Marcos 6

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Jesus kon komot for dat place go en house town with en disciples.
1 Tendo saído dali, Jesus foi para a sua terra, e os seus discípulos o acompanharam.
2 Wen Sabat Day rish, e kon start to tish for di sinagog.
2 Chegando o sábado, começou a ensinar na sinagoga, e muitos, ouvindo-o, se maravilhavam, dizendo: — De onde lhe vem tudo isso? Que sabedoria é esta que lhe foi dada? E como se fazem tais maravilhas por suas mãos?
3 Nor bi di karpenter, wey Mary born bi dis? Nor bi en brodas bi James, Josef, Judas and Simon? Nor bi en sistas dey with us so?” So dem kon dey vex for am.
3 Não é este o carpinteiro, o filho de Maria e irmão de Tiago, José, Judas e Simão? As suas irmãs não vivem aqui entre nós? E escandalizavam-se por causa dele.
4 Den Jesus tell dem, “Na only for profet town, among en own pipol and for en own family na-im di profet nor dey get respet.”
4 Jesus, porém, lhes disse:
5 Jesus nor fit do any mirakle for der, so e only tosh some pipol wey nor well kon heal dem.
5 Não pôde fazer ali nenhum milagre, a não ser curar uns poucos doentes, impondo-lhes as mãos.
6 Jesus sopraiz, bikos dem nor bilive am. So e komot from der go oda village wey near der kon tish dem.
6 E admirava-se da incredulidade deles. Jesus percorria as aldeias vizinhas, ensinando.
7 Jesus koll di twelf disciples kon send dem two-by-two. E give dem pawa to drive evil spirits komot from pipol body.
7 Chamou os doze e passou a enviá-los de dois em dois, dando-lhes autoridade sobre os espíritos imundos.
8 E tell dem make dem only take dia walkin stik for di journey. E sey make dem nor karry bread, bag or money follow body.
8 Ordenou-lhes que não levassem nada para o caminho, exceto um bordão; nem pão, nem sacola, nem dinheiro;
9 E still sey, “Una fit wear shoe, but make una nor karry estra klot
9 e que fossem calçados de sandálias e não usassem duas túnicas.
10 and any house wey una enter, make una stay der until una komot for di place.
10 E recomendou-lhes:
11 If dem nor welkom una or listin to wetin una dey tok for any place, make una shake di san komot from una leg as una dey leave der, to show sey dem rijet di message.”
11 Se em algum lugar não quiserem recebê-los nem ouvi-los, ao saírem dali sacudam o pó dos pés, em testemunho contra eles.
12 So, di disciples go out kon prish sey make evribody turn from sin kom meet God.
12 Então, saindo eles, pregavam ao povo que se arrependesse.
13 Dem drive many demon komot from pipol body and pour oil for many pipol wey nor well head kon heal dem.
13 Expulsavam muitos demônios e curavam numerosos enfermos, ungindo-os com óleo.
14 King Herod kon hear wetin dey happen, bikos pipol don know Jesus name well-well. Some pipol sey, “John wey dey baptize don wake-up from deat and bikos of dis, e don get pawa to do mirakles.”
14 Isto chegou aos ouvidos do rei Herodes, porque o nome de Jesus havia se tornado conhecido. E alguns diziam: “João Batista ressuscitou dentre os mortos e, por isso, forças miraculosas operam nele.”
15 Odas sey, “Na Elijah e bi.”
15 Outros diziam: “É Elias.” Ainda outros diziam: “É profeta como um dos antigos profetas.”
16 But wen Herod hear am, e sey, “John wey I sey make dem kut en head komot, don wake-up from deat!”
16 Herodes, porém, ouvindo isto, disse: — É João, a quem eu mandei decapitar, que ressuscitou.
17 Na Herod send men go arrest John put for prison, bikos of Herodias, en broda Filip wife wey e marry.
17 Porque o próprio Herodes havia mandado prender João e amarrá-lo na prisão, por causa de Herodias, mulher do seu irmão Filipe, com a qual Herodes havia casado.
18 Bikos John don tell Herod plenty times sey, “E nor good as yu marry yor broda wife.”
18 Pois João lhe dizia: “Você não tem o direito de viver com a mulher do seu irmão.”
19 So Herodias kon get bad belle for John and e won kill-am, but e nor fit.
19 Herodias odiava João Batista e queria matá-lo, mas não conseguia fazer isso.
20 Herod dey fear John well-well, so e dey protet am, bikos e know sey John na holy man wey dey do wetin God like. Anytime Herod hear John dey prish, en mind go dey worry am, but e still dey like to listin to am.
20 Porque Herodes temia João, sabendo que era homem justo e santo, e o mantinha em segurança. E, quando o ouvia, ficava perplexo, embora gostasse de escutá-lo.
21 But one day wen Herod dey do en birtday, en ofisas, en sojas oga dem and di leaders for Galilee, dey der with am.
21 Chegando uma ocasião favorável, em que Herodes, no dia do seu aniversário, deu um banquete às autoridades, aos oficiais militares e às pessoas importantes da Galileia,
22 Wen Herodias dota kom dance, Herod and di pipol wey e invite kon dey happy well-well.
22 a filha de Herodias entrou no salão e, dançando, agradou a Herodes e aos seus convidados. Então o rei disse à jovem: — Peça o que quiser, e eu lhe darei.
23 Herod kon promise sey, “Anytin wey yu as mi, I go give yu, even if e go rish half of my kingdom.”
23 E fez este juramento: — O que você me pedir eu lhe darei, mesmo que seja a metade do meu reino.
24 So di girl go outside go ask en mama, “Wetin I go ask for?”
24 Ela saiu e foi perguntar à mãe: — O que pedirei? A mãe respondeu: — A cabeça de João Batista.
25 Kwik-kwik e rush go meet di king kon tell am wetin e wont, “I wont John di Baptist head for plate naw.”
25 No mesmo instante, voltando apressadamente para junto do rei, disse: — Quero que, sem demora, o senhor me dê num prato a cabeça de João Batista.
26 Even doh e pain di king well-well, e nor won rijet wetin di girl ask, bikos e don promise for evribody present.
26 O rei ficou muito triste, mas, por causa do juramento e dos que estavam com ele à mesa, não quis negar o pedido da jovem.
27 So di king send di soja wey dey kill criminals, make e go bring John head kom. So di man go inside di prison, go kut John head komot.
27 E, enviando logo o executor, mandou que lhe trouxessem a cabeça de João. Ele foi e o decapitou na prisão,
28 E put di head for plate kon give di girl and di girl go gi-am to en mama.
28 e, trazendo a cabeça num prato, a entregou à jovem, e esta, por sua vez, a entregou à sua mãe.
29 Wen John disciples hear wetin happen, dem kom karry en body go beri.
29 Os discípulos de João, logo que souberam disto, vieram, levaram o corpo dele e o colocaram num túmulo.
30 Den di disciples gada round Jesus kon tell am evritin wey dem don do and tish.
30 Os apóstolos voltaram à presença de Jesus e lhe relataram tudo o que tinham feito e ensinado.
31 Jesus tell dem, “Make una follow mi make wi go rest for sometaim”, (Bikos many pipol dey-kom-dey-go and time nor dey to chop).
31 E ele lhes disse: Isto porque eles não tinham tempo nem para comer, visto serem muitos os que iam e vinham.
32 So only dem kon enter boat go one place where pipol nor dey.
32 Então foram de barco para um lugar deserto, à parte.
33 But many pipol si dem wen dem dey go, so di pipol kon run with leg from all di towns kon first Jesus and en disciples rish di place.
33 Muitos, porém, os viram sair e, reconhecendo-os, correram para lá, a pé, de todas as cidades, e chegaram antes deles.
34 Wen Jesus kom down from di boat, e si plenty pipol and e kon sorry for dem, bikos dem bi like animal wey nor get who dey look afta dem. So e kon tish dem many tins.
34 Ao desembarcar, Jesus viu uma grande multidão e compadeceu-se dela, porque eram como ovelhas que não têm pastor. E começou a ensinar-lhes muitas coisas.
35 Wen day don dey dark, en disciples kom meet am sey, “Dis na place wey pipol nor dey stay and day don dey dark.
35 Como já era bastante tarde, os discípulos se aproximaram de Jesus e disseram: — Este lugar é deserto, e já é bastante tarde.
36 Make yu send dis pipol go buy wetin dem go chop for di town and village wey near here.”
36 Mande essas pessoas embora, para que, indo pelos campos ao redor e pelas aldeias, comprem para si o que comer.
37 But Jesus ansa, “Make una give dem sometin chop.”
37 Jesus, porém, lhes disse: Mas eles disseram: — Iremos comprar duzentos denários de pão para lhes dar de comer?
38 Jesus ask dem, “How many bread una get? Make una go shek.”
38 E Jesus lhes disse: Eles foram se informar e responderam: — Cinco pães e dois peixes.
39 Jesus kon tell di pipol make dem share diasef into group, sidan for grass.
39 Então Jesus lhes ordenou que todos se assentassem, em grupos, sobre a relva verde.
40 So dem sidan for difren-difren group, hundred-hundred, fifty-fifty.
40 E eles o fizeram, repartindo-se em grupos de cem e de cinquenta.
41 Jesus take di five bread and two fish, e look heaven kon tank God, den e divide di bread. E give en disciples make dem share am for di pipol and e kon divide di two fish among dem too.
41 Jesus, pegando os cinco pães e os dois peixes, erguendo os olhos para o céu, os abençoou. Depois partiu os pães e os deu aos seus discípulos para que os distribuíssem. E também repartiu os dois peixes entre todos.
42 All of dem chop beleful
42 Todos comeram e se fartaram,
43 and wen dem gada di fish and bread wey remain, twelf basket full.
43 e ainda recolheram doze cestos cheios de pedaços de pão e de peixe.
44 Di pipol wey chop di bread, rish 5,000 men.
44 Os que comeram os pães eram cinco mil homens.
45 So Jesus tell en disciples make dem enter boat cross go di oda side for Betsaida, den e send di pipol go house.
45 Logo a seguir, Jesus fez com que os seus discípulos entrassem no barco e fossem adiante dele para o outro lado, para Betsaida, enquanto ele despedia a multidão.
46 Afta e don tell dem bye-bye, e kon go pray for one mountin.
46 E, tendo-os despedido, ele subiu ao monte para orar.
47 Wen evening rish, di boat don rish di sea centre, but Jesus still dey alone for land.
47 Ao cair da tarde, o barco estava no meio do mar, e Jesus estava sozinho em terra.
48 E si en disciples dey use all dia pawa dey padol di boat, bikos di breeze strong well-well. As morning won rish, Jesus waka kom meet dem, like sey e won pass dem.
48 De madrugada, vendo que os discípulos remavam com dificuldade, porque o vento lhes era contrário, Jesus foi até onde eles estavam, andando sobre o mar; e queria passar adiante deles.
49 Wen dem si am dey waka on-top di wota, dem tink sey na ghost, so dem kon dey shaut,
49 Eles, porém, vendo-o andar sobre o mar, pensaram tratar-se de um fantasma e gritaram.
50 bikos as dem si am, fear katch dem.
50 Pois todos viram Jesus e ficaram apavorados. Mas Jesus imediatamente falou com eles e disse:
51 Den Jesus enter di boat with dem, den di breeze kon stop. Dem kon sopraiz well-well,
51 Então subiu no barco para estar com eles, e o vento cessou. Ficaram totalmente perplexos,
52 bikos dem konfuse and dem nor undastand how Jesus take feed 5,000 pipol.
52 porque não haviam compreendido o milagre dos pães, pois o coração deles estava endurecido.
53 Afta Jesus and en disciples don cross di river, dem kon rish Gennesaret, den dem tie dia boat for der.
53 Estando já no outro lado, chegaram à terra de Genesaré, onde atracaram.
54 As dem kom down from di boat, pipol kon si sey na Jesus bi dat.
54 Saindo eles do barco, o povo logo reconheceu Jesus.
55 Di pipol run pass all di aria, karry di pipol wey nor well for mat go where dem hear sey Jesus dey.
55 E eles, percorrendo toda aquela região, começaram a trazer em leitos os enfermos e os levavam para onde ouviam que ele estava.
56 Anywhere wey Jesus go, weda na village or town or farm, dem go karry di pipol wey nor well for dia market place kon ask Jesus weda dem go fit tosh en klot and evribody wey tosh am, kon well.
56 Onde quer que ele entrasse, nas aldeias, cidades ou campos, punham os enfermos nas praças, pedindo-lhe que os deixasse tocar ao menos na borda da sua roupa. E todos os que tocavam nela ficavam curados.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Marcos 6, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.