Mateus 25

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 “God Kingdom bi like wen ten virgins karry dia lamps go meet man wey won marry wife.
1 Então o Reino dos céus será semelhante a dez virgens, que saíram com suas lâmpadas ao encontro do esposo.
2 Five get sense and five nor get sense.
2 Cinco dentre elas eram tolas e cinco, prudentes.
3 Wen di ones wey nor get sense karry dia lamp, dem nor take estra kerosine follow body.
3 Tomando suas lâmpadas, as tolas não levaram óleo consigo.
4 But di ones wey get sense karry estra kerosine.
4 As prudentes, todavia, levaram de reserva vasos de óleo junto com as lâmpadas.
5 E kon happen sey di man wey won marry, nor kwik kom, so all di virgins kon sleep.
5 Tardando o esposo, cochilaram todas e adormeceram.
6 “For mid-nite, somebody kon shaut, ‘Make una wake-up, di man wey won marry, dey kom o-o! Make una kom meet am.’
6 No meio da noite, porém, ouviu-se um clamor: Eis o esposo, ide-lhe ao encontro.
7 “So all di virgins wake-up, kon inkrease dia lite.
7 E as virgens levantaram-se todas e prepararam suas lâmpadas.
8 But di ones wey nor get sense kon tell di wise wons sey, ‘Make una give us some kerosine, bikos awa lite won kwensh.’
8 As tolas disseram às prudentes: Dai-nos de vosso óleo, porque nossas lâmpadas se estão apagando.
9 “But dem ansa, ‘No! Wetin wi get nor go rish wi share, instead make una go buy for unasef.’
9 As prudentes responderam: Não temos o suficiente para nós e para vós; é preferível irdes aos vendedores, a fim de o comprardes para vós.
10 “Wen dem go buy, di man wey won marry kon kom and di ones wey dey ready kon enter di party with am and dem kon lock di door.
10 Ora, enquanto foram comprar, veio o esposo. As que estavam preparadas entraram com ele para a sala das bodas e foi fechada a porta.
11 “Afta, di oda virgins kom back dey sey, ‘Oga God, Oga God! Make yu allow us enter.’
11 Mais tarde, chegaram também as outras e diziam: Senhor, senhor, abre-nos!
12 “But e ansa dem, ‘No! I nor know una!’
12 Mas ele respondeu: Em verdade vos digo: não vos conheço!
13 “So, make una dey ready, bikos una nor know di day or time wen Christ go kom.”
13 Vigiai, pois, porque não sabeis nem o dia nem a hora.
14 “One man wey dey travel kon koll all en savants divide en propaty give dem.
14 Será também como um homem que, tendo de viajar, reuniu seus servos e lhes confiou seus bens.
15 E give one five koins, give anoda one two koins and di last, one koin. E give each savant wetin e go fit use, den e kon travel.
15 A um deu cinco talentos; a outro, dois; e a outro, um, segundo a capacidade de cada um. Depois partiu.
16 Di savant wey get five koins kwik-kwik go use en money trade kon gain five koins join wetin e get.
16 Logo em seguida, o que recebeu cinco talentos negociou com eles; fê-los produzir, e ganhou outros cinco.
17 Di same way, di savant wey get two koins, gain two estra koins join en own.
17 Do mesmo modo, o que recebeu dois, ganhou outros dois.
18 But di savant wey get one koin kon go dig hole for outside, hide di money wey en oga gi-am.
18 Mas, o que recebeu apenas um, foi cavar a terra e escondeu o dinheiro de seu senhor.
19 “Afta, dia oga kon kom back make e for know how dem use di money wey e give dem.
19 Muito tempo depois, o senhor daqueles servos voltou e pediu-lhes contas.
20 Di savant wey e give five koins, kon bring anoda five koins join en own, sey, ‘Oga God yu give mi five koins. Si, I don gain five koins join dem.’
20 O que recebeu cinco talentos, aproximou-se e apresentou outros cinco: - Senhor, disse-lhe, confiaste-me cinco talentos; eis aqui outros cinco que ganhei.'
21 “En oga kon tell am, ‘Yu bi good and wise savant and yu do well! Since yu fit use di small tin wey I give yu, e show sey yu go fit kontrol big-big tins. Make yu kom enjoy with mi!’
21 Disse-lhe seu senhor: - Muito bem, servo bom e fiel; já que foste fiel no pouco, eu te confiarei muito. Vem regozijar-te com teu senhor.
22 “Di one wey dem give two koins still sey, ‘Oga God yu give mi two koins. Si, I don get two koins join dem.’
22 O que recebeu dois talentos, adiantou-se também e disse: - Senhor, confiaste-me dois talentos; eis aqui os dois outros que lucrei.
23 “En oga tell am, ‘Yu bi good and wise savant and yu do well! Since yu fit use di small tin wey I give yu, e show sey yu go fit kontrol big-big tins. Make yu kon enjoy with mi!’
23 Disse-lhe seu senhor: - Muito bem, servo bom e fiel; já que foste fiel no pouco, eu te confiarei muito. Vem regozijar-te com teu senhor.
24 “Den di savant wey e give one koin kon sey, ‘Oga God, I know sey yu bi wayo man, yu dey harvest wetin yu nor plant and dey pak fruits wey yu nor plok,
24 Veio, por fim, o que recebeu só um talento: - Senhor, disse-lhe, sabia que és um homem duro, que colhes onde não semeaste e recolhes onde não espalhaste.
25 so fear katch mi and I kon hide yor money for groun. So oga, make yu take wetin yu give mi.’
25 Por isso, tive medo e fui esconder teu talento na terra. Eis aqui, toma o que te pertence.
26 “En oga kon tell am, ‘Yu wiked and lazy savant! Since yu know sey I dey harvest wetin I nor plant and dey pak fruits wey I nor plok,
26 Respondeu-lhe seu senhor: - Servo mau e preguiçoso! Sabias que colho onde não semeei e que recolho onde não espalhei.
27 yu for put my money for bank, so dat wen I kom back, I go kollect my money back with intrest!
27 Devias, pois, levar meu dinheiro ao banco e, à minha volta, eu receberia com os juros o que é meu.
28 “ ‘Make una take di money from am and gi-am to di savant wey get ten.
28 Tirai-lhe este talento e dai-o ao que tem dez.
29 Bikos di pesin wey get sometin go get more and wetin e get, go plenty. But di pesin wey nor get, even di small one wey e get, dem go take am from am.
29 Dar-se-á ao que tem e terá em abundância. Mas ao que não tem, tirar-se-á mesmo aquilo que julga ter.
30 Make una trow dat wiked savant inside darkness for outside, where e go kry and grind en tit.’
30 E a esse servo inútil, jogai-o nas trevas exteriores; ali haverá choro e ranger de dentes.
31 “Wen Man Pikin and en angels go kom with en glory, e go sidan for en king throne.
31 Quando o Filho do Homem voltar na sua glória e todos os anjos com ele, sentar-se-á no seu trono glorioso.
32 Evribody for di world go gada for en front and e go separate pipol as shepad dey separate sheep from goat.
32 Todas as nações se reunirão diante dele e ele separará uns dos outros, como o pastor separa as ovelhas dos cabritos.
33 E go keep di sheep for en rite hand and di goat for en left.
33 Colocará as ovelhas à sua direita e os cabritos à sua esquerda.
34 “Den di king go tell di pipol wey dey en rite hand, ‘Make una kom, una wey my Papa don bless and make una inherit di kingdom wey God prepare for una before di world start.
34 Então o Rei dirá aos que estão à direita: - Vinde, benditos de meu Pai, tomai posse do Reino que vos está preparado desde a criação do mundo,
35 Wen I dey hongry, una give mi food, wen I dey thirsty, una give mi sometin drink and wen I bi strenja, una let mi enter una house.
35 for I hungered, and ye gave me to eat; I thirsted, and ye gave me to drink; I was a stranger, and ye took me in;
36 I dey naked and una give mi klot wear, wen I nor well, una kare for mi, wen I bin dey prison, una kom visit mi.’
36 naked, and ye clothed me; I was ill, and ye visited me; I was in prison, and ye came to me.
37 “Den di raitious pipol go ansa, ‘Oga God, wish time wi si yu hongry and dey thirsty, kon feed and give yu sometin drink?
37 Then shall the righteous answer him saying, Lord, when saw we thee hungering, and nourished thee; or thirsting, and gave thee to drink?
38 Wish time wi si yu as strenja, kon take yu enter awa house, or naked, kon give yu klot wear?
38 and when saw we thee a stranger, and took thee in; or naked, and clothed thee?
39 Wish time wi si yu wen yu nor well or dey for prison kon visit yu?’
39 and when saw we thee ill, or in prison, and came to thee?
40 “Den di king go ansa, ‘I tell una true word, just as una do am give di pesin wey small pass among my brodas and sistas, una don do am for mi.’
40 And the King answering shall say to them, Verily, I say to you, Inasmuch as ye have done it to one of the least of these my brethren, ye have done it to me.
41 “Di king go tell di pipol wey dey en left hand, ‘Make una komot from my side, una wey God don curse! Make una enter hell-fire wey dem prepare for devil and en wiked angels.
41 Then shall he say also to those on the left, Go from me, cursed, into eternal fire, prepared for the devil and his angels:
42 Bikos di time wey I dey hongry and thirsty, una nor give mi food and wota drink.
42 for I hungered, and ye gave me not to eat; I thirsted, and ye gave me not to drink;
43 Di time wen I bi strenja, una nor let mi enter una house, wen I dey naked, una nor give mi klot wear, wen I nor well and dey for prison, una nor kom visit mi.’
43 I was a stranger, and ye took me not in; naked, and ye did not clothe me; ill, and in prison, and ye did not visit me.
44 “Den, dem go ansa, ‘Oga God, wish time wi si yu dey hongry or won drink and wi nor give yu food or sometin to drink, wish time yu bi strenja or naked or nor well or dey for prison and wi nor give yu wetin yu wont?’
44 Then shall *they* also answer saying, Lord, when saw we thee hungering, or thirsting, or a stranger, or naked, or ill, or in prison, and have not ministered to thee?
45 “Den, di king go ansa dem, ‘I tell una true word, just as una nor do am for di pesin wey small pass among my brodas and sistas, una nor do am for mi.’
45 Then shall he answer them saying, Verily I say to you, Inasmuch as ye have not done it to one of these least, neither have ye done it to me.
46 “So wiked pipol go enter ponishment wey nor go end, but raitious pipol go get life wey nor go end too.”
46 And these shall go away into eternal punishment, and the righteous into life eternal.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 25, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.