Lucas 23

Holy Bible Nigerian Pidgin English (PCM) vs VC

Sair da comparação
VC Versão Católica
1 Den di Farisee pipol and di oda pipol take Jesus go meet Pilate,
1 Levantou-se a sessão e conduziram Jesus diante de Pilatos,
2 dey akuiz am sey, “Wi hear dis man wen e dey deceive and tell awa pipol sey make dem nor pay tax give Caesar and e dey tok sey naim bi Christ, wey bi king.”
2 e puseram-se a acusá-lo: Temos encontrado este homem excitando o povo à revolta, proibindo pagar imposto ao imperador e dizendo-se Messias e rei.
3 Pilate kon ask Jesus, “Na yu bi di Jew pipol king?”
3 Pilatos perguntou-lhe: És tu o rei dos judeus? Jesus respondeu: Sim.
4 Den Pilate tell di priest oga dem and di pipol, “I nor si anytin wey go make mi kondemn dis man.”
4 Declarou Pilatos aos príncipes dos sacerdotes e ao povo: Eu não acho neste homem culpa alguma.
5 But dem still sey, “E dey kause wahala with wetin e dey tish pipol for Judea. E start am for Galilee and naw e don kom here!”
5 Mas eles insistiam fortemente: Ele revoluciona o povo ensinando por toda a Judéia, a começar da Galiléia até aqui.
6 Wen Pilate hear dis one, e kon ask weda Jesus na Galilee pesin.
6 A estas palavras, Pilatos perguntou se ele era galileu.
7 Wen e hear sey Jesus kom from Jerusalem, where Herod dey rule for dat time, e kon sey make dem take Jesus go meet am.
7 E, quando soube que era da jurisdição de Herodes, enviou-o a Herodes, pois justamente naqueles dias se achava em Jerusalém.
8 Wen Herod si Jesus, e happy well-well, bikos e don tey wen e won si am since e hear about am. E dey hope sey Jesus go do mirakle for en present.
8 Herodes alegrou-se muito em ver Jesus, pois de longo tempo desejava vê-lo, por ter ouvido falar dele muitas coisas, e esperava presenciar algum milagre operado por ele.
9 Herod kon ask Jesus many kweshon, but Jesus nor ansa am at-all.
9 Dirigiu-lhe muitas perguntas, mas Jesus nada respondeu.
10 Di priest oga dem and di law tishas dey akuiz Jesus with vexnashon.
10 Ali estavam os príncipes dos sacerdotes e os escribas, acusando-o com violência.
11 Herod with en sojas too dey take Jesus make yeye and dey laf am. Den Herod sey make dem wear fine klot for Jesus body, den make dem take am go back go meet Pilate.
11 Herodes, com a sua guarda, tratou-o com desprezo, escarneceu dele, mandou revesti-lo de uma túnica branca e reenviou-o a Pilatos.
12 Dat day, Herod and Pilate kon bi friends, bikos before dis time dem bi strong enemy.
12 Naquele mesmo dia, Pilatos e Herodes fizeram as pazes, pois antes eram inimigos um do outro.
13 Den Pilate koll di priest oga dem, di eldas and di pipol for dat place
13 Pilatos convocou então os príncipes dos sacerdotes, os magistrados e o povo, e disse-lhes:
14 kon tell dem, “Una bring dis man kom meet mi sey e dey deceive pipol. Wen I ask am kweshon for una present, I nor si any bad tin wey una sey e do.
14 Apresentastes-me este homem como agitador do povo, mas, interrogando-o eu diante de vós, não o achei culpado de nenhum dos crimes de que o acusais.
15 Even Herod nor still si anytin too, so e sey make dem bring am kom meet us. Dis man nor do anytin wey go make am die.
15 Nem tampouco Herodes, pois no-lo devolveu. Portanto, ele nada fez que mereça a morte.
16 So I go give orda make dem flog am, den I go free am.”
16 Por isso, soltá-lo-ei depois de o castigar.
17 (Na dia tradishon sey Pilate must release one prisona anytime wen dem dey do Passova Feast.)
17 {Acontecia que em cada festa ele era obrigado a soltar-lhes um preso.}
18 But all of dem kon dey shaut, “Take dis man komot! Na Barabas wi wont!”
18 Todo o povo gritou a uma voz: À morte com este, e solta-nos Barrabás.
19 (Barabas na pesin wey dem put for prison bikos e kause wahala and kill pesin for di town.)
19 {Este homem fora lançado ao cárcere devido a uma revolta levantada na cidade, por causa de um homicídio.}
20 Pilate kon tok to dem again, bikos e won free Jesus.
20 Pilatos, porém, querendo soltar Jesus, falou-lhes de novo,
21 But dem still dey shaut, “Kill-am trowey, Kill-am trowey!”
21 mas eles vociferavam: Crucifica-o! Crucifica-o!
22 Again Pilate ask dem, “Why? Wish bad tin e do? I nor si any bad tin wey e do wey go make am die, so I go give orda make dem flog am, den I go free am.”
22 Pela terceira vez, Pilatos ainda interveio: Mas que mal fez ele, então? Não achei nele nada que mereça a morte; irei, portanto, castigá-lo e, depois, o soltarei.
23 But dem shaut more-more dey sey, “Kill-am trowey.” Dem shaut sotey Pilate kon do wetin dem wont.
23 Mas eles instavam, reclamando em altas vozes que fosse crucificado, e os seus clamores recrudesciam.
24 So Pilate orda en sojas sey make dem give Jesus to di pipol make dem go kill-am.
24 Pilatos pronunciou então a sentença que lhes satisfazia o desejo.
25 E kon free Barabas, wey di pipol wont, wey dem bin put for prison, bikos e kause wahala and kill pesin for di town.
25 Soltou-lhes aquele que eles reclamavam e que havia sido lançado ao cárcere por causa do homicídio e da revolta, e entregou Jesus à vontade deles.
26 As dem dey take Jesus komot, dem kon katch one man wey dey kom from Sirene and en name na Simon. Dem put di cross for en back make e karry am follow Jesus.
26 Enquanto o conduziam, detiveram um certo Simão de Cirene, que voltava do campo, e impuseram-lhe a cruz para que a carregasse atrás de Jesus.
27 Many pipol follow Jesus and di wimen among dem kon dey kry.
27 Seguia-o uma grande multidão de povo e de mulheres, que batiam no peito e o lamentavam.
28 But Jesus turn look dem sey, “Jerusalem wimen, make una nor kry bikos of mi, but make una kry for unasef and for una shidren.
28 Voltando-se para elas, Jesus disse: Filhas de Jerusalém, não choreis sobre mim, mas chorai sobre vós mesmas e sobre vossos filhos.
29 Bikos true-true, di time dey kom wen pipol go sey, ‘E good well-well for wimen wey nor born or feed pikin at-all!’
29 Porque virão dias em que se dirá: Felizes as estéreis, os ventres que não geraram e os peitos que não amamentaram!
30 Den,
30 Então dirão aos montes: Caí sobre nós! E aos outeiros: Cobri-nos!
31 But if dem do dis kind tin for wood wen e still fresh, wetin go happen wen di wood don dry?”
31 Porque, se eles fazem isto ao lenho verde, que acontecerá ao seco?
32 Dem still take two oda men wey bi tif, wey dem wont kill, follow Jesus.
32 Eram conduzidos ao mesmo tempo dois malfeitores para serem mortos com Jesus.
33 Wen dem rish di place wey dem dey koll, “Di Skull,” dem kon nail Jesus for cross with di two tif, one for en left and di oda for en rite side.
33 Chegados que foram ao lugar chamado Calvário, ali o crucificaram, como também os ladrões, um à direita e outro à esquerda.
34 (Den Jesus kon sey, “Papa, make yu forgive dem, bikos dem nor know wetin dem dey do.”) So, di sojas kon gambol to know who go take Jesus klot.
34 E Jesus dizia: Pai, perdoa-lhes; porque não sabem o que fazem. Eles dividiram as suas vestes e as sortearam.
35 Di pipol still stand der dey look, but dia leaders dey laf Jesus sey, “E save oda pipol. Make e save ensef if e bi di Mezaya wey God choose!”
35 A multidão conservava-se lá e observava. Os príncipes dos sacerdotes escarneciam de Jesus, dizendo: Salvou a outros, que se salve a si próprio, se é o Cristo, o escolhido de Deus!
36 Di sojas still dey laf Jesus and dem kon gi-am wine wey don sawa make e drink,
36 Do mesmo modo zombavam dele os soldados. Aproximavam-se dele, ofereciam-lhe vinagre e diziam:
37 den sey, “If yu bi di Jew pipol king, make yu save yorsef!”
37 Se és o rei dos judeus, salva-te a ti mesmo.
38 Dem kon rite on-top en cross sey, “Dis na, ‘Jew Pipol King.’ ”
38 Por cima de sua cabeça pendia esta inscrição: Este é o rei dos judeus.
39 One of di tif dey shaut for Jesus, “Nor bi yu bi di Mezaya? Make yu save yorsef and us naw!”
39 Um dos malfeitores, ali crucificados, blasfemava contra ele: Se és o Cristo, salva-te a ti mesmo e salva-nos a nós!
40 But di oda tif kon shaut for di first tif, “Yu nor dey fear God as e bi sey na di same ponishment wi dey sofa?
40 Mas o outro o repreendeu: Nem sequer temes a Deus, tu que sofres no mesmo suplício?
41 Na dis ponishment fit us, bikos na wetin wi do naim make dem dey ponish us so. But dis man nor do any bad tin.”
41 Para nós isto é justo: recebemos o que mereceram os nossos crimes, mas este não fez mal algum.
42 Den e tell Jesus, “Wen yu rish yor kingdom, make yu remember mi!”
42 E acrescentou: Jesus, lembra-te de mim, quando tiveres entrado no teu Reino!
43 Jesus ansa am, “I tell yu di trut, today yu go dey with mi for paradise.”
43 Jesus respondeu-lhe: Em verdade te digo: hoje estarás comigo no paraíso.
44 By naw, twelf oklok don nearly rish for aftanoon and darkness kover di whole kountry until three oklok for dat aftanoon,
44 Era quase à hora sexta e em toda a terra houve trevas até a hora nona.
45 bikos sun stop to shine. Di Temple curtain kon tear into two.
45 Escureceu-se o sol e o véu do templo rasgou-se pelo meio.
46 So, Jesus shaut, “Papa, I put my spirit for yor hand!” Afta e tok finish, e kon die.
46 Jesus deu então um grande brado e disse: Pai, nas tuas mãos entrego o meu espírito. E, dizendo isso, expirou.
47 Wen di soja oga si wetin happen, e kon praiz God sey, “True-true, dis man na good pesin!”
47 Vendo o centurião o que acontecia, deu glória a Deus e disse: Na verdade, este homem era um justo.
48 So wen all di pipol wey gada dey look si wetin happen, dem kon dey kry go dia house.
48 E toda a multidão dos que assistiam a este espetáculo e viam o que se passava, voltou batendo no peito.
49 And evribody wey know Jesus before, stand for far and di wimen wey follow Jesus kom from Galilee, si di tins wey happen.
49 Os amigos de Jesus, como também as mulheres que o tinham seguido desde a Galiléia, conservavam-se a certa distância, e observavam estas coisas.
50 E get one man for di kansol, wey bi Josef and e kom from Arimatea wey dey Judea. E bi betta pesin wey dey do wetin God like and e dey wait for di time wen God Kingdom go kom.
50 Havia um homem, por nome José, membro do conselho, homem reto e justo.
51 (E nor gri with di oda kansol membas with dia plan and for wetin dem do so.)
51 Ele não havia concordado com a decisão dos outros nem com os atos deles. Originário de Arimatéia, cidade da Judéia, esperava ele o Reino de Deus.
52 E go meet Pilate kon ask for Jesus dead body.
52 Foi ter com Pilatos e lhe pediu o corpo de Jesus.
53 Den e karry di body from di cross, wrap am with linen klot kon put am for di grave wey e dig inside rock, where dem neva beri anybody put before.
53 Ele o desceu da cruz, envolveu-o num pano de linho e colocou-o num sepulcro, escavado na rocha, onde ainda ninguém havia sido depositado.
54 Dat day na Friday wen dem dey ready for Sabat Day serimony.
54 Era o dia da Preparação e já ia principiar o sábado.
55 Di wimen wey follow Jesus from Galilee kon follow Josef go si di grave. So dem put Jesus body inside.
55 As mulheres, que tinham vindo com Jesus da Galiléia, acompanharam José. Elas viram o túmulo e o modo como o corpo de Jesus ali fora depositado.
56 Den di wimen go house go prepare betta perfume. But for Sabat Day, dem kon rest as Moses Law tok.
56 Elas voltaram e prepararam aromas e bálsamos. No dia de sábado, observaram o preceito do repouso.

Ler em outra tradução

Comparar com outra

Estude este capítulo no WhatsApp

Peça à IA da Bíblia Fala para explicar Lucas 23, comparar traduções ou montar um estudo — tudo direto pelo WhatsApp.