Levítico 19

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs BKJ

Sair da comparação
1 God tell Moses:
1 E o SENHOR falou a Moisés, dizendo:
2 “Make yu tell Israel pipol sey, ‘Una must dey holy, bikos mi wey bi Oga una God, dey holy.
2 Fala a toda a congregação dos filhos de Israel, e dize-lhes: Sereis santos; porque eu o SENHOR vosso Deus sou santo.
3 Each of una must respet en papa and mama and una must keep my laws. Na mi bi Oga una God.
3 Cada homem temerá a sua mãe e a seu pai, e guardará os meus shabats. Eu sou o SENHOR vosso Deus.
4 Make una nor woship juju or make juju with iron. Na mi bi di Oga una God.
4 Não vos volteis a ídolos, nem façais para vós deuses fundidos. Eu sou o SENHOR vosso Deus.
5 “ ‘Wen una won give una peace ofrin to God, una must sakrifice am well, so dat I go asept am.
5 E se oferecerdes sacrifício de oferta de paz ao SENHOR, o oferecerás da vossa própria vontade.
6 Una must chop am for di day wey una sakrifice am or di next day, but una go burn di ones wey remain with fire for di third day,
6 Se comerá no mesmo dia em que o oferecerdes e no dia seguinte; e se restar até o terceiro dia, será queimado no fogo.
7 bikos e don dey unklean. If anybody chop am, I nor go asept di ofrin.
7 E se for comido ao terceiro dia, isto será abominável, não será aceito.
8 Anybody wey chop am go dey guilty, bikos e trit wetin dey holy wey dem give to God like ordinary tin and e nor go dey among my pipol again.
8 Portanto, qualquer que o comer levará a sua iniquidade, porque ele profanou a coisa santificada do SENHOR; e aquela alma será cortada de entre seu povo.
9 “ ‘Wen una don gada di tins wey una harvest for una land, make una nor kut di korn wey dey di land front and make una nor go back go kut di korn wey remain.
9 E quando fizerdes a colheita da vossa terra, o canto do teu campo não colherás totalmente, nem colherás os restos da tua colheita.
10 Make una nor go una farm back go gada grape wey don dey yuzles or pick di grape wey fall for groun; but make una leave dem for poor pipol and strenjas. Na mi bi Oga una God.
10 E não recolherás a tua vinha, nem colherás toda uva da tua vinha; tu as deixarás para o pobre e estrangeiro. Eu sou o SENHOR vosso Deus.
11 “ ‘Make una nor play wayo, tif or lie.
11 Não roubareis, nem usareis de falsidade, nem mentireis uns para com os outros.
12 Make una nor lie with my name kon promise pipol, bikos una go disgrace my name. Na mi bi di Oga una God.
12 E vós não jurareis falsamente pelo meu nome, e nem profanarás o nome do teu Deus. Eu sou o SENHOR.
13 Make una nor opress or play una neighbour wayo. Make una nor make una worker wait until di next day, before una pay dem.
13 Não defraudarás o teu próximo, nem o roubarás; o salário daquele que é contratado não ficará contigo até a manhã.
14 Make una nor curse anybody wey nor dey hear or set trap for blind pesin. Una must fear una God; bikos na mi bi God.
14 Não amaldiçoarás o surdo, nem colocarás pedra de tropeço diante do cego; mas temerás o teu Deus. Eu sou o SENHOR.
15 “ ‘Make una dey honest and pure wen ever una dey judge any matter. And make una nor dey trit poor pipol matter anyhow kon dey show good face to pipol wey get money.
15 Não fareis injustiça no juízo; não respeitarás a pessoa do pobre, nem honrarás a pessoa de poder; mas com justiça julgarás o teu próximo.
16 Make una nor lie about anybody and if anybody dey pass thru problem for life; make una help am. Na mi bi God.
16 Não andarás para cima e para baixo como um mexeriqueiro entre o teu povo; não estarás contra o sangue do teu próximo. Eu sou o SENHOR.
17 Make una nor keep malice with anybody, but make una setol una kworel with dat pesin, so dat una nor go sin, bikos of dat pesin.
17 Não odiarás a teu irmão no teu coração; tu deverás de qualquer forma repreender o teu próximo, e não sofrerás pecado sobre ele.
18 Make una nor revensh anybody or kontinue to dey hate di pesin, but make una love una neighbour as una love unasef. Na mi bi God.
18 Não te vingarás, nem guardarás qualquer ira contra os filhos do teu povo; mas amarás o teu próximo como a ti mesmo. Eu sou o SENHOR.
19 Make una obey my laws. Make una nor allow two difren animal sleep togeda. Make una nor plant two difren seed for one whole; or wear klot wey dem use difren material take make.
19 Guardareis os meus estatutos; tu não permitirás que o teu gado se reproduza com uma espécie diferente; não semearás no teu campo semente misturada, e nem uma veste misturada de linho e lã vestireis.
20 “ ‘If man sleep with woman slave wey anoda man suppose marry and dem neva free or pay money for en head, den dem must pay evritin komplete. Dem nor go kill-am, bikos di woman na slave.
20 E, qualquer um que se deitar carnalmente com uma mulher, que é uma serva, desposada a um marido, e que não foi resgatada; nem se lhe houver dado liberdade, ela será açoitada; eles não serão mortos, porque ela não era livre.
21 Di man go bring ram kom di tent gate for God present as guilt ofrin
21 E ele trará a sua oferta pela transgressão ao SENHOR, até a porta do tabernáculo da congregação, um carneiro, por oferta pela transgressão.
22 and di priest go make sakrifice for am for di sin wey e kommit.
22 E o sacerdote fará expiação por ele com o carneiro da oferta pela transgressão perante o SENHOR, pelo seu pecado que cometeu; e o seu pecado que cometeu lhe será perdoado.
23 “ ‘Wen una enter di land kon plant tree for food, make una nor chop di first fruit wey e go bear. Make una nor chop am for di first three years.
23 E quando entrardes na terra e tiverdes plantado todo o tipo de árvore para o alimento, considerarás o seu fruto como incircunciso; três anos vos será incircunciso; dele não se comerá.
24 For di fourt year, all en fruit go dey holy and e go bi praiz ofrin to God.
24 Mas, no quarto ano, todo o seu fruto será santo, para adorar ao SENHOR.
25 Den for di fift year, una fit chop di fruit wey e bear kon add am join una harvest. Na mi bi di Oga una God.
25 E no quinto ano, comereis o seu fruto, para que vos produza o aumento. Eu sou o SENHOR vosso Deus.
26 “ ‘Una must nor chop anytin wey still get blood for inside. Una must nor do majik or serve juju.
26 Não comereis coisa alguma com sangue; nem usareis encantamento; nem adivinhareis.
27 Una must nor kut di hair wey kover una head or barb una bear-bear,
27 Não arredondareis os cantos das vossas cabeças, nem rasparás a tua barba pelos lados.
28 or draw picture for body; or kut mark to mourn pesin wey die. Na mi bi God.
28 Não fareis nenhum corte em vossa carne pelos mortos; nem imprimireis marca alguma sobre vós. Eu sou o SENHOR.
29 Make una nor disgrace una girl pikin kon make am bi like ashawo; if una do like dat, di land go turn where ashawo and wiked pipol full.
29 Não prostituas tua filha, para fazer com que ela seja uma prostituta; para que a terra não caia pela prostituição, e a terra se torne cheia de maldade.
30 “ ‘Make una keep di Sabat Day and honor di house where una for dey woship mi. Na mi bi God.
30 Guardareis os meus shabats e reverenciareis o meu santuário. Eu sou o SENHOR.
31 Make una nor go take advise from pipol wey dey serve dead pipol spirit. If una do am, una go dey unklean. Na mi bi Oga una God.
31 Não considerareis os que têm espíritos familiares, nem buscareis feiticeiros, para serem contaminados por eles. Eu sou o SENHOR vosso Deus.
32 Make una dey respet and honor pipol wey senior una. Make una fear una God; Na mi bi God.
32 Te levantarás diante das cãs, e honrarás a face do homem velho, e temerás teu Deus. Eu sou o SENHOR.
33 Make una nor ponish strenjas wey dey stay for una land.
33 E se o estrangeiro peregrinar contigo na vossa terra, não o aborrecereis.
34 Make una trit dem as una go trit una fellow Israel pesin. And make una love dem as una love unasef. Make una remember sey, una bi strenja for Egypt before. Na mi bi di Oga una God.
34 Mas o estrangeiro que habita convosco vos será como um nascido entre vós; e amá-lo-ás como a ti mesmo; porque estrangeiros fostes na terra do Egito. Eu sou o SENHOR vosso Deus.
35 Make una nor play wayo wen una dey measure how sometin long and wide rish or oda tins wey many.
35 Não cometereis injustiça no juízo, nem na vara, nem no peso, nem na medida.
36 Make una dey measure well for evritin wey una dey do. Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt.
36 Balanças justas, pesos justos, efa justo e um him justo tereis. Eu sou o SENHOR vosso Deus, que vos tirei da terra do Egito.
37 Make una obey all my laws and kommandment. Na mi bi God.’ ”
37 Portanto, observareis todos os meus estatutos, e todos os meus juízos e os cumprireis. Eu sou o SENHOR.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Levítico 19, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.