Levítico 11

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs ACF

Sair da comparação
ACF Almeida Corrigida Fiel
1 God tell Moses and Aaron,
1 E falou o SENHOR a Moisés e a Arão, dizendo-lhes:
2 “Make una tell Israel pipol sey: ‘Among all di animal wey dey di land, dis na di ones wey una fit chop.
2 Fala aos filhos de Israel, dizendo: Estes são os animais, que comereis dentre todos os animais que há sobre a terra;
3 Una fit chop animal wey get two toes and dey re-shop grass wey e don swallow.
3 Dentre os animais, todo o que tem unhas fendidas, e a fenda das unhas se divide em duas, e rumina, deles comereis.
4 But make una nor chop animal wey dey re-shop grass but nor get two toes: Kamel nor dey klean, bikos e dey re-shop grass, but e nor get two toes.
4 Destes, porém, não comereis; dos que ruminam ou dos que têm unhas fendidas; o camelo, que rumina, mas não tem unhas fendidas; esse vos será imundo;
5 Doz animals wey dey stay for rock nor dey klean, bikos dem dey chop dia vomit, even doh dem nor get two toes.
5 E o coelho, porque rumina, mas não tem as unhas fendidas; esse vos será imundo;
6 Hare nor dey klean, bikos e dey chop en vomit, even doh e nor get two toes.
6 E a lebre, porque rumina, mas não tem as unhas fendidas; essa vos será imunda.
7 Pig nor dey klean, bikos e get two toes, but e nor dey chop en vomit.
7 Também o porco, porque tem unhas fendidas, e a fenda das unhas se divide em duas, mas não rumina; este vos será imundo.
8 Make una nor chop dis meat or tosh dia dead body; bikos dem nor dey klean.
8 Das suas carnes não comereis, nem tocareis nos seus cadáveres; estes vos serão imundos.
9 “ ‘Dis na di animal for wota wey una fit chop: Any animal wey get both fin and skale, weda e dey sea or river.
9 De todos os animais que há nas águas, comereis os seguintes: todo o que tem barbatanas e escamas, nas águas, nos mares e nos rios, esses comereis.
10 But make una nor chop anytin for wota wey nor get fin or skale.
10 Mas todo o que não tem barbatanas, nem escamas, nos mares e nos rios, todo o réptil das águas, e todo o ser vivente que há nas águas, estes serão para vós abominação.
11 Since una dey forbid am, make una nor chop dia meat or tosh dia dead body.
11 Ser-vos-ão, pois, por abominação; da sua carne não comereis, e abominareis o seu cadáver.
12 Any animal for wota wey nor get fin and skale, make una nor chop or tosh en dead body.
12 Todo o que não tem barbatanas ou escamas, nas águas, será para vós abominação.
13 “ ‘Dis na di bird wey una nor suppose chop. Make una nor ever chop any kind vulture,
13 Das aves, estas abominareis; não se comerão, serão abominação: a águia, e o quebrantosso, e o xofrango,
14 kite, buzzard,
14 E o milhano, e o abutre segundo a sua espécie.
15 crow,
15 Todo o corvo segundo a sua espécie,
16 di eagle owl, owl wey en ear short or long, any kind hawk,
16 E o avestruz, e o mocho, e a gaivota, e o gavião segundo a sua espécie.
17 small owl, kormorant, great owl,
17 E o bufo, e o corvo marinho, e a coruja,
18 white owl, owl for wildaness, Egypt owl,
18 E a gralha, e o cisne, e o pelicano,
19 stork, any kind heron, hoopoe and bat.
19 E a cegonha, a garça segundo a sua espécie, e a poupa, e o morcego.
20 “ ‘All di insect wey get feada nor dey klean, dem nor dey good for una.
20 Todo o inseto que voa, que anda sobre quatro pés, será para vós uma abominação.
21 But una fit chop insect wey get four leg and dey jump for land.
21 Mas isto comereis de todo o inseto que voa, que anda sobre quatro pés: o que tiver pernas sobre os seus pés, para saltar com elas sobre a terra.
22 Una fit chop lokust, cricket and grasshoppa.
22 Deles comereis estes: a locusta segundo a sua espécie, o gafanhoto devorador segundo a sua espécie, o grilo segundo a sua espécie, e o gafanhoto segundo a sua espécie.
23 But all di oda animal for groun wey get feada nor dey good for una.
23 E todos os outros insetos que voam, que têm quatro pés, serão para vós uma abominação.
24 “ ‘Anybody wey tosh unklean animal dead body don spoil ensef and dat pesin go dey unklean till evening.
24 E por estes sereis imundos: qualquer que tocar os seus cadáveres, imundo será até à tarde.
25 Anybody wey karry dia dead body, go-go wosh en klot and e go dey unklean till evening.
25 Qualquer que levar os seus cadáveres lavará as suas vestes, e será imundo até à tarde.
26 “ ‘All di animal wey get toe wey nor divide into two finish and dem nor dey re-shop dia food, dey unklean to una. Anybody wey tosh dem don dey unklean.
26 Todo o animal que tem unha fendida, mas a fenda não se divide em duas, e todo o que não rumina, vos será por imundo; qualquer que tocar neles será imundo.
27 All di animal wey dey waka with four legs, doz wey get finger, dey unklean to una. Anybody wey tosh dia dead body go dey unklean till evening
27 E todo o animal que anda sobre as suas patas, todo o animal que anda a quatro pés, vos será por imundo; qualquer que tocar nos seus cadáveres será imundo até à tarde.
28 and di pesin wey karry dia body, go-go wosh en klot, but e go dey unklean till evening. Dis animals nor dey good for una.
28 E o que levar os seus cadáveres lavará as suas vestes, e será imundo até à tarde; eles vos serão por imundos.
29 “ ‘Naw, dis na di tins wey dey unklean among di animal wey dey stay land: rat, any kind big lizard,
29 Estes também vos serão por imundos entre os répteis que se arrastam sobre a terra; a doninha, e o rato, e a tartaruga segundo a sua espécie,
30 krokrodie, lizard wey get spot for body, wall-deko for house and kameleon wey en kolour dey shange.
30 E o ouriço cacheiro, e o lagarto, e a lagartixa, e a lesma e a toupeira.
31 Dis na di ones wey dey unklean among di animals for land. Anybody wey tosh dia dead body go dey unklean till evening.
31 Estes vos serão por imundos dentre todos os répteis; qualquer que os tocar, estando eles mortos, será imundo até à tarde.
32 Anytin wey dem fall put wen dem die go dey unklean; weda na wood, klot, leda or sak. Doz tins nor dey yuzful again. Even wen dem deep am for wota, e go still dey unklean till evening.
32 E tudo aquilo sobre o que cair alguma coisa deles estando eles mortos será imundo; seja vaso de madeira, ou veste, ou pele, ou saco, qualquer instrumento, com que se faz alguma obra, será posto na água, e será imundo até à tarde; depois será limpo.
33 “ ‘And if dia body fall inside pot wey bi klay, evritin wey dey inside di pot go dey unklean and una must break di pot.
33 E todo o vaso de barro, em que cair alguma coisa deles, tudo o que houver nele será imundo, e o vaso quebrareis.
34 If di wota from di pot tosh any food wey una suppose chop or wota wey una won drink, den evritin don dey unklean.
34 Todo o alimento que se come, sobre o qual cair água de tais vasos, será imundo; e toda a bebida que se bebe, depositada nesses vasos, será imunda.
35 Anytin wey dia dead body fall put go dey unklean. Weda na stove or oven, dem go break am to pieces.
35 E aquilo sobre o que cair alguma parte de seu corpo morto, será imundo; o forno e o vaso de barro serão quebrados; imundos são: portanto vos serão por imundos.
36 “ ‘Wota wey dem fetch from spring dey klean, but if dia dead body tosh di pot, e go dey unklean.
36 Porém a fonte ou cisterna, em que se recolhem águas, será limpa, mas quem tocar no seu cadáver será imundo.
37 If any one fall for any seed wey dem won plant, dem go plant am and e go dey klean.
37 E, se dos seus cadáveres cair alguma coisa sobre alguma semente que se vai semear, será limpa;
38 But if dem put wota for di seed and one dead body fall put, e go dey unklean.
38 Mas se for deitada água sobre a semente, e se dos seus cadáveres cair alguma coisa sobre ela, vos será por imunda.
39 “ ‘If any animal wey yu suppose chop die on en own, anybody wey tosh en dead body go dey unklean till evening.
39 E se morrer algum dos animais, que vos servem de mantimento, quem tocar no seu cadáver será imundo até à tarde;
40 If anybody chop any part for di animal, e must wosh en klot, but e nor go still dey klean till evening. Anybody wey karry di dead body must wosh en klot, but e go dey unklean till evening.
40 E quem comer do seu cadáver lavará as suas vestes, e será imundo até à tarde; e quem levar o seu corpo morto lavará as suas vestes, e será imundo até à tarde.
41 “ ‘Una must nor chop any animal wey dey creep for groun,
41 Também todo o réptil, que se arrasta sobre a terra, será abominação; não se comerá.
42 weda dem dey creep or waka with four leg or dem get many legs.
42 Tudo o que anda sobre o ventre, e tudo o que anda sobre quatro pés, ou que tem muitos pés, entre todo o réptil que se arrasta sobre a terra, não comereis, porquanto são uma abominação.
43 If una chop any of dis animals, una nor go dey klean.
43 Não vos façais abomináveis, por nenhum réptil que se arrasta, nem neles vos contamineis, para não serdes imundos por eles;
44 I bi di Oga una God and una go make unasef pure kon dey holy, bikos I dey holy. Una must nor dirty unasef.
44 Porque eu sou o Senhor vosso Deus; portanto vós vos santificareis, e sereis santos, porque eu sou santo; e não vos contaminareis com nenhum réptil que se arrasta sobre a terra;
45 Na mi bi God wey take una komot from Egypt, so dat I go bi una God and una go dey holy, bikos I dey holy.
45 Porque eu sou o Senhor, que vos fiz subir da terra do Egito, para que eu seja vosso Deus, e para que sejais santos; porque eu sou santo.
46 “ ‘Dis na di law for di animal wey dey land; di birds, all di animals for wota and doz ones wey dey creep for land.
46 Esta é a lei dos animais, e das aves, e de toda criatura vivente que se move nas águas, e de toda criatura que se arrasta sobre a terra;
47 And dis law na to separate between wetin dey klean and wetin nor dey klean, so dat pipol go know di animals wey dem suppose chop and di ones wey dem nor go chop.’ ”
47 Para fazer diferença entre o imundo e o limpo; e entre animais que se podem comer e os animais que não se podem comer.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Levítico 11, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.