Marcos 4

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NAA

Sair da comparação
NAA Nova Almeida Atualizada 2017
1 Again, Jesus kon bigin tish pipol for di wotaside. Since pipol wey gada round am many, e enter boat dey tish di pipol as dem sidan for groun near di wota.
1 Jesus começou a ensinar outra vez à beira-mar. E uma numerosa multidão se reuniu em volta dele, de modo que entrou num barco, onde se assentou, afastando-se da praia. E todo o povo estava à beira-mar, na praia.
2 E kon tish dem many tins for parabol sey:
2 Assim, ensinava-lhes muitas coisas por parábolas e, durante o seu ensino, dizia:
3 “Make una Listin! One farmer go plant seed for en farm.
3 — Escutem! Eis que o semeador saiu a semear.
4 As e dey plant, some seed fall for road and birds kom chop dem.
4 E, ao semear, uma parte caiu à beira do caminho, e vieram as aves e a comeram.
5 Odas fall for where stones and san dey. Dem kwik grow kom out, bikos good soil nor dey der.
5 Outra parte caiu em solo rochoso, onde a terra era pouca, e logo nasceu, visto não ser profunda a terra.
6 Wen sun kom out, e burn di plant, bikos dem nor get deep rut, dem kon die.
6 Saindo, porém, o sol, a queimou; e, porque não tinha raiz, secou-se.
7 Odas fall for where shuku-shuku dey and wen dem grow kom out, di shuku-shuku, shuk dem die.
7 Outra parte caiu entre os espinhos; e os espinhos cresceram e a sufocaram, e não deu fruto.
8 But odas fall for betta groun. Dem grow well kon bear oda seeds, some bear rish thirty, some sixty and some hundred.”
8 Outra, enfim, caiu em boa terra e deu fruto; a semente brotou, cresceu e produziu a trinta, a sessenta e a cem por um.
9 Jesus kon sey, “Anybody wey get ear, make e hear wetin I dey tok!”
9 E Jesus acrescentou:
10 Wen Jesus dey alone, pipol wey dey with am and en twelf disciples kon ask am about di parabol.
10 Quando Jesus ficou só, os que estavam junto dele com os doze começaram a lhe fazer perguntas a respeito das parábolas.
11 E kon tell dem, “God don show una di kingdom sekret. But doz wey dey outside God Kingdom, na parabol e bi for dem,
11 Jesus disse a eles:
12 so dat,
12 para que, vendo, vejam e não percebam; e, ouvindo, ouçam e não entendam; para que não venham a converter-se e sejam perdoados.
13 Jesus kon ask dem, “Una nor undastand dis parabol? Den how una go take undastand any oda parabol?
13 Então Jesus lhes perguntou:
14 Na God word di farmer dey plant.
14 O semeador semeia a palavra.
15 Some pipol bi like di seed wey fall for road: anytime dem hear God word, Satan go kom tif am from dem kwik-kwik.
15 Estes são os da beira do caminho, onde a palavra é semeada: quando a ouvem, logo Satanás vem e tira a palavra semeada neles.
16 Some bi like di seeds wey fall for where stones and san dey: as dem hear God word, dem go receive am with happiness,
16 E estes são os semeados em solo rochoso, os quais, ouvindo a palavra, logo a recebem com alegria.
17 and bikos dem nor get rut and patient, wen trobol or wahala kom bikos of di word, dem go forget God word.
17 Mas eles não têm raiz em si mesmos, sendo de pouca duração. Quando chega a angústia ou a perseguição por causa da palavra, logo se escandalizam.
18 Odas bi like di seeds wey fall for where shuku-shuku full: dem hear di word,
18 Os outros, os semeados entre os espinhos, são os que ouvem a palavra,
19 but trobol for life, big eye for money and di way dem dey run follow oda tins, go kon block di word and e nor go bear anytin for dia life.
19 mas as preocupações deste mundo, a fascinação da riqueza e outras ambições aparecem e sufocam a palavra, e ela fica infrutífera.
20 But di ones wey fall for betta groun, na doz wey hear di word kon receive am and bear many fruits, some bear rish thirty, some sixty and some hundred.”
20 Os que foram semeados em boa terra são aqueles que ouvem a palavra e a recebem, frutificando a trinta, a sessenta e a cem por um.
21 Jesus still ask dem, “Pipol dey hide lamp for under basket? Nor bi on-top di place where dem dey keep lamp, dem suppose put am?
21 Jesus também lhes disse:
22 E nor get wetin pipol hide wey God nor go show and e nor get wetin dey for sekret naw, wey nor go kom out for open.
22 Porque não há nada oculto, senão para ser manifesto; e nada escondido, senão para ser revelado.
23 If anybody get ear, make e hear wetin I dey tok!”
23 Se alguém tem ouvidos para ouvir, ouça.
24 Jesus kon tell dem, “Make una dey kareful for wetin una dey hear, bikos na wetin yu use take measure give oda pipol, na-im God go take measure for yu too and E go add join am.
24 Então lhes disse:
25 Bikos anybody wey get, God go gi-am more, but anybody wey nor get, even di small one wey e get, God go take am from am.”
25 Pois ao que tem, mais será dado; e, ao que não tem, até o que tem lhe será tirado.
26 Jesus kon sey, “God Kingdom bi like pesin wey skata seed for groun.
26 Jesus disse ainda:
27 Di pesin dey sleep and wake-up day and nite; di seed grow kom out, even doh di man nor know how e take happen.
27 Ele dorme e acorda, de noite e de dia, e a semente germina e cresce, sem que ele saiba como.
28 As plant dey grow from groun, di body go first kom out, den di head go bear fruit and seed go kom out from inside.
28 A terra por si mesma frutifica: primeiro aparece a planta, depois, a espiga, e, por fim, o grão cheio na espiga.
29 Wen e ripe, di farmer go kut am, bikos di time to plok wetin e plant, don rish.”
29 E, quando o fruto já está maduro, logo manda cortar com a foice, porque chegou a colheita.
30 Jesus kon ask dem, “Wetin wi go take kompare God Kingdom? Wish parabol wi go fit use take show as e bi?
30 Disse mais:
31 E bi like mustard seed wey bi di seed wey small pass for di world, wey pesin plant for groun.
31 Ele é como um grão de mostarda, que, quando semeado, é a menor de todas as sementes sobre a terra;
32 Afta dem don plant am, e go grow kon big pass all di oda plants and en branches go big and birds go land kon build dia nest for der.”
32 mas, uma vez semeada, cresce e se torna maior do que todas as hortaliças; cria ramos tão grandes, que as aves do céu podem se aninhar à sua sombra.
33 Na with many parabol like dis one, Jesus take prish God word to dem, so dat dem go fit undastand.
33 E com muitas parábolas semelhantes Jesus lhes expunha a palavra, conforme podiam compreendê-la.
34 E nor get wetin e tell dem wey e nor use parabol. But wen only en and di disciples dey, e dey esplain evritin give dem.
34 E sem parábolas não lhes falava; tudo, porém, explicava em particular aos seus próprios discípulos.
35 Wen evening rish dat day, Jesus kon tell en disciples, “Make wi cross go di oda side for di river.”
35 Naquele dia, sendo já tarde, Jesus disse aos discípulos:
36 So afta dem leave di pipol, dem enter di boat wey Jesus sidan and oda boat still dey der with dem.
36 E eles, despedindo a multidão, o levaram assim como estava, no barco; e outros barcos o seguiam.
37 Den, strong breeze kon dey blow and wota dey enter di boat, so di boat kon dey won sink.
37 Ora, levantou-se grande temporal de vento, e as ondas se arremessavam contra o barco, de modo que o mesmo já estava se enchendo de água.
38 But Jesus put en head for pillow dey sleep inside di boat. Den, dem koll am dey sey, “Tisha, yu nor even kare sey wi won die?”
38 E Jesus estava na popa, dormindo sobre o travesseiro. Os discípulos o acordaram e lhe disseram: — Mestre, o senhor não se importa que pereçamos?
39 So Jesus get up kon kommand di breeze, den e tell di river, “Make yu kwayet!” Di breeze stop and evriwhere kon kwayet at wons.
39 E ele, despertando, repreendeu o vento e disse ao mar: O vento se aquietou, e tudo ficou bem calmo.
40 Den Jesus tell dem, “Why una dey fear? Una still nor get faith?”
40 Então Jesus lhes perguntou:
41 Fear katch dem well-well and dem kon dey ask each oda, “Who dis man bi sef? Even breeze and river dey obey am!”
41 E eles, possuídos de grande temor, diziam uns aos outros: — Quem é este que até o vento e o mar lhe obedecem?

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Marcos 4, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.