Marcos 8
Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA
1 Dat time, plenty pipol gada and nor-tin dey for dem to chop. So Jesus koll en disciples tell dem,
1 Naqueles dias, quando outra vez se reuniu grande multidão, e não tendo o que comer, Jesus chamou os discípulos e lhes disse:
2 “I dey sorry for dis pipol, bikos dem don dey here with mi for three days naw and dem nor get anytin to chop.
2 — Tenho compaixão desta gente, porque já faz três dias que eles estão comigo e não têm o que comer.
3 If I send dem go with honga, dem go faint for road and some kom from far place.”
3 Se eu os mandar para casa em jejum, desfalecerão pelo caminho; e alguns deles vieram de longe.
4 Jesus disciples kon sey, “Where pesin go fit si bread buy wey go rish dis pipol chop, since pipol nor dey stay dis place wey bi wildaness?”
4 Mas os discípulos lhe responderam: — Como poderá alguém saciá-los de pão neste deserto?
5 Jesus ask dem, “How many bread una get?”
5 Então Jesus perguntou: Eles responderam: — Sete.
6 Den Jesus sey make di pipol sidan for groun. Afta e take di seven bread tank God, e kon divide am give en disciples, sey make dem share am for di pipol.
6 Então mandou o povo assentar-se no chão. E, pegando os sete pães, partiu-os, após ter dado graças, e os deu aos seus discípulos, para que estes os distribuíssem, repartindo entre o povo.
7 Dem still get some small-small fish too and afta Jesus don tank God, e kon tell en disciples make dem share am for di pipol too.
7 Tinham também alguns peixinhos. E, abençoando-os, mandou que estes igualmente fossem distribuídos.
8 Evribody chop beleful and di ones wey dem gada, full seven basket.
8 Comeram e se fartaram; e dos pedaços restantes recolheram sete cestos.
9 All di pipol wey chop rish 4,000 men. Den, Jesus kon send dem go house.
9 Eram cerca de quatro mil homens. Então Jesus os despediu.
10 En and en disciples kon enter boat go Dalmanuta aria.
10 Logo a seguir, tendo entrado no barco juntamente com os seus discípulos, foi para a região de Dalmanuta.
11 Di Farisee pipol kon dey argue with Jesus sey make e show dem sign from heaven, bikos dem won try am.
11 Os fariseus chegaram e começaram a discutir com Jesus. E, tentando-o, pediram-lhe um sinal vindo do céu.
12 Jesus kon ask dem, “Why pipol for dis world naw dey ask for sign? Make I tell una true word, dem nor go get any sign.”
12 Jesus, porém, arrancou do íntimo do seu espírito um gemido e disse:
13 Den e kon leave dem enter boat go di oda side.
13 E, deixando-os, tornou a embarcar e foi para o outro lado.
14 Jesus disciples forget to take bread join di ones wey dey with dem inside di boat.
14 Ora, os discípulos se esqueceram de levar pão e, no barco, não tinham consigo senão um só.
15 Jesus kon tell dem, “Make una shine una eye, so dat una go guide unasef against di Farisee pipol and Herod yist!”
15 Jesus os preveniu, dizendo:
16 So, dem kon dey tok to each oda about di bread wey dem nor take follow body.
16 E eles começaram a discutir entre si, dizendo: — Ele diz isso porque não temos pão.
17 Wen Jesus know wetin dem dey tok, e kon tell dem, “Why una dey tok about bread wey una nor take? Una nor dey si or undastand? Na so una foolish rish?
17 Jesus percebeu isso e perguntou:
18 Una get eye, but una nor fit take am si? Una get ear, but una nor fit take am hear? Una nor dey remember anytin at-all?
18 Tendo olhos, não veem? E, tendo ouvidos, não ouvem? Não se lembram
19 Wen I divide five bread for 5,000 pipol, how many basket una gada wen di pipol don chop finish?”
19 de quando parti os cinco pães para os cinco mil, quantos cestos cheios de pedaços vocês recolheram? Eles responderam: — Doze!
20 “Den, wen I divide seven bread for 4,000 pipol, how many basket una gada wen di pipol don chop finish?”
20 — E de quando parti os sete pães para os quatro mil, quantos cestos cheios de pedaços vocês recolheram? Responderam: — Sete!
21 Den Jesus tell dem, “Una neva still undastand?”
21 Ao que Jesus lhes disse:
22 Wen dem rish Betsaida, dem bring one man wey nor dey si kom meet Jesus make e tosh am.
22 Então chegaram a Betsaida. E lhe trouxeram um cego e pediram a Jesus que tocasse nele.
23 E hold di man for hand kon take am go outside di village. Jesus spit for di man eye kon tosh am, den ask am, “Yu dey si anytin?”
23 Jesus, tomando o cego pela mão, levou-o para fora da aldeia. Então cuspiu nos olhos do homem e, impondo-lhe as mãos, perguntou:
24 Di man look up kon sey, “Yes, I dey si pipol, but dem bi like tree wey dey waka about.”
24 O homem, recuperando a visão, respondeu: — Vejo pessoas, mas elas parecem árvores que andam.
25 Jesus tosh di man eye again. Di man eye kon open and e kon dey si well-well.
25 Então Jesus novamente pôs as mãos sobre os olhos dele. E o homem, passando a ver claramente, ficou restabelecido; e distinguia tudo de modo perfeito.
26 E kon tell di man make e dey go en house, but e warn am sey, “Make yu nor go inside di village again.”
26 E Jesus o mandou para casa, recomendando-lhe:
27 Jesus and en disciples kon go di village dem wey dey Caesaria Filippi. As dem dey go for road, e kon ask en disciples, “Na who pipol dey sey I bi sef?”
27 Então Jesus e os seus discípulos foram para as aldeias de Cesareia de Filipe. No caminho, perguntou-lhes:
28 Dem ansa, “Some sey yu bi John di Baptist, odas sey, yu bi Elijah and some still sey, yu bi one for di profets.”
28 Os discípulos responderam: — Uns dizem que é João Batista; outros dizem que é Elias; e ainda outros dizem que é um dos profetas.
29 Jesus ask dem again, “But who una sey I bi?”
29 Então Jesus perguntou: Respondendo, Pedro lhe disse: — O senhor é o Cristo.
30 Den e warn dem make dem nor tell anybody who e bi.
30 Então Jesus os advertiu de que a ninguém dissessem tal coisa a seu respeito.
31 Den Jesus bigin tish dem sey, “Man Pikin must sofa many tins, bikos di eldas, di priest oga dem and di law tishas go kill-am and afta three days, e go wake-up from deat.”
31 Então Jesus começou a ensinar-lhes que era necessário que o Filho do Homem sofresse muitas coisas, fosse rejeitado pelos anciãos, pelos principais sacerdotes e pelos escribas, fosse morto e que, depois de três dias, ressuscitasse.
32 As e nor hide dis tins from dem, Pita koll am go korna kon tell am, “Wetin yu dey tok so nor good o-o.”
32 E isto ele expunha claramente. Então Pedro, chamando-o à parte, começou a repreendê-lo.
33 But Jesus turn look en disciples kon shaut for Pita, “Satan! Make yu go my back, bikos yu nor put yor mind for wetin God wont. Na wetin human being wont, na der yor mind dey.”
33 Mas Jesus, voltando-se e vendo os seus discípulos, repreendeu Pedro e disse:
34 Den Jesus koll di pipol with en disciples kon tell dem, “If anybody one follow mi, e must deny ensef, karry en cross, den kon follow mi.
34 Então, convocando a multidão e juntamente os seus discípulos, Jesus lhes disse:
35 Bikos anybody wey won save en life, go luz am and anybody wey luz en life bikos of mi and dis gospel, go save am.
35 Pois quem quiser salvar a sua vida a perderá; e quem perder a vida por minha causa e por causa do evangelho, esse a salvará.
36 Wetin pesin go gain if e get di whole world and e luz en soul?
36 De que adianta uma pessoa ganhar o mundo inteiro e perder a sua alma?
37 Wetin pesin fit use take eschnage for en life?
37 Que daria uma pessoa em troca de sua alma?
38 If anybody shame for mi and wetin I dey tish for dis world wey wiked and ashawo pipol dey, Man Pikin go shame for am too, wen e go kom back for en Papa and en holy angels glory.”
38 Pois quem, nesta geração adúltera e pecadora, se envergonhar de mim e das minhas palavras, também o Filho do Homem se envergonhará dele, quando vier na glória do seu Pai com os santos anjos.
Atalhos do teclado
- Capítulo anterior←
- Próximo capítulo→
- Versículo anteriork
- Próximo versículoj
- Limpar seleçãoEsc
- Esta ajuda?
Estude este capítulo no WhatsApp
Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Marcos 8, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.