Mateus 23
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NTLH
1 Jesus kon tell di pipol and en disciples sey,
1 Então Jesus falou à multidão e aos seus discípulos.
2 “Na di law tishas and Farisee pipol dey tok wetin Moses Law mean.
2 Ele disse:
3 So make una listin and do wetin dem dey tell una. But nor do wetin dem dey do, bikos dem nor dey do wetin dem dey tish.
3 Por isso vocês devem obedecer e seguir tudo o que eles dizem. Porém não imitem as suas ações, pois eles não fazem o que ensinam.
4 Dem dey put heavy load for pipol shoulder and dem nor ready to help dem.
4 Amarram fardos pesados e os põem nas costas dos outros, mas eles mesmos não os ajudam, nem ao menos com um dedo, a carregar esses fardos.
5 “All wetin dem dey do, na make pipol for si dem. Dem dey tie tins wey dem rite God word put for dia fore head and hand, so dat pipol go si dem.
5 Tudo o que eles fazem é para serem vistos pelos outros. Vejam como são grandes os trechos das das suas
6 Dem like betta place for party and betta chair for inside sinagog.
6 Eles preferem os melhores lugares nos banquetes e os lugares de honra nas
7 Dem like make pipol dey greet dem with respet for market and make pipol dey koll dem, ‘Tisha.’
7 Gostam de ser cumprimentados com respeito nas praças e de ser chamados de “mestre”.
8 “Nor let anybody koll yu ‘Tisha,’ bikos na only one tisha una get and all of una na brodas.
8 Porém vocês não devem ser chamados de “mestre”, pois todos vocês são membros de uma mesma família e têm somente um Mestre.
9 Make una nor koll anybody for dis world ‘Papa’, bikos na only one real Papa una get and e dey for heaven.
9 E aqui na terra não chamem ninguém de pai porque vocês têm somente um Pai, que está no céu.
10 Make yu nor let pipol koll yu ‘Leader’, bikos na only one leader una get and na-im bi Christ.
10 Vocês não devem também ser chamados de “líderes” porque vocês têm um líder, o
11 Di pesin wey big pass among una, go bi una savant.
11 Entre vocês, o mais importante é aquele que serve os outros.
12 Anybody wey dey karry body up, God go bring am down and anybody wey nor dey karry body up, God go raiz am up.
12 Quem se engrandece será humilhado, mas quem se humilha será engrandecido.
13 “But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter.
13 — Ai de vocês,
14 E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey use long prayer shit wimen wey dia husband don die, bikos of dis, God go ponish una well-well.”
14 [— Ai de vocês, mestres da Lei e fariseus, hipócritas! Pois vocês exploram as viúvas e roubam os seus bens e, para disfarçarem, fazem longas orações! Por isso o castigo de vocês será pior!]
15 “E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey travel go evriwhere just to win one pesin kon meet God and afta una don win am, una go kon make am bad well-well like devil pikin, pass as una bi!
15 — Ai de vocês, mestres da Lei e fariseus, hipócritas! Pois vocês atravessam os mares e viajam por todas as terras a fim de procurar converter uma pessoa para a sua religião. E, quando conseguem, tornam essa pessoa duas vezes mais merecedora do inferno do que vocês mesmos.
16 “E go bad for una, leaders wey blind, una sey, ‘Anybody wey take di temple swear, nor-tin go do am. But if e take di gold for Temple swear, curse go dey for en head.’
16 — Ai de vocês, guias cegos! Pois vocês ensinam assim: “Se alguém jurar pelo Templo, não é obrigado a cumprir o juramento. Mas, se alguém jurar pelo ouro do Templo, então é obrigado a cumprir o que jurou.”
17 Una bi fool wey blind! Wish one big pass, na di gold or di temple wey make di gold holy?
17 Tolos e cegos! Qual é mais importante: o ouro ou o Templo que
18 Una dey tish sey, ‘Anybody wey take di altar swear, nor-tin go do am, but if pesin take wetin dey for di altar swear, e must do wetin e tok.’
18 Vocês também ensinam isto: “Se alguém jurar pelo altar, não é obrigado a cumprir o juramento. Mas, se jurar pela oferta que está no altar, então é obrigado a cumprir o que jurou.”
19 Una blind o-o! Wish one big pass, na di gift or di altar wey make di gift holy?
19 Cegos! Qual é mais importante: a oferta ou o altar que santifica a oferta?
20 So, anybody wey take di altar swear, na both di altar and evritin wey dey inside, e take swear.
20 Por isso, quando alguém jura pelo altar, está jurando pelo altar e por todas as ofertas que estão em cima dele.
21 And anybody wey take di temple swear, na both di temple and God wey dey stay inside, e take swear.
21 Quando alguém jura pelo Templo, está jurando pelo Templo e por Deus, que mora ali.
22 Anybody wey take heaven swear, na both God throne and di Pesin wey sidan put, e take swear.
22 E, quando alguém jura pelo céu, está jurando pelo trono de Deus e pelo próprio Deus, que está sentado nele.
23 “E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey give one out of evry ten tins wey una get, but una nor dey do di important tin wey di law tok, wey bi to give korrect judgement, to trit pipol well and to do wetin dey good! Una suppose to dey do dis tins join di oda one.
23 — Ai de vocês, mestres da Lei e fariseus, hipócritas! Pois vocês dão a Deus a décima parte até mesmo da hortelã, da erva-doce e do
24 Una wey bi oga wey blind! Una dey remove fly from una drink, but una dey swallow melu!
24 Guias cegos! Coam um mosquito, mas engolem um camelo!
25 “E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey wosh cup and plate body make dem for klean, but bad belle and long-trot full inside una.
25 — Ai de vocês, mestres da Lei e fariseus, hipócritas! Pois vocês lavam o copo e o prato por fora, mas por dentro estes estão cheios de coisas que vocês conseguiram pela violência e pela ganância.
26 Una Farisee pipol wey blind! Make una first wosh inside di cup, den di outside go klean too!
26 Fariseu cego! Lave primeiro o copo por dentro, e então a parte de fora também ficará limpa!
27 “E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una bi like grave wey fine for outside, but di pesin body for inside, don rotin.
27 — Ai de vocês, mestres da Lei e fariseus, hipócritas! Pois vocês são como túmulos pintados de branco, que por fora parecem bonitos, mas por dentro estão cheios de ossos de mortos e de podridão.
28 Na so e bi with una too, for outside, una bi like good pipol, but for inside, na wayo and sin full una life.
28 Por fora vocês parecem boas pessoas, mas por dentro estão cheios de mentiras e pecados.
29 “E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una build grave for di profet wey don die kon dekorate koffin for pipol wey fear God.
29 — Ai de vocês,
30 And una sey, ‘If to sey wi dey alive for awa grand-grand papa time, wi nor for help dem wen dem dey kill di profets.’
30 E dizem: “Se tivéssemos vivido no tempo dos nossos antepassados, não teríamos feito o que eles fizeram, não teríamos matado os profetas.”
31 So na una grand-grand papa dem kill di profets.
31 Assim vocês confirmam que são descendentes daqueles que mataram os profetas.
32 Make una go finish di work wey una grand-grand papa dem start!
32 Portanto, vão e terminem o que eles começaram!
33 “Una bi snake! Wiked snake shidren! How una go take eskape hell?
33 Cobras venenosas, ninhada de cobras! Como esperam escapar da condenação do inferno?
34 I go send profets, wise pipol and law tishas kom meet una and una go kill and nail some for cross, flog some inside una sinagog, den porshu di odas from one town go anoda.
34 Pois eu lhes mandarei profetas, homens sábios e mestres. Vocês vão matar alguns, crucificar outros, chicotear ainda outros nas
35 So all God pipol blood wey una kill for dis world, go dey una head. From Abel blood go rish Zekaraya wey bi Barakaya pikin, wey una kill for inside di temple.
35 Por isso Deus castigará vocês pela morte de todas as pessoas inocentes que os antepassados de vocês mataram, desde a morte do inocente Abel até a de Zacarias, filho de Baraquias, que vocês mataram entre o Templo e o altar.
36 I tell una true word, pipol for dis generashon go sofa di ponishment for dis tins wey una do!”
36 Eu afirmo a vocês que isto é verdade: o castigo por tudo isso cairá sobre o povo de hoje.
37 “O! Jerusalem pipol, O! Jerusalem pipol! Una wey kill di profets and stone di pipol wey God send kom meet una! I don dey try to gada una shidren as fawol dey gada en shidren under am, but una nor let mi do am.
37 Jesus terminou, dizendo:
38 Si, from today go, una go skata and una house go empty.
38 Agora a casa de vocês ficará completamente abandonada.
39 Make una know sey, una nor go si mi again until una go sey, ‘Make God bless di pesin wey kom with God name!’ ”
39 Eu afirmo que vocês não me verão mais, até chegar o tempo em que dirão: “Deus abençoe aquele que vem em nome do Senhor!”
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 23, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.