Levítico 24

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs NVI

Sair da comparação
NVI Nova Versão Internacional
1 God tell Moses:
1 Disse o Senhor a Moisés:
2 “Make yu kommand Israel pipol make dem bring pure olive oil wey fine well-well kom put for di lamp wey dey di tent, so dat lite go dey di temple.
2 "Ordene aos israelitas que lhe tragam azeite puro de oliva batida para as lâmpadas, para que fiquem sempre acesas.
3 For evening, Aaron go lite am till morning for God present outside di curtain for di Kovenant Box front wey dey for di holy place. Dis law go dey forever.
3 Na Tenda do Encontro, do lado de fora do véu que esconde as tábuas da aliança, Arão manterá as lâmpadas continuamente acesas diante do Senhor, desde o entardecer até a manhã seguinte. Este é um decreto perpétuo para as suas gerações.
4 Aaron go kare for di lamp wey dey di lampstand and e go always dey arrange am for God present.
4 Mantenha sempre em ordem as lâmpadas no candelabro de ouro puro perante o Senhor.
5 “Una must take twelf kilogram of flower kon bake twelf bread,
5 "Apanhe da melhor farinha e asse doze pães, usando dois jarros para cada pão.
6 una go put di bread for two row, six-six for one row on-top di tabol wey dem kover with gold, wey dey God present.
6 Coloque-os em duas fileiras, com seis pães em cada uma, sobre a mesa de ouro puro perante o Senhor.
7 Una must put pure incense for each row to dey remember di bread and e go bi gift ofrin to God.
7 Junto a cada fileira coloque um pouco de incenso puro como porção memorial para representar o pão e ser uma oferta ao Senhor preparada no fogo.
8 For each Sabat Day, Aaron go always dey arrange am before God; dis na Israel pipol work forever.
8 Esses pães serão colocados regularmente perante o Senhor, cada sábado, em nome dos israelitas, como aliança perpétua.
9 Na Aaron and en sons get di bread and dem go chop am for di holy aria, bikos na holy food wey dem offa to God.”
9 Pertencem a Arão e a seus descendentes, que os comerão num lugar sagrado, porque é parte santíssima de sua porção regular das ofertas dedicadas ao Senhor, preparadas no fogo. É decreto perpétuo".
10 E get one man, en papa kom from Egypt and en mama name na Shelomit wey Dibri from Dan tribe for Israel, born. For di kamp, di man kon dey kworel with one Israel man.
10 Aconteceu que o filho de uma israelita e de um egípcio saiu e foi para o meio dos israelitas. No acampamento houve uma briga entre ele e um israelita.
11 As dem dey fight, di Israel woman pikin kon curse God name, so dem take dem go meet Moses. (En mama name na Shelomit wey bi Dibri pikin from Dan tribe.)
11 O filho da israelita blasfemou o Nome com uma maldição; então o levaram a Moisés. O nome de sua mãe era Selomite, filha de Dibri, da tribo de Dã.
12 Dem put am for prison dey wait for God to tell dem wetin dem go do.
12 Deixaram-no preso até que a vontade do Senhor lhes fosse declarada.
13 Den God tell Moses:
13 Então o Senhor disse a Moisés:
14 “Make yu bring di man wey curse mi kom out from di kamp, anybody wey hear am dey curse go put dia hand for en head to bear witness against am sey e dey guilty and evribody for Israel go stone am till e die.
14 "Leve o que blasfemou para fora do acampamento. Todos aqueles que o ouviram colocarão as mãos sobre a cabeça dele, e a comunidade toda o apedrejará.
15 Make yu tell Israel pipol sey anybody wey curse God, go sofa di ponishment for en sin
15 Diga aos israelitas: Se alguém amaldiçoar seu Deus, será responsável pelo seu pecado;
16 and pesin wey use God name anyhow, must die. Israel pipol go stone am weda na strenja e bi or not; anybody wey use God name anyhow, go must die.
16 quem blasfemar o nome do Senhor terá que ser executado. A comunidade toda o apedrejará. Seja estrangeiro, seja natural da terra, se blasfemar o Nome, terá que ser morto.
17 If pesin beat pesin die, dem must kill dat pesin too.
17 "Se alguém ferir uma pessoa a ponto de matá-la, terá que ser executado.
18 If pesin beat animal die, di pesin must give anoda animal to di pesin wey en animal don die, bikos di law sey, ‘Una go give life-for-life.’
18 Quem matar um animal fará restituição: vida por vida.
19 If pesin wound en neighbour wey bi Israel pesin; just as e do am, na so dem go do am back!
19 Se alguém ferir seu próximo, deixando-o defeituoso, assim como fez lhe será feito:
20 If e break en neighbour bone, dem go break en bone too; if e blind pesin eye, dem go blind en own too; if e remove pesin tit, dem go remove en own too. Anytin wey pesin do en neighbour, dem go do am back.
20 fratura por fratura, olho por olho, dente por dente. Assim como feriu o outro, deixando-o defeituoso, assim também será ferido.
21 Pesin wey kill any animal, go replace am. But pesin wey kill pesin, go die too.
21 Quem matar um animal fará restituição, mas quem matar um homem será morto.
22 Dis law na for all of una, weda yu bi Israel pesin or strenja. Na mi bi di Oga una God.”
22 Vocês terão a mesma lei para o estrangeiro e para o natural. Eu sou o Senhor, o Deus de vocês".
23 Wen Moses don tell Israel pipol evritin finish, dem take di man go outside di kamp kon stone am die. Like dis, Israel pipol kon do as God kommand Moses.
23 Depois que Moisés falou aos israelitas, levaram o que blasfemou para fora do acampamento e o apedrejaram. Os israelitas fizeram conforme o Senhor tinha ordenado a Moisés.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Levítico 24, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.