Marcos 14

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Two days before Passova and di Bread wey nor get yist Feast, di priest oga dem and di law tishas kon dey find as dem go take arrest Jesus, make dem for kill-am.
1 Ora, dali a dois dias seria a festa da Páscoa e dos {pães} Ázimos; e os sumos sacerdotes e os escribas buscavam algum meio de prender Jesus à traição para matá-lo.
2 Dem sey, “Make wi nor do am naw wen dem dey do di Feast, so dat pipol nor go rayot.”
2 Mas não durante a festa, diziam eles, para não haver talvez algum tumulto entre o povo.
3 Wen Jesus dey Betany for Simon house (wey get leprosy before), e sidan with dem to chop, naim one woman bring oil inside alabasta box kom, di oil dear well-well and dey send fine. Afta e don open di kontaina, e pour di oil for Jesus head.
3 Jesus se achava em Betânia, em casa de Simão, o leproso. Quando ele se pôs à mesa, entrou uma mulher trazendo um vaso de alabastro cheio de um perfume de nardo puro, de grande preço, e, quebrando o vaso, derramou-lho sobre a cabeça.
4 But some pipol wey dey der kon dey vex, dey tell each oda, “Why dis woman dey waste oil wey dear well-well like dis?
4 Alguns, porém, ficaram indignados e disseram entre si: Por que este desperdício de bálsamo?
5 Dem for sell am pass three hundred silva koins and give di money to poor pipol!” So, dem kon vex dey tok to di woman anyhow.
5 Poder-se-ia tê-lo vendido por mais de trezentos denários, e os dar aos pobres. E irritavam-se contra ela.
6 But Jesus ansa dem, “Make una leave di woman alone. Why una dey wori-am? Na good tin e do for mi so o-o!
6 Mas Jesus disse-lhes: Deixai-a. Por que a molestais? Ela me fez uma boa obra.
7 Poor pipol go always dey with una and una go fit do good for dem anytime una like. But mi, I nor go dey with una always!
7 Vós sempre tendes convosco os pobres e, quando quiserdes, podeis fazer-lhes bem; mas a mim não me tendes sempre.
8 Dis woman don do wetin e fit do. E anoint my body to prepare mi for beri before di time go rish.
8 Ela fez o que pode: embalsamou-me antecipadamente o corpo para a sepultura.
9 I tell una true word, anywhere wey dem go prish dis gospel for di whole world, pipol go tok about dis tin wey dis woman don do so.”
9 Em verdade vos digo: onde quer que for pregado em todo o mundo o Evangelho, será contado para sua memória o que ela fez.
10 Den Judas Iskariot, wey dey among Jesus disciples, kon go meet di priest oga dem sey e won sell Jesus give dem.
10 Judas Iscariotes, um dos Doze, foi avistar-se com os sumos sacerdotes para lhes entregar Jesus.
11 Wen dem hear am, dem happy well-well kon promise am money. So, Judas kon bigin find how e go fit take sell Jesus give dem.Mary pour oil for Jesus leg|alt="Mary anointing the feet of Jesus with oil" src="WA03839b.tif" size="col" loc="MRK 14:3-11" copy="Wade" ref="14:3-11"
11 A esta notícia, eles alegraram-se e prometeram dar-lhe dinheiro. E ele buscava ocasião oportuna para o entregar.
12 Di day wen dem start di Bread wey nor get yist feast and wey dem dey sakrifice small sheep, Jesus disciples kon ask am, “Where yu wont make wi prepare for yu to chop Passova food?”
12 No primeiro dia dos Ázimos, em que se imolava a Páscoa, perguntaram-lhe os discípulos: Onde queres que preparemos a refeição da Páscoa?
13 Jesus send two disciples go for front kon tell dem, “Wen una enter di town, una go si one man wey karry wota kontaina. Make una follow am.
13 Ele enviou dois dos seus discípulos, dizendo: Ide à cidade, e sair-vos-á ao encontro um homem, carregando um cântaro de água.
14 Di house wey e go enter, make una tell di pesin wey get am sey, ‘Di Tisha sey make wi ask, “Where di room wey mi and my disciples go for chop Passova food?” ’
14 Segui-o e, onde ele entrar, dizei ao dono da casa: O Mestre pergunta: Onde está a sala em que devo comer a Páscoa com os meus discípulos?
15 E go show una one big room for upstair where tabol and chairs dey. Make una prepare evritin for der.”
15 E ele vos mostrará uma grande sala no andar superior, mobiliada e pronta. Fazei ali os preparativos.
16 So en disciples go di town and dem si evritin just as Jesus tell dem sey e go bi, dem kon prepare di Passova food for der.
16 Partiram os discípulos para a cidade e acharam tudo como Jesus lhes havia dito, e prepararam a Páscoa.
17 Wen evening rish, Jesus kon go di house with en twelf disciples.
17 Chegando a tarde, dirigiu-se ele para lá com os Doze.
18 As dem dey chop for di tabol, Jesus kon sey, “I tell una true word, one of una wey dey chop with mi, go sell mi give my enemies.”
18 E enquanto estavam sentados à mesa e comiam, Jesus disse: Em verdade vos digo: um de vós que come comigo me há de entregar.
19 Wetin Jesus tok kon dey worry di disciples for mind, so dem kon dey ask am one-by-one, “Oga God! Na mi?”
19 Começaram a entristecer-se e a perguntar-lhe, um após outro: Porventura sou eu?
20 Jesus ansa, “Na one of una wey dey follow mi chop for di same plate.
20 Respondeu-lhes ele: É um dos Doze, que se serve comigo do mesmo prato.
21 Man Pikin go die as dem rite for God word about am, but curse dey di pesin head wey go sell am. E for betta sey dem nor born dat pesin at-all.”
21 O Filho do homem vai, segundo o que dele está escrito, mas ai daquele homem por quem o Filho do homem for traído! Melhor lhe seria que nunca tivesse nascido...
22 As dem dey chop, Jesus take bread, tank God, den divide am give en disciples kon sey, “Make una take and chop, bikos dis na my body.”
22 Durante a refeição, Jesus tomou o pão e, depois de o benzer, partiu-o e deu-lho, dizendo: Tomai, isto é o meu corpo.
23 Afta, e take cup, tank God, den e give en disciples and all of dem, drink from inside.
23 Em seguida, tomou o cálice, deu graças e apresentou-lho, e todos dele beberam.
24 E kon tell dem, “Dis na my blood, di kovenant blood wey I pour for evribody.
24 E disse-lhes: Isto é o meu sangue, o sangue da aliança, que é derramado por muitos.
25 I tell una true word, I nor go drink wine again, until di day wen I go drink di new wine for God Kingdom.”
25 Em verdade vos digo: já não beberei do fruto da videira, até aquele dia em que o beberei de novo no Reino de Deus.
26 Afta dem don sing one hymn, dem kon enter inside Mount Olives.
26 Terminado o canto dos Salmos, saíram para o monte das Oliveiras.
27 Jesus kon tell en disciples, “Una go run leave mi, bikos God word sey,
27 E Jesus disse-lhes: Vós todos vos escandalizareis, pois está escrito: Ferirei o pastor, e as ovelhas serão dispersas {Zac 13,7}.
28 But afta God don wake mi up from deat, I go-go una front, go wait una for Galilee.”
28 Mas depois que eu ressurgir, eu vos precederei na Galiléia.
29 Pita kon sey, “Even if odas run leave yu, I nor go run leave yu o-o!”
29 Entretanto, Pedro lhe respondeu: Ainda que todos se escandalizem de ti, eu, porém, nunca!
30 Jesus ansa am, “I tell yu di trut, today, for dis nite, before fawol go do ‘Kukuruku’ two times, yu go don deny mi three times.”
30 Jesus disse-lhe: Em verdade te digo: hoje, nesta mesma noite, antes que o galo cante duas vezes, três vezes me terás negado.
31 But Pita still sey, “Even if I go die with yu, I nor go ever deny yu.” All of dem still tok di same tin.
31 Mas Pedro repetia com maior ardor: Ainda que seja preciso morrer contigo, não te renegarei.E todos disseram o mesmo.
32 Jesus and en disciples kon go one place wey dem dey koll Getsemani and Jesus tell dem, “Make una sidan for here, bikos I won go pray.”
32 Foram em seguida para o lugar chamado Getsêmani, e Jesus disse a seus discípulos: Sentai-vos aqui, enquanto vou orar.
33 E take Pita, James and John follow body. E mind kon dey trobol am and e nor dey happy.
33 Levou consigo Pedro, Tiago e João; e começou a ter pavor e a angustiar-se.
34 E kon tell dem, “My heart dey heavy well-well like sey I won die. So, make una stay here dey wosh.”
34 Disse-lhes: A minha alma está numa tristeza mortal; ficai aqui e vigiai.
35 E waka go front small kon fall face groun, bigin pray, “Papa! If yu wont, make yu let dis sofa pass mi.”
35 Adiantando-se alguns passos, prostrou-se com a face por terra e orava que, se fosse possível, passasse dele aquela hora.
36 Jesus kon pray, “My Papa, e nor get wetin yu nor fit do. Make yu take dis sofa cup from mi. But nor bi as I wont am, but na as yu wont.”
36 Aba! {Pai!}, suplicava ele. Tudo te é possível; afasta de mim este cálice! Contudo, não se faça o que eu quero, senão o que tu queres.
37 Wen Jesus kom back, e meet en disciples dey sleep, so e tell Pita, “Simon, yu dey sleep? Yu nor fit stay make yu nor sleep for one hour?
37 Em seguida, foi ter com seus discípulos e achou-os dormindo. Disse a Pedro: Simão, dormes? Não pudeste vigiar uma hora!
38 Make yu nor sleep, but dey pray make yu nor for fall enter temptashon. Man spirit won pray, but en body dey weak.”
38 Vigiai e orai, para que não entreis em tentação. Pois o espírito está pronto, mas a carne é fraca.
39 E komot again, go pray as e pray before.
39 Afastou-se outra vez e orou, dizendo as mesmas palavras.
40 Wen e kom back again, e si sey dem still dey sleep; dem nor dey pray, so dem nor know wetin to tell am.
40 Voltando, achou-os de novo dormindo, porque seus olhos estavam pesados; e não sabiam o que lhe responder.
41 E kom di third time kon ask dem, “Una still dey sleep? Di sleep don do, bikos time don rish! Make una si, dem don sell Man Pikin give sinnas.
41 Voltando pela terceira vez, disse-lhes: Dormi e descansai. Basta! Veio a hora! O Filho do homem vai ser entregue nas mãos dos pecadores.
42 Make una get up make wi dey go. Si, di pesin wey won sell mi, dey kom!”
42 Levantai-vos e vamos! Aproxima-se o que me há de entregar.
43 As Jesus still dey tok, Judas, one of di twelf disciples kon kom with plenty pipol wey di priest oga dem, di law tishas and di eldas send and all of dem karry swod and big-big stik.
43 Ainda falava, quando chegou Judas Iscariotes, um dos Doze, e com ele um bando armado de espadas e cacetes, enviado pelos sumos sacerdotes, escribas e anciãos.
44 (By dis time, di man wey won sell Jesus don give dem sign sey, “Di pesin wey I go kiss, naim bi di man. Make una arrest and hold am well-well.”)
44 Ora, o traidor tinha-lhes dado o seguinte sinal: Aquele a quem eu beijar é ele. Prendei-o e levai-o com cuidado.
45 Wen Judas kom, e go meet Jesus kon sey, “Tisha!” Den e kiss am.
45 Assim que ele se aproximou de Jesus, disse: Rabi!, e o beijou.
46 So, di pipol kon seize and arrest Jesus.
46 Lançaram-lhe as mãos e o prenderam.
47 One pesin wey stand for der kon take en swod kut di High Priest savant ear komot.
47 Um dos circunstantes tirou da espada, feriu o servo do sumo sacerdote e decepou-lhe a orelha.
48 Jesus kon tell dem, “Na mi una karry swod and big-big stik kom arrest like sey I bi tif?
48 Mas Jesus tomou a palavra e disse-lhes: Como a um bandido, saístes com espadas e cacetes para prender-me!
49 I dey with una evriday for di temple dey tish, but una nor arrest mi den.” Dis tin happen so dat wetin dem rite for God word, go bi true.
49 Entretanto, todos os dias estava convosco, ensinando no templo, e não me prendestes. Mas isso acontece para que se cumpram as Escrituras.
50 Den all en disciples kon run leave am.
50 Então todos o abandonaram e fugiram.
51 One yong man wey tie small klot for waist, dey follow Jesus. So dem won kon arrest di man join,
51 Seguia-o um jovem coberto somente de um pano de linho; e prenderam-no.
52 but e kon run komot with nakednes and leave en klot for der.
52 Mas, lançando ele de si o pano de linho, escapou-lhes despido.
53 Den, dem take Jesus go meet di High Priest, so all di priest oga dem, di eldas and di law tishas kon gada.
53 Conduziram Jesus à casa do sumo sacerdote, onde se reuniram todos os sacerdotes, escribas e anciãos.
54 Pita follow Jesus from far till e rish di High Priest varanda. E sidan with di guards dey warm en body near fire.
54 Pedro o foi seguindo de longe até dentro do pátio. Sentou-se junto do fogo com os servos e aquecia-se.
55 Di priest oga dem and di Sanhedrin dey find wetin dem go take akuiz Jesus, so dat dem go fit kill-am, but dem nor si anytin.
55 Os sumos sacerdotes e todo o conselho buscavam algum testemunho contra Jesus, para o condenar à morte, mas não o achavam.
56 Many pipol lie for Jesus head and dem dey tok difren-difren tins, but dia story nor gri with each oda.
56 Muitos diziam falsos testemunhos contra ele, mas seus depoimentos não concordavam.
57 Some pipol stand up kon lie against am sey,
57 Levantaram-se, então, alguns e deram esse falso testemunho contra ele:
58 “Wi hear wen e sey, ‘I go distroy dis Temple wey dem build with hand and afta three days, I go build anoda one wey dem nor use hand build.’ ”
58 Ouvimo-lo dizer: Eu destruirei este templo, feito por mãos de homens, e em três dias edificarei outro, que não será feito por mãos de homens.
59 All dia story nor dey good, bikos dem nor gri with each oda.
59 Mas nem neste ponto eram coerentes os seus testemunhos.
60 Den di High Priest stand for dia front kon ask Jesus, “Yu nor get ansa? Wetin bi dis wey dem dey tok against yu so?”
60 O sumo sacerdote levantou-se no meio da assembléia e perguntou a Jesus: Não respondes nada? O que é isto que dizem contra ti?
61 But Jesus kwayet and e nor ansa dem.
61 Mas Jesus se calava e nada respondia. O sumo sacerdote tornou a perguntar-lhe: És tu o Cristo, o Filho de Deus bendito?
62 Jesus ansa, “Na mi and yu go si Man Pikin sidan for God rite hand, wen e dey kom inside di kloud from heaven.”
62 Jesus respondeu: Eu o sou. E vereis o Filho do Homem sentado à direita do poder de Deus, vindo sobre as nuvens do céu.
63 Den di High Priest tear en own klot kon sey, “Why wi dey find more pipol to tok for dis matter?
63 O sumo sacerdote rasgou então as suas vestes. Para que desejamos ainda testemunhas?!, exclamou ele.
64 Una don hear di word wey e tok against God! Wetin una tink sey make wi do am?”
64 Ouvistes a blasfêmia! Que vos parece? E unanimemente o julgaram merecedor da morte.
65 Den some bigin spit for Jesus body, dem tie en eye kon dey nak am dey sey, “Profesai naw!” Di pipol wey dey guide di place still join beat am.
65 Alguns começaram a cuspir nele, a tapar-lhe o rosto, a dar-lhe socos e a dizer-lhe: Adivinha! Os servos igualmente davam-lhe bofetadas.
66 For dis time, Pita dey for di varanda, den di High Priest girl savant kom der.
66 Estando Pedro embaixo, no pátio, veio uma das criadas do sumo sacerdote.
67 Wen e si Pita sidan dey warm ensef, e look am well-well kon sey, “Yorsef dey follow dat man wey kom from Nazaret, wey dem dey koll Jesus Christ.”
67 Ela fixou os olhos em Pedro, que se aquecia, e disse: Também tu estavas com Jesus de Nazaré.
68 But Pita deny kon sey, “I nor even know wetin yu dey tok about!” Den e waka go di gate and fawol kon do, “Kukuruku!”
68 Ele negou: Não sei, nem compreendo o que dizes. E saiu para a entrada do pátio; e o galo cantou.
69 Wen di savant girl si am, e kon dey tell di pipol wey stand der sey, “Dis man dey among dem.”
69 A criada, que o vira, começou a dizer aos circunstantes: Este faz parte do grupo deles.
70 But e deny again.
70 Mas Pedro negou outra vez. Pouco depois, os que ali estavam diziam de novo a Pedro: Certamente tu és daqueles, pois és galileu.
71 Pita kon bigin curse and swear sey. “I nor know dis man wey una dey tok about so o-o!”
71 Então ele começou a praguejar e a jurar: Não conheço esse homem de quem falais.
72 At wons, fawol kon do, “Kukuruku!” di sekond time. So Pita kon remember wetin Jesus tell am: “Before fawol go do ‘Kukuruku!’ two times, yu go deny mi three times.” Den Pita kon bigin kry well-well.
72 E imediatamente cantou o galo pela segunda vez. Pedro lembrou-se da palavra que Jesus lhe havia dito: Antes que o galo cante duas vezes, três vezes me negarás. E, lembrando-se disso, rompeu em soluços.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Marcos 14, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.