Mateus 20

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ARIB

Sair da comparação
ARIB Almeida Revisada Imprensa Bíblica
1 “God Kingdom bi like wen pesin komot for early morning go hire pipol wey go work for en farm.
1 Porque o reino dos céus é semelhante a um homem, proprietário, que saiu de madrugada a contratar trabalhadores para a sua vinha.
2 Afta en and di workers don gri how mush dem go get for dia work, e kon send dem go work for en farm.
2 Ajustou com os trabalhadores o salário de um denário por dia, e mandou-os para a sua vinha.
3 “Wen nine oklok rish for morning, e kon si pipol wey nor get work stand for market.
3 Cerca da hora terceira saiu, e viu que estavam outros, ociosos, na praça,
4 E kon tell dem, ‘Make una go work for my farm, I go pay una well.’
4 e disse-lhes: Ide também vós para a vinha, e dar-vos-ei o que for justo. E eles foram.
5 So dem kon go. Wen e go out around twelf and three oklok for aftanoon, e still tell oda pipol make dem go work for di farm.
5 Outra vez saiu, cerca da hora sexta e da nona, e fez o mesmo.
6 Wen five oklok for evening don nearly rish, e si some pipol wey nor get work and e ask dem, ‘Why una nor dey work and today don nearly finish?’
6 Responderam-lhe eles: Porque ninguém nos contratou. Disse-lhes ele: Ide também vós para a vinha.
7 “Dem ansa am, ‘Na bikos nobody hire us.’
7 Responderam-lhe eles: Porque ninguém nos contratou. Disse-lhes ele: Ide também vós para a vinha.
8 “Wen evening rish, di pesin wey get di farm kon tell en managa, ‘Koll di workers make yu pay dem, start from di last pipol wey I hire.
8 Ao anoitecer, disse o senhor da vinha ao seu mordomo: Chama os trabalhadores, e paga-lhes o salário, começando pelos últimos até os primeiros.
9 “Pipol wey dem hire for five oklok, kollect full day salari.
9 Chegando, pois, os que tinham ido cerca da hora undécima, receberam um denário cada um.
10 And wen di pipol wey dem first hire waka kom, dem tink sey di oga go pay dem pass like dat. But dem get di same amount.
10 Vindo, então, os primeiros, pensaram que haviam de receber mais; mas do mesmo modo receberam um denário cada um.
11 Wen di first pipol kollect dia money, dem bigin komplain to di farm owner,
11 E ao recebê-lo, murmuravam contra o proprietário, dizendo:
12 ‘Dis last pipol work for only one hour and wi work for di whole day inside hot sun, but yu pay all of us di same amount.’
12 Estes últimos trabalharam somente uma hora, e os igualastes a nós, que suportamos a fadiga do dia inteiro e o forte calor.
13 “Di farm owner ansa one of dem, ‘My friend, I nor do yu bad. Nor bi wetin wi gri, dem pay yu?’
13 Mas ele, respondendo, disse a um deles: Amigo, não te faço injustiça; não ajustaste comigo um denário?
14 ‘Make yu take yor money dey go. I like give dis last pipol di same amount wey I give yu.
14 Toma o que é teu, e vai-te; eu quero dar a este último tanto como a ti.
15 Abi I nor fit use wetin bi my own as I like? Or yu dey jealous bikos I dey do good tin?’
15 Não me é lícito fazer o que quero do que é meu? Ou é mau o teu olho porque eu sou bom?
16 “So, di pesin wey bi last, go bi first and di first, go bi last.”
16 Assim os últimos serão primeiros, e os primeiros serão últimos.
17 As Jesus dey go Jerusalem, e take en twelf disciples go one korna kon tok to dem.
17 Estando Jesus para subir a Jerusalém, chamou à parte os doze e no caminho lhes disse:
18 “Make una look, wi dey go Jerusalem and dem go sell Man Pikin give di priest oga dem and di law tishas. Dem go sey make dem kill-am
18 Eis que subimos a Jerusalém, e o Filho do homem será entregue aos principais sacerdotes e aos escribas, e eles o condenarão à morte,
19 and dem go gi-am to Gentile pipol make dem laf and flog am well-well, den dem go nail am for cross. But for di third day, God go wake am up.”
19 e o entregarão aos gentios para que dele escarneçam, e o açoitem e crucifiquem; e ao terceiro dia ressuscitará.
20 Den Zebedee wife with en shidren, James and John kom meet Jesus. Dia mama kon knee down dey beg Jesus.
20 Aproximou-se dele, então, a mãe dos filhos de Zebedeu, com seus filhos, ajoelhando-se e fazendo-lhe um pedido.
21 Jesus kon ask am, “Wetin yu wont?”
21 Perguntou-lhe Jesus: Que queres? Ela lhe respondeu: Concede que estes meus dois filhos se sentem, um à tua direita e outro à tua esquerda, no teu reino.
22 Jesus ask dem again, “Una know wetin una dey ask for so? Una go fit drink from di cup wey I won drink from?”
22 Jesus, porém, replicou: Não sabeis o que pedis; podeis beber o cálice que eu estou para beber? Responderam-lhe: Podemos.
23 Jesus kon tell dem, “Na true sey una go fit drink from my cup, but e nor dey my hand to choose who go sidan for my rite and left, but na for doz wey my Papa choose.”
23 Então lhes disse: O meu cálice certamente haveis de beber; mas o sentar-se à minha direita e à minha esquerda, não me pertence concedê-lo; mas isso é para aqueles para quem está preparado por meu Pai.
24 So wen di oda ten disciples hear dis matter, dem kon dey vex with di two brodas.
24 E ouvindo isso os dez, indignaram-se contra os dois irmãos.
25 But Jesus koll and tell dem, “Una know sey Gentile pipol oga and pipol for big pozishon dey kontrol and opress dia pipol.
25 Jesus, pois, chamou-os para junto de si e lhes disse: Sabeis que os governadores dos gentios os dominam, e os seus grandes exercem autoridades sobre eles.
26 Make e nor bi like dat among una! Instead, anybody wey won bi oga among una, must serve di rest pipol
26 Não será assim entre vós; antes, qualquer que entre vós quiser tornar-se grande, será esse o que vos sirva;
27 and anybody wey wont bi first among una, must bi savant to di odas,
27 e qualquer que entre vós quiser ser o primeiro, será vosso servo;
28 just as Man Pikin nor kom make pipol serve am, but make e for serve and give en life to save many pipol.”
28 assim como o Filho do homem não veio para ser servido, mas para servir, e para dar a sua vida em resgate de muitos.
29 As Jesus and en disciples dey komot from Jeriko, many pipol kon dey follow dem.
29 Saindo eles de Jericó, seguiu-o uma grande multidão;
30 Two men wey blind sidan for di road korna. Wen dem hear sey Jesus dey pass, dem kon bigin shaut, “David Pikin, make yu sorry for us!”
30 e eis que dois cegos, sentados junto do caminho, ouvindo que Jesus passava, clamaram, dizendo: Senhor, Filho de Davi, tem compaixão de nós.
31 Pipol kon dey shaut for dem make dem kwayet. But dem kon dey shaut more-more, “David Pikin, make yu sorry for us.”
31 E a multidão os repreendeu, para que se calassem; eles, porém, clamaram ainda mais alto, dizendo: Senhor, Filho de Davi, tem compaixão de nós.
32 Jesus kon stop, koll and ask dem, “Wetin una wont make I do for una?”
32 E Jesus, parando, chamou-os e perguntou: Que quereis que vos faça?
33 Dem ansa, “Oga God, make awa eye open again.”
33 Disseram-lhe eles: Senhor, que se nos abram os olhos.
34 Jesus sorry for dem, so e tosh dia eye. At wons, dem bigin si and dem kon follow Jesus.
34 E Jesus, movido de compaixão, tocou-lhes os olhos, e imediatamente recuperaram a vista, e o seguiram.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Mateus 20, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.