colheita, e fabricar armas de guerra e equipamentos para os seus carros de guerra.
13 Una dotas go make pomade, kook and bake for di king.
13 Tomará as filhas de vocês para serem perfumistas, cozinheiras e padeiras.
14 E go take una best field and vineyard kon give dem to en own savants.
14 Tomará de vocês o melhor das plantações, das vinhas e dos olivais, e o dará aos criados dele.
15 One part out of evry ten seed and food wey una harvest, e go kollect am go give en ofisas and savants.
15 Tomará um décimo dos cereais e da colheita das uvas e o dará a seus oficiais e a seus criados.
16 Una man and woman savant, plus una best animals, di king go take and use dem for ensef.
16 Também tomará de vocês para seu uso particular os servos e as servas, o melhor do gado e dos jumentos.
17 E go take one out of evry ten animals wey una get and unasef go bi en savants.
17 E tomará de vocês um décimo dos rebanhos, e vocês mesmos se tornarão escravos dele.
18 For dat day, una go kry, bikos of una king wey una take una hand choose, but God nor go ansa una.”
18 Naquele dia, vocês clamarão por causa do rei que vocês mesmos escolheram, e o Senhor não os ouvirá".
19 But di pipol still sey dem wont king. Dem nor gri listin to di warnin wey Samuel dey give dem.
19 Todavia, o povo recusou-se a ouvir Samuel, e disseram: "Não! Queremos ter um rei.
20 Dem dey sey, “Wi won bi like oda nashons. Awa king go judge and lead us and e go fight awa fight.”
20 Seremos como todas as outras nações; um rei nos governará, e sairá à nossa frente para combater em nossas batalhas".
21 So Samuel listin to all wetin di pipol dey tok kon go tell God.
21 Depois de ter ouvido tudo o que o povo disse, Samuel o repetiu perante o Senhor.
22 God tell Samuel, “Go do as dem tok and make yu give dem king wey go rule dem.”
22 E o Senhor respondeu: "Atenda-os e dê-lhes um rei". Então Samuel disse aos homens de Israel: "Volte cada um para sua cidade".
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar 1 Samuel 8, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.