Tiago 1

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 Mi James, wey bi God and Jesus Christ savant, dey greet una wey bi di twelf tribes wey dey for evriwhere for di world.
1 Tiago, servo de Deus e do Senhor Jesus Cristo, às doze tribos da Dispersão, saúde.
2 My brodas and sistas, make una dey happy wen una dey face temptashon,
2 Meus irmãos, tende por motivo de grande gozo o passardes por várias provações,
3 bikos una know sey, if una win di temptashon, una patient go strong.
3 sabendo que a aprovação da vossa fé produz a perseverança;
4 And make una let patient do en work, so dat una go dey pafet and komplete, den una go gain evritin.
4 e a perseverança tenha a sua obra perfeita, para que sejais perfeitos e completos, não faltando em coisa alguma.
5 But if anybody nid wisdom, make e ask God wey dey gi-am to evribody. E nor go sey, “No,” but E go give yu.
5 Ora, se algum de vós tem falta de sabedoria, peça-a a Deus, que a todos dá liberalmente e não censura, e ser-lhe-á dada.
6 Di pesin wey dey ask, must get faith and make en mind nor shake, bikos anybody wey en mind dey shake, bi like river wey strong breeze dey blow up-and-down.
6 Peça-a, porém, com fé, não duvidando; pois aquele que duvida é semelhante à onda do mar, que é sublevada e agitada pelo vento.
7 Make dat pesin nor tink sey e go receive anytin from God,
7 Não pense tal homem que receberá do Senhor alguma coisa,
8 bikos e get doubol mind and e nor dey stabol for anytin wey e dey do.
8 homem vacilante que é, e inconstante em todos os seus caminhos.
9 Any biliver wey poor, make e happy, bikos God don lift am up.
9 Mas o irmão de condição humilde glorie-se na sua exaltação,
10 But pesin wey get money, make e nor proud, bikos e go soon perish like flower wey dey for bush.
10 e o rico no seu abatimento; porque ele passará como a flor da erva.
11 As sun dey dry grass and flower and dia beauti dey die forever, na so rish pesin go dry, as e dey porshu and love money.
11 Pois o sol se levanta em seu ardor e faz secar a erva; a sua flor cai e a beleza do seu aspecto perece; assim murchará também o rico em seus caminhos.
12 Di pesin wey fit bear wen problem kom meet am, make e happy, bikos e don show sey en faith strong and e go get di crown wey get life, wey God don promise sey E go give pipol wey love am.
12 Bem-aventurado o homem que suporta a provação; porque, depois de aprovado, receberá a coroa da vida, que o Senhor prometeu aos que o amam.
13 Make nobody tok wen temptashon kom meet am sey, “God dey test mi,” bikos nor-tin fit tempt God and God ensef, nor dey tempt anybody.
13 Ninguém, sendo tentado, diga: Sou tentado por Deus; porque Deus não pode ser tentado pelo mal e ele a ninguém tenta.
14 But temptashon dey kom meet pesin wey get bad tins for mind.
14 Cada um, porém, é tentado, quando atraído e engodado pela sua própria concupiscência;
15 Wen di bad tins wey e won do, don mature, e go make am sin and wen sin don grow well-well, e go kause deat.
15 então a concupiscência, havendo concebido, dá à luz o pecado; e o pecado, sendo consumado, gera a morte.
16 My brodas and sistas, make nor-tin deceive una,
16 Não vos enganeis, meus amados irmãos.
17 bikos evry betta and pafet gift dey kom from God. E dey kom down from di Papa wey kreate lite and E nor dey shange.
17 Toda boa dádiva e todo dom perfeito vêm do alto, descendo do Pai das luzes, em quem não há mudança nem sombra de variação.
18 As God wont am, E kon born us with di true message, so dat wi go bi first among all wetin E kreate.
18 Segundo a sua própria vontade, ele nos gerou pela palavra da verdade, para que fôssemos como que primícias das suas criaturas.
19 My brodas and sistas, make una undastand dis tins: Make una dey listin well-well and nor dey kwik tok or vex.
19 Sabei isto, meus amados irmãos: Todo homem seja pronto para ouvir, tardio para falar e tardio para se irar.
20 Human being vexnashon nor dey make pipol live di life wey God wont.
20 Porque a ira do homem não opera a justiça de Deus.
21 So make una remove una hand from evry dirty and wiked tins kon put una body down to asept God word wey dem don plant inside una, bikos e get pawa to save una soul.
21 Pelo que, despojando-vos de toda sorte de imundícia e de todo vestígio do mal, recebei com mansidão a palavra em vós implantada, a qual é poderosa para salvar as vossas almas.
22 Make una nor dey deceive unasef as una dey hear God word, but make sure sey una dey do wetin en word tok.
22 E sede cumpridores da palavra e não somente ouvintes, enganando-vos a vós mesmos.
23 Pesin wey hear God word and e nor dey do wetin e tok, bi like pesin wey dey look en face for mirror.
23 Pois se alguém é ouvinte da palavra e não cumpridor, é semelhante a um homem que contempla no espelho o seu rosto natural;
24 Wen di pesin look ensef finish kon komot go out, e go kwik-kwik forget how en face bi.
24 porque se contempla a si mesmo e vai-se, e logo se esquece de como era.
25 But di pesin wey dey look God pafet law wey dey free pipol; dey do wetin di word tok and e nor dey listin and forget, God go bless am for evritin wey e dey do.
25 Entretanto aquele que atenta bem para a lei perfeita, a da liberdade, e nela persevera, não sendo ouvinte esquecido, mas executor da obra, este será bem-aventurado no que fizer.
26 If anybody tink sey en dey follow wetin wi dey tish and e nor fit kontrol en mout, dat pesin dey deceive ensef and en relijon nor mean anytin.
26 Se alguém cuida ser religioso e não refreia a sua língua, mas engana o seu coração, a sua religião é vã.
27 But betta relijon wey nor get stain for God eye, naim bi dis: to kare for shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dey sofa bikos dia husband don die. So, make una keep unasef, so dat dis world nor go stain una.
27 A religião pura e imaculada diante de nosso Deus e Pai é esta: Visitar os órfãos e as viúvas nas suas aflições e guardar-se isento da corrupção do mundo.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Tiago 1, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.